Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,291 members, 7,954,164 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 01:29 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62609 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (40) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by oluwdashmi(f): 3:41pm On Apr 02, 2009 |
@ the NL intending couples na ur choice of inviting onyenka for vibes to give us rhymes of different tribes makes me think we could dish in some jokes as people dey drink their bottle of cokes what if some comedians con do their jokes like that leaving in us memories we no go fit format so te e go pass night of a thousand lafter make u think of that and lets organize that after |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 6:54pm On Apr 02, 2009 |
@Maedan, jus 4 d record,no get d wrong impressionEven though u talk say u go put me on trial I take style reveal wetin dey your oblongata And thru d demonstration of my shakara I don know say u be correct gal! Tell your sista say she no need d reserve I fit guarantee to play an extra half After the full time, na so she go dey shout 'Cos I go still dey stand after penalty shootout. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:47pm On Apr 02, 2009 |
@oluwdashmi hw i go 4get my right-hand chick hope u don decide d bridal colors we go pick i no mind golden green and burnt orange or bright shocking red2 give us courage i hear say u go help organise d buffet in dat case i go arrange am so na u go catch d bouquet!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:01pm On Apr 02, 2009 |
@ tayo-d e don reach d stage 2 give u commendation na only u persist with all concentration e seem say, u b d kind dey call "finisher" so far, IF u get my sis,u no go turn 2 "punisher"!?! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 9:15pm On Apr 02, 2009 |
@Maedan, Dem call me Mr Lover Smooth talker, not a Punisher The more you get to know it Na so you go dey feel me! Naughty no dey my nature Look well, no indignation And if you see my future U go see your Sista feature! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 10:33am On Apr 03, 2009 |
na wa o for dis thread, i dey trip e dey make me wanna skip take care to keep am going make sure no space 4 overthrowing! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:40pm On Apr 03, 2009 |
oluwdashmi: I never come shake for de sake of other men, As dem fit try their luck on plenty of other women. Maedan no be de type dem call girl next door, She agree to marry me when I dey very poor. Because I dey very bold to tell her de truth from day one, E come dey hard for Heyo & others to truly turn her on. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 3:53pm On Apr 03, 2009 |
sugabelle: Make u no skip de trip for Abuja come Easter Sunday, The Rotmy-Maedan wedding go give you joy all day. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 8:08am On Apr 04, 2009 |
rotimy: nice i just dey feel ur ringtone e for nice to add my own to the love zone but i no wan maedan to break my head if i try thief her roti sweetheart 4rm this thread |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 8:46am On Apr 04, 2009 |
Chei! The next episode of super story be say The clanking gongs of nl's towncriers of Mae and Roti's wedding day I hope say una go sing lyrics, inspired from Roti's cynic critics! Chorused by well wishers, friends and family. . . De song go reach top music charts for MTN, Music Africa and Soundcity. . . Abi? Yu gree? |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:26am On Apr 04, 2009 |
sugabelle: lol madam sugabelle, make u think well well i know say u dey joke, so i no go carry d yoke i dey busy dey write up all d invitation wey go attend the special occasion so i no get time to break ya head i go dey plan for my wedding instead! but if u want, u fit try ur luck tho i kno say with me, my roty don dey stuck! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:30am On Apr 04, 2009 |
Tayo-D: no vex say i no reply since all dis time e no easy to dey always rhyme i get a lot of shopping to do i neva even buy d wedding shoe in any case, my sista still dey on hold to be captured only by d one wey dey v.bold! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:36am On Apr 04, 2009 |
firestar: how i no go gree so far u dey wish good thing 4 me! e go sweet if i make some pay from d effort at least after d wedding, we go still need to live in comfort so i no mind make we release an album if e sell well well, i go know say, d good times don come! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 3:57pm On Apr 04, 2009 |
***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN*********** [color=#990000][/color] Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto, My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto. Your face no just dey very fine but na shining angel face, No beauty contest you enter which u no go win the race. Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise, And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice. You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer, And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer. Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach, And when we marry I go take time and lick them inch by inch. Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya, And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya. With only one week to our speacial wedding, I wan promise that our love go be unending. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 4:30pm On Apr 04, 2009 |
Posted by: rotimy Insert Quote ***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN*********** Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto, My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto. Your face no just dey very fine but na shining angel face, No beauty contest you enter which u no go win the race. Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise, And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice. You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer, And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer. Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach, And when we marry I go take time and lick them inch by inch.Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya, And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya. With only one week to our speacial wedding, I wan promise that our love go be unending. @so disgusting brother, |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 4:35pm On Apr 04, 2009 |
Posted on: Today at 03:57:47 PMPosted by: rotimy Insert Quote ***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN*********** Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto, My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto. Your face no just dey very fine but na shining angel face, No beauty contest you enter which u no go win the race. Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise, And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice. You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer, And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer. Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach, And when we marry I go take time and lick them inch by inch.Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya, And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya. With only one week to our speacial wedding @roty dats so disgusting brother ur sexual tactics are like those of a villager, yulk!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:11pm On Apr 04, 2009 |
@ heyo i no jus understand i think say u b civilized man those very lines u dey call disgusting be d kind wey dey last without rusting na so he take capture me 4rm d 1st page so i beg make u save ur rage me wey don already write ur special I.V. Card bt now i go tear am bc ur heart too dey hard |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:21pm On Apr 04, 2009 |
@ my romantic, caring, sexy & CIVILIZED rotimy, sweet'art, pls no mind heyo, e no get clue, about d diamond wey dey deep inside of u na ur kind humble guy dey get all d chicks wey hot, while d show-offs dey get d back of pot. In fact, na dat ur poem we go print 4 d wedding programme make pple see say u truly luv ur maedan! ***kisss*** |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:07pm On Apr 05, 2009 |
maedan: ))))))))))))))))TEN WORDS TO DESCRIBE MY MAEDAN(((((((((((((((((((((( Princess Priceless Gift Lift Diamond Almond Rose flower Mind blower Lovely Maedan My only Madam |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:18pm On Apr 05, 2009 |
maedan: I beg you my love make Heyo still get our speacial card, Two people at the time no de show say dem dey mad. No matter wetin e say he no go succeed to me make sad, Make e come dat day look as Roty & Maedan go[b] kiss [/b] hard. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:31pm On Apr 05, 2009 |
heyo: Bros wetin dey disgusting for couple wey don marry? No be anyhow dem like am na so dem go try & no tarry? When you marry your own, make you no kiss d mouth but her toe, No matter how you abuse or curse me, I no go ever be your foe. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 9:15pm On Apr 05, 2009 |
@Maedan, no vex say i no reply since all dis time Your silence has been astonishing And your reply is no less comforting Per your Sista I am still pursuing Though her hand you are witholding He dey hard to always rhyme No matter how hard a broda try But so far luv dey abound Inspiration go come around. Good luck on your your shopping spree But tell me who dey pay the bill Rotimy talk say hin no get any dough How u come dey manage am so? Let me know if you need a sponsor I know one for the city of London All dey need is a night with the bride-to-be And with dat they go meet your every need. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:16am On Apr 06, 2009 |
Tayo-D: see dis one, i no blame you dem say in d end, person go talk true from ur words, i see say u fit cause a lot of strife na so u suppose yarn to person wife? anyway, my roty no talk say e no fit afford, he only say make we manage in one accord even millionaires dey spend their money with sense abeg my guy no come here dey yarn nonsense |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:24am On Apr 06, 2009 |
rotimy: so i be a princess wey dey priceless and a gift wey dey give person heart a lift? diamond wey dey like almond, na only me? even a rose flower and mindblower -chei, see me see i sure say u dey sweeten me up for that our honeymoon u wan make sure we rock am pass d one for mills & boon no wahala, as an e-hubby, u go electronically enjoy ur maedan and then carry am go ur house make i come be your madam! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:56pm On Apr 06, 2009 |
maedan: }}}}}}}}}}}}}}DAYS AND NIGHTS OF OUR HONEYMOON{{{{{{{{{{{{{{{[ Days of lovely laughter, Nights of inimate matter. Days of sweet kiss, Nights of honey bliss. Days of watching de waves, Nights of making de moves! Days of feeding each other, Nights of loving each other! P.S, Onyeka Onwenu for our show charged five hundred thousand naira, I do pay am and she promise her best for people from land of naira. Pls suggest the man of God wey go officiate for de Church, Dem be so many now and I want de best from de bunch! My travel agent don book our 1st class flight to Island of Bahamas, De beach of that Caribbean and their hotel go make us go bananas |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:11pm On Apr 06, 2009 |
Tayo-D: |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:15pm On Apr 06, 2009 |
rotimy:@ TAYO-D Na before Rotimy say he no get money, But God come butter my bread with honey. I no fit afford all de fine things in dis world, But I not fit leave my sweet wife naked for cold. We dey take wisdom dey spend for dis marriage, Maedan na very good wife who know how to manage. Tayo, you kin sponsor na type wey get big K-leg, because your type dey pursue person's wife with him 3rd-leg |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 6:18pm On Apr 06, 2009 |
@Rotimy, Na before Rotimy say he no get money,If to say you use the "big" qualify my 3rd-leg I for no tell everyone say your tory get k-leg Abi you don go London go see that marriage sponsor 'Cos this sudden money you jam dey raise big question. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 6:37pm On Apr 06, 2009 |
@maedan see dis one, i no blame youSee me see wahala, abi na trouble Why this unnecessary hustle and bustle You overlook my very smart and good intention Designed to help you for your special occassion I say I know a generous sponsor No be by force by force make u concur All I know be say u get power to choose If u no like am, make you just press snooze No be say I wan cause any wahala But funding a wedding no be small matter As for Rotimy, hin don catch my clue Him luv don drive am to love-vendor for you |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:22pm On Apr 06, 2009 |
Tayo-D: Na wa for this man way say I get clue, May be him dey suffer from de bird flu. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:03pm On Apr 06, 2009 |
rotimy: lolxxxx Tayo-D: which kain dirty good intention with all d useless ideas wey u dey mention as for roty pimping me, thenk u better than 2 self-love-vendor which is wetin u dey do i go advise say make u just stay ur own any good chance u for get 4 here has flown! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:05pm On Apr 07, 2009 |
@ Nairalanders If you never get our card. I beg make U no dey sad. Make you drop your name and address, We promise to get to you without stress. signed, ROTIMAEDAN |
(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (40) (Reply)
Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 93 |