Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,439 members, 7,819,621 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 07:17 PM

Warri Parables: Words Of Our Popsi's - Culture (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Warri Parables: Words Of Our Popsi's (42679 Views)

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney / Words Of Tribal Origin Used As General Slangs & Their Meanings / Warri Parables (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (11) (Reply) (Go Down)

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 11:53am On Oct 16, 2008
Avoko, dem dey tell person
Wetin concern fowl with maccleans, or wetin concern vulture with barber?
You strong you strong you dey chop bottle?

2 Likes

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 11:54am On Oct 16, 2008
Small pikin wey say e wan get bald head na headache go kill am
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by barin24(m): 11:56am On Oct 16, 2008
Man wey vex go shake Iroko tree na im blokos e dey worry and if na woman na her bosom

Lizard for warri no dey turn crocodile for london

Paynt wey slack na im dem dey call boxers

When monkey wear canvass enter town make we know say im get plans

Na determination dey make okada rider overtake trailer
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by barin24(m): 12:00pm On Oct 16, 2008
Goat say e know say waka dey this world na im make am wear e own shoe come

2 Likes

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by nossycheek(f): 12:40pm On Oct 16, 2008
dey no dey sell banga for supermarket
dead woman no dey wear buluku
na watch night pikin dey resemble landlord
na so e dey do na pikin take craze he mama no know
na condition make crayfish bend
monkey wowo but I'm mama like am
na person wey no get sence dey pursue mad man wey collect I'm cloth
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by nossycheek(f): 12:43pm On Oct 16, 2008
na wetin concern agbero with overload
na poverty make person wey dry pass bonga fish say e be lepa
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Blackcat(f): 1:14pm On Oct 16, 2008
I no be wafi but I throw way salute for this fine thread wey una start so grin grin

I go leave una with some Tiv proverbs, here goes:

person wey bite my nose no fear say cater go enter him mouth me too i go bite him nyash and no go fear say shit go enter my mouth

them no de find virgin for maternity ward

no bi yanga de make agama lizard nod head
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Rothstein: 2:23pm On Oct 16, 2008
una pomo no thick reach. na fake wafi all una be express go leave all
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Reptyle(m): 2:43pm On Oct 16, 2008
I no be waffi o! But I hear one of my friend tok dis ones. Im say:

King house wey burn, e near filling station b dat!!!

Cow wey no get tail, na suffer go kill am!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by kokoye(m): 2:44pm On Oct 16, 2008
all this ur lines just take me back to the time I served in Warri o. I remember those streets: okumagba avenue, airport raod, enhenren junction, ohuworun, edjeba junction, NPA,

Also the funny way peeps used to talk there like they were sings grin

The mosquitoes for warri na die o.  They always had a cane in hand - daring you to turn on the fan or the a/c. I think they used to love  the a/c sef.

It is also in warri that you'll see pure oyinbo half - castes walking around barefeet - oyinbo don sleep with their mamas run comot.

Na wah o, I no miss that place sha.  it was the first place where I saw a real sacrifice.

All of them dey go church - but na sacrifice you go dey see for every junction o.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 2:53pm On Oct 16, 2008
Blackcat:

I no be wafi but I throw way salute for this fine thread wey una start so grin grin

I go leave una with some Tiv proverbs, here goes:

person wey bite my nose no fear say cater go enter him mouth me too i go bite him nyash and no go fear say shit go enter my mouth

them no de find virgin for maternity ward

no bi yanga de make agama lizard nod head




This is the funniest thing i've heard this month.

barin24:

Man wey vex go shake Iroko tree na I'm blokos e dey worry and if na woman na her bosom

Lizard for warri no dey turn crocodile for london

Paynt wey slack na I'm them dey call boxers

When monkey wear canvass enter town make we know say I'm get plans

Na determination dey make okada rider overtake trailer



A close second
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 3:06pm On Oct 16, 2008
@kokoye
No be lie you lie about Mosi Mosi oh,
Mosquito wey no join mend for warri na hungry dey kill am.
A fool at 40, , no be today e mugu start oh
Threaten na water , , action na blood.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by nossycheek(f): 3:21pm On Oct 16, 2008
Chrisbenogor:

@kokoye
No be lie you lie about Mosi Mosi oh,
Mosquito wey no join mend for warri na hungry dey kill am.
A fool at 40, , no be today e mugu start oh
Threaten na water , , action na blood.

Yes, tell them, show them say na we dey break bottle.
pege pege amre okaka
mege mege amre usewu,
unutakunu, mouth talk to mouth (A FUNNY NAME I HEARD)
yamiyacha, go I dey come (ONE OF THE FUNNIEST NAMES I HAVE EVER HEARD)
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by AKO1(m): 3:25pm On Oct 16, 2008
If na Yoruba children;:

1: Bros please cut small biscuit for me, ebi n pa mi
2: Ahn ahn now, okay (reluctantly gives the guy pauper's ration)

But for Warri,

1: Bros abeg remen small for me, I dey hung even sef I never chop sinc yestiday.
2: Comot for here jo!! Na your papa buy am? grin



He who laughs last. . . .  na mumu be that. Why I'm no catch the joke at the first time and laugh when others dey laugh?

All work and no play. . . . na banker be dat!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by tollu: 3:29pm On Oct 16, 2008
Na wa o! roflmcao

As I dey read this thread so, I don laf sotay, I nearly titrate for chair. grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by luvli(f): 3:54pm On Oct 16, 2008
finally, topic wey flavour to my boring day!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by luvli(f): 3:56pm On Oct 16, 2008
finally, topic wey add flavour to my boring day!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Woodpecker(m): 4:00pm On Oct 16, 2008
na hail i take diwge for una, e don tey wey i dey wait make this kain thing happen for this place.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 4:03pm On Oct 16, 2008
abeg make una no stopp o!!!!
una don make my dai 2day
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by delwu(m): 4:12pm On Oct 16, 2008
Feel at home dey spoil television!!!!!!

1 Like

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 4:23pm On Oct 16, 2008
when 2 elephant dey fight
na d grass dey suffer am
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by benice2: 4:27pm On Oct 16, 2008
if na only dis topic dey 4 nairaland i no mind 2 sleep 4 ma computer.

this one na nairaland of a thousand laugh. . . .

no bi small tin oh!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by fyneboi(m): 4:31pm On Oct 16, 2008
Like play like play na Ngozi take carry belle
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 4:35pm On Oct 16, 2008
when 2 elephant dey fight
na d grass dey suffer am


to baff with garri
no dey heal hunga problem
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Godalone(m): 4:37pm On Oct 16, 2008
I hail una o.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 4:40pm On Oct 16, 2008
dey say if u give man fish
na one day u go take feed am
but if u come teach am how to fish
na fisherman e go be
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 4:48pm On Oct 16, 2008
fish no dey know as hot water be
until e enter inside pot
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by tollu: 4:52pm On Oct 16, 2008
fyneboi:

Like play like play na Ngozi take carry belle

Ngozi no carry belle o, na Awoof she bin chop!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 4:55pm On Oct 16, 2008
Area i still dey hail una o!!!

dem no need to tell blind man say rain dey fall

Na with serious cooperation na I'm rice take dey full pot
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 5:04pm On Oct 16, 2008
tollu:

Ngozi no carry belle o, na Awoof she bin chop!

Awwoof dey run belle now grin grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skfa1: 5:07pm On Oct 16, 2008
SeXYhOTmOM:

Awwoof dey run belle now grin grin

u mean awwooof dey run ur belle too buhehehehe  grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 5:09pm On Oct 16, 2008
Na nyash wey bingo dey look make am miss road enter calabar man compound.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (11) (Reply)

Meet Wodaabe Men, A Fulani Ethnic Group Who Make-up For Easy Marriage, / Naomi Oluwaseyi Stuns In New Photo / Xenophobia: Oluwo Of Iwo, Akanbi, Protested, Carried Placard In 2014 (Throwback)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.