ALERTEFCC's Posts
Nairaland Forum › ALERTEFCC's Profile › ALERTEFCC's Posts
una own good oh, people dey pursue una una dey run wen dey go stop una go begin pursue, oya come pursue me na you go waka on your own. |
e be like say you know bible well well, for genesis them say god create everything and everything good but bad things dey happen today because satan dey so talk true some people worwor, no decieve yourself, abi you worwor too. |
wetin you wan use gun do , na iraq you dey, e be like say you like war like me, instead of me to carry gun i prefer to be suicide bomber. i dey read how women wey get mind dey do am for iraq. |
let people beat gong for you so that you go fit dance well. , before you leave your house this morning light dey? no let me begin talk ooo i get temper oo. i no dey use eye see nonsense. |
who be this one, trouble dey sleep yanga dey go find am, throw yourself come my side no be person go tell u, okada speed no go reach to carry you go back from where you dey come. |
i beg who go fit help me with bicycle colour: white i need am to take to go farm. una do well |
eya, great sultan, thank God for your life, the God wen save you go provide a better car for you, Amen. |
abanna:if you use SMS abi CFC take send my papa invitation na you saka, because you go buy goat for all the elders of the village, you see life , you don get wife now your problem na how you go take call people come chop your hard earned money, anyhow you like do am, but make sure your wife carry belle and born after one year otherwise all this one na nonsense,even if the I.V pass thru moon. |
@marziplan 73, i know how e be sha, but one thing wen i don learn for life be this, i no dey let situation intimidate me, because i don see things ooh, wen i go dey talk people go think say i dey craze but na true, instead intimidate your situation and e go find e levels, abi na lie i talk, if wetin you dey do make you happy, carry on wetin dey the life sef. take am easy my sister, i hail your courage jare. |
me i dey toast guys oohh, wetin dey, abi dem get two head, if you like porson you no go tellam, abeg e. |
why you dey worry you still young na, me i be 44 and i still get hope. |
®~^Sly^~®:second that! my own na 4 step mama i get, my papa na player because him be dey find boy pikin,na the boy pikin wen him dey find make my mama die, na me be the last pikin. |
na today, make i hear word, una better leave matter for mathias |
