AKPOSbaba's Posts
Nairaland Forum › AKPOSbaba's Profile › AKPOSbaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 17 pages)
onatisi:na me talk am? Buhari,goodluck dem dey mad! Dem hep me? |
Rapper Nicki Minaj,di ikebe queen and her boyfriend of twef years Safaree Samuels,no dey again and dis one no be news. Di news be say she don get new boyfriend, Meek Mills and di bobo sef na rapper. Nicki Minaj fans across di world don dey even begam make she try settle wit di Jamaica born Safaree bicos di guy swagga no be here. Make i sampo una some picchors as pipo don dey argue about who get swag pass among dis two bobos. Bitwin Meek Mills and Safaree,who get swagga pass? Na di di old bobo,Safaree? Or di new bobo,Meek Mills? Check out dia photo for bottom hia: SOURCE....http://ogakpatakpata..co.uk/2015/06/nicki-minaj-old-and-new-boyfriendwho_11.html?m=1
|
Rappers Safaree Samuels,who's of Jamaica descent and Meek Mills,have something in common. One is presently Nicki Minaj's boyfriend and the other is her former boyfriend. Safaree, her boyfriend of twelve years is the former while Meek Mills presently owns Nicki's charming assets especially from the rear. Nicki Minaj fans across the world are already pleading with her to reunite with Safaree cos he's got matching swag with his ex bae. Between Safari and Meek,who would you put your money on? Who's cuter? Who rocks the best? Who's got more swag? MORE PHOTOS.....http://ogakpatakpata..com/2015/06/nicki-minaj-old-and-new-boyfriendwho_11.html
|
RaDaZaBaNa:ogbonaya onu is the secretary to his govt. but he too travel sha |
Ejigbo has d worst roads in Lagos shame to the govt |
I dont pray we get eliminated but trust Nigerians if we do,dats wen football fanatics,commentators like Oliseh,Ikpeba etc will start calling Manu Garba names. They will say he's not sound technically,they will even say why was he benching Iheanacho in the first place?In d Brazil match,Iheanacho had a good first half. He even hit d upright with his volley and had one assist.The whole team had a bad second half but Manu Garba is only singling him out for blame.i wish dem luck sha. |
Icon4s:Messi has been caged in few occassions Dat doesnt stop his high grade talent.iheanacho still remains d biggest talent in d team.he even hit the woodwork and had one assist in d said Brazil match.the whole team had a poor second half.manu garba is just singling him out for blame to divert Nigerians attention from blaming him.na common sense. God forbid! I bet u if Nigeria get knock out from d tournament,dats wen football fanatics,commentators like Ikpeba,Oliseh etc will be saying he is a useless coach.why was he benching Nacho in d first place?everybody seems to be carried away with their victories. |
Ghana tv presenter,Gabriel Enoch don blast naija presido, Muhammadu Buhari dressing to di 2015 G7 meeting for Germany. He yarn for twita say, wen Africa leaders and dia yeye dressing go improve sef?. Di G7 kontris take photo togeda plus Buhari and na only Buhari no deck suit and dis one kon give Enoch mind to dey yarn opata. Di truth be say no be by force to chop okro if u dey forbid am. If Gabriel Enoch wey be Africa pikin from Ghana no biliv in Africa culture naim be say him head don knock. America,UK, Japan, France, Canada and Italy and Germany naim make up di G7 kontris and dem invite Buhari come dia meeting as one of di guest. Di other guest wey dem invite come to di G7 meeting na,Ethipia Prime Minister,Hailemariam Desalegn Iraq Prime Minister, Haider al-Abadi,Liberia President,Ellen Johnson Sirleaf, Senegal President, Macky Sall, Tunisia President,Beji Caid Essebsi and Ban Ki-moon di United Nations Secretary-General. SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/06/buhari-no-sabi-dress-at-all-ghana-tv.html
|
Wonders never cease to come by as dog turns celeb. See dog,Barry the Bedlington riding a tricycle unabated. Bedlington becomes a cycling star after learning to ride downhill on child's tricycle in England. The owners,Wayne Sowerby and Kate Hayllar are so proud of their dog. lol. ![]() What is the strangest thing your dog or any other pet can and has done? SEE MORE PICS....http://ogakpatakpata..com/2015/06/see-as-dog-dey-ride-bicycle.html
|
Ogogoro na acid for bodi from today akordin to govment. Federa govment don ban ogogoro alias kai-kai for naija. Di director general of National Agency for Food and Drugs Administration and Control, NAFDAC, Dr. Paul Orhii naim yarn dis one on monday. He say na 38 pipo don die for Rivers state sake of say dem shack ogogoro and wack dog meat recently and dem no go fit fold hands dey look until e kill evribodi. Rivers state don alreadi banam since last week for di state. Apart from Rivers,pipo don die for Ondo state too and dem stil put all di blame for Ogogoro head. Dis ban go affect many Ijaw,Urhobo,Itsekiri and many oda malleh dem from other area wey be say na dis bizness dem take dey take care of dia family. I rememba ebola wen dem say na bush meat dey cause am. Bush meat sellers carry protest enta town say make govment find anoda excuse say bush meat na koret meat. I go siddon dey watch how di mata go end weda dem go protest or dem go change enta anoda bizness. SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/06/ogogoro-drinking-go-land-you-for.html
|
Nice one Mrs own goals |
youineed:Who the stars dem help? |
Airforce1:Really? Lets hear from Empress Njamah first then we'll know who to believe. |
E don red! |
E no easy. With tracks like ojuelegba and joy,i can only say YES to dis awards. Big up yourself kid. Congrats |
Poison |
Nice |
YBNLs |
BIUTIFUL GRAHAM RACHELLE
|
Senegal footballer,Papiss Cisse don brake di heart of him girlfriend into smalsmall pieces. Graham Rachelle forma Miss Newcastle beauty queen and model,still dey struggle to gada di pieces togeda. Cisse wey dey tap leather for Newcastle United for England, no tell him white girlfriend,Rachelle anything bifor he fly go marry volleyball star, Awa Diallo for Paris. Rachelle and Cisse don dey do dis kelekele love for over two years now but dis oyibo pepper get di shock of her life wen she see di wedding picchor of Cisse and Awa for facebook and instagram. She say wetin pain am pass be say, Cisse no letam know about him plans as dem spend beta qualiti time togeda recently. Cisse marry Awa for one swish yatch club on May 30, three days afta Rachelle hep di bobo pack him bag and escortam go enta aeroplane for airport and she kon even sama Cisse goodbye kiss bifor he enta di plane. One Rachelle friend later yarn pipo say, di rizin why Cisse no date her friend wit all him heart na bicos, di footballer family expectam to marry Africa muslim woman. Papiss Cisse na strong muslim wey no dey drink and na five times a day he dey pray. Sorry Rachelle, it is well. SEE MORE PICTURES HERE.....http://ogakpatakpata..com/2015/06/cisse-don-marry-anoda-babe-for-him.html
|
kipesco:I'm a true Niger Deltan but i no dey support rubbish. In d history of Nigeria,no regime has been indebted like Jona regime. We were deceived we have d sweetest economy in Africa and we dey die dey go. We've neva xperienced fuel scarcity like dis b4 except u jst wonna act blind to d situation on ground. He has admitted few times dat he didnt meet expectations and even beg for forgiveness. I'm sure he is even surprised why u guys are showing him lot of support. |
Dj Bolt Di Noisy Neighbour-Jodi Jinx ![]()
|
Distraction |
Did i hear u call Ameachi a judas bicos he did not support a south south candidate? Jonathan dats from d SS,wetin him do? He turned out to be d worst president in d history of d world. He turned Naija Upside down. Abeg spare me dat rubbish! |
U fit dey your own,u no go know say some kain of yor doings wey u take as normal, dey abnormal to oda pipu. Dis na exactly wetin dey appun bitwin di fastest man, di man wey sabi tia race pass for di world,Usain Bolt and grammy award winning reggae miuzishan,Sean Paul wife, wey her name na Jodi Jinx. Jodi Jinx don accuse Usain Bolt of noise polution for dia area for Jamaica. She also yarn for facebook say Usain Bolt na neighbor from hellfire bicos he dey disturb di area wit too much noise. She say,di loud noise from cars,motorcycles and di loud miuzik from Usain Bolt house fit make pesin run mad. She also yarn say apart from di bike noise, na so so party and so so shout Usain Bolt sabi and she no fit wait to park comot for di area. She say she no get one singo respect for Bolt again bicos na evriwia he dey carry him bad karata go. She even yarn say, although pipo love di bobo welwell sha,but na bad example to di world. Jodi Jinx say two times now for dia area, Usain Bolt don shoot gun gbosa! gbosa! and di gunshot sef fit deaf pesin ears. Some pipo nor go too blame di 100 and 200 mita record holder, Usain Bolt for di loud miuzik bicos, apart from di race,di oda work wey dem know am for,na DJ work. Usain Bolt and Jodi Jinx husband,Sean Paul neva yarn anytin for di mata but plenti of Bolt fans including reggae,dancehall miuzishan,Popcaan,won kill her wit curse for twita and facebook . READ MORE FOR HIA....http://ogakpatakpata..com/2015/06/usain-bolt-na-bad-neighbour-from-hell.html
|
Rogues |
missclassy1:to you |
Great. |
ionsman:What u said its true as many stations av adjusted there pump and sell for over N150 but i disagree bruv that no station sold for N87. I av bought fuel from Mobil and Forte on Lekki-Epe expressway at least 3times in my car during dis hard times and i filled my tank with same amount i use to pay. Aside that,though its difficult convincing them to sell in kegs but i av succeeded in two occassions and its d same amount i use to pay b4 the scarcity to fill my 25 litres keg. Na so e be. |
ionsman:What of the few stations still selling for N87? Were did they bought theirs from? |