Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,455 members, 7,816,052 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 01:15 AM

Warri Parables: Words Of Our Popsi's - Culture (8) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Warri Parables: Words Of Our Popsi's (42659 Views)

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney / Words Of Tribal Origin Used As General Slangs & Their Meanings / Warri Parables (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) (Reply) (Go Down)

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skibochi(m): 6:19pm On Oct 24, 2008
ok make una shadow dis ones:

- a rolling stone, na person push am
- a stitch in time, dey prevent further tia-tia
- birds of the same feather, na thesame mama born dem
- d patient dog, na hunger go kill am
- let sleeping dogs, run from calabar men
-charity, na local girl name o!!

guys nothing meegaaaa!!!

cool cool
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by allboyz(m): 9:26pm On Oct 24, 2008
skoba!!! cool
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by samsworld(m): 12:31am On Oct 26, 2008
area! area!!, them say shit no get bone but who match shit must stagger. i hail all my waffi brothers for dis side.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by DeHero1: 3:54pm On Oct 27, 2008
No tro stone, E fit nak your mama head

The patient Dog, Eat the strongest bone

What a man can do, A woman can never try it

[/i]catch ya at tha oda side of tha Jungle[i]
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Kaliyat(f): 5:52pm On Oct 28, 2008
Oh boy!!! this girl too shakara. If dem leave her she go iron kpomo, use needle ringboiler boil ocean come use needle turn eba.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Kaliyat(f): 5:54pm On Oct 28, 2008
Oh boy!!! this girl too shakara. If them leave her she go iron kpomo, use needle ringboiler boil ocean come use needle turn eba.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by dasko(m): 11:51am On Oct 30, 2008
how una dey my people, i don hear una yannins tey tey, any way make i see talk as me see am.
Me i sabi sey na wen person don chop belle full na im dey make noiseooo
Abi u no know say na play play na im dem take dey see free fork
And my mamma tell me say small tin nor be like devil.na im be at all at all na im bad pass[keremu keremu]
abeeg if u no know say kaki no b leather make u try use am sow cloth make ur eye clear
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by dasko(m): 11:54am On Oct 30, 2008
dasko link=topic=warri parables
how una dey my people, i don hear una yannins tey tey, any way make i see talk as me see am.
Me i sabi sey na when person don chop belle full na I'm dey make noiseooo
Abi u no know say na play play na I'm them take dey see free fork
And my mamma tell me say small tin nor be like devil.na I'm be at all at all na I'm bad pass[keremu keremu:


abeeg if u no know say kaki no b leather make u try use am sow cloth make ur eye clear

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 2:31pm On Oct 30, 2008
dey say na person wey shit dey forget say im shit but person wey pack the shit no dey ever forget. grin grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by lysaa(f): 12:12pm On Nov 03, 2008
When someone is obviously lying; 'Guy, if dem give u chance, u fit fry ice-block come shade am o.'
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by hclacid(m): 8:34pm On Nov 04, 2008
omg what a thread grin grin
"if the akpu is naked who go chop the akpu?"
dem talk say if man hit table and shout he dey control, but if na woman she dey loose control.
tell me who your friends are and i go talk if i go follow you.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by samboribo(m): 12:37am On Nov 05, 2008
EGBESU!!!

cunny man die, cunny man bury am.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by uzygirl(f): 12:10am On Nov 06, 2008
UP WAFFI!

Them say ogoro (frog) smart, but na wen e die, everybody go see im true length.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chukwu25(m): 6:46pm On Nov 06, 2008
Area! Area!! Area!!! i hail
warri no dey carry last,still for dat level,
bat know say he ugly na why he dey fly for night
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by kellygirl(f): 4:26pm On Nov 07, 2008
hilarious cheesy cheesy cheesy cheesy cheesy
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by A40(m): 1:50am On Nov 09, 2008
I get am before no be property
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by lucabrasi(m): 4:42pm On Nov 09, 2008
small pikin wey no know fish na him dey call am digbi grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by bawomolo(m): 9:23pm On Nov 09, 2008
bat know say he ugly na why he dey fly for night


grin grin grin grin grin cheesy cheesy
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by crush: 10:22am On Nov 10, 2008
well done all of u,
my body no dey
cos wetin i no dey chop i no dey use my mouth divide am!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 3:48pm On Nov 10, 2008
pap and akamu no be the same thing o
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by uzygirl(f): 6:09pm On Nov 11, 2008
chamotex:

pap and akamu no be the same thing o
grin


Fast guy no be thief
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 10:58pm On Nov 11, 2008
one day one day, James Bond go die inside film!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by obinna5000(m): 11:47am On Nov 13, 2008
WOW! grin
NOW THIS IS HILARIOUS. grin

@chamotex
your signature is an eye-sore. sad
But your parables are wonderful. grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Arnold23(m): 6:22pm On Nov 14, 2008
becos of love wey u get for kpomo no mean say you go call cow 'broda'
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Arnold23(m): 6:35pm On Nov 14, 2008
Up Niger Delta!!!!!!!!!!!

wash hand come join person chop u wash am reach elbow
wetin concern fowl with toothbrush abi na wetin concern bicycle with filling station?
if yam no dey, beans no dey sweet? at all at all na witchcraft na
e easy for man na im ezekiel go do conductor for lagos?
na monkey wey go dey check wetin dey make noise na im hunter dey shoot for eye
pikin wey money dey catch for body na im dey go buy akpangiri bicycle

I hail una ohhhhhhh!!!!!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by raffite: 12:21pm On Nov 15, 2008
Waffi, una don reach here too. Them really talk am say:

Rat no dey big pass thief
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by lysaa(f): 7:26pm On Nov 15, 2008
from the dayz of John the Baptist, the Kingdom of God suffereth gbege and only the gragra taketh it by force. grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Opslag(m): 7:50pm On Nov 15, 2008
Lumber men always make a pathway to the timber they wish to market.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 7:54pm On Nov 15, 2008
anyhow, which way, Monday must come after Sunday
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by samboribo(m): 10:28am On Nov 17, 2008
EGBESU!!!

na over-feeding dey make man misbehave.
no b all big belle na im b sign of enjoyment. some na kwashiokor.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by obailala(m): 6:53pm On Dec 27, 2008
betta native doctor nor dey put signboard
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 10:01pm On Jan 07, 2009
obailala:

betta native doctor nor dey put signboard
ROTFLMAO ABI OH grin grin grin grin

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) (Reply)

Meet Wodaabe Men, A Fulani Ethnic Group Who Make-up For Easy Marriage, / Naomi Oluwaseyi Stuns In New Photo / Photos: Nigerian Woman Spotted Eating Amala On A Train In The UK

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 23
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.