Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,673 members, 7,827,472 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 12:30 PM

I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi - Literature (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi (64743 Views)

Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi / Bottle Warriors(beer Parlour Night Tale)story By Youngzubi / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (12) (Reply) (Go Down)

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Donspicey: 7:48am On Sep 22, 2018
Youngzubi:
abeg wia my people dey,for sure i don make the story cold asin i don Bleep up big time but challenge na watin dey always face us,na the ability to overcome am and still stand strong and bounce back be the main thing


my people abeg i take God beg una,i dey sorry o,as personal problem wey i face comot my mind for the tori for sometimes,but i don overcome and am back now as ever

watin no kill a man go make am live longer,without challenge we fit no see watin go make us climb to the next step,so brothers make una come show me love,come welcome youngzubi back as we continue our tin..
I Got Ur Bk Bro,,.Kip Up D Gud Job,,.Pesin Wey No Get Problem Na Big Problem To The World,,.God Wil C U Tru,,.Believe And Stay Focused
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Karrisleo(m): 1:17pm On Sep 22, 2018
Nice one bro, abeg they Samar us the update quick , u k now say as e de hot so, we need am for the brain. More grace to your finger
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Dpleaser: 1:23pm On Sep 24, 2018
welcome back bro
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by daviesblaze(m): 8:54am On Sep 25, 2018
$$ Re-followed thread after unfollowing ¿¿ Nice One Youngzubi
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Danicomrade(m): 1:42pm On Sep 26, 2018
[b]Were dis bros da na ur bak ur bak were are u[b/]
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by popesammy2(m): 7:48pm On Sep 26, 2018
bro you won the august award with the part one, let's do it again.
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by JOGICE(m): 6:00pm On Sep 30, 2018
✔️
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Holywizard: 8:03pm On Sep 30, 2018
He is not consistent bro!
popesammy2:
bro
you won the august award with the part one, let's do it again.
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Enny2013(f): 9:09am On Oct 01, 2018
ha!! stl no update yet?
I am tired of checking all d tym jare..���
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by UpdatesiOS147(m): 3:09pm On Oct 01, 2018
How far Youngzombie!!! Wetin happen return my phone if you know say you no go dey update your story again ooo if I see you for area lasan ma gba etii iyaa eee ���

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by goodnessme1(f): 7:31pm On Oct 01, 2018
nice one bro
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by WarriFirstBorn(m): 6:33am On Oct 02, 2018
Make una nor bother una sef. He is more engaged with his Facebook group page now. I said it before at the beginning.

Make I unfollow Jare. At least no need of checking every time if oga has dropped update. That's how they start. If you don't beg them for updates, e nor dey Jones dem.

1 Like

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Holywizard: 7:31am On Oct 02, 2018
This is nonsense.
Just to update dey hard him.
I'm done wit this crappy behavior.
I don unfollow

1 Like

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:43pm On Oct 02, 2018
I FIT BE SECOND JESUS BY YOUNGZUBI

SNF EPISODE 3

SUNDAY GBEDU!!

AS E GO BE NA TIME GO TELL
----------------------------------------------------

I Sidon ontop my bed, as my back rest for wall with plenty things wey dey run through my mind like electric current, jejely I drag one stick comot from the packet wey position well ontop my bed and light, I shuk am enter mouth as I drag one long draw, omo I begin see how God take mold buhari inside him mama Belle, ahhh!! I sigh as smoke begin evolve go ceiling through my nustirls,life no fit be worst, my life my trouble, everything begin display ontop my head again but E dey more bright this time as anger begin find im entrance door into my body system, all the whole palava wey I bin pass through just because sey I get one bastered wey I think sey na my friend, spata!!! Sparta!!

Revenge begin ring like alarm for my head, na time to show big mama,Mr frank, Florida and spata sey peson nodey shuk hand inside dragon mouth, I care wetin the outcome go be, but na time to show my real self, I go show dem pepper, I don kill people, governor's, business men, military men, so big mama and spata no go be hard matter, I no fit wait till Mike ready to help me, as the matter take be now na one man gang I dey, both Stevo and Mike dem na long tin, I ready to face my life battle alone after all na man wey I be, and na something must kill a man, if ever nobi money then ever go be woman, God punish devi!!

With my mini traveling bag, I begin arrange the most important things wey I go need onto sey I no need plenty loads, once I land naija I go buy anything wey I want but for now make I find my back to naija

45 mins later
-------------------------

With my small bag for my hand I begin descend the stairs, I sight Mike, Bobo with Stevo dem for parlor relaxing, sharply I coordinate my self well, with better lie we I go smah dem well arranged I shuk head burst out for parlor, everybody jab up instanta

"spans! Which level na?", Bobo yan.

"o! boy relax, E get one mission wey my agent just assign me, so I won go do the runs as him don put better money down," I yan.

"na man you be, just dey careful, and incase things no work as planned, no fail to Halla us" Mike yan as him stand up shuk my hand,

"so na which side you won ball go na", Stevo yan

"na Colombia, but I don plan my moves already, once the agent man forward me the details about the person wey I won go killna to complete my map be that" I yan

"You gbaski, no wahala we dey ya back, so no shaking" simple yan as dem begin shake my hand one by one, after the whole long thing I grab my back to Waka

"make I drive you go wia you won drop" Mike yan standing up as one of him white guy trow him car key for am

"no need, I go find my way brother" I yan then shuk head outside comot for gate and enter street

I trek down small till I sight one taxi, after I don yan the man my destination him fire life enter the taxi engine nahim the motor release vooom! Sound and zoom off to the hotel wey I go lodge and arrange my travel back to Nigeria, time Don reach, I no dey lay any low again!

***********/********** * * *************

AJANLA STREET LAGOS
=====================

"O! BOY WOMEN get serious wahala on, dem get problems Sha, see na so so makeup nonsense full this handbag" sambisa Para as him just dey bring out powder upon lipstick, mirrow and lady care pack inside the handbag wey we just successfully thief from those two women for ajanta pipeline

"ogbe ni cool down and search am well, look well money go dey inside, better money definitely, just relax and nodey make noise so that you no go attract people attention come here, you hear me so?" I yan give sambisa.

As I turn won continue my ultimate search ontop the small purse wey I bin scatter dey search like sey my destiny dey inside when I sight causetrouble grab something wey be like poly bag from the handbag wey him bin dey search and raise an up, I snatch am comot for him hand sharpaly

"guy wetin happen, why you drag the bag comot for my hand na,?" causetrouble yan as him dive me but I quickly shift one side, nahim he land for ground, but I nor even care as I begin loose the bag mouth sharp sharp, everybody just focus their attention for my hand dey wait to see wetin dey inside the bag

" jejely I begin comot everything wey dey inside the poly bag, but na something wey be like card just dey fall comot from the bag as I turn upside down,
" hahaha!!! Sambisa tear better laugh as him begin release mess up and down

"I sha continue bringing everything wey dey inside the bag till another small nylon fall comot, I nor waste time as I grab the bag and open it, omo wetin I see shock my hand, as I begin see myself inside range rover cruzing street of heaven..
" jesu!!"I shout
" omo na money be this??, causetrouble shout as him open mouth begin drop spit

"on boy we don hama, sambisa yan as him near me begin touch the bundles of money wey them use robberband tie into five bundles

I grab one card from the ones wey full ground and open it, na that time the whole thing hit me, ahhh!!!! I shout

" lascard wetin happen, why you dey shout na?" sambisa ask me but him no comot eye for the money him just dey busy dey touch the money as him continued dey ask me wetin happen

"the woman wey get this handbag dey work for micro finance bank, she dey collect daily contributions from customers wey dey do daily savings for their bank, nahim make this cards full the bag, see naw the customers names the amount wey dem don save full the cards, I yan to my pady dem, but causetrouble don dey share the money into three equal places

To be continued..........

3 Likes 1 Share

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by pradoic(m): 10:23pm On Oct 02, 2018
#I_FIT_BE_SECOND_JESUS

#SNF_S2_EPISODE_3_BY_YOUNGZUBI

SUNDAY GBEDU!!!
-------------------------------

AS E GO BE NA TIME GO TELL
----------------------------------------------------

I Sidon ontop my bed, as my back rest for wall with plenty things wey dey run through my mind like electric current, jejely I drag one stick comot from the packet wey position well ontop my bed and light, I shuk am enter mouth as I drag one long draw, omo I begin see how God take mold buhari inside him mama Belle, ahhh!! I sigh as smoke begin evolve go ceiling through my nustirls,life no fit be worst, my life my trouble, everything begin display ontop my head again but E dey more bright this time as anger begin find im entrance door into my body system, all the whole palava wey I bin pass through just because sey I get one bastered wey I think sey na my friend, spata!!! Sparta!!

Revenge begin ring like alarm for my head, na time to show big mama,Mr frank, Florida and spata sey peson nodey shuk hand inside dragon mouth, I care wetin the outcome go be, but na time to show my real self, I go show dem pepper, I don kill people, governor's, business men, military men, so big mama and spata no go be hard matter, I no fit wait till Mike ready to help me, as the matter take be now na one man gang I dey, both Stevo and Mike dem na long tin, I ready to face my life battle alone after all na man wey I be, and na something must kill a man, if ever nobi money then ever go be woman, God punish devi!!

With my mini traveling bag, I begin arrange the most important things wey I go need onto sey I no need plenty loads, once I land naija I go buy anything wey I want but for now make I find my back to naija

45 mins later
-------------------------

With my small bag for my hand I begin descend the stairs, I sight Mike, Bobo with Stevo dem for parlor relaxing, sharply I coordinate my self well, with better lie we I go smah dem well arranged I shuk head burst out for parlor, everybody jab up instanta

"spans! Which level na?", Bobo yan.

"o! boy relax, E get one mission wey my agent just assign me, so I won go do the runs as him don put better money down," I yan.

"na man you be, just dey careful, and incase things no work as planned, no fail to Halla us" Mike yan as him stand up shuk my hand,

"so na which side you won ball go na", Stevo yan

"na Colombia, but I don plan my moves already, once the agent man forward me the details about the person wey I won go killna to complete my map be that" I yan

"You gbaski, no wahala we dey ya back, so no shaking" simple yan as dem begin shake my hand one by one, after the whole long thing I grab my back to Waka

"make I drive you go wia you won drop" Mike yan standing up as one of him white guy trow him car key for am

"no need, I go find my way brother" I yan then shuk head outside comot for gate and enter street

I trek down small till I sight one taxi, after I don yan the man my destination him fire life enter the taxi engine nahim the motor release vooom! Sound and zoom off to the hotel wey I go lodge and arrange my travel back to Nigeria, time Don reach, I no dey lay any low again!

***********/********** * * *************

AJANLA STREET LAGOS
=====================

"O! BOY WOMEN get serious wahala on, dem get problems Sha, see na so so makeup nonsense full this handbag" sambisa Para as him just dey bring out powder upon lipstick, mirrow and lady care pack inside the handbag wey we just successfully thief from those two women for ajanta pipeline

"ogbe ni cool down and search am well, look well money go dey inside, better money definitely, just relax and nodey make noise so that you no go attract people attention come here, you hear me so?" I yan give sambisa.

As I turn won continue my ultimate search ontop the small purse wey I bin scatter dey search like sey my destiny dey inside when I sight causetrouble grab something wey be like poly bag from the handbag wey him bin dey search and raise an up, I snatch am comot for him hand sharpaly

"guy wetin happen, why you drag the bag comot for my hand na,?" causetrouble yan as him dive me but I quickly shift one side, nahim he land for ground, but I nor even care as I begin loose the bag mouth sharp sharp, everybody just focus their attention for my hand dey wait to see wetin dey inside the bag

" jejely I begin comot everything wey dey inside the poly bag, but na something wey be like card just dey fall comot from the bag as I turn upside down,
" hahaha!!! Sambisa tear better laugh as him begin release mess up and down

"I sha continue bringing everything wey dey inside the bag till another small nylon fall comot, I nor waste time as I grab the bag and open it, omo wetin I see shock my hand, as I begin see myself inside range rover cruzing street of heaven..
" jesu!!"I shout
" omo na money be this??, causetrouble shout as him open mouth begin drop spit

"on boy we don hama, sambisa yan as him near me begin touch the bundles of money wey them use robberband tie into five bundles

I grab one card from the ones wey full ground and open it, na that time the whole thing hit me, ahhh!!!! I shout

" lascard wetin happen, why you dey shout na?" sambisa ask me but him no comot eye for the money him just dey busy dey touch the money as him continued dey ask me wetin happen

"the woman wey get this handbag dey work for micro finance bank, she dey collect daily contributions from customers wey dey do daily savings for their bank, nahim make this cards full the bag, see naw the customers names and the amount wey dem don save full the cards, I yan to my pady dem, but causetrouble don dey share the money into three equal places

To be continued..........

1 Like 1 Share

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by MrsEvakinqz(m): 1:53pm On Oct 03, 2018
Chai, you guys are so ungrateful..
Just ask your self,
Do you pay him to update?? No
Den Y make it look like we pay him


Let's understand nd bear with him at least he updated the previous story to da end...

I don't care what you guys say or think, I stand with YoungZubi to da end


Take your time bro your faithful fans are waiting patiently....

Kudos best writer ever cool

2 Likes

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:39pm On Oct 03, 2018
Since last month I have been dropping episodes here but I kept getting ban upon ban, each update i post got deleted by the anti spam bot, am really worried as hell, please if you know what I can do kindly help so that we can continue our groove, sorry guys it wasn't my intention to abandon my work , do suggest something

YOUNGZUBI is still here

I check everyday trying to post episodes but all I get is ban upon ban, maybe it's because of the pidgin

2 Likes 1 Share

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:43pm On Oct 03, 2018
WarriFirstBorn:
Make una nor bother una sef. He is more engaged with his Facebook group page now. I said it before at the beginning.

Make I unfollow Jare. At least no need of checking every time if oga has dropped update. That's how they start. If you don't beg them for updates, e nor dey Jones dem.



Lie lie Facebook ko, i write the story directly here before I copy it to Facebook, but I always get banned here once I post them, I don't really understand be because it wasn't like that before

See this last update it was seized like four good times with 24 hours ban, so I told my guy pradoic to help me post it, he did and got banned too

But it has been released now
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:46pm On Oct 03, 2018
Holywizard:
This is nonsense. Just to update dey hard him. I'm done wit this crappy behavior. I don unfollow

Thank you........
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:48pm On Oct 03, 2018
goodnessme1:
nice one bro

Thank you dear.....
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:53pm On Oct 03, 2018
MrsEvakinqz:
Chai, you guys are so ungrateful..
Just ask your self,
Do you pay him to update?? No
Den Y make it look like we pay him


Let's understand nd bear with him at least he updated the previous story to da end...

I don't care what you guys say or think, I stand with YoungZubi to da end


Take your time bro your faithful fans are waiting patiently....

Kudos best writer ever cool

True fan will always be true, not those who only care about themselves and what they get not minding what the situation is like on the other side, before they place judgment and conclusion

Thank you bro for standing by me, na naira land anti spam cause my delay o, I don dey post update since
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by rowdymind(m): 12:08am On Oct 04, 2018
Youngzubi No Fear, I Stand Gidigba For You Back. We Done Scale Season 1, We Fit Do Am Again. No Let This Pipo Maja You. Where My Homie Pradoic Make We Form Our Own Avengers Here
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by MrsEvakinqz(m): 3:37pm On Oct 04, 2018
Youngzubi:


True fan will always be true, not those who only care about themselves and what they get not minding what the situation is like on the other side, before they place judgment and conclusion

Thank you bro for standing by me, na naira land anti spam cause my delay o, I don dey post update since
it's owk bro, you are welcome back
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(m): 4:30pm On Oct 04, 2018
SNF SEASON 2 EPISODE 4
STORY BY YOUNGZUBI

GBEDU
------------


THE GAMER (1)
--------------------------


As i waka comot from the hotel through the exit door, i checked time on my wrist watch, i still get like 45mins left before my departure time, so i carry head up begin find taxi wey go concvey me from the hotel go airport, to show you sey bad market dey, three taxi men rush me for wia i stand as them begin drag who carry me...

I just stand dey watch, onto sey time no dey my side again, jejely i point one taxi guy wey wear joggers.....

"hey lets go" i yan pointing at the guy..

"yo man" the taxi guy yan as him grab my bag we begin match go wia he park him taxi.....


"no need for long tin, so i made myself comfortable ontop the back seat with my mini traveling bag well placed beside me, the taxi guy took him position as he occupied the driver seat, jejely he begin touch some botten, within 7 second he give the taxi engine life as he twist the key nahim the moto release one kind mechincal sound zuuuuuuum!!!!!! and took off.......




Inside the taxi i begin watch the beautiful city of Jamaica through the side glass, i watch as people move around the streets, i bin won ask the taxi guy why E be sey nah mad and crazy people full Jamaica, but on a second thought i kukuma kick against the idea as i remember sey the driver guy slangs too much so i nor go fit understand wetin him dey talk wella, i just swallow the question sharpaly, life here good but man gat to face him life battle........


*******


I sight as plenty taxi same as the one wey carry me line up in a straight line, the taxi guy match leg ontop the brake as the moto stop abruptly in response to the brake, i move foward as i nod in response to the effect of the brake wey the taxi guy natch......

"yo man here we are" the taxi guy yan......


"i look around nahim i see sey we don reach airport, i deep hand inside my pocket as different colured Jamaican currency accompanied it outside, then the thought of wetin i go fit use Jamaica money do for nija enter my head, E go just useless, for sure i know sey the money pass wetin the taxi guy go fit make in a month but i nor get choice than to give am the whole money....

"have it man" i yan as i foward the cash to the taxi guy.....


"what!!!!!, man whats this, you wonna buy my taxi??... The taxi guy yan with him mouth wide open

" no man, i dont need yo taxi but i just wonna bless you, take the money and goodbye am off to my country"i yan as i hit the guy shoulder and begin match enter the airport ruggedly leaving him in confusion......


" immediately i step inside the airport, i begin go process everything wey need process, from one paper to another, check up to scan, after all the wahala i waka enter the awaiting room, as i shuk head enter inside there omo i sight as people take full everywhere, jejely i made myself comfortable ontop one chair, i notice as people just dey stare and steal glance at me, especially ladies but i nor even send as i no just get time for woman again, women don do me shege, God and him family members know sey nothing fit make me look woman twice again lie lie.....


"hello!"......


"deeply in my thought i hear as the angelic voice resound inside my brain, with a heated verocity i turn my head 360 degrees as my eye jam her, although she nor get smile for her face but she still melt my heart, i bin think sey nah anger go full mybody anyday i jam my eye on her,from head to toe she get wetin blind go see clearly, only her yansh fit turn scientist to mumu, like sey i bin dey sleep since i jab up instantly to grab her but unfortunately a female voice emitted loudly from the speaker wey dem hang inside the waiting room, announcing our departure.......

"since you dont want to respond to my greeting, i think i should just do a quick introduction so that you guys will get along later, maybe when you get to Nigeria" she yan, na that time i sight one guy wth well built body with a crazy look standing beside her....


"spana meet my boo xain, and you xain meet my friend spana, i think thats enough for you guys to get along since you're guys i dont think i need much talk, she yan as we match towards the plane


" i nor fit believe sey na she i dey see so, i begin tink when all of a sudden i sight her pecking the zain guy, then she hit my back and said goodbye and safe journey guys.......


" through the open steps i found my way enter the plane, as i locate my seat and relax, plenty thoughts running through my mind, 5mins later the pilote announced through the mega phone sey make everybody hook him or her seat belt, i grab the belt attached to my seat and and hook it round my waist, within 2mins everybody don ready,i begin feel am as the plane begin vibrate slowly and begin move forward.....

The vibration increased as the plane tear one kind better speed with one kind zuuuuuuuuuu!!!! Noise, the sound too much as some people begin cover their ear while some begin wear earphone, the speed increased to the extent that person no fit see anything through the windows again then the plane enter edo people midnight style "E begin fly for air".....


"i let out a very wide grin as the thought of landing in nija enter my head, na time to face battle.....


" hey dude wassup man"xain yan from my back...


*****************************************

LASCARD
-----------------


I sidon dey watch as sambisa serious dey dress, as him don buy some better better clothes, fila palm with some gifts, he turn begin look himself for sky-b mirror, the guy fine sha, and i know for sure sey that chioma girl go fall for am, that na if him no fumble as he never get strong mind to face the girl....

"oya oya o!, sambisa she don dey pass, causetrouble shout as him burst inside where we sidon for sky-b shop,viam sambisa dash outside forgetting the gift pack...

" i sha stand up, grab the pack and waka go outside make see how things go unfold..


"sambisa rush go stand for main road dey wait for chioma, wey dey come down the street from the junction, him heart beat begin change dancing steps, upon sey he be bad boy he still dey find am hard to follow the girl yan, cold, fear and anxiety took over him as the girl near am, he just fold hand begin turn head like standing fan dey watch the girl like zombie, as she waka pass.....



"chai i no fit believe wetin just happen now, sambisa!! I shout as i begin rush am with vex for wia him stand like dry wood and fold hand, i bin won hit am for head but i sight danshiki boys coming towards me with pkako, as i don already know wetin i do, i tear better race leaving sambisa with him love blindness, if those guys catch me eh, omo na my body parts go full ground so i begin run as fast as my small leg fit carry me...


"i never know sey i fit run with this kind speed, but i know sey na just matter of time before them go catch me which i no want make E hapoen, so i increase my speed as i turn to see if them don near me not knowing sey i don reach express already, na the brake sound wey the car wey don near me make draw my attention but E over late as i hear people shout from different directions then the moto hit me gbooooo!! As E loose control go jam electric pool, i sight myself fly for air without wing before i land for the express road gbosaaaa!!!!!!, the pain nobi here as everywhere black for me eye and i pass out....


To be continued...

Stay tuned still your guy YOUNGZUBI

5 Likes

Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Danicomrade(m): 5:21pm On Oct 04, 2018
the boy is back
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by famopompy(m): 6:34pm On Oct 04, 2018
Youngzubi is back....... welcome bro
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by donaldphilipizu(m): 7:54pm On Oct 04, 2018
OK LETZ WAIT ND C WOT SPANA GOT 4 US IN 9JA.
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Damibiz(m): 9:38pm On Oct 04, 2018
Land welll,the youngest of all Zubilisious Otinkpo is back..nice update man
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Nobody: 10:16pm On Oct 04, 2018
Welcome back yung zubi
Re: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Mcjay104(m): 11:36pm On Oct 04, 2018
Correct:bros abeg no dull am as e dy hot
Just dy fire am front and back

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (12) (Reply)

Chimamanda Adichie Buying Corn By The Roadside In Anambra State / Three Virgins / Caleb (Non-human Fiction) By Safarigirl

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 96
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.