Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,072 members, 7,835,616 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 12:32 PM

Beware Of Stingy Guys In Relationships!!!a Must Read ,girls Ur Opinion Please. - Romance (4) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Beware Of Stingy Guys In Relationships!!!a Must Read ,girls Ur Opinion Please. (8410 Views)

Annoying Places Broke And Stingy Guys Ask Ladies For Date / Emotional Blackmail In Relationships: A Necessary Evil? / 10 Keys To Healthy Relationships: A Must Read!!!!! (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (Reply)

Re: Beware Of Stingy Guys In Relationships!!!a Must Read ,girls Ur Opinion Please. by Renz(m): 6:47pm On Oct 25, 2012
No one up here seems to be talking about the love in the relationship but the food & money... so i guess Love no dey exist again abi?? Broda, this na clear indication say if u luv a girl and u no get the coins to grease the luv make your luv die naturally inside u to avoid stories like this one here. Or alternatively, the girls wey dey our cities there wahala dey too much, quietly enter village go look for one fine girl wey dey look for love (city girls make una no vex ooh, abeg make una no curse me i just wan help in this matter)They say wisdom is profitable to direct, so my broda cut the coat in accordance to d pocket.....

You can call a person stingy if the person has more than enough to share and refuses to share... The question is; the guy him get d coins? him don chop bele full? where him dey work? u know whether na once a day him dey chop? They say life is in stages while men are of different sizes (Ladies abeg if una want money make una look for men wey Grab too..Look for Otedola and Dangote them)LOL i go die for here ooh.
They say "Fine Girl na Wazobia, Ugly Girl na Mineral" If you be girl (no bi woman man or man woman ooh) as -in say u fine like mami-water, naturally endowed with bobi and backside (God help me i don dey talk rubbish for here) as in you set, the type of girl wey fit cause accident for road, if u open ur mouth tell ur boyfriend say na BB u want, him no mind sell him TV buy u BB ooh.. he go b like say u do am juju oooh but na lie na ur beauty dey talk ahead of u. SO e fit be say the babe no fine and d guy no wan invest on that kind property (no b joke ooh dis na true talk) - So for the ladies make una dey ask according to una beauty... LWKMD for here.

Now this guy man knows his pocket too well and asked the lady to eat b4 you come to avoid quarrel (This na correct warri guy, him no fit fall him hand), this na strong message to d babe make she no ask for BB (LWKMD), but the babe fall hand she too for tell d guy ahead of time say look as i dey come so na u go take care of the food and d transport to & fro.

The bottom line is that in this kind of case u can never tell the real issue behind the act and so don't jump to stingy conclusions..
Re: Beware Of Stingy Guys In Relationships!!!a Must Read ,girls Ur Opinion Please. by fairygeh(f): 6:53pm On Oct 25, 2012
^i
Renz: No one up here seems to be talking about the love in the relationship but the food & money... so i guess Love no dey exist again abi?? Broda, this na clear indication say if u luv a girl and u no get the coins to grease the luv make your luv die naturally inside u to avoid stories like this one here. Or alternatively, the girls wey dey our cities there wahala dey too much, quietly enter village go look for one fine girl wey dey look for love (city girls make una no vex ooh, abeg make una no curse me i just wan help in this matter)They say wisdom is profitable to direct, so my broda cut the coat in accordance to d pocket.....

You can call a person stingy if the person has more than enough to share and refuses to share... The question is; the guy him get d coins? him don chop bele full? where him dey work? u know whether na once a day him dey chop? They say life is in stages while men are of different sizes (Ladies abeg if una want money make una look for men wey Grab too..Look for Otedola and Dangote them)LOL i go die for here ooh.
They say "Fine Girl na Wazobia, Ugly Girl na Mineral" If you be girl (no bi woman man or man woman ooh) as -in say u fine like mami-water, naturally endowed with boobs and backside (God help me i don dey talk rubbish for here) as in you set, the type of girl wey fit cause accident for road, if u open ur mouth tell ur boyfriend say na BB u want, him no mind sell him TV buy u BB ooh.. he go b like say u do am juju oooh but na lie na ur beauty dey talk ahead of u. SO e fit be say the babe no fine and d guy no wan invest on that kind property (no b joke ooh dis na true talk) - So for the ladies make una dey ask according to una beauty... LWKMD for here.

Now this guy man knows his pocket too well and asked the lady to eat b4 you come to avoid quarrel (This na correct warri guy, him no fit fall him hand), this na strong message to d babe make she no ask for BB (LWKMD), but the babe fall hand she too for tell d guy ahead of time say look as i dey come so na u go take care of the food and d transport to & fro.

The bottom line is that in this kind of case u can never tell the real issue behind the act and so don't jump to stingy conclusions..
. Owkai,seen undecided
Re: Beware Of Stingy Guys In Relationships!!!a Must Read ,girls Ur Opinion Please. by thrugemaster(m): 11:32pm On Nov 07, 2012
big baboon

(1) (2) (3) (4) (Reply)

My Long Gone Girlfriend Comes Back, Want Me To Disvirgin Her By Force / ** Suggestions Plz!!what Action/ Adventure Film Can I Download To Ease Boredom** / “close Your Legs” Fans Tell Korra Obidi During A Live Broadcast - Video

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.