₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,670 members, 8,432,047 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 08:11 AM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 15 16 17 18 19 20 21 22 23 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:15pm On Aug 12, 2020
So, Eric don confirm say Ozo and Nengi shower together.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:13pm On Aug 12, 2020
Fayar:
Mansalughter is different from murder bro.. smiley
I know

But I interpreted murder in that sentence to mean "killing someone"

Not murder, according to law.

Layman no sabi wetin be manslaughter, murder na general term.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:11pm On Aug 12, 2020
Bottom 4 (for now):

Tricky Tee
Kaisha
Tolani
Wathoni
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:09pm On Aug 12, 2020
dominique:
Nengi how can rape be the only offence that is unjustifiable? Is stealing justifiable? Is murder justifiable?
If you get pikin wey hunger go soon kill and you steal to save them, people fit consider your matter, if you kill person wey wan rape you or wey wan rape another person, even for court, dem no go charge you for murder, but if you rape person....I no fit imagine your defense for that kain thing, because even if you dey drunk, e no go still justify am
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:09pm On Aug 12, 2020
MzCherry:
Erica is annoying, power is getting to her head
Calm down, she go vex you for another three days, before the power comot from her head. Drink water and enjoy.

Una go dey happy when dem dey walk all over somebody, when the same person change am for housemates, una go come here dey complain say dem dey annoying.

I dey enjoy this version of her, e sweet me die grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:02pm On Aug 12, 2020
Eeghe:
That’s the other reason why I added my Tolanibaj’s boo tongue to my list
I may give Dora some too
They were on point
Dora dey sub Erica too much, I no like am.

E get wetin she talk this morning wey annoy me. Na small thing she take better pass Vee if na that one.

Lucy dey talk something about Erica, na just normal discussion with Praise and Dora, she mention her name, na so Dora talk, "Don't shout her name o, I no wan collect slap this morning"
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:59am On Aug 12, 2020
Hallenjay:
this friendhsip tin de really pain erica ooooo
.
Imagine saying for some stupid reason he cant speak with him Again.
This girl need a coach now, she wants laycon like never b4, if not for consistent space request from laycon, erica will go bak to him after ds discussion because she was referring to a situation where dora takes back ozo after nengi gve attitude but laycon cant just take her bak because of some stupid reason.
Erica ia pained and she cant endure ds for long, max ds week, she will ignite relationship wt laycon again.
D tin is affecting her lifestyle and ds affection is d same tin giving Laycon false hope.
De will still go bak n d internet will erupt once more
E no dey affect anything. She don collect Ozo advice move on, that video don reach like 3 days now
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:56am On Aug 12, 2020
ERICAsHawk:
Oh, nice idea.

Did you watch Kidd call Erica "Eri"? Or "Baby G"? grin grin

There's also a video of her telling Lucy she'd love to learn how to cook from her, she was seated next to Kidd and he said something ( I didn't get it) but Eri replied and said she's cooked before, Kidd said "ehhhhnnn" grin grin grin grin grin
He dey tell Lucy say he go send Erica go her cooking school.

E get another video, when she been wake up, dem siddon for chair, she come dey stretch, na so her shirt rise. Kiddi come dey rub her belle, dey tell her say her belle too small to carry baby grin. She come dey ask am say why he dey always talk about babies, say she dey too young to start having babies shocked

E get one Instagram page wey dey post all their moments, kiddrica.live
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:51am On Aug 12, 2020
Eeghe:
I switched on my TV to see Laycon and Vee talking about Erica
angry
Vee voting is cancelled cheesy
Praise voting is cancelled
Anyway I am surely voting for Tolanibaj, Ozo and Prince ...
But will wait till tmr just in case irritating Praise redeems himself
Na only Ozo, Prince and Tricky I don give votes this week.

I never too sure of the rest, but I still dey consider Praise.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:48am On Aug 12, 2020
Eeghe:
I laikkit
He shouldn’t undermine her authority
Exactly.

Because she dey smile plenty, e easy for people to take her for granted, so, she needs to assert her authority.

Na wetin Prince and Dora been dey advise her last night, say, if as HOH, you dey complacent, na so your subordinates go be. So, you gats dey strict and change am for them, because anything wey happen, dem go say na your regime dem lose wager.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:34am On Aug 12, 2020
Pericious:
What did Bright do? She insulted him and said he's not going to be in the drama.
When others dey baff, BrightO lie down for bed, dey follow Tolani gist. Na when Erica say make dem rehearse, na im pastor Bright remember say he never baff.

She come kick am out of the drama, as e no dey serious.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:31am On Aug 12, 2020
zicoraads:
Knew this since last week when I traveled to see a friend. cheesy
They are doing us dirty, walahi.
TV/MoviesRe: Erica Slams Fellow Housemate, Lucy, Calls Her A Clown In A Heated Argument by InSanety: 11:09am On Aug 12, 2020
adesmarty:
after insulting then you go back to apologise
That is how maturity works.

You admit you were wrong and then apologize.

It is prideful and immature people that refuse to apologise after a quarrel.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:04am On Aug 12, 2020
My beautiful Elites, una good morning.

Brethren, showmax has been hoarding premium content

I say make I drop some links of the videos wey dem no dey gree us watch of our babe.


Tears tears inna the toilet, after the discussion with you-know-who

https://twitter.com/nokwanda_tembe/status/1293323996931522560?s=19

Erica meeting the ogbonge Master of Entanglement for Advice. If no be Ozo advice you, who wan advice you again?

https://twitter.com/irepunited/status/1293361242225217539?s=19

Finally, finally, video of the Christening of HOH room, wey dem no gree us see. Even that one na Premium Content

https://twitter.com/nokwanda_tembe/status/1293328541375967237?s=19

Showmax wan use Kiddrica matter pepper us, na wetin make dem no dey show them plenty for 198

Cc BlackHawk01, Eeghe, doziefrank, Tatiana4u
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:33pm On Aug 11, 2020
Erica is on her period.

Na wetin make her dey do like this.

One minute, she dey smile, the next thing she dey sulk, if you see am again, she dey smile.

Period wahala.
TV/MoviesRe: Bbnaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:03pm On Aug 11, 2020
77up:
Bet why closing the thread na angry
Plenty nuisance, plenty derailing.
TV/MoviesRe: Bbnaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:01pm On Aug 11, 2020
spinna:
thank you .. pls set the ball rolling by explaining what happened during the games that upset vee...and what made Erica so vexed with Lucy..then if you can just fill u in with whats happening now

Person no fit change channel again with bb sometimes..i just flipped back and saw Erica with claws out..sexy kitty

Pls those full of rhetorics and trolling should stay away abeg
The other team dey laugh because Vee been no dey kick ball well, so, she vex say the thing is disheartening.

Earlier during the task, Lucy been make one comment about Kidd and Erica, say, if the neck (Kidd) no show the head (Erica) where to look, the head no go move, na wetin vex Erica be that.

E don dey pain her since afternoon, so, she confront Lucy this night.
TV/MoviesRe: Bbnaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:58pm On Aug 11, 2020
RTSC:
How did Erica win HOH?

I watched her competition with praise and the girl was too slow for my liking.



na only to kiss she sabi?
She was fast with the HOH task and got good numbers.

She sabi do HOH too, no be just kiss

You no go watch important parts of the show, you go come dey form opinion here.

She even had the best time out of the girls in Arena games last week, but I know say you no watch that one too.

Una go just dey hate for nothing
TV/MoviesRe: Bbnaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:53pm On Aug 11, 2020
Rehearsals have started.
TV/MoviesRe: Bbnaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:49pm On Aug 11, 2020
tsquaure:
Lucy is a trouble maker
When she was HOH, na she dey cry for Big Brother say nobody respect her, now she wan dey form rebel.

She never start

Anyway, she don join rehearsals.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:22pm On Aug 11, 2020
xenoo:
ABEG WHO CAN GIVE US FULL GIST OF WHAT LED TO THE FIGHT BETWEEN ERICA AND LUCY TODAY.

LUCY SHOWED MATURITY BUT ERICA IS LOOKING FOR CONTENT NOW THAT LAYCON DON SMART UP
Where was Lucy's maturity on Sunday with Nengi?

Maturity indeed, she jam who pass her today, she no go try am again.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:21pm On Aug 11, 2020
stephleena:
team laycon alone, is okay to get the team highest numbers of likes and everything.
Where Was Team Laycon when Erica's team won the polls for the Dulux challenge last week?

Team work is team work, na everybody dey contribute.

Team Laycon alone is enough, story.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:20pm On Aug 11, 2020
Erica don speak her peace, dey chop her food, dey gist normal with Kidd.

Who no watch quarrel no go know say e happen sef
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:00pm On Aug 11, 2020
stephleena:
she should meet Lucy another day again.

Lucy is obviously happy for their win.
Abeg shift.

Erica won this round and has put Lucy in her place

Erica 1-0 Lucy

Lucy been dey even find who she go call, Erica block her road.

You don hate Erica reach sotey you dey make excuses for her win.

Make Lucy go back fight Nengi, Erica no go follow her enter gutter to win, but make una dey there dey make excuses.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:57pm On Aug 11, 2020
ToyinDipo:
Lucy no fit face Erica, at first Lucy was begging Kidd to settle the dispute, Erica no gree, Lucy kept quite even though Erica was dropping some bombs, immediately Erica walked away, she started throwing indirect subs. Erica was ready to turn her over and use her head to mop the floor.
LOL

Lucy no see the trailer, e clear her sotey even Kidd no fit save am
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:56pm On Aug 11, 2020
ArchAnge1:
Lucy fall my hand

Should have attacked her relationship with kidd

It will have really pained erica

Lucy is a mugu abeg, na nengi body she get power
Lucy call Kidd for the matter, na Erica clear her say make she no even mention Kidd for the matter.

She no get talk, this one pass her.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:55pm On Aug 11, 2020
Erica don call Lucy clown.

Lucy no get hit?

Nothing about Powerpoint or fake body?

Na only to dey call Kidd she sabi, sister face your fight.

I dey laugh.

Levels dey to this madness.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:52pm On Aug 11, 2020
Erica to Lucy:

"Carry mop for your head like idiot"

Hehehe
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:51pm On Aug 11, 2020
This one wey Lucy no get correct gbasgbos for Erica.

She just dey wonder
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:23pm On Aug 11, 2020
genius43:
Overs citizenship nor be beans at least this one don eliminate looking for an old woman to marry.
After show, he go jam plenty girls with citizenship
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:22pm On Aug 11, 2020
galaxyball:
It tends to associated with being malicious but it isn’t always bad. It depends on context, sometimes it can just mean someone has a very “detailed” way of thinking
Ok

Make I hold the one wey I sabi sha. No time for plenty explanation
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:21pm On Aug 11, 2020
ToyinDipo:
http://lmgtfy.com/?q=calculative
Your phone no sabi screenshot?

Just hold the correction, make you no go talk am outside, come dey find as you go type inside Google to convince people.

No be everybody go correct you.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 15 16 17 18 19 20 21 22 23 (of 90 pages)