Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,150,838 members, 7,810,219 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 12:31 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61108 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 3:44pm On Mar 29, 2009 |
heyo:Walai countryman no get any time for your english, Because the whole thing dey sound like gibberish. I don finsh the sharing of cards & now wan hire the reception hall, Mature men no dey see love as a civil war or a game of football. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 3:57pm On Mar 29, 2009 |
maedan:2 my mama maedan I be de true son of my father wey be an ogbenga fighter, But my Papa warn say de fight for a woman go dey tighter. No be say I no go defend you when you don become my wife, I go do so at any time and for you I go even lay down my life, But person wey wear him fine clothe for body no dey pursue a naked man, I no dey shake for any competition as you don assure me U be my woman. The news dat you go soon be the mama of my pickins come sweet me for head, As I pass one super market today I come take style ask the price of baby bed. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:06pm On Mar 29, 2009 |
heyo: Chai, a butterfly dey think say e be bird because e dey fly, A small wey throw him elder for ground na him go first cry. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 7:04pm On Mar 29, 2009 |
rotimy:gbam!! @roty these young pretenders de on a serious long ting |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Chuckdee(m): 9:44pm On Mar 29, 2009 |
;d :d ;d |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:54pm On Mar 29, 2009 |
I try my best 2 put enuf welcome banners, make al of una no tink say i get bad manners i try make una feel at home but now una dey throw me stone, by putting san-san 4 my garri, wit my roty wey i wan marry i blive time don reach2 face my wedding plans, &4get heyo&bililis wey claim2 b my fans! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 10:55am On Mar 30, 2009 |
Chai this rhymn dey make flow i dey flow like boat upon the hill How i wan put things right now maedan i think say we dey pursue the same rat now u say my leg looks like that of the rat Your sister i must hook up with whether u like it or not abi u wan make i pure san-san for your mat. Your sister self don dey die for me but she said she need your go-ahead order and u are redirect my emotions. am in motion for emotional notion a gigantic conflageration is engolfing my domiciliary habitation of love So maedan gravitate here with trememduous acceleration and alacrity Maedan dear i need no competitor unless you want me to divert and redirect my emotion to having you now instead of your sister and if i do, bet me nobody will put a stop to it cos' i must have you to the fullest am trying to be good, just hand your sister over to me or or or @ Billis, Heyo and Roty This is clash of the titans Fight to the last Roty started the fight now lets see who will wins |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 11:53am On Mar 30, 2009 |
@ denony Chai, a butterfly dey think say e be bird because e dey fly, A small boy wey throw him elder for ground na him go first cry. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by dimitri(m): 12:03pm On Mar 30, 2009 |
where the hell did u come from? @ heyo you just come here de yarn opata trying to cause kasala for this whole matter. me na proper naija guy no be fake mushine butler wen de here de form aje butter like u. @ Maedan I Still de wait make u sister feature so i got fit put her for my picture together we go go into the future even heyo no go fit punture. even with the situation in our country when don make things go awry make u tell ur sister say she no need worry because i go make sure say she no go hungry even if e means to join dangote lorry come go de work for quarry in oder for her not to 2b scary, all she need do na to tarry because for my stew, she go be my only curry and last last, na she i go marry. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:03pm On Mar 30, 2009 |
denony: Country men and dem women, make una come see me see trouble, How man wey propose to a woman for marriage wan enter a rumble? E don reach the stage now when my sweet sugar come dey grumble. These boys don try to disrupt our marriage plans but dem go stumble. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:17pm On Mar 30, 2009 |
maedan: Mummy,You don try for them no be for small, All of dem want My Maedan both short & tall. You be fine flower wey dey open for de sun, All incests wan come perch & others wan born. Make you draw the lists of officials of de day, Because in this marriage you go dey have a say! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 5:35pm On Mar 30, 2009 |
Roty why you dey shiver like say u get fever because now i wan shizzle cos i gat the brizzle and the gizzle |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 6:25pm On Mar 30, 2009 |
Wetin be all dis na? Na who dey try put asunder - for loff wey dey tey? Maedan oya make una dey ansa my question na. Na yu ga-an dey inspire me so , Shuo!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by dalaha: 6:35pm On Mar 30, 2009 |
i dont know how i read this to the end but some one has to pay for my time if not i would take this script to nollywood and make some pay for my time hope u would buy the movie it would be coming out soon when i find maedans real huby and make him break up with her then adobe rotimy with my x girls naked pic and mail it to maedan , there has to be an end and i smell heart break the only thing missing is a bad guy in this plot so i guess i'll be him |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:06pm On Mar 30, 2009 |
denony: Rotimy dey healthy and he no dey shiver as he get fever, Maedan love for me dey strong and dey flow like Naija river |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:24pm On Mar 30, 2009 |
dalaha: No be today you begin dey smell things like rat and heart break. But soon you go come jolly for our wedding and eat our cake. Almajeri na de bad boy wey dey cause wahala for de North, For the East we come get Ofeke wey de behave as him be nut. West get im own Alaye wey day take violence as their handiwork. Even in South de militants and kidnappers dey talk bad guy talk. But me and my Maedan no go mind them as our wedding day dey tick for clock |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:07pm On Mar 30, 2009 |
rotimy: thenk u, my darlin, i don dey do d shopping, i also go meet caterers to plan d things 4 chopping no matter wot, do show must continue so make u quick go rent d fine venue |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:15pm On Mar 30, 2009 |
dalaha: dahala, abi make i call u "wahala" no take enjoyment 4rm planning kasala cos nothing dey happen, i stand gbam gbam for dis e-romance, u wan sing what-a-bambam make you come be d paparazzi wey go cover our wedding kamakazi and as for all ur time wey u don spend u go get am in dollars wen dis saga end! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:20pm On Mar 30, 2009 |
firestar: firestar, my sista no1 fit put us asunder keep watching, no shaking d marriage is in d making! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:31pm On Mar 30, 2009 |
@denony na abeg my friend no dey stress yasef just hang all ur troubles on top d shelf n sit dey watch my own superstory n join me in d end 2 say, "2 God b d Glory! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 11:59pm On Mar 30, 2009 |
@dalaha dalaha, ur name makes me wanna laff like ha ha ha wat tha hell r u talkin about? hommie u wanna put an end 2 this? let me giv u a benefit of doubt u r no bad guy n ur nollywood jokes r dry u don't reveal ur ulterior motives 2 da public hommie u conceal n do wat u wanna with no gimmic since u need the bad guy throne,its yours i am tired of this sh**t,am goin offshores do ur thingny cuz this is a freestyle thingny wolaa!! @dmitri wateva!! @roty left ur chic 4 u,cuz what must be must be and in case ur wife gets kidnapped on dat day,dnt think its me there a lotta bad guys in hurr now so i think i must take a bow do ur thing homeboy heyo thinking out loud (why am i quitting? maybe its my mood today,well let's see how my next mood would be like) aight homeboy,i can see u r stubborn well this sorta love isn't common cheers!! @maedan making a huge mistake marrying dat bloke i know u r buying ur gown on credit cuz ur man is so broke like beyounce 2 jay-z,i wanted 2 upgrade u but village boy roty is gonna outdate u am gonna find me some hot models and freek in expensive hotels and leave u guyz da hell alone u cant pour water 2 melt a stone una get stronghead let me tell u,u n roty aint match made in heaven u r too hot 4 dat guy seems u were cooked in tha oven well i gatta bounce, u still gat billis 2think about cheers!! @malthuss hey dude,remember me from hybrid-x''s star-wars some time ago? yeah u good with lyrics,y don't u show maedan wat u gat,she's gon melt maybe N.B; ain't nobody talk smack about my exit,it was part of the script |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 9:05am On Mar 31, 2009 |
Now i have seen the end of the saga Heyo is bowing out with a testimonial song Love can't be bought with gold nor silver It is extremely priceless It's something you feel inside, heart convenant. thats why u see some people kill theirself becuase of love chei Love is powerful. So guys can you all do a massive bow Lets arrange this wedding for Roty and Maedan They are the best couple of the year in Nairaland. As for me all i need is Maedan sister as my reward to this whole saga. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:32am On Mar 31, 2009 |
dimitri: e dey good to b so determined, but plenty still dey to b ascertained u sound like say u get strong mind to give a babe everythin' she dey find even if e mean make u wear rag, she must to drive d finest jag anyway, i go see wetin i fit do dis ur kind ponmo go dey hard 2 chew! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:34am On Mar 31, 2009 |
denony: |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:36am On Mar 31, 2009 |
@ denony d only reward wey u deserve na d rice n stew very plenty wey we go serve d wedding no too far again, just help us pray make u save ur fight 4 my sista for anoda day! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 11:37am On Mar 31, 2009 |
denony: Na massive bow Rotimy and Maedan go chop? You no hear say things don too cost for shop? Our own wedding no be rice and stew very plenty, We go need massive gifts make we no go empty. I go help U see U win de love of my sista in-law, Because from your poems, U no be an out-law. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:40am On Mar 31, 2009 |
rotimy: ah ah, roty my baby why u go dey disgrace me i don already promise denony chopchop now u dey ask am make he go dey shop shop if gifts go dey, good, if not, no stress all i need b say, make d guests dress to impress |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 11:45am On Mar 31, 2009 |
maedan: Because na your day, I no go put you for disgrace, I go make sure that our fine guests we go impress. No be only rice and stew go dey plenty but meat, Make Nairalanders come jolly and see plenty to eat. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:51am On Mar 31, 2009 |
rotimy: yes o, to satisfy d guests na im dey beta make dem no come reject our invitation letter i go make sure we go put them first esp those who stand by we for our time of test |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:01pm On Mar 31, 2009 |
maedan: I come dey think say I dey for another world, How your advice come de help us work in accord. We go make sure we keep strong our super bond, Because we go always be the the first no be second. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 6:33pm On Mar 31, 2009 |
Na rice and meat i go love? Chei see me see wahala as my good job wan land me for nothing see as maedan and roty wan turn me to Aaron But i reject to be Aaron rather let me be lenon cus now i don gree to canon now or the day of the wedding camon Roty fight for this gizzy cos i need something fishy and that is maedan sisy My love i go give that chicksy and she go enjoy am like chinggy Maedan dear are u sleepy ur sister will have my love full of candy her shopping go be only in the Mr. Shaggy Shoppy where go get her shopping fascinating try and do somethingy snapy cos' ur sister is highly needed by denony and i no go loose sleep on this very thingy |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 9:45pm On Mar 31, 2009 |
Walai talai I must confess This puppy love gat me impressed Maedy and Rotimy dearest Your lovin' is of the purest! I came on nairaland to spend a minute But this thread has kept me busy I clicked page one to catch a clue Now on page seven, I think I'm glued! What shall I say to my Boss Who paid me today to do some work I began the day designing power lines But here I am writing love rhymes! |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)
Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 77 |