ALERTEFCC's Posts
Nairaland Forum › ALERTEFCC's Profile › ALERTEFCC's Posts
if bombing Nigeria will help rid the country of these corrupt, greedy and self centered beasts they should go ahead with all urgency. before i forget, MAKE SOMEBODY HELP ME FIND OUT IF DEM DEY RECRUIT FEMALE SUICIDE BOMBERS, "I SWEAR, I WILL WEAR A SUICIDE BELT, IT WILL BE MORE PRESTIGIOUS". |
RICE KOR CONDOLEEZA NI, if rice too cost try garri or cassava klafes abi flakes. |
PAPA AJASCO, i like the man. |
una get power, something wey the pastor don shine finish, make e marry you na, e pass like that, yeye fowl |
na people wey life don show pepper wey come manage get smal money dey think say woman dey follow dem because of money, how nmuch e get sef wey e no go let people hear word. and you say na family money that one get as ie be oo |
na una know the deal wey una strike, you sure say she never carry belle for you so, when she go come na you go run leave house for am oo. as e don say 'Ignore this message at your own risk', abi you promise am say you go buy land or moto, then yawa go gas be that. na only for this we yeye country na im man go wake up tell woman say e don tire, pray make she no be like me, you go run leave house. |
na this one make i say make me dey speak my pidgin jeje, atleast since i dey break my bottle nobody don halla instead them dey run, SEE AS EVERY BODY EVEN ME SEF DEY USE stone dey whip your head, next time you go think 50 times before you vomit for our NA ONLY beards YOU NO GET. |
legs:you mean something like anticult? hehehe hehehe hehehe, those days for my school na dem na im the boyz com fall first, i mean 8 of them to tell everybody say make dem go balm up or run we don dey carry this thing too far, the boy sef noi dey here again to hear our yarnings. for me oo relax first, try to gather your moral, keep your sim card make dem no fit call u, no waka their way, if dem meet you tell dem say you no follow, if dem disturb you report to police then the school authority, dem dey fear too ooo na dem fear pass, na the group movement dey make people dey fear |
na im be say the guy mouth dey smell nor ni. igbe ni |
some people stupid well well, they come naijaland come dey advertise, how many bush yiu don enter sef? , UNA KNOW HOW MANY DEY HERE, WEY SOME PEOPLE WAN CARRY AM FOR HEAD my only yarn: NEVER NEVER TELLTHE SCOOL AUTHORITY, UNLESS YOU DON REPORT TO POLICE FIRST BECAUSE MAY BE THE PEOPLE WEY DEY THREATEN YOU NO BE STUDENTS AGAIN, ME I THINK SAY YOU TOO REACT TO THE SITUATION OOO. BE WISE. IF E TOO TOUGH CUT OUT FROM THE EFFING SKOOL, NO BE PRE DEGREE YOU DEY, WHY YOU WAN DIE FOR PRE. |
even if goat dey rule if things dey in order no wahala, but if angel dey there and katakata full ground that one na rubbish, everybody na thief, except those wey never reach there |
which army, i think dem say 'a little leaven ferments the whole lump', na that one be the real problem for nigeria, some influential people want to finish us, make dem continue na the wey when dem like am |
i don learn one big lesson for this country and i sure say na wetin IBB dey regret, if you steal GOOD money fear no dey let them come near you, if i reach there for one minute i go sell nigeria give all of una the change. |
SEE THEIR HEAD , where ibori, igbinedion and odili enter. olosi |
the best name for this country na MONEY MISS ROAD |
why una dey shed crocodile tears, all the people wey dey steal this country money go die one way or the other , wen e reach anybody turn dem go dey find sympathy, if i join chop nigeria money the next minute i go dey pray to die, make god judge our leaders, but any innocent one may their souls rest in peace. |
if govt kill am like that e means say dem be dey torture am, how many people( ibori and co) dem torture like that because dem steal money, una see say if you try to stop this govt from thiefing money dem go plan to kill you, e better make e be say the guy never die because plenty people go follow and that one go dey very interesting because me sef go follow . make dem allow e lawyer go see am or family members. |
which one be moto again for relationship, if you dey go do me the thing down there na im be say you don carry me for moto be that if you no do am na im be say i dey trek for under rain ni |
you dey craze for head you think say na your mama you dey tell story, as e put am there how e take dey suck the aie make the cigar dey burn abi e just leave am make e dey burn on e own, shey be you don smoke befor, if you no suck the air anything go comot, see am e girlfriend dey boarding house how that one take affect the gist, after she smoke finish you too come smoke your own too inside the same place, YOU ARE SICK, you wan begin make me speak in tongues now foooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooooool. |
i save my own as OLE BURUKU |
if na joke you come joke u no know where you suppose to go, you whole body no even big reach my laps, 2pac ko biggy ni |
una sabi wasye time well well wen una suppose to go to the main thing 1000. cook poundy and egusi soup for me 1001. cane me i cane you |
love don teach me say make i no ever love, e say if i see am for anyperson body say make a run because your sense go waka |
me i dey single desperating searching, hapily dating, if you enter my hand na u sabi because to comot no be one day matter. |
see as evrybody dey show english skills, na today, after all this talk wetin we go achieve? e nor change the mind of the government kokoroko!!!!!!!!!!! make una keep una power take do something else, if no be papa wen shit for body who be pikin to come tellam say e body dey smell, government don shit for church so? before we go comot here somebody go say e get right to burst pipe wen carry oil say because e pass under e house, make una comot make i see road bo |
who be this KSA sef? say spraying na our culture, tufiakwa!! e be like say person say to craze na our culture, make una ask am how much e get for e account wey e no wan make we hear word, people wey get money no dey even spray na beggars wey small money just enter their hand no go let people see road, e no go tey dey go say to shoot person with gun na our culture, this one na im me dey call KOLO. wetin govermnment dey do about people wey dey block road because dem wan do burial? |
who be this 12 yrs old pikin |
make una no dey talk like this, love no get eye, if you see person wey you like your natural stupidity go come show eself, you no dey feel me. i bow for you oo. you don see where two womwen dey fight because of one man, you don see where three men dey kill eachj other because of one woman, that stupidity dey for everyboby body, pray make u no see who go bring am out, otherwise e must com out. i don talk my own . |