Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,164,219 members, 7,856,885 topics. Date: Tuesday, 11 June 2024 at 08:47 AM

Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! - TV/Movies (101) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / TV/Movies / Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! (207100 Views)

Big Brother Africa 'hotshots' Official Thread / Big Brother Amplified (The Official Thread of BBA 6) / Big Brother Africa 4 (The Official Thread) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (98) (99) (100) (101) (102) (103) (104) ... (179) (Reply) (Go Down)

Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by akinsadeez(m): 8:19pm On Sep 26, 2010
hope dere wnt be nominatns 2moro.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by preshizeee(m): 8:20pm On Sep 26, 2010
Best thing na 2 send d bombo raggae man & d won dem burst im mouth na both of dem sure pass , as e dey we don loose TZ Vote
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 8:23pm On Sep 26, 2010
@ l. luciano. I get una logic but if u don dey read my analysis since dis show don start, u for understand say mumu too get mouth for all those sadc countries (except Angola thanks to Ricco). even d time wey mal vote for guitar man, na because say dem (mufc) no focus there. Trust me when final hour reach mufc go claim all those obodos no shaking. abi mozambique wey don dey vote Sheila, Mwisho, Uti follow mnc, dem no abandon their pesin (Jen) come follow mufc 2 weeks ago. D best thing na say make you hope naija boy fit hold d one wey he get for hand, or transfer am to pesin wey fit beat mumu (if him comot). But if una come support sadc people to return, if fit be say d some of d obodos wey naija boy get, go vex comot from your fragile alliance. You know say GH, UG, TZ, MOZ and ROA don support mufc well, well before. Madam bakassi wey get 6 votes against bushman, no be because of mufc she get am, abi cricket wey 6 votes against naija boy no be because of mufc. cricket wey dem suppose don evict if not for fake eviction come dey get a whole 6 votes. Na d power of mufc help these 2. Leave dat thing pple, mumu go claim at least 6 sadc votes no matter wetin una do. unless him fvk up well between now and d finals, una no go fit split him votes.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:25pm On Sep 26, 2010
preshizeee:



Best thing na 2 send d bombo raggae man & d won dem burst im mouth na both of dem sure pass , as e dey we don loose TZ Vote

Me I tink say na bombo & ekebe mama naim be d surest bet. Dem no lef dem pips O!
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by preshizeee(m): 8:32pm On Sep 26, 2010
rovert:

Me I tink say na bombo & ekebe mama naim be d surest bet. Dem no lef dem pips O!
any thing wey we dey do we must snd d won dem punch enta d house bkos na dem dere dat mumu get fans wella
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:33pm On Sep 26, 2010
Whateva happens, make we lock down the 8 wey we get now. Leave TZ for bushman; Bots for follow Mumu so make we put guitar man to shake im obodo. Make we give Igwe the best chance abeg!
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 8:42pm On Sep 26, 2010
@ Montelik, na which level u dey na? u just dey yarn wetin dey discourage person. abeg abeg abeg .
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Ambber(f): 8:43pm On Sep 26, 2010
@montelik, so wetin be d conclusion of your tori? if Mumu don corner some adugbos abi na obodos make we sidon dey look? everybody just dey try make dem hol their own as u dey fear dem na so dem dey fear you. we don too try to come dey shake now. we go go dey shout for every madu say na we no wan thumb their pikin back for house? if una hol moth do wetin una wan do. I still think bakassi should waka go duplex. the obam babe fit make our boi commit something wey go spoil im chance. if una like add Jen just to make color she no go comt anybody thumb print
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 8:47pm On Sep 26, 2010
rovert:

Whateva happens, make we lock down the 8 wey we get now. Leave TZ for bushman; Bots for follow Mumu so make we put guitar man to shake im obodo. Make we give Igwe the best chance abeg!

That is a better approach. Concentrate on holding what we have. 8 beats 7 no matter d %. All that wan wey be say una wan commot from mumu's 6 - 7 obodos, no go work. D performer wey dem bring from madam bakassi's obodo, when dem ask her say who she like pass, no be mumu she talk. She no even mention her country woman. Trust me mumu is just too popular in that side. Since when una dey try to invade all dem obodos with numerous attacks, una ever see end result.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 8:51pm On Sep 26, 2010
My persons, make we dey follow the straps, dey take mouth 'vote' for lesbo, so dem go still dey think we dey for them kampe. But na kurukere we go take finish the rest. Me  I support make we vote that babe, cos I know say whether we like am or no, she go return, so make we remain loyal. But make we come put san-sand for inside mumu people gari, by using kurukere to also vote in mama africa. Dat way, mumu go definitely lose 2 obodo out of d 6 wey im get alredy.

My persons, make we dey careful so other obodos no go tink say we dey selfish. Rmber wetin happen to bushman, after e don show say hin dey desperate to win last week wen he dey fight our boy. Africa dey see all these tins o. So make we maintain say we dey loyal
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 8:55pm On Sep 26, 2010
So we don agree say bakassi babe go take one slot . and we don agree say NO slot for lesbo . what of d other slot?
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 9:01pm On Sep 26, 2010
E no go good make me abandon Obama pickin now o. E go too show sey we dey play other obodos. I for say make we suppot am, but for the finals, make each person bear im own papa name. I sure say d babe go only get her own obodo, but if we come dey show ourselves now, other obodos fit abandon us too.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 9:10pm On Sep 26, 2010
I for advice say make try arrest ROA and the obodo of mama monkey using our kurukere because e dey risky to depend on just dose 8.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 9:11pm On Sep 26, 2010
I for advice say make try arrest ROA and the obodo of mama monkey using our kurukere because e dey risky to depend on just dose 8.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by preshizeee(m): 9:13pm On Sep 26, 2010
ANY THING WEY WE DEY DO MAKE WE MAKE SURE SAY OUR DECISION NA D SAME WITH UTI FACEBOOK FANS AND TWITTER FANS
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by preshizeee(m): 9:17pm On Sep 26, 2010
preshizeee:

ANY THING WEY WE DEY DO MAKE WE MAKE SURE SAY OUR DECISION NA D SAME WITH UTI FACEBOOK FANS AND TWITTER FANS
SO WE NO GO SHARE VOTES
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 9:25pm On Sep 26, 2010
My people no be say i wan discourage una, but d truth is bitter. mumu don do him home work since before him enter that house. From d one wey be say he dey nominate far away countries and never nominate from sadc, to d one wey him come dey befriend cricket. D boy wey know say him get mad fan base for sadc (una see Meryl's aunty dey check him out wink)and he don tour all these countries before he come enter d house. Even when bba revoultion hms dey campaign madly for Jen, dem still no fit dent am. Oh boy d truth is bitter, mumu is very powerful in sadc and all the hms from his region no just be am at all, dem no fit compete with am.

My people loyalty is what brought us this far. From 3 votes with Meryl, 5 votes with Sheila to Uti now commanding a consistent 8 vote majority. See what disloyalty and opportunism has done to bushman mogoro. Only 1 vote, even d east africans abandoned him because of him and his country peoples behavior. It is d alliance we built through loyalty that has brought mumu down from 12 - 14 votes to now 6 - 7 votes. If we start trying to be too scheming like mufc we will start losing votes d way they did as well. Do you think Moz would have supported Uti this round if we hadn't saved Jen from an embarrassing 15-0 drubbing. Before we start to dey over-calculate just look at Mwisho who went from 9 votes to 1 vote in just a few weeks because he started being too smart for himself. Food for thought.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 9:28pm On Sep 26, 2010
preshizeee:

SO WE NO GO SHARE VOTES

SO WHO GO TELL DEM FOR TWITTER & FB SAY NA WETIN NAIRALAND TALK? ABEG WE NEFA AGREE WETIN WE WANT - GUITARMAN & IKEBE FOR SURE. WE FIT THROWAY SOME FOR OBAM SIS
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 9:32pm On Sep 26, 2010
montelik:

My people no be say i wan discourage una, but d truth is bitter. mumu don do him home work since before him enter that house. From d one wey be say he dey nominate far away countries and never nominate from sadc, to d one wey him come dey befriend cricket. D boy wey know say him get mad fan base for sadc (una see Meryl's aunty dey check him out wink)and he don tour all these countries before he come enter d house. Even when bba revoultion hms dey campaign madly for Jen, dem still no fit dent am. Oh boy d truth is bitter, mumu is very powerful in sadc and all the hms from his region no just be am at all, dem no fit compete with am.

My people loyalty is what brought us this far. From 3 votes with Meryl, 5 votes with Sheila to Uti now commanding a consistent 8 vote majority. See what disloyalty and opportunism has done to bushman mogoro. Only 1 vote, even d east africans abandoned him because of him and his country peoples behavior. It is d alliance we built through loyalty that has brought mumu down from 12 - 14 votes to now 6 - 7 votes. If we start trying to be too scheming like mufc we will start losing votes d way they did as well. Do you think Moz would have supported Uti this round if we hadn't saved Jen from an embarrassing 15-0 drubbing. Before we start to dey over-calculate just look at Mwisho who went from 9 votes to 1 vote in just a few weeks because he started being too smart for himself. Food for thought.

NA FOR WHERE BUSHMAN GET 9 VOTES? I HEAR WETIN U TALK; 9JA GO GIVE AM TO OBAM SIS BUT ALL ODA KURUKERE VOTE MAKE PUT FOR IKEBE & GUITARMAN
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by lluciano: 9:41pm On Sep 26, 2010
rovert:

NA FOR WHERE BUSHMAN GET 9 VOTES? I HEAR WETIN U TALK; 9JA GO GIVE AM TO OBAM SIS BUT ALL ODA KURUKERE VOTE MAKE PUT FOR IKEBE & GUITARMAN
Make Baba God slap with you with plenty blessings! You are on point mate!
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by jejelolatu(f): 9:54pm On Sep 26, 2010
Hey pplz, na wa to una, so na to dey yarn for broken inglis now. all join sha, make una 4giv me in advance incase d yarns no tanda well 4 d page. . . . Lol, i'm loffin dis.

Ehn ,NL pipo, e be lyk say montelik dey yarn correct o, Na loyalty Uti + Nigerians don take reash where we dey so o, make we no com take desperado moves spoil am now o.

Me i bin feel say make we jus organise our votes giv obama pikin out of appreciatn for d way wey dem don stand gidigba for Uti/MNC back. Any oda kurukere waka wey we do go be for mama africa.

if we go yarn true talk giv ourselves, dat mumu don dey Biggie default to win and im SADC pipo no dey take im matter play at all, d only wey to stand d chance of winnin na to just remain loyal to our allies and hope sey for d final week, we go fit ginger enuff Naijas for d diff obodos wey dem dey to use all d machinery wey dem disposal to do kurukere waka toh behd.

For now, make we remain loyal , so even if (God Forbid) we lose for d finae, we go lose honorably, and e no go be mumu 15- homeboy 1.
Abeg abeg abeg o! Make we take sense do dis thing o!
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by preshizeee(m): 10:00pm On Sep 26, 2010
SO NA OBAMA CANDIDATE AND MAMA BIG YANSH/GUITAR MAN WE DEY VOTE,
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by emmadinoyi: 10:04pm On Sep 26, 2010
there is gonna be an eviction the weekend before the finale so even if u strategically vote anyone by next week there still stand a chance to be evicted. so I think we  should just vote for Uti's pals and peeps that will make his life better even if it for 1 wk, my take is L an S, they'l up his game for the while they are there, and when push comes to shove we go do our kurukere give the doe to our boy.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 10:31pm On Sep 26, 2010
jejelolatu:

Hey pplz, na wa to una, so na to dey yarn for broken inglis now. all join sha, make una 4giv me in advance incase d yarns no tanda well 4 d page. . . . Lol, i'm loffin dis.

Ehn ,NL pipo, e be lyk say montelik dey yarn correct o, Na loyalty Uti + Nigerians don take reash where we dey so o, make we no com take desperado moves spoil am now o.

Me i bin feel say make we jus organise our votes giv obama pikin out of appreciatn for d way wey dem don stand gidigba for Uti/MNC back. Any oda kurukere waka wey we do go be for mama africa.

if we go yarn true talk giv ourselves, dat mumu don dey Biggie default to win and im SADC pipo no dey take im matter play at all, d only wey to stand d chance of winnin na to just remain loyal to our allies and hope sey for d final week, we go fit ginger enuff Naijas for d diff obodos wey dem dey to use all d machinery wey dem disposal to do kurukere waka toh behd.

For now, make we remain loyal , so even if (God Forbid) we lose for d finae, we go lose honorably, and e no go be mumu 15- homeboy 1.
Abeg abeg abeg o! Make we take sense do dis thing o!

Thank you my sister. I will rather we try to win honorably and possibly lose, than try to win dishonorably and end up surely losing dishonorably. Loyalty has work well for us so far, let us not make d same mistake d bushman made. Uti has stood behind his friends no matter what and has never back-stabbed or betrayed anyone (even his enemies), that is why most of these 8 countries are still with him. And as someone rightly noted there may still be further evictions so bringing back these sadc spoilers may not work and by then we will have lost d support of our friends.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Ambber(f): 10:40pm On Sep 26, 2010
ok nothing spoil make we thumb Ob siz and mama africa. I hail una we don over try and track record anytime our boi dey line stand gidigba. I still believe we no go lose.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by emmadinoyi: 10:44pm On Sep 26, 2010
U guys know Uti relys gets his strenght from mainly d girls, when sheila left, meryl became his strenght and thats why he almost shed a tear today when she was evicted, leaving him without his friends for 3wks might make him loose it, Uti doesnt have any true friend in the guys, so if we go bring that mamaput or boboguitar its gonna make things worse for him cos I can see he is already falling apart, i'm just praying he holds it up till next week.pls na our babe we dey vote, make una start to dey campaign massively for twitter and TV,  we fit add Madiba pikin or even newly wedded babe. ITs either L,M,or S, we are doing this for our boy
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 10:45pm On Sep 26, 2010
Christ this Tatiana is something else. No subtlety at all. See how she stripped down for Code. shocked
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by lluciano: 10:57pm On Sep 26, 2010
montelik:

Thank you my sister. I will rather we try to win honorably and possibly lose, than try to win dishonorably and end up surely losing dishonorably. Loyalty has work well for us so far, let us not make d same mistake d bushman made. Uti has stood behind his friends no matter what and has never back-stabbed or betrayed anyone (even his enemies), that is why most of these 8 countries are still with him. And as someone rightly noted there may still be further evictions so bringing back these sadc spoilers may not work and by then we will have lost d support of our friends.
Forget all these honorable talk. Fact is mumufc are voting Tatiana and Sheila just to reduce our boy's number. It's crystal clear how the votings have been from time. Nobody is saying we shld dump our friends, hell no. Wetin we dey talk be say, we go vote obam pikin as naija but our kurukere runs go be for mama bakassi and omo guitar.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by imconfused(f): 11:01pm On Sep 26, 2010
So R0A went to uti!! Yayyyy!dat's soo good to know.Please decide on who to vote next so I know how to vote, thankss
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by preshizeee(m): 11:14pm On Sep 26, 2010
Na gt man and big bakassi dem decide 4 face ur book and switter oh so make we dey prepared but we go vote obama pikin usin green white green
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Ambber(f): 11:16pm On Sep 26, 2010
All MUFC talk on oboma and the unofficial biggy fan site is to divide Uti's final votes by voting for Sheila and Tatiana so whether we vote for Sheila or not courtesy these joronjo madus, she will be in. are we gonna fold our hands? we also have to return them the favour o. if we fail to bring in one of theirs to the house then we will be letting Uti down when it matters most. I agree with Yacob, why stay 90 days if you are going to walk out empty handed? so let's vote like Uti is on the line. thanx
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 11:17pm On Sep 26, 2010
If you leave Uti in dat house for 3 weeks without any friends, don't be shocked if he has a Hannington moment of madness.

(1) (2) (3) ... (98) (99) (100) (101) (102) (103) (104) ... (179) (Reply)

Some Nigeria Movie Stars Profile / MTN Project Fame Season 9 Official Thread / Watch Nigerian Movies Online For Free

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 60
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.