Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,895 members, 7,817,629 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 03:54 PM

He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own (876 Views)

Apart From Sex What Else Have You Benefited From Your Girlfriend(s) So Far? / Ink / Advantages And Disadvantages Of Having Girlfriend(s) In Varsity. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 7:06pm On Sep 02, 2012
na wah 4 dis my pally oo.na woman matter come be im alpha and omega,im bread and tea and im beginin and end or wetin u wan call am.since wen i don know dis my pally na three babes im don train for university do far wit the small money wey he dey hustle as a shoe maker 4 cotonou.d thin wey dey vex me 4 dis my pally be say anytime he dey date a babe na so he go jus waste all im money on d babe.he go take over the babe responsibility dey pay her house rent,dey give her transport money and dey stock her house wit provision.3 babes so far wey he don train for university wit the promise of marriage after their graduation dump am sayin the guy no reach their level.me sef i don advise my pally make im do away wit woman matter 4 now and make im face im shoe making business and develope am or if possible make im go back to school.i don talk sotay the saliva 4 my mouth don dry and yet he no wan hear word.right now na one babe frm ijebu-ode na im dey currently date.the girl get tribal marks wit pimples 4 face but my pally no mind at all.he say the pastor 4 im church tell am say he get vision and for the vision baba God tell him say na dat ijebu babe go be my pally wife.right now my pally jus dey happy like say na ten million naira he win for lottery.no be say the babe fine and even sef she no sabi dress and yet i wonder wetin dey trip my pally about dis babe.i dey very sure say he don already start to dey waste im money on dis babe.me sef dey wonder wetin a 25 yr old man wey no get better job wan take wife do in dis current harsh economy 4 naija wey worse pass the civil war for afghanistan.abeg oooo my fellow members make una help me advise dis my pally ooo.i go show una response to am make he see as dis matter take serious sad
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by onila(f): 7:34pm On Sep 02, 2012
grin grin
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by onila(f): 7:36pm On Sep 02, 2012
lefulefu: na wah 4 dis my pally oo.na woman matter come be im alpha and omega,im bread and tea and im beginin and end or wetin u wan call am.since wen i don know dis my pally na three babes im don train for university do far[b] wit the small money wey he dey hustle as a shoe maker 4 cotonou.[/b]d thin wey dey vex me 4 dis my pally be say anytime he dey date a babe na so he go jus wast(
grin grin
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by scribble: 7:45pm On Sep 02, 2012
love is sacrifice...lefulefu im not sure you have known love before?
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 7:47pm On Sep 02, 2012
cheesy cheesy cheesy
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 7:57pm On Sep 02, 2012
scribble: love is sacrifice...lefulefu im not sure you have known love before?
dis one no be love.dis one na mumuity sad.i sure say all these babes dey use juju on this my pally sad
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 7:58pm On Sep 02, 2012
Booty4me: Am i the only one who think lefulefu is now into Garri business?
look at dis village headmaster sad.i know all ur secret.na village girls u still dey chase.ehen u no dey shame grin
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Flashaldrin(m): 8:03pm On Sep 02, 2012
Please whats the current price of garri now??
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by scribble: 8:09pm On Sep 02, 2012
Flashaldrin: Please whats the current price of garri now??

yellow or ijebu?
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Flashaldrin(m): 8:15pm On Sep 02, 2012
scribble:

yellow or ijebu?
the red one
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by ikechukz(m): 9:51pm On Sep 02, 2012
Ur pally na correct guy
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Mynd44: 10:49pm On Sep 02, 2012
This clown is back with his friends
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Excelboi(m): 10:59pm On Sep 02, 2012
Can't even understand what you're saying OP
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 3:19pm On Sep 03, 2012
Mynd_44: This clown is back with his friends
ur yansh angry
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by cindyrella(f): 4:00pm On Sep 03, 2012
^ hin yansh fine pass ya own I swear! undecided


@topic
Ur pally don drink punny water, he need prayers! grin
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 4:10pm On Sep 03, 2012
cindyrella: ^ hin yansh fine pass ya own I swear! undecided


@topic
Ur pally don drink punny water, he need prayers! grin
mynd yansh dey very flat and the thing rough like sandpaper.no tell me say na dat type of yansh u dey trip for grin

1 Like

Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by slimyem: 4:10pm On Sep 03, 2012
stories written in pidgin and shorthand hurt my eyes!
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Nobody: 4:11pm On Sep 03, 2012
slimyem: stories written in pidgin and shorthand hurt my eyes!
madame slimyem wetin dey?
anything 4 the guy?
i dey hungry ooo cheesy
i hear say u don go hammer for dubai cheesy
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by cindyrella(f): 4:20pm On Sep 03, 2012
lefulefu:
mynd yansh dey very flat and the thing rough like sandpaper.no tell me say na dat type of yansh u dey trip for grin
How u take know? So u still dey look men yansh? I think say dat ur boyfriend don burst ur anus? grin grin
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Acidosis(m): 4:42pm On Sep 03, 2012
cindyrella:
@topic
Ur pally don drink punny water, he need prayers! grin
[quote author=cindyrella]


grin grin grin grin grin
Re: He Dey Put Im Girlfriend"s Interest B4 His Own by Mynd44: 8:43pm On Sep 03, 2012
lefulefu:
mynd yansh dey very flat and the thing rough like sandpaper.no tell me say na dat type of yansh u dey trip for grin
Dude get my ynash off your mind, I am not gay. How many time must I tell you that?

(1) (Reply)

Need Advice / Why Did I Get Married? / Trapping A Guy With Pregnancy

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.