Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,843 members, 7,831,727 topics. Date: Saturday, 18 May 2024 at 04:26 AM

Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend (1213 Views)

Suitable Songs During Disagreements Between Couples. / Disadvantages Of Dating A Fat Woman(orobo) / Love B/w A Blackman And A White Woman (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Nobody: 5:14pm On Oct 13, 2012
One of my pally wey date one orobo Itsekiri babe get wahala wit the babe oo.Him and the babe no dey ever agree over any matter.ever since my pally meet this babe he don try make the babe reduce her weight but she no dey ever listen to my pally.me sef fit understand why my pally dey anxious make the babe reduce her weight because if u see this babe na so she fat full ground.her legs alone be like those tubers of yam wey dem dey harvest during new yam festival for igboland and her yansh sef if u see am na so the thing come wide and e come look intimidating like those bulldozers wey dem dey use pull down houses.
anyway back to my pally he say he be carry dis im babe go register for one Gym for two months and he even pay with im money to register her.he say wetin come surprise am be say one day wen he return for work na so he come meet this babe for sittin room dey consume a whole two loaves of Agege bread with six eggs and at the same time watching african magic for tv.he come ask the babe wetin she dey do for house and why she no dey gym at that hour dey excercise.na so the babe come start to dey vex and come reply say all her body dey pain her and dat my pally no go kill her with gym stress.he say im and the babe really quarrel dat day.he say another thing wey he no like about this babe na her midnight feeding.he say wether na 12 oclock for midnight oooo,2 oclock for morning she go still dey munch her mouth.anytime he ask her wether na glutton she be she go just dey vex and dey shout on my pally wether na im belly she dey chop the food.my pally say he don tire for this im babe behavior and if no be say two of her brothers na members of MEND he for don sack this im babe long ago.my pally say any advice wey una go fit give am on how he go make im babe take dey respect am he go really appreciate am.
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by onila(f): 5:22pm On Oct 13, 2012
grin
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Nobody: 5:26pm On Oct 13, 2012
loose the girl, way less mouth to feed and I mean literally
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Nobody: 9:43pm On Oct 18, 2012
grin grin grin
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Kenistry(m): 12:04am On Oct 19, 2012
Nairaland, losin its value

1 Like

Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by deshclones(m): 2:50pm On Oct 19, 2012
Kenistry: Nairaland, losin its value

N1ggah where is your sense of humor??

@ topic....lefulefu and his unending pallies..... grin grin grin grin grin grin grin

1 Like

Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Nobody: 1:00pm On Oct 30, 2012
deshclones:

N1ggah where is your sense of humor??

@ topic....lefulefu and his unending pallies..... grin grin grin grin grin grin grin
haba anything dey wrong if i get plenty friends?
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Nobody: 1:43pm On Oct 30, 2012
grin grin grin grin grin grin
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by boron10(m): 2:28pm On Oct 30, 2012
hahahahahaha Mr Lefulefu!!! I beg en, na joke section you go for make sense pass. By the way, how come most of your Nairaland posts revolve around your numberous padi and their babes? Shey all your friends get issues with picking correct girlfriends ni?
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by omotola1(m): 2:38pm On Oct 30, 2012
What‘s dis thing about orobo thread these days?
Abeg dem no be human being?
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by Nobody: 4:57pm On Oct 31, 2012
boron10: hahahahahaha Mr Lefulefu!!! I beg en, na joke section you go for make sense pass. By the way, how come most of your Nairaland posts revolve around your numberous padi and their babes? Shey all your friends get issues with picking correct girlfriends ni?
my brother dis na romance section nah and dats why i dey always about babes and the ones wey my pallies dey friend.if i start to dey yarn politics for here no be out of point i go come dey? grin
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by bknight: 5:23pm On Oct 31, 2012
grin grin grin grin grin
Re: Disagreements B/w Him And His Orobo Girlfriend by roymary: 5:27pm On Oct 31, 2012
I am not a fan of skinny girls. Fat girls rock!

(1) (Reply)

Anyone Ever Got Back With An Ex? / Tips On Avoiding Heart Breaks In A Relationship / Please Advice Me On What To Tell Ma Cousin

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.