Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,224 members, 7,818,765 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 01:14 AM

Warri Parables: Words Of Our Popsi's - Culture (9) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Warri Parables: Words Of Our Popsi's (42669 Views)

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney / Words Of Tribal Origin Used As General Slangs & Their Meanings / Warri Parables (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (Reply) (Go Down)

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 7:01pm On Jan 08, 2009
@ arnold23

wash hand come join person chop u wash am reach elbow
e easy for man na I'm ezekiel go do conductor for lagos?

lmao

@ chamotex, I troway salute o!

Everyone, abeg make una "keep it coming." Nice thread already and I haven't gone through every page yet.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by lucabrasi(m): 1:45pm On Jan 09, 2009
no matter as albino yellow reach,he no fit turn oyibo
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 6:55pm On Jan 12, 2009
Area I dey hail O!! Happy New Year.

I just dey waka pass say make I Hail Mary.
Which levels sef. Infact this year, person wey say you no chop, Na over-dose of "My Pikin" na ehn go kill am. grin

Any which ways sha, dem say man wey no get leg, no dey price bicycle.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Uby40(m): 2:23pm On May 28, 2009
if dem leave some ppls for nairaland eh,
dem do come hawk garri for New Jersey.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Uby40(m): 5:39pm On May 28, 2009
Area!!!
Area!!!!


Oh boy, so na here all of una gboro come shock in abi?

wey i dey use microscope dey find una for Upper Erejuwa and Ogboru street.


Una no dey try at all.

o boy!

bob we don relocate oh, our malle wan make we turn aje over night,
na im all of us giv am combine warning oh!!

she smart,go rent house for Bendel estate Airport road, that one mean say i no go fit role with all dem Erikefe and Edirin again oh!

anyway sha,

Ogoro must jump oh, never say die, e too bad i dis-mother am b4 she dis-son me.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by patwhizkid(f): 9:08am On Jun 01, 2009
Area! I hail o! How una dey run shows 4 wafi nao! Una mingwor ooo
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by donjon: 5:27pm On Jun 01, 2009
I hail all of una! Ur piyarns make sense!

Bird wey fly ontop ant hill, no know say im still dey ground.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by kenypumpin: 9:52am On Jun 05, 2009
mehn, me hail everybody oooo grin grin, u na fit kill person na, me don laff taya wey b say person wan choke cheesy cheesy cheesy, may una carry go, WARRI NO DEY CARRY LAST OOOO, KPATA KPATA NA DRAW!!!!!!!!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by ekpan: 6:00am On Aug 10, 2009
Area I Hail

, Reppin Ekpan/ jakpan Area,

I no too fine like that but una know say "Monkey no fine but im mama like am"

na so I kawa go Morroco via morroco route say I wan reach Europe last year, na so immigrae for morroco come catch ur boy say na prison for me o, O boy una don see when blacky dey scatter arabic like say na im invent the language? Shuooo Warri no go fit carry last confrimed

Area anyha anyha OGORO MUST JUMP

LATER
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 12:47am On Sep 10, 2009
hi
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 11:59am On Sep 10, 2009
What. . . .?.i have been missing this thread. Well AREAAA-A I DEY HAIL OO shocked shocked grin grin. hehehe. . . Wafi nor dey carry last jare.(Eye Bling)
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by IFELEKE(m): 12:44pm On Sep 10, 2009
What a thread! grin
Area! i troway hailings oo, notin do all of una!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chinesedoll(f): 8:06pm On Sep 10, 2009
IFELEKE:

What a thread! grin
Area! i troway hailings oo, notin do all of una!

Nothing do u sef!!!!

so dis thread still dey?
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 8:15pm On Sep 10, 2009
Efreboh! Just becos u first me reach court no mean say u go win case o.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 4:06pm On Sep 11, 2009
hehehehehe. . . . . . Ogoro must Jump! ! ! ! !. I feel you Die my people. grin  grin,Warri. Them nor reach!.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 4:35pm On Sep 11, 2009
Monkey wey wear canvas enter market, e get game plan
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 5:25pm On Sep 11, 2009
She don go put water for garri when i buy from IGBUDU-Market- but hope say the Fish never get K-legs ooo . . .   shocked
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 5:35pm On Sep 11, 2009
2 wrongs dont make a right but 3 rights go make left ooo
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 5:52pm On Sep 11, 2009
Chamotex dear i dey feel you jare. . .carry Go!!.(Eye Bling) Warri??. Well,im Tempted to ask how do you know the word(Bobaraba)-you use in your location?,Do you Understand Diuola?,have you gotten an Ivoirian friend?,have you ever travel to Abidjan?,Did you hear this word on a Music?,How come because im so shocked to see it in your profile.lol grin grin

Honestly i like BOBARABA.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 6:11pm On Sep 11, 2009
^^^^^ I love booties, so that's where I reside. grin grin grin grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 6:24pm On Sep 11, 2009
hahahahaha. . . .Great dude,Great bother's wink means we have something in common. Yes . . but so supprise you know (Bobaraba) and hardly for Nigerians to know what it means,Well. . .Curiously wanna know how come you understand this.By Music,By Friends,or somewhere else?.

I reside in Dioula Area in Ivory Coast and one of my Zuglou Musician dude(DJ MIX) have this BOBARABA has his song tittle. C'est le momment . . . ! Bobaraba eehh Bobaraba=Continuesly grin grin grin grin.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by KINGSOLALA: 3:33pm On Sep 16, 2009
Mad man say if u never reach where u dey go , de only tin u goo doo na to day waka

No mata how a bird flies , i no fit touch the sky

Na small small elephant dey take dance

Old woman no dey old 4 dey music wey she sabe dance

Mad man no sabe anything , no be where i dey sleep
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 8:41pm On Sep 16, 2009
[size=13pt]hehehehehehhehehe. . . . .You Guys are Good!! shocked - Keep Cracking me up *eye bling* Warri dey kampe. We nor dey quik dey Provoke!. grin grin grin grin[/size]
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igboboy1(m): 1:31pm On Sep 19, 2009
Warri how i missed thee, place where i for grow.

those days we dey run things for demonstration sec schl com dey fight dom dom mingos shuooo, memories

Abeg free me small body no be sickness, E get one day one kosini boy wan obtain me cos me i just dey crisp with my white outfit (even the sole for my white shoe na white). People for the area trip that day na. I give am stainless for on top kpoto kpoto, i.e even sole 4 under my shoe no stain, ah ah na warri we dey o, Dem dey tell person? Free me
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 7:15pm On Sep 20, 2009
[size=13pt]igbo boy:

lol grin grin grin @ Free me! ,I remember the time. Those days in Warri whenever someone,maybe friend or somebody else from neighbourhood or familly hold me in the wrong place i alway's say: Free me! angry angry, Free me naaa. . .or Free me,wetin bi your own. grin grin.

But i most use this word when im on the Action mode,like in Attemting to fight and some people is holding so i wont break the bottle. Only when the Guy Provoke=Paracid.

Well, i use to have a friend from dom dom mingos missing him by now.
[/size]
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by tubabie(f): 7:24pm On Sep 20, 2009
cool
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by WarfyBoy(m): 9:56pm On Sep 20, 2009
MUDIAGA!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 1:19pm On Sep 21, 2009
[size=13pt]Stand feet. . . ! [/size]
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by mamagee6(f): 6:20pm On Sep 21, 2009
Escort me, nwa pikin. grin grin grin grin grin grin grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igboboy1(m): 12:31am On Sep 22, 2009
Ogaga:

no be lie, those days boys for warri dey voke,

Imagine the time wey i dey SS3 i come dey laugh one guy for Jss1 becos the prefects wey be my friends obtain im shoe, Na im the guy say bros na me u dey laugh? I was like see this small boy o, i go tear u slap, na im i slap am, O boy na im the smallie say i don price, you know for warri if u price u must to buy.
I know no say this guy bros na Confra guy, O boy dey block me for school for one week straight, Dem dey tell person? As a correct guy wey no wan chop unnecessary beat na im i miss school for that one weeek grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Ogaga4Luv(m): 12:47am On Sep 22, 2009
[size=13pt]igbo boy that was Funny like Crasy. . .buhahaha. You get luck say the Smallie nor Cut Chain follow you. body for tell you naaa. Man fear those warri ''Small but Mighty'' ooooo grin grin grin. [/size]
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Rapmoney(m): 5:05pm On Dec 03, 2009
Area! Area!! Area!!!
Warri nor dey carry last, nor be lie.
dem ask fowl why e nor dey ever belleful,
e come talk say na wen e won belleful na im night come reach grin grin grin

I dey hail all my guys 4 warri: Okumagba layout, Esisi, Ekpan,
Jakpa road, Enerhen, Edjeba, PTI road. una too mush oh!!!
Bros Peter, mingwo, i hail you oh!!!

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (Reply)

Meet Wodaabe Men, A Fulani Ethnic Group Who Make-up For Easy Marriage, / Naomi Oluwaseyi Stuns In New Photo / Xenophobia: Oluwo Of Iwo, Akanbi, Protested, Carried Placard In 2014 (Throwback)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 32
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.