Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,590 members, 7,823,565 topics. Date: Friday, 10 May 2024 at 11:44 AM

No Sex Before Marriage? - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / No Sex Before Marriage? (1676 Views)

When She Is Not A Virgin And She Says " No Sex Till Marriage ". / She Broke Up When I Told Her No Sex Before Marriage / The Lies Of The "No Sex Before Marriage" Deals. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

No Sex Before Marriage? by Nobody: 6:12pm On Nov 10, 2012
kingsley aka kizo na very sociable guy.he be young bachelor and im sabi all the beer palours and night clubs 4 town.there is no day wey kizo and im paddys dey ever miss beer palour and night clubs and na so dem jus dey runs all those fine fine night club babes like no man business.kizo na comfortable bobo and he dey work for one big oil company and na so babes dey die follow am because of im oil money.
now time for kizo to marry don reach and im mama for village don already dey wahala am say if he no bring wife come then she go get no choice than bring a village girl put for bros kizo house as im wife.anyway as circumstances go have am kizo come across one average looking very strict born again babe.this babe name na angelina and na kizo cousin introduce her to him.b4 u know it kizo don already fall in love wit this babe at first sight and as u go expect guyman he don already dey toast the babe.as u go expect of a typical naija babe angelina start to dey form as oga kizo dey toast am.after 7 months angelina come gree to be kizo girlfriend after endless toasting,expensive gifts and expensive take outs.but then she come give certain conditions.that kizo must start to dey attend her church,that kizo must cutt off links with im club paddys dat kizo must start making friends with the boring male members for her church wey dey wear over sized coats and dey tie their trousers for belle and dat there will be no smooching,kissing,holding hands,tonguing and yanshing until the day of their marriage.kizo agree to all the terms and after one year dem come marry.
now the wedding night was so disapointing for mister kizo.compared to the experiences wey kizo don get from im former club babes wen it comes to yanshing madam angelina no jus sabi anything at all for bedroom.she go jus lie down like log of wood while kingsley dey busy dey drill her,anytime kingsley tell her to suck im level na so she go jus sqeeze her face and tell kingsley say she no fit do dat kind of dirty thing.if kinglsey wan eat her congo meat na so she go jus slap kizo for im bald head and tell am say na were he learn dat rubbish.if kizo wan suck boobi she go do vex and she go say she no be kizo mama.the thing dey really pain kizo wen she no let am suck boobi and u suppose say oga kizo na the type of paddy wey like boobi like me.on wednesdays,thursdays,fridays and saturdays na holy week for angelina church and durin those days yanshing is not allowed.to top it all angelina no sabi cook and na for mama put kizo dey always dey find imsef.im wife angelina don even turn into a fanatical prayer warrior and na so every night she go carry bible for hand dey cast and bind all the witches,wizards,warlocks,warlords,mammywater,pappy water etc wey dey hold meeting for inside river niger,on top of river niger,inside atlantic ocean,for lagos-ibadan expressway and inside market.na so she go jus dey cast and bind and poor kizo go carry mattrass enter sittingroom.now kizo don dey miss all those im former club babes and anytime wey he sight them na so dem go jus shake their yansh at am and give am this wicked smile and na so im third leg go jus stand and dey sing "ARISE OO COMPATRIOTS".one voice dey tell kizo make im start to dey runz im former club babes and another voice dey tell am make im no ever try such a thing.if na u dey kizo situation na wetin u go do?
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 5:25am On Nov 11, 2012
God pls give me a dream wife. God pls also help kizo..
Re: No Sex Before Marriage? by ajailer(m): 6:26am On Nov 11, 2012
grin grin grin grin grin grin
Re: No Sex Before Marriage? by ikechukz(m): 10:36am On Nov 11, 2012
LOL
Re: No Sex Before Marriage? by cindyrella(f): 11:29am On Nov 11, 2012
Lefu, this one too long na.
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 4:20pm On Nov 11, 2012
cindyrella: Lefu, this one too long na.
awhy u dey pretend say u no understand wetin i dey yarn about? grin
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 4:49pm On Nov 11, 2012
LOLz
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 5:26pm On Nov 11, 2012
SMH
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 5:31pm On Nov 11, 2012
lmaooooo!!! lefool lefool has done it again.
this na real one chance for kizo o, but make him manage am still, e go better.
Re: No Sex Before Marriage? by AlterEgoTM: 9:03pm On Nov 11, 2012
lolz... Kizo enta one chance come take head swap am grin grin
Na to do dat kain babe strong thing o
BÐ$M thingy noni...
grin grin grin
Re: No Sex Before Marriage? by cindyrella(f): 9:30pm On Nov 11, 2012
lefulefu:
awhy u dey pretend say u no understand wetin i dey yarn about? grin
I no talk say I no understand o! I just say the tin too long!
Re: No Sex Before Marriage? by edlion57(m): 12:08am On Nov 12, 2012
Kizo shld bring one his club babe home as housemaid
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 12:40am On Nov 12, 2012
Still laughing. grin
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 12:50am On Nov 12, 2012
Kizo should not worry, he will get used to the system, after all Rome was not built in a day.
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 5:53am On Nov 12, 2012
Simple. Kizo should ignore her and start living his former life. Nobody will tell her to go and learn how to suck blokos.
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 4:39pm On Nov 12, 2012
kizo should sue for divorce.his wife is not living up to her wifely duties.
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 5:51pm On Nov 12, 2012
You are a fool indeed! smiley Your friend must let his wife know that he cannot go on in this manner. He needs to let her know that he is suffering and it is ruining their marriage. A husband should ask his wife the real reasons she is refusing him. If there is something he can change, then he should do so immediately. If there is no change, then he should get someone to talk to her mother about the matter before he makes a decision. Ladies don't let the runz girls get your household money LOL!
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 11:06am On Nov 14, 2012
;DMost of these women who dey carry church for head they punish their husbands with sex ;DMost of these women who dey carry church for head they punish their husbands with sex.Sometimes its better marrying a worldly wise lady than a woman who is a church freak
Re: No Sex Before Marriage? by Nobody: 7:01pm On Nov 27, 2012
diz woman can't even cok sef. SMH. family b4 da ministry naso Bible talk am. d man even change bcoz of am o n she no happy. well d man shud pray 2 God 2 change d woman, He jes might.....
Re: No Sex Before Marriage? by mickypounds(m): 12:31am On Nov 28, 2012
Kizo should start goin on biz trips and board meetings,it helps.

(1) (Reply)

I Can't Stop Dreaming About Her. Any Hope? / Boy Knew That He Is Going To Die / My Gf Has To Choose Between Me N Football!!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 23
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.