FatherOF2's Posts
Nairaland Forum › FatherOF2's Profile › FatherOF2's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 (of 25 pages)
@ Easimoni, On the large sale of Diamond volume yesterday,i gist with my broker well well this morning oh. E say no be major institution sell oh. Na just one man institution contribute mostly to the selling. Dem say the guy need cash badly yesterday. |
samstone4:I no talk oh, but my suspicion gets deeper. |
SavvyLanre:I think some stocks go need to fall to represent oh. This friday no too good except for one or two insurance wen dey fall now. Three good ones dey fall now, but TWO are making good hasty retreat. I don dey pray all week say make PUMPING AND EASIMONI no quick observe dem yet. Na full force Air hostess take slam Diamond door shut this morning. |
eniyanman:No oh. Na time go TALK and PROVE am. |
pumping777:Wetin i see for one page here eh, na only Biro dem fit take write am talk. Dem no fit type am here. If you get PO Box, i fit write am send you. SERIOUS. |
RoughCut:You get the spelling very CORRECT my guy. |
eniyanman:Bros i don see son tin too convincing. |
wanaj0:AhHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHHH, |
Ah i don see am finish, DOUBLE PERSONALITY INDEED DEY HERE. |
I no trust this place again oh. I SERIOUSLY SUSPECT THERE IS A DOUBLE PERSONALITY AMONG US. |
http://www.vanguardngr.com/index.php?option=com_content&task=view&id=2237&Itemid=42 Magomago still dey worry cadbury?. |
ololufemi:How work bro. I hail you oh. How d issues of some weeks ago. Hope you don resolve am finish. Make we dey see your face with those fine fine news.I dey enjoy those informative postings. Minus proshare, i no know how else you dey get some. |
bibiking1:Hahahahahahahhaaaa with Elephant hide piercing rounds. |
yodiyokun:E go be very temporary one. |
yodiyokun:Good one there. |
Prince11:So na you don dey weigh down our fuselage. But seriously, you're right.Its always better to take position on a stock when its falling.You try and anticipate it before everyone else. I think a good fall for PHB tomorrow will be an excellent entry for you.Then you'll get at a SAFE ZONE price,even if it falls slightly,you've already worn your seatbelt.You have this Thursday and Friday to chose an entry.You should be in a safe zone,then you wait. |
kpineo:No i doubt it sha. E go rise, na those when quick get certificates dey do small small selling. E dey rise like PP.When e don do some serious percentage rise before e go come crashing again. Even me till today i no understand the kind one day Juju brokers do for that NASCON last year. |
@ tboy1 Na jan31st i post AIR SERVICES pop up my radar at N18 card.I no know if you buy am that day. Na N23 today oh and on full bid. loma:Men i dey wait make people do selling oh. But one good one dey wen i dey see. I just PRAY say Pumping and Easimoni no see am on time. |
kpineo:Leave UBA for now, e go still represent later. If you wan fire, na Diamond you fit fire now,but you for fire am today,na wen people dey sell na e dem dey buy.E get better statistics than FCMB at this current moment only oh. I still dey FCMB big time. Na the fastest i choose of the two. Me i dey expect great things from NASCON results wise. You no see their half year last year?. |
Men anybody wen no buy Diamond today, today fit be one of the last chances oh.Killing wan come for Diamond. |
@ Kpineo, More christmas salt and pepper just dey enter NASCON men. See another killing in the making. KPINEO na small remain to wipe off your @dbenzd, na here your N5m for enter oh. But as you fit don miss am, another killing dey for pipeline soonest. mmmm, see money on top of money. |
londoncool: @FatherOF2,Question mark dey d end. Na you be that ?. Na that kind belle i dey target every saturday for gym. |
@ Londoncool I wan believe that na you for that your profile oh. Na you be that?. |
debenzd:Hmmmm, the EXPERIMENT. I no know as you fast reach sha. But generally the system you just talk so.i will advice you adopt it after Mid year,not now.Na den me dey adopt am. Right now, its not that you can use it,but this na GREEN SEASON.Earnings,reports,etc are coming out now. There's general growth.Many fit no drop back to their previous low of lows. That's why i talk of HALF CICO now, then FULL CICO from mid year wen we don clean mouth finish. There are many PARTIES going on right now in NSE,you need to attend all of them the same time right now with that N5m. Except you're worth at least N100m as we speak, i no go advice you use all N5m for biweekly action.But like i said, how fast can you be?. When i mean fast,i mean fast.Its not that you no go fit do am,but you must remove " I WISH" from your heart,wen you hit 14% u must bail out so fast and no let greed catch you for any stock or you'll go down with that stock and all the N5m no go fit take part for all the other parties when go dey go on for next door. You need to split am into 5 places this season. Take note again, no market in this world get 52 Bullish weeks. The tail tail signs of bear hibernation being over will reveal themselves later in the year. IT MUST HAPPEN. As per UBA, the stock go good if you wan put money inside. But i always dey look 3months time frame. I get some there,but my killer movement into UBA go be when Q2 announcement dey approach because e go still dey available at about this price or slightly higher.By then, na only 3 months man need to wait for the BIG 9months when dey trully move price. |
endure:Hmmmm, ha, pumping don answer you sha on isolated cases. But besides that one. Me no sure say na two weeks i talk oh. 0-3months (and everything in between). |
ololufemi:How you dey my brother. I dey fine.Same with family. We dey watch the next big ride oh. I dey do serious scanning now.Some come out yesterday. i wan still see those wen go fall inline today. Make you hold your UBA oh,you know na in between season we dey now for UBA. 6months dey end next month so from April, things suppose dey happen. |
Pumping777: The best way for me to answer this question is to let you understand why Oceanic does not meet my objectives NOW. I sold every unit of Oceanic I have in my trading and long term portfolios and thank God I did.A CICOer to the CORE.You will know a natural born CICOer wen you see am. Welldone. |
aktopgun:Even me dey laugh tire tooo. ![]() |
aktopgun:Make am 35, make i see. |
aktopgun:Me i want make you convert. I wan give you position. .No worry i no harrass you again. But if you convert, make you hala oh. |
@ Easimoni, How much you take buy that your NASCON?. E get sometin wen i don newly observe this year for NSE. I want make this month end to confirm my suspicion.If e tru, na another strategy be that. |
@ aktopgun Na wa oh. All this stock wen you dey call so, you dey buy am so?. I for like make you still name like 10 longterm stock too oh. You no wan gree admit say you don covert. |
That na serious disorder OOOO