₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,654 members, 8,431,946 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 04:52 AM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 13 14 15 16 17 18 19 20 21 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:01pm On Aug 13, 2020
Ozo talk sotey housemates dey greet am as he finally comot from the Diary Room

"Oga, what were you discussing? Shalaye FC" grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:57pm On Aug 13, 2020
zicoraads:
This is the Ozor that dwarf and bigot on Twitter was comparing to Kiddwaya.

I don't really blame some of you.
LOL

Ozo na my guy o, but you see that Noble, that guy na Premium troll.

He dey always insult Kidd and Erica to elevate Ozo and Nengi.

As he old reach, he go dey misyarn like pikin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:55pm On Aug 13, 2020
Ka3na just dey do Indaboski on Twitter today.

Everybody must collect grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:55pm On Aug 13, 2020
Amya:
3000
You dey really hustle this 3000
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:54pm On Aug 13, 2020
Ozo loves his family sha

He dey do me like all those men wey if dem born daughter, the love wey dem go shower on the girl ehn, e go hard her to date most guys, because her Papa don use love scatter her life.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:52pm On Aug 13, 2020
MissAnnBoleyn:
How is Efe doing these day? This is the first season of BB I am watching fully. 85 million naira is a lot of money but that money can quickly disappear with bad investments and family/friends that come with their begging bowls.

My Father's late friend left 40 million naira to his son, within 2 years he was back to being broke due to bad investments. He started asking my father to pay his rent lipsrsealed lipsrsealed
The prize money is 30 million Naira.

I repeat.

I don tire to dey read this 85 Million talk.


Na when dem add other things like the Innoson Vehicle, the one year supply of Pepsi, trip for 2 to Dubai, two-bedroom apartment. You go come get total of 85M naira (inflated sef)

So, na 30 million naira, prize money

55 Million worth of other Prizes

Total: 85 Million Naira
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:46pm On Aug 13, 2020
zicoraads:
You go read some things here sometimes and shake your head.

If you no de watch, or you no dey active for all these social media, you will believe anything.
Honestly.

The lies here plenty pass the truth.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:45pm On Aug 13, 2020
[quote author=ANTISIMPS post=92775957][/quote]In-law, we get immunity.

Make we help our family friends this week.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:42pm On Aug 13, 2020
geezprince:
you no go thank me? After I help you beg finish. I go tell am to ban you back now. grin

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:42pm On Aug 13, 2020
Ozo na correct guy

I no regret the hundred web votes wey I give am.

Make I go add more
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:40pm On Aug 13, 2020
aduntemi:
Unnecessary if you ask me sha. In this life, you can't be nice all the time
He and Erica get the same problem

Dem no wan lose friendships because of relationship, but the friends no wan be friends.

Na flaw. Dem go dey alright
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:37pm On Aug 13, 2020
Dansuqi:
I mean at the finals,she won without ike fans
Na because Tacha been no dey finals.

So, Ike fans been no dey necessary.

If say Tacha been dey that finals, e for bloody. No reason am.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:36pm On Aug 13, 2020
Liposure:
all of a sudden cuppy is his fav. B4 now who knew kid with cuppy
Na you no dey follow up.

Dem even get picture together for him IG page, no be all of a sudden
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:35pm On Aug 13, 2020
Ozo dey worried because Dora dey give am attitude.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:32pm On Aug 13, 2020
Kiddwaya IG handler wey dey always flirt with Erica handler on IG na who no be shipper?

That one wey dey ship pass anything, dem ship sotey Erica handler come dey ship by force, make e no be like say e dey one-sided

This Nairaland sef.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:28pm On Aug 13, 2020
geezprince:
For Insanety, the editor in chief of “the twisting narratives newspaper” and her crew. smiley grin tongue
Shey Noble don become neutral person?

That one too na narrative twister, just because he get verification badge, no mean say e sabi wetin e dey talk.

Be like he don abandon him Ozo, to focus on our Content Queen
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:20pm On Aug 13, 2020
The anti-spambot wey ban me in the middle of my back and forth this early morning, make virus catch am.

Nonsense and John Thomas angry
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:19pm On Aug 13, 2020
nazablossom:
How dare her huh I will drag her by her nose ring grin
grin grin

She no understand.

You wey don dey wait outside for Prince since, her eye go clear
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:18pm On Aug 13, 2020
geezprince:
Lmao! Anyone associated with laycon automatically trends. Vee has never trended on her own, until Laycon came into the picture. Same with praise. While y’all were spinning and twisting narratives about Laycon a couple of days ago...that dude trended worldwide(No 3) that night.
Laycon has been carrying the weight of the show on his back. Insanety, I know you’ll disagree, but Facts don’t care about your feelings.
You see me for dream ni?

Why you just dey mention my handle up and down? Se wa alright?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:07am On Aug 13, 2020
homesteady:
Wow, another angle grin grin grin grin
What made you think so?
I feel like, when people have ideas in thir head, they interpret actions to reflect the ideas.

For instance, if you tell person say her husband dey cheat, maybe if he been dey hide him phone from her before, and she been no suspect anything, once she dem plant that information for her head, she go come dey suspect that action.

Because the idea has been implanted in our minds, say he like Nengi, him normal argument, don dey look like insistence. As he take argue the Ozo and Nengi matter, na so he been dey argue the Laycon matter too. Besides, Nengi na him friend, as Ozo be Erica friend, even Erica been dey argue the matter seriously.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:03am On Aug 13, 2020
Beorn1:
God bless you. Kidd is very smart and sees the truth. The moment he told Erica about how he leads Laycon without doing it intentionally, made him realizes he reads the HMs perfectly.
Very much so.

Erica dey use Kumbaya glasses read people, but you see Kidd, he dey read them with clear eye.

If you notice, na wetin make he dey supply people with limited information when dem mention him relationship with Erica, even when BrightO dey try prod am sometimes, he go just stay quiet.

He dey use their words take gauge them.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:57am On Aug 13, 2020
homesteady:
But if Kidd likes Nengi as you people are implying, why will a guy be teaching a girl he likes how to flirt? grin
He's saving her for outside, you don forget?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:47am On Aug 13, 2020
Beorn1:
That poster is Jude. I've known him for years on this forum. He did the same thing to Frodd last season. Lying against every of his move and actions. I watched that convo all through and Kidd never said one thing wrong. Erica was even shocked that Nengi sees and says Ozo is just his friends despite how close they are. But it's the truth. Ozo wants a relationship, Nengi doesn't want that. Isn't that why viewers think Nengi is manipulating the men? Is that why viewers are mad at Ozo for fooling himself with Nengi? How did Kidd saying the truth means he is jealous of Ozo?


What exactly will Kidd envy about Ozo? Nengi? Person that's not an item with Ozo? That Jude is a duplicitous hater.
The entire thing surprise me.

These people desperately want Kidd and Nengi to hook up, and the intent is more malicious, than positive.

I been dey even tell my cousin say, as Kidd take analsyse Ozone, na so me sef see am. Erica fit no dey see am, the same way she been no see as she dey lead Laycon on, but Kidd dey very observant, and he dey closer to Nengi sef, so, he go get inside information on the relationship wey Erica no go get. Erica dey spend time with Ozo, so, na from Ozo angle she dey argue, while Kidd dey tell her as e be from Nengi side.

Anybody wey give that conversation any different interpretation, na dem sabi
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:32am On Aug 13, 2020
galaxyball:
My mummy
My daddy
My sisters
My cousins
My gecko
My fish
A family-oriented man.

Good guy
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:32am On Aug 13, 2020
Beorn1:
Everybody Ignore this lie. None of that happened. Kidd never wished Ozo don't date Nengi.


In short, any report coming from this moniker especially about Kidd, comes from a place of hate. Don't believe it. He does this every season when he hates a HM, he'll start twisting facts about the HM.
Thank you for being awake
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:31am On Aug 13, 2020
bentenny:
There is no Ozone ship....they are not compatible!
If they miraculously get into a relationship,they will tear and destroy each other!
Their Friendship is okay!
Na wetin Kidd tell Erica be this

And as he take explain am, na so me sef dey see the relationship. Ozo na nice and caring guy, so, ladies go like am, but Nengi no like Ozo the way wey Ozo like Nengi.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:28am On Aug 13, 2020
bentenny:
Those who like such guys should not complain when he uses them as an example!
She tell am say na good girl he need.

I pray make dem send good girl, make Ozo see am and like her.

These conversations no dey put the guy in a good light and e dey make me feel bad, because Ozo na correct guy.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:18am On Aug 13, 2020
MizzD:
The only joy I also have is that I watched it myself too, with my headphones too, so I heard everything loud and clear. cheesy

I was already thinking of how to type the gist for the sake of those who matter but it’s like you all are awake too.

And I thought content had finished for the day, yet the boring and scam ships are keeping the same set of people awake grin
Video even dey Twitter

So, anybody wey no hear am well, fit still go watch.

But, hearing is one thing, interpretation is another.


Kidd and Erica na scam

Kidd don chop Erica, I no know wetin make he no wan go meet Nengi wey he love so much.

Abi, he no be hard guy again?

Make we dey look the scam.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:16am On Aug 13, 2020
Nengi say she want guys wey if dem comot and dem get confrontation outside, the guy go fit step up for her.

She say she no like guys wey go dey resolve conflict in a civil manner, she likes guys wey dey talk am as e be.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:07am On Aug 13, 2020
ERICAsHawk:
Omo! Thank God say I no sleep off come miss this gist, una mad well well for here. See twists shocked shocked shocked
LOL

Thank God say you dey awake.

I no even get strength, anybody wey wan collect anything from that conversation, make dem collect.

I no fit wait for new housemates sef, make Erica see fresh guys wey she go flirt with
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:05am On Aug 13, 2020
Akshow:
If this denials will make you sleep peacefully, who I'm I to deny you your peaceful rest.


Awa fierce!

Icons signing out grin
K
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:04am On Aug 13, 2020
igasiboy98:
But why is Erica still staying with that fool called Kidd? Why is she constantly enduring this disrespect? Imagine that statement. No reassurance in anyway just fvck partners.
He no talk say he no go care.

He talk say he no go vex for am, sotey he go stop dey talk to her. Basically, saying, he no go react the way wey Laycon dey react.

I no even get time this night.

I don type the one wey my strength do me. Make una carry on.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 13 14 15 16 17 18 19 20 21 (of 90 pages)