AKPOSbaba's Posts
Nairaland Forum › AKPOSbaba's Profile › AKPOSbaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 17 pages)
YEmi Alade all d way. Di most hardworking after d late Goldie. From her songs delivery and she is also a wonderful dancer. Goldie was not your-go-to-musician but she put a lot of hardwork into it and twas yielding result b4 her demise. Its gonna be a straight fight btw Tiwa,yemi and Seyi Shay. |
kazmanbanjoko:U gat me laffing ![]() Na Snoop yarn di pidgin Snoop na Kwale boi na! Wit d thickness of dia Smoke,u Shall know dem |
America rappa,Snoop Dogg,don tell all him Sweden fans say make dem blame dia police pipo for di swear wey him swear say, him no go eva visit dia biutifu kontri again. Snoop yarn dis wan on top twitta on sunday afta Sweden police stopam for road, arrestam go station and force am to piss for cup sake of say dem won do test wit di piss to know weda igbo(marijuana) dey him system. Snoop bin go do show for di university town of Uppsala Stockholm,Sweden. Snoop later yarn say na bicos him na black man naim make dem tritam like dat but di police pipo say na lie bicos na dia work dem just dey do. If u check and balance am,u go blame Snoop? For police to arrest am go station from him car and force am to piss for cup and no be say dem catcham wit igbo,naim be say dat wan pass opression. SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/07/una-bye-bye-i-no-go-ever-visit-sweden_27.html
|
Super Eagles forma coach,Stephen Keshi wey Naija Futbol Assosiation sack sake of say him no value him job,don write dem leta to tell dem say na N1billion naira dem go arrange am as dem sackam. He say dem do wrong to sackam as dem don robish him pesin base on di contract wey him sign as Eagles coach. Akordin to one tori pesin wey know about di mata,he say NFF receive Keshi leta on friday from one Kaduna base lawyer compini. Four months afta dem givam di job,NFF sack Keshi July 5 afta dem conclude say di coach no value him job as he apply to coach Ivory Coast di sametime wen he still dey unda kontrat wit NFF. SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/07/una-must-pay-me-one-billion-naira-keshi.html
|
xtrorse:If U won send me recharge card, tell me and stop to yarn puan!. |
This is not good news for African viewers as the biggest reality TV show in Africa, Big Brother Africa (BBA) may not take place this year as expected. This is due to lack of sponsorship. The organizers of the show, Africa Magic and Endemol were unable to get sponsorship for this year’s edition of the show. The Manager of Multichoice Ghana, Anne Sackey confirmed to peganews that they at Multichoice Ghana have received notice from MNET that this year’s edition of Big Brother Africa will not hold. She explained that MNET did not give them any reasons as to why they will not be doing the Big Brother this year, but then, she personally thinks it’s due to sponsorship constraints. SOURCE....http://www.vanguardngr.com/2015/07/breaking-news-big-brother-africa-2015-cancelled/ |
xtrorse:Do i need to state my tribe?my name says it all. |
I Have 6 ways |
Is Jonathan ringworm? Why is d Igbo community carrying his problems on dia head? We Niger Deltans,we no sendam bicos Jona no do anything for us to warrant dieing for his mata. A case of crying more than d bereaved. What rubbish! |
Crase pipo |
My brothas situation right now is more precarious compared to Duncan's own ![]() I dey pray make nothing Bad happen |
sixpee:Nah! Wud av bought ur assertion but Dr Sid is duely married to Simi and they had their daughter couple of months ago. |
Continuation of Xenophobia By police. Dunno wha we waiting for to bring down d walls of shoprites. ![]() |
Only came out after Tiwa delivered It goes to show her position in d group. Tot all men were equal in d eyes of d lord ![]() |
Naija answa to Bob Marley, Majek Fashek don see chomchin and he dey pass tru some deep issue. Some even they say na spiritual problem why some say na drugs turn him life upside down. Dis past few years no easy for Majek Fashek as many tins don go wrong for him life style. One of dis problem na di color and di setings of he teeth wey don nearly scata finish. If u know Majek Fashek bifor all dis plenti wahala start for him life, u go know say him teeth dem no be as dem be bifor. Now,if Majek smile,you go shock if u see him teeth. I no undastand weda na tabacco naim do am like dat but as somebodi wey don watch am live dey play him kpangolo style of miuzik bifor, i no say dis man get koret teeth dat year. Di good news be say Majek don start di re-arrangement of him life, starting from his teeth as he don carry waka go meet dentist(doctor for teeth mata). Him friend Black Rice post for facebook di pictures of wen di teeth doctor dey work on Majek teeth. Black Rice also write for facebook say "dem dey tank evribodi wey donate and kontriboot to see Majek stand gidigba again. He say naija pipo kindness dey show wella and e dey work for Majek bodi. SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/07/majek-fashek-don-dey-work-on-his-teeth.html
|
During one join bodi siddon talk wit tori pipo, Manchester united coachee,Louis Van Gaal,forget di name of him player and call am "Mike Smalling" instead of "Chris Smalling". Pipo bin laff President Buhari welwell anytime wey he no call di name of any animal,place or ting corectli. For example,Buhari won say Germany,he kon say West Germany. He say ANPC instead of APC. He supose say Chancellor Merkel but he kon say President Merkel of Germany. Even our vice president name,Buhari call am Osunbade instead of Osinbajo during campaign but now we don know say it can appun to anybodi. On tuesday for America wia Man U for dey train dey prepia for di new season,dia Coach Van Gaal follow tori pipo dey yarn about who him three captain dem be. He kon misyarn say na 'Mike' instead of 'Chris' naim be di numba three captain. Wayne Rooney naim be Manchester United captain. Michael Carrick na numba two why Chris Smalling na di numba three captain akordin to Loius Van Gaal. SOURCE....http://ogakpatakpata..co.uk/2015/07/no-be-only-buhari-dey-do-mistake-as-van.html?m=1
|
SEE HOW LAGOS BEGGARS, RUN SHIFT, A VERY FUNNY VIDEO INDEED... U NEED TO SEE FOR YOURSELF https://www.youtube.com/watch?v=4ehr7Fxmk5o |
For Mkpuma Agbaja in Izzi local government of Ebonyi State last weekend, one bobo, Mr Egede Nwofe, wey he nickname na 'monkey' fall from palm tree and break him spinal cord. Akordin to Mr Nwamimi Okwuta, di man wey get di palm trees, he say for di past five years naim he don dey hire Nwofe to helpam harvest palm fruit and dat kain tin neva appun bifor. Wen tori pipo carry waka enta dia village go hear from dem, Mr Nwofe yarn say, di money wey him dey make from di palm tree climbing,naim he take dey feed im family. He say na N500 him dey collect for tall palm tree and N300 for short one. For dat day, Mr Nwofe don alreadi climb three trees. He say as he dey climb di numba 4 tree,naim him bodi start to dey shake like shakespeare, Cold kon enta him. Bifor he say Jesus! him don reach ground break him spinal cord. Spinal cord wahala no be small pikin problem. We wisham goodluck as he dey recover. SOURCE.....http://ogakpatakpata..com/2015/07/monkey-fall-from-palm-treebreak-spinal.html
|
Some days ago if u dey follow up,u go don hear wen Obasanjo yarn say, pipo from Niger Delta go suffer tey bicos of di way wey Jonathan take rule. Akordin to OBJ,he say Uncle Jona no use di oportuniti wey him get to rule dis kontri well at all. Him say so diafor,to pick anoda pesin from dat area go hard. Bifor di presido elections for April wey Buhari win,Obasanjo withdraw all im suport for Jona. Earlia today, di Govnor of Ekiti state,Ayo Fayose don release statement say make di grand Palle of Naija politiks Olusegun Obasanjo, stop to attack forma presido,Dr Goodluck Ebele Jonathan from left,right and centre bicos no be di man be president again. Ayo Fayose di one man mopol of PDP, say make he try leave Jona make he leave him private life jejely since he don give Aso Rock chance. SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/07/shuooooo-obasanjo-abeg-leave-jonathan.html |
Reggae miuzishan,Majek Fashek, don yarn afta he carry waka go one church say make dem no force am go place like Uselu, wia dem for dey cure pipo craze or pipo wey small nut don loose for dia head. He say him spirit go dey low if dem force am. If you rememba three weeks ago,di whole intanet scata wey dem say Majek dey beg ogogoro waka nowadays and dis one kon make Area Fada,Charly Boy beg naija pipo make dem join am to hep di reggae star. Pipo also dey yarn say,di ting wey putam for dis problem na bicos, di ganja farmers product wey him dey smoke no good for him bodi. Majek say him know how he take dey escape dis tritment bicos God don givam differen differen knowledge like orisha and babalawo knowledge. He say naim ancestors knowledge he dey use right now and him dey drink akpeteshie (ogogoro) wit di orisha idea wey him get. Di Rain maker wey him jam,"Send Down The Rain" reign scata dat year say, him go take di tritment afta he release him next album. His Royal Freshness,one of Majek Fashek guy name some years ago bicos him skin fresh finish like fresh vegetable in dose days yarn say, he no want make him spirit dey low bicos na Jesus be him hero, Lord and Saviour and naim don carry am reach dis level. Majek say make pipo calm down afta di album bicos he no won enta hospital now bifor somebodi go givam bad injection. SOURCE.....http://ogakpatakpata..com/2015/07/majek-fashek-i-go-cure-my-craze-after-i.html
|
A VERY FUNNY SKIT BY COMEDIAN WHALE MOUTH AND PRINCEWILL, VERY HILARIOUS. U JUST NEED TO SEE THIS YOURSELF https://www.youtube.com/watch?v=1mHci6AllDQ |
Sam Smith and Boyfriend, Jonathan Zeizel
|
If there is any celebrity who gayism is in-built in his system,it has to be Sam Smith. The pop,R&B singer who celebrated to high heavens when America legalised same sex marriage across all 50 states on June 26th,won the Best New Artiste at the much talked about BET Awards grand finale which was held at the Microsoft Theatre in Los Angeles, USA, on Sunday, June 28. The British born singer fetched for himself four Grammy Awards earlier in February with his singing prowess which many Africans would preferably associate themselves with. Sam Smith, who came out as gay last year, after the supreme court legalized their activities in US, shared a picture of two men kissing and wrote: “ALL 50 STATES!!!! So happy. He continued “Times are changing my friends. We have such a long way to go and so much more fighting to do so I hope nobody stops and thinks everything's ok because it isn't, BUT it's days like today, and moments like this that we've all gotta have a drink and celebrate how far we have come. “I couldn't be prouder to be gay x love to all x #PRIDE #EQUALITY”. Na wa O! Orisirisi! Notably,no Nigerian won an award on the night. Wizkid,Yemi Alade,Sarkodie(Ghana),AKA (South Africa), Fally Ipupa (DR Congo),Sauti Sol (Kenya),The Soil (South Africa), were not lucky as Ghana’s Stonebwoy went home with the coveted prize as the Best International Act for Africa. It was double celebration for Ghana as UK-based Ghanaian musician, Stormzy also won the award for Best International Act – UK at the 2015 BET Awards. More pics here......http://ogakpatakpata..com/2015/06/gay-lord-don-win-bet-awards.html
|
If you dey look for book wey get plenti inspiration to read, make u no look far again as di life of di Nigerian Idol season 5 winna,K-Peace, na beta book to read. Watch out for yor area as very soon, di bookshops and cd shops wey dey near you, go soon stat to dey sellam. From ordinari pure water,gala and chin-chin hawker, K-Peace don hama as he win N7.5 million, one Hyundai Sports Utiliti motor,record deal with Univasal Miuzik for South Africa, and he go also carry joliment waka go sleep for five star hotel and chop high grade chin-chin, drink korect wine for Dubai and all di bill na from di pocket of di organizas of Nigeria Idol. Olakunle Ogunrombi A.K.A K-Peace, enta street go hussle afta him papa wey be di bread winna of di family die of heart attack. Di bobo say im come from a family of five and to chop 3 times a day no be problem for dem. Infact,wen dem dey grow up,him papa dey always buy dem chocolate,donkwa,kulikuli, goody goody,biskit, anytime he dey come back from work. Bifor K-Peace papa die,he work for Leventis Motors as engineer. Afta dat work finish,he enta motor parts bizness and naim he take dey take care of di family. But as di old boi kpai,naim yawa gas. Di mama no fit carry di load alone as tins kon konk and kon dey veri hard. Dis one kon make K-Peace vex enta street. He hawk chin-chin,gala,pure water sotey, he turn hawking king for traffic just to sorvive afta him papa die. But bifor he enta hawking,di bobo say him do factory work for Maza-Maza from 7am to 5pm and na one N120 dem dey pay am and anytime wey he do ovatime join,dem go add N30 join di money. K-Peace stop di work afta one year and kon enta hawking bicos di KevinLittle wey di company dey pay am,no dey reach am do anytin. But now,Baba God don shook hand for di guy mata as levels don change. K-Peace don finally find peace wit him singing talent as he don win di Nigeria Idol season 5 and di rest as dem talk am, na history. Area! I hail una. SOURCE.....http://ogakpatakpata..com/2015/06/i-hawk-galachin-chin-for-mile.html
|
wike na true? |
baby dada |
His village juju were on board the same flight. |
Hbd in advance sir Knackout! |
Sad |
Naija is finished! |
Forget! Wetin don be don be. 2face alias 2baba na man wey sabi. If you no gree sef,e get wife wey fit die for di bobo mata and also wife wey bilivam finish. Annie Idibia,wife to 2face, don cut rope for instagram as she post say she dey proud welwell and she kon dash enta Okoro feeli funky mood. On top Instagram,she post di photo of shelf wey her husband arrange awards wey he don win for dis miuzik wey he dey play. She even yarn for Instagram say,no be all di awards be dat o! She say she dey proud die for her husband bicos,she get husband wey sabi and husband wey be legend finish. If e no be 2face e cannot be 2face. Kpakam. SOURCE....http://ogakpatakpata..co.uk/?m=1
|



