Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,449 members, 7,816,039 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 12:25 AM

Sweet In The Middle: My Love Story With A Church Sister - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Sweet In The Middle: My Love Story With A Church Sister (1994 Views)

Church Sister Cries Out As Members codedly sex In Their Church Whatsapp Group / What Does Sweet In The Middle Mean, In Reference To A Fat Person / Man Proposes To Girlfriend On A Boat In The Middle Of A River (Photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Sweet In The Middle: My Love Story With A Church Sister by LoveEtRomance6: 11:33am On Mar 30, 2022
Na for inside one Sunday service last year this one happen.
For my church, na three times dem dey sing from our hymn book. And if you no get the book, you go draw near to anybody wey get am, and una go sing from same book together. 
Ehen.
So na so o; as we sing second hymn, this fine sister wey sit down beside me get the hymn book o, but when she open am, she see say her own version no reach hymn 258 wey dem talk say make we sing.
I reason am and I see say na opportunity for me to do good for mankind, and share my own book with am.
So I shift near am small, and she sef, she shift come my side.
Na so song start o.
I know say I no get perfect voice like some people here; but I dey try small small if I no too stress my voice.
I fit sing bass well, na tenor dey always destroy my voice.
As per person wey get sense, I quick choose bass key, and I start to sing as my mouth open like school gate.
As she see say I start sing, the sister sef start to sing.
The sister voice sweet ehn! Chai! 
Come see as she dey draw her voice inside the song, wey she dey raise pitch, drop am back like who dey wash plate.
And when you come add my own low cool bass, our voice just gel together like beans and garri.
We sing first stanza, sing second one, sing chorus together.
Both of us know say we dey deliberately gel our voices o, but we no even look each other face.
We just dey sing the sweet song dey go, e come be like say na only the two of us sef dey church.
As the last line of the chorus come slow down to finish the song, na so me and she still use our voice take draw the song slow slow like okra.
The thing sweet so tey, even the usher wey dey for the next row begin look us.
‘Imagine say Na my wife be this sha…’ one mind tell me but I just bone am.
Na so that song take end sha.
Our Pastor come say make we sing the third one for hymn 18.
As dem call the hymn ehn, e be like say make I cry, cos I know say that one go dey the sister hymn book.
But you know wetin come shock me? 
This sister no even bother check the book again, she just stand beside me like before, and wait make I open the book back to hymn 18.
My legs begin scratch me, say make I burst dance for the matter o, but I control myself sharp sharp.
Na so we start again, we begin sing the second hymn.
I shift near am, she sef shift near me small. As I dey sing, I dey smile. And she sef smile one kin tiny smile.
By the time we reach middle of the song like this, almost half of the people wey dey front of our row don dey look back. 
Some dey smile, some dey wink, others dey shake their head.
The two of us sha do like that till the song end and dem talk say make everybody sit down.
As my body touch my chair like this, wey I balance well, I look beside me, say make I check the sister face well, take know who she really be.
But as I look her face small, na that same time this better sister sef look my face. 
Like play like play, na so our face jam together like say car accident happen.
Me smile small, nod head give her.
She sef smile small, look front.
Me just dey sit down, begin thank God say He don finally remember me for my marital department.
Before before, if dem dey preach message for church, sometimes I go doze, even sleep sef sometimes.
But that day o, even devil and Jonah no fit combine make me sleep.
My eyes sharp like cutlass. I no even doze once till message end.
Continue Reading...
https://mobilevina.com/sweet-in-the-middle-my-love-story-with-a-church-sister/

(1) (Reply)

Nigerian Men Need To Stop This / See My Futurr Wife.... With Pics / When A Girl Ask You For Money, U Didn't Give Her

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.