Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,311 members, 7,957,806 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 08:45 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62633 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (40) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:16pm On Apr 07, 2009 |
@rotylovy i don almost finish 2 dey compile i know say e go take a while bt d long list dey almost ready 2 invite al those who dey hold us steady 4rm olulu 2 even dat tayo-d both d haters & naysayers,make dem no talk say i dey heady |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:03pm On Apr 07, 2009 |
maedan: My egg-yolk,I sabi say you dey wetin oyibo de call meticulous, U go make sure all are invited so dem go take us very serious. I happy say soon I go de eat your food wey go dey delicious. I beg no forget all those wey dey cheer & those wey dey jealous! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 7:06pm On Apr 07, 2009 |
@Ritimy, Na wa for this man way say I get clue,Ha-tchoo! God bless me too much This sneezing, where hin come from To say na bird flu or cold I catch I still no go dey sneeze like that. Surely this na case of allergy My only way to detect true bullshit Inside wetin Rotimy write and tell There is a lie hin dey try to sell Last week d guy say hin dey too broke To manage money be hin only goal This week hin dey throw dollar around Like I no know what its all about You know from time I dey by your side To marry Maedan my hand dey inside But no try to score a cheap point By throwing your guy under the bus! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 7:20pm On Apr 07, 2009 |
@Maedan, which kain dirty good intentionNow there is some misunderstanding Evident by your misrepresenting Still with you I am not venting Even if your post is upsetting Anyway sha, I shall concentrate Time and effort must not go to waste In God I trust, and in you I must Because we shall soon become in-laws. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:33pm On Apr 07, 2009 |
@tayo d i go take am say u dey apologize but next tym no make my temper rise &pls no dey yab my roty,he no b pauper he jus dey humble which is v.proper! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BonHomme(m): 7:01am On Apr 08, 2009 |
@maeden & roty Abeg una too try i just gbadun una stlye Make una carry go With dis naija love flow as i dey jack dis una story i feel una no need to worry no matter wetin haters wan spring cos dis una love no be small thing |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:01am On Apr 08, 2009 |
BonHomme: bonhomme, you be our good hommie if u know any beta couple, make u show me but i no think say any 2 pple dey wey like themsef pass maedan & roty, we dey sell pass ovation 4 shelf! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:04am On Apr 08, 2009 |
rotimy: verrry nice but i must to warn u say, i no b fantastic cook instead 2 dey stay kitchen, i go dey read book but i sabi prepare indomie well well e beta pass pounded yam wey go make ur belle swell! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 1:06pm On Apr 08, 2009 |
@maedan, but i must to warn u say, i no b fantastic cookWhich one you dey sef Why reveal this bombshell U for wait till after wedding To reveal this shortcoming Rotimy no dey play with hin food Steaming hot, no be one wey don cool Nothing dey remain mama sikira soup Which hin dey chop everyday at noon. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:00pm On Apr 08, 2009 |
Lol @ tayo-d u don come again u 4 know say,no pain,no gain roty must 2 b told im stomach go suffer bt e go get maedan as im blanket cover! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:41pm On Apr 08, 2009 |
Tayo-D: A man wey wan be true man no dey annouce all him wealth, Rotimy no dey very broke, just dey save and dey tight my belt. When I wan insist that our honeymoon must be for Calabar, Abi I no agree to take her to Carribben when she shout "haba"? Rotimy don dey poor before and no wan be poor again, He dey reluntant to throw money around which can't be regain. In dis e-love story, him strong love for de wife dey motivate him, To make his pretty caring wife happy now seems to be his life aim. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:57pm On Apr 08, 2009 |
maedan: My African Princess, Cook or no cook no go be a problem to us, I no go marry you make you come work and tire like a horse. But I think say dat Indomie na for our children wey dey come? Na true na only dat kind oyibo food country man go chop for home? Anyway shaa,I sabi cook very well and go take time teach you gently, When you get belle, I go dey cook all de food and feed you lovingly. You go try read all the fine cooking books and about men & their lives, Even films go help you adjust esp dat series about " Desperate Housewives". |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:08pm On Apr 08, 2009 |
Tayo-D: Walai you be true son of your father, But I get cooking training from my mother. Mama Sikira dey use white maggi dey cook, E don tey I went there to eat or to book. True true I No dey play with my correct African delicious food, I go prove to Maedan say I dey cook food wey dey very good. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:07pm On Apr 08, 2009 |
@roty my lovy jus dey use im discretion he always get smthing positive 2 mention datz y many girls dey jealous me 4 nairaland dey wan dyyyeee bc roty ask 4 my hand!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:20pm On Apr 09, 2009 |
@ Nairalanders, count down to d our e-wedding! Easter Sunday, April 12,2009.10.00AM @ Abuja. If you never get our card. I beg make U no dey sad. Make you drop your name and address, We promise to get to you without stress. signed , MAEDANROTIMY |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 4:37am On Apr 10, 2009 |
@Maedan, my lovy jus dey use im discretionWhich kain yeye descretion Let me bring to your attention Person wey like humility No go marry Maedan the beauty Person wey drive Bentley go turn head Especially if hin go Ajegunle Maedan too na head turner Hot mama, like Tina Turner Like many people, me sef I wonder How Rotimy manage be your lover But if I dey think like that Wetin I go say for Ojukwu and Bianca I know money fit do anything Bring together, Beauty and the Beast Seal and Heidi Klum tell me say With money, you go get the whole package |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by princesa(f): 11:19am On Apr 10, 2009 |
was up all of you am loving thia hread invincibly Maedan a lady that rule supreme nice flow u got whatever language to use nice up rotimy too and tayo d i never could rhyme in pidgin not my knack besides my fire is out i can t even rhyme for a money sack later then |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:33pm On Apr 10, 2009 |
princesa: Thanks for de encouragement, I go soon hear of ur engagement And me & Madam Maedan go come for enjoyment. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:41pm On Apr 10, 2009 |
Tayo-D: Maedan dey make my heart yori-yori, And our royal marriage go be jolly-joli |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BonHomme(m): 11:56pm On Apr 11, 2009 |
i just dey coutdown to d wedding of roti baba and sweet maeden dis na true NairaLand love story na baba God we give all the glory |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:29pm On Apr 15, 2009 |
I jus say make i hail evryone as i dey enjoy 4 d carribean sun dis honeymoon no get equal i beg make una watch out 4 d sequel!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:49pm On Apr 16, 2009 |
To marry the person you love and enjoy your honeymoon dey cool, Maedan sweet love don turn me to an aje butter from de old school |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:45pm On Apr 20, 2009 |
@ all this na the official thank u message to all of una wey pray for the smooth passage of dis our naija luv rhyme journey and who kept us company during d romantic tourney big-ups to those who attend the wedding there was plenty plenty happy tears-shedding! my good friend[b] olulu,[/b] i no go eva forget u even meexteriox, so mysterious hope u no still dey too furious to the babes akaraoku, moyola and firestar plus including oluwdashmi and stillwater and especially the sweet-talking princesa i don take am say i be una e-sista i remember jollof, who add im own curry & thyme to sweeten our aromatic love rhyme not forgetting pureminded and deoye05 una try as u keep the dream alive! djlimpse & lagbaja, safex101 & cvibe no matter d distance, we all be d same tribe vanosa and kingzli, chuckdee and nuzo kidgenious, chubistone and plus ashmanpolo i hapi say una make sure me & roty no go solo! ebami007 wey talk of d girls of warri make u carry all d good tidings back with big lorry! greenman, hope u enjoyed d fairytail ending now u see say, we were neva pretending! ascony and denony na una make am more funny to heyo, wey bring im own hip-hop if u still dey vex4me, pls make u stop then bililis and zillionair, and of course bonhomme i happy well well say una come of course, tayo-d, malthuss and dimitri una really help us in d making of history last but not least, lexdino and dalaha una come see say, all tears don turn to laughter in conclusion. make i make dis resolution say no matter wot, i go always continue to mention all of una in my morning prayer make Baba God always cover u with Him Strong Layer!! p.s. e good to dey proud of our pidgin culture make neo-colonialism no overtake us like hungry vulture we must to always promote our rich heritage make history remember us with high percentage! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:33pm On May 26, 2009 |
For all of una wey make dis marriage divine, I go send una two kegs of African palmwine! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:15am On May 29, 2009 |
rotimy: palmwine na for drunkard u wan make our pastor ban us for d churchyard instead we go share plenty new naira wey CBN governor dash us for Zaria i try now, e don tey u know |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:54pm On Jun 04, 2009 |
This tin wey una start so, no be only una go enjoy am oh. . . . God forbid bad tins, I been think sey I wan read about love & sins. . . . . Na im I waka kuru kere enter this thread, See kolo inside everybodi head. . . . Maedan & rotimi, road una no lef for we. . . BonHomme & Princesa, sef come follow donate to d kasala. . . I wait small look again, na wetin i see, like play, like play na Tayo-Dee. . . . . Ol' boy, no do no do e be like sey na swine flu. . . . cuz me sef don siddon dey type, my craze cure sotey e dey ripe. . . . . my hand dey pain, shirt don stain. . . . . but wusai i no go carry last, to give up na tory wey don past. . . . . . me sef i must write my own, if u no like am make u bone. . . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:35pm On Jun 04, 2009 |
RuuDie: how we no go like am as u too come join d naija luv jam but how u come call am swine flu e be like say u no get d clue how this thread come be an inspiration and last last, a nairaland pidgin sensation! u fit be last, but not d least congrats as u enjoy the rhyming love feast |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:14pm On Jun 05, 2009 |
maedan: erhm. . . erhm, no fear i jus dey clear my throat, no go think say i be ewu-goat, to all una wey start am, dis no be beans talk or yam tu'gbaski to all una, later we go jam for iya basira corner, madam maedan I thank you very much, as greet me so my heart jus flash waaaa like torch, una do well for this kain jolly wey una arrange, as e be say man jus dey manage, na die to keep bodi and soul kan'pe, to stand fit omo gats take se'pe, night and day na hassle, if no be brain na muscle, economy don wear jacket, no show for omo boy racket, evryday nuttyn for pocket, but yet we can cry full bucket, evrywhere for town people dey fear fear, but anytime i waka enter here, omo na heaven, i fit tan'da here till eleven, mind no dey to tire, na only down the keyboard go dey fire, even if this we small market no sell, una too try well well. . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:13pm On Jun 05, 2009 |
RuuDie: na wow abi na wa, i no know which one i go talk see as ur poem long an' sweet pass jack & im beanstalk i dey wonder dey ponder where u dey all dis while u for don dey on top of the pidgin rhyming pile 2nd to my roty of course u know with him na beta 4 worse as d rhymes don dey mature from the love zone come enter into a more serious life tone in fact, i too much appreciate how d economy don depreciate people dey waka around with a big frown and blood pressure dey rise all over d town but as u talk say, for here u find comfort, i happy say u dey recommend our effort to put a little smile for the face of the masses and crack d ribs of both the low and high classes i mean dem dem wey think say we dey too local to dey rhyme for this naija pidgin vocal as always i go say, make we always dey real b4 our beautiful identity, westernisation no steal |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:29pm On Jun 05, 2009 |
na now i understand, why my roty say make we always dey prudent becos when suffer go come, e go teach u lesson like jamb student now wey d economy dey bite with im credit crunch and person no fit buy one whole plantain bunch I happy say we remember to pinch and manage Or else, after d big society wedding, nothing for remain for us to salvage! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:11am On Jun 06, 2009 |
No need for me to repeat I no go even try say I wan even compete, Becuz I know say my own go be defeat, you and roty na stew and meat. . . . no matter how e be ma mind no jus reesh, me i be student na una dey teesh roty na shark me i be crayfish, if i tranga too mush d end na inside dish, as per the love matter me still dey wish, to find that babe wey go complete me finish. . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:52pm On Jun 06, 2009 |
Madam maedan me soji say u na correct, no need to vote na u i go elect, something dey worry my brain, and i sure sey u get d melecine 4 d pain, abeg neva hiss, me know say u no be pastor chris, i know sey u can fit helep me, na who wear shoe know as e dey be, i don culee arrange d wahala list, but b4 i give u d gist, i dey feel sey make i first collect oga roty allowance? becuz i dey fear 4 im annoyance, abi make i begin download, dis matter wey don carry me enter road. . . . . |
(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (40) (Reply)
Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 77 |