FatherOF2's Posts
Nairaland Forum › FatherOF2's Profile › FatherOF2's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 (of 25 pages)
aktopgun:Amen my brother. Na January i take buy am. My money just dey rise from all corners. I don comot leg for Eterna with 70% profit.killing of the month. This wan na total CICO (full liquidation). I no wan hear tori tomorrow. Nascon must deliver some good percentage again. I just dey check out this loosers chart now now. Interesting developments. 1.Diamond just dey open e door one more time. E be like dem fit announce this week or next. 2.FCMB dey do the same thing. 3. As per this number 3, there is no better way to guaranttee profits from a stock than a stock which has just been marked down for bonus. It works ALL THE TIME.When DEAP CAPITAL has finished a fall of at least 20% from today's marked down price. Fire that stock with all cylinders. This will be the case with every stock that gives out bonus this year,if you miss the bonus train,you're sure to make money from the mark down train. 4. @dbenzd, RT Briscoe is called a Ranging Stock. It stays within tight trading limits for long periods until when the real action starts very close to announcement. It will present itself again,but target a day people are selling. That stock no get water (illiquid),so na wen people dey sell you MUST BUY. 5. Three other stocks to be named later are beating a hasty retreat since yesterday that will make dem very good for friday reentry. Na wa oh. Una don give 1st Bank Elephant name finish. I come get so used to the name. I reach CSCS website and i spend 30secs searching for a stock called Elephant.Na letar i remember say na 1st bank. But Elephant no go make am pass this next two days sha. |
kpineo:Hahahahahahahahaha, I tell you say make you hold that NASCON early Jan. E go recover before your PP action of that time. Worry not my brother.You shall move from Loss to profit on that stock. |
yodiyokun:No ohHHH sister no oh. i never reach there oh. I no dey carry money outside Nigeria oh. Na CNN talk am. |
aktopgun:Notin beat am at all. |
Geees:1. Nigeria, 2. I hear Dubai has done very well for some people. 3. Vietnam is another excellent one.Growing fast with fantastic returns like niger. |
@ Temmie10' One of the sweetest names on this forum. Welcome back. How oyinbo UK?. |
Geees:If i dey developed market where na only 20% return. I go sell everything go put for undevloped market., |
aktopgun:Ahhhhh, die na strong one there oh. Na only person wen go go sell e Eterna go use am buy S-Class, na d S-CLASS go die for Nigeria Road oh. When you pull am out like my 70% profit in 3weeks for Eterna go put am for Diamond, IBTC, IEI,Nascon,FCMB,CCNN wetin wan kill am. |
aktopgun:Ohhhhh, see d bad news when you just dey give me. I be don go buy wan white FOWL KILL NOW NOW to celebrate new short term member. I go reserve am for later until you don convert finish. ![]() |
upward: @ aktopgunUpward PZ now stands at about 20% profit since that result came out when there were some worries that day. Like i said, I BUY wen i see what i want to see. Today is monday. Anything happens on Mondays. Lets see the momentum till about wednesday for PZ. If it continues, then this week will be an excellent exit for PZ.I'm looking between N31-N32.83 for an exit. Some people have just been credited with the bonus of last year and the price needs to get to at least N33 to absorb the shock of the selling that will follow this.Then one can reenter after the storm will be over.This would be around 9months results time. @ aktopgun When did you suddenly become a short termer. You were an avowed Longtermer like a month or two ago or there about. You just dey use Bomber language.Daily price movements no suppose excite you now?. |
E don dooo ohh. make we end. |
aktopgun: @fof2Hahahahahahahah, anytime i hear aktopgun, i think of only TOM CRUISE. Since you're (ak) (also known) topgun. I trust you on that one.hahaha .yodiyokun]Father of 2Eh normally i no dey advice entering stock when e don dey move like this oh.I know all this insurance dey in a hot race to reach some particular figures. I can't really tell you to go in as its running and running. But if you must go in at all,just enter when in tries to reset itself with some two or three day drops and power back up again,because now,bid is still high,people no go wan sell.But no stay too long if you manage enter oh. (TS scare). But generally i'll suggest make you wait,all this bull bull when dey stampede everywhere so, them need to stop to drink water.Na den you go enter their back before them continue again. |
aktopgun: anyone on the oceanic flight to bangkok yet. last call for oceanic flight 101recover to bangkok, plane now boarding at gate NSEAhhhhhhhhh, brosss, but you be no wan accept say the tin don bottom out na wen we talk am some 2.1 weeks ago now.Which time you enter na?. Right now IEI seems to hold best value. N12 target is clearly on it. @ Prince11 just hang on. AIR LARFARGE,,,,,,,,, This week na cross over week. "Panic buying". GTB don present one of e last chance last week of Jan. E dey repeat that pattern yearly. Easimoni you go agree on this point. We discuss this GTB issue last December. |
dbenzd: FATHEROF2,WINDYWENDY,My benz sister. I sure you dey ride benz.Talk true. As per dnmeyer. Wait small.E take style high small for me at that price. This INTENERGIN considering dem don reduce the number of shares for that stock, e be like its painted with a N12 destination price. @ YODI, E go hard OBAMA oh. |
Eh u , i dey miss my beautifull thread oh. Wey time now. elemu:Hmmmm, make dem no go hack my money join oh. That one no go funny for cscs. shigidi: wendy,I agree with you here.Who wants to see his price crashing down wen year never end and e no give bonus. They can release certs., just to obey sec.,but will delay listing. Besides which day offer end and they came out of TS, no just november for here. easimoni: UBA needs to make gains o! Your boy is in big time.Yes oh my brother, its crawling into buy domain again. I'm also watching IBTC make its gradual falls.That one fit complete e own this week or early next, beginning of the months is always bullish, but its not forever. shigidi: AND TO THINK I SOLD MY UNIC AFTER MAKING 40%. ITS NOW GONE ON TO DO ANOTHER 40% AFTER THAT. NA WA OOOOO. SO MUCH FOR FUNDAMENTALSMy dear shigidi. I so love this name. You know what you need is strategy refinement. You no need to fret about wetin don happen pass. That na one rule wen my broker teach me very early. I go buy one stock two times on the same week because i think say e go still climb more,not remembering say bad side dey for stock. One vocabulary you go remove from your investment dictionary na " I WISH". I wish dey work both ways. Good and Bad "i wish" dey.Na d one wen your hand fall put be your NSE cross. You know on strategy refinement, dem get two types of CICO's. HALF CICO and FULL CICO.. HALF CICO na strategy you suppose adopt for this period named by YODI as " GREEN SEASON". Na now money dey come,till about June/July. After June/July, you start FULL CICO wen we don hear all the better for all these December companies finish. When you do HALF CICO now,you fit move am into other companies,so you go dey grow continuously, meanwhile your principal still dey perform.Like me now.I still get principal for Lasaco, Law Union and Mutual, but i don comot profit two times for Lasaco and Law Union. Also eterna recently. No matter wetin happen for those stock,all i know na money wen no be my own before i don cash am finish.E no go run comot from my hand again again.If e like make TS catch am.But TS no go catch am sha. You know say projections for this year dey bright all round,so chop from all corners while you can,but e no go be forever oh. But after june time,na FULL CICO i dey oh(total liquidation), na rebalancing for 9 months towards year end and attacking mid year stocks wen still dey ground. After June/July actions noh too plenty like that. Dem say anything that goes UP must come DOWN. Later on in the year, BEARS must come out of hibernation.They must by all means,even if briefly otherwise cold and hunger go kill am under the snow. Na so i see am for pidgin english. SavvyLanre: Fof2 - When do you think the bull run on the Insurance coy would end temporarily? Currently, for all the coys - the fundamentals is way too high, and for many of them they would need to triple or quadriple their earnings to meet the current value of those stocksMy brother i happy say you see am well. Right now,d way i dey do insurance na like armed robber. I no wan hear story later, free money just dey come, i dey evacuate am fast fast.i no wan see free money evaporate like that. Computer wealth dey very irritating. The insurance companies are solely being driven by sentiment,nothing else. They have defied all logic as it stands. At the prices dem dey now, dividends need to be fantastic to meet up. I don't see that happening later on in the year. Another thing i've observed again is that their prices are all in the upper red zone. All my technicalists understand what i mean by upper red zone.If dey go into TS in this zone, they're more likely to descend post TS than to go up,no matter the sentiment.Who knows sef,bears may have woken up then and its first meal is usually the insurance companies.That na why i just dey evacuate every profit wen i dey get fast fast. @ Roughcut, I read all the tech happens some pages ago. You know i get your back anytime, anyday for this place. But just switch the number for the tech stuff and you don get am. @ Ololufemi, How you dey now. That one strong oh. Insurance now and yet avoid TS. Na only juju doctor fit get that one. E dey tight oh for insurance.Tell d guy say some bank dey open door small small.Na only if you don enter insurance before na e you fit ride on. @ Kpineo, How you dey.Longtime no daily bid. How your work now and family.i dey miss you oh. @ Upward How are our flights doing, PZ is up N2 card since then,don't worry more are coming. Air Larfarge is all up (feet)(N)4 since last week. Excellent bro. @ Captain Men e be like na this week we go kill goat for our plane oh. That N32 card must come do or die. 25% must complete for this flight otherwise na hand i go take push plane go air like superman take push that space shuttle go space. @ Prince11 I go dey advice make you dey target this week oh make you comot SOME money for your Eterna oh. Your profit go don enter fat figures now.Money dey get leg oh. |
springss: Fo2, other gurus,I entered Eterna because i wanted to take advantage of opportunities that usually present themselves after BAD NEWS.Enter when everyone has finished disembarking.I still believe from my calculations that there is at least another N3 to be made from Eterna from yesterday's closing price.It broke through psychological friday on a bullish note.I took out some 25% profit earlier,but my balance is still yielding more. Right now one top guy on my list last friday is CCNN. I entered it after all panic selling from the importation bad news was complete.Now i'm waiting for institutional investors to come and pick me up.Air Larfage will also have an effect on this guy ccnn.There're many to choose.I concentrate more on the Loosers chart daily for analysis. krrush: Again,a good illustratioin in the way Trends are applied in trading was pointed out in predicting the Q4 earnings of GTB on previous pages on this thread.Correction, That was Easimoni's lovely analysis. |
This na why i no like to watch Nigeria match, person tell me say Nigeria dey lead,na wen i come dey watch am dem score us. Na so e dey be everytime.I don off am again make nigeria score back. |
Mr. Risky:For all the attempts made at that photo.This is one of the strongest. My intestine be wan burst. ![]() I believe you oh. |
This NNFM just dey blink red light oh.Dem don too sell this stock. E don dey due for U=TURN particularly as Q3 for e and Flour mills of Nigeria dey come oh. |
Favour08:Are you outside the country?. My broker no get online presence. But e dey effective. E go execute my order even if na 10am,but i must call and text am the order. TradeLink securities ltd. 2nd floor Bookshop House, 50/52 Broad street,lagos. But i tell you most solemnly, you have to ensure you send your mandate either in the morning or the day before and follow up before trading starts. Then ensure you get trade alert even if you dey. Norway.Once you have that you're covered. |
Oh men Aiico come out today. Na N2.96 i be take buy am before TS catch me.But i happy na beta CATCH ME. |
easimoni: NSL will stop gaining 5% daily sometime next week. I expect.Yes yes, correct man. You dey come out small small. GRADUALLY DOING short FUTURE BOMBING. I like that man. True to yourself. You no dey do pretend bombing. |
Men this must be one of the lowest deals i've ever seen on the floor. N102.00 I no sure that transaction pass thru computer. Na over the counter loose change na e broker take pay for this one. kpineo: @Father of 2,No oh, nothing like that oh. I only make reference to that PP deal you be wan do that time. Nascon go recover before that deal go see light finish. THE KEY TO THIS BUSINESS IS TO DETECT BEFORE ACTION STARTS FOR A STOCK. |
ty_ademolu:Sorry i missed earlier messages. Which stocks are listed on the bank share loan.?. List them,make we see.There's always a list. The unfortunate thing sometimes is that some of their stocks go dey so high or na stock wen no dey cyclical and them want you to stay there for long long make your interest plenty small. Just put up d list.Good one must dey inside. |
yodiyokun: OPARI!! Strong woman.@ ebony9ja You're right about NASCON. I told one or two people to hold on with theirs because it'll surely perform before that PP. @ Wendy Another good point.I remember in early Jan we talked about discussing with your brokers.Ask deep questions. Then on FCMB. I remember in December when Diamond was N18. I saw posts like. " Diamond is good,but i'm not sure about this GDR thing. I'll wait". " People what do you think of Diamond, how will this GDR affect it?." I responded that GDR will affect nothin on Diamond. So we can see how far Diamond has gone now. If you bought at N18 in December while some were worried about GDR, you would have at least been 28% richer two weeks ago and still be 22% richer now. GDR's effect on GTB last year was much later and minimal. GTB lost ground after the Bonus was credited. FCMB is still in its safe zone right now.That safe zone for me was N19,but as each day ticks away,its leaving safe zone. Me i see these ones as tradeable. CCNN Air Lafarge= Alias wapco Oceanic= If you can wait till Q2 announcement UBA= Also Q2 Air Services= This monopolistic guy. GTB= Gradually getting late NBC= Still so cheap Diamond= With a little more drop to about N21. 7up= As we await Q3. PHB= Still above TS price, but we fit beg CAPTAIN to open door for Waski-Waja to enter. DSR= Just entered cheap zone considering the time when still remain. Last one na that sometin when double barrel shoot yesterday, e go still stand again.Na bonus enter e blood small. |
tboy1:. I'm drawing up a list this evening. AIR SERVICES JUST POPPED UP ON RADAR |
upward:Slowly but surely it must rise,e no get how e wan do. Remember them announce bonus last year.The price needs to rise enough to a point to absorb the effect of the bonus.Na the same thing for our AIR PHB.It will surely get there before bonus effect kick in. That na why i no worry. For wapco we go call am AIR LAFARGE. |
Una don see market today. E be like double BARREL shoot something today for floor. Heavy Earthquake. @ Prince11 Your Eterna don dey rise,if you wan sell, no sell all oh. I no sell all last week.But stay action.Bid on the stock heavy today. E go add join am tomorrow. question:No go Afroil oh. E don too late. Its too expensive now.I doubt it will pass this week. Na wetin dey drive Eterna small small don dey drive am.As all their senior brother don too cost,na only dem look small enough to chop their head now. |
E be like the guy wen just lost Societe General money don join this thread oh. |
no_shaking:@ No_shaking YOU HIT THE NAIL ON VONO'S HEAD.Very correct my man. Abu-Maryam:Abu-Maryam, just leave that hummer oh,e too dey chop fuel. How you go dey drive small boy jeep. Na Royal Rolls Royce you suppose price oh,nothing less.Take only Black. Black dey fine for that una side. 20'' wheels oh, no forget. As per IPO/PO/PP we go soon give dem new name for this thread. |
I'VE NOTICED THIS THREAD IS GETTING INFECTED WITH PIDGIN ENGLISH. @ Ololufemi, For you specially. I would strongly recommend FCMB right now.It has bottomed out. The banks are towin a new line now.Very quick releases.I'm strongly of the opinion FCMB will follow others for its 9months. I'm expecting at least N23 for that stock. I've doubled my stake in it since the last CICO some weeks ago. I'm currently waiting for IBTC to complete its descent in at least one half to two weeks max. @ Osazeet How are you too. I'm very ok,but very absent now.So i'm not posting as i would like to.It may take about 3 weeks before i can finally settle back again. Thanks for your concern. You look like a very GENTLE MAN. Thomas wyatt,i've not really done any business with that stock.BUT I STRONGLY WILL NOT ADVICE YOU TO GO THERE.IT'S NOT SAFE.I'm assuming you seem to want to go there for long term reasons and because it looks pennyish.If you want to do any longterm,put it in a safe place.Like i've always said, I LOVE BANKS,thats the only place that can absorb big money.You can place your tent in Afribank Now.It bottomed out last week as expected.Forget that its not pennyish,its your percentage gain that matters. @ Upward,Koksieboy, Same applies above. Well Unilever could have been ok sha,but it has already gained 10% since two fridays ago when i expected BLOW007 should have gotten it. Meanwhile BLOW007 did you still get GTB last week. That was the 3rd stock i expected you to use your last N600K on from the breakdown. I'm also liking CCNN. I believe wapco's sentiment may rub off on it ,if wapco announces in early march. Besides that CCNN is quite cheap too now. Diamond needs a slight descent and stabilization around the N21 axis for good reentry in a few weeks as we approach the Q3 for that stock. Just tell your ogas to pay you your February salary before the end of Febraury so u can take advantage. Got to go. |
easimoni: The thing baffle me no be small. I bought small at 7.50 thinking it'd take 2-3 months to RORO/CICO/GIGO (do I sense Fo2 smirking, saying "this fundamentalist dey CICO?"You catch me for there. fatherof2: My dear brother pumping,na lagos state govt. get julius berger shares oh.Its hardly available.@ Windywendy The post above was made on Dec.17 2007 at 7:21pm in a response to pumping. As you can see,no be two days ago i start to dey dislike Chellarams.You can see the reasons attached. Na same reason i put again. And the post when follow am sef na your own. "MY THOTS EXACTLY". Remember. If chellarams make 3000% profit on N100,000 to make am swell to N300000 in 4years. Wetin be N200k profit in 4years,when banks dey where you can pump N5m, e go move 8% in one week and you go end up with same 4% profit in 1 WEEK. I no know oh, e be like na you dey translate another meaning oh. BUT ON THE OTHERHAND,IF I WAN LOOK FOR TROUBLE,E NO TOO HARD,NA TWO TIMES YANGA COME LOOK FOR TROUBLE FOR HIA. I NO GO FORGET SOMETIME LAST YEAR, WEN YANGA COME LOOK FOR TROUBLE WEN E DEY SLEEP. But really i think you read my post in a different way.No forget i dey do short term volume,so Chellarams no go fit be my friend. Most of my time,i dey smile with my daily activities. Smiling and happiness dey make man handsomer and handsomer i know say them go fire this english @ Tonyjon I like that your friday strike.Eterna na quick one for me.Though i no sell all. I just collect the 25% when i make so i fit reserve am for me and wife holiday with d two pikins.Na PHB i dey wait for. |
you these guys I bow for you ooo, I refuse to think of the size of your portfolio
). 