InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 18 19 (of 90 pages)
MadeMan01:What kind of lie is this? He said he will use 1. 5Million to take Erica on a date So, you think say even 200k to use carry woman on date, makes her cheap? 200K, cheap? How much you don ever spend to dine woman, that you will come here and claim that dining woman with 200k is cheap? Na who no get money dey talk plenty yawo like this. Nobody dey use 200k take dine cheap women. Some poeple six months salary, guy, fear God! Stop spreading foolish lies, and making mumu comments like this. This Erica matter dey really bring out the bitterness and envy in msot of una |
Andrew13:Very twisted versions, and plenty people wanking to it. Na wetin make anything wey i see here, I must still go Twitter to confirm. |
Fayar:Thank God say no be only me see am |
Praise adn Kidd wan bet for table tennis Praise been drop 1 Million Kidd say e too small, make he bring all the money wey dey him account. Praise say na 7.5 Million he get for account, come tell Kidd, "You think say you get money" Kidd say make dem play for 7.5 M Praise, come vex say, "I'll take 6 million and use 1.5M to take Erica on a date." Kidd come tell am, "She doesn't need your fucking money" |
ItsCookie:Na so you see say Nengi dey do runs and Kidd wan use am do ashawo Thank you for staying up late to watch our Content Queen, we need loyal haters like you, make her story dey spread ![]() |
Erica CONTENT QUEEN Haters everywhere If people no dey hate on you, you no be threat be that. Na who dey progress, people dey like drag. Team Erica, make we enjoy this spotlight. The more they hate, the more her name dey fly ![]() |
ItsCookie:Laugh, na so bad belle dey do. Anybody that is truly happy, no dey anticipate another person unhappiness. Be happy for others, make you find joy for this life ![]() Bad energy, stay far away ![]() |
scondy:LOL Opinion of a biased party ![]() Abeg, wetin she dey use substance do, when she don turn millionaire for Biggie house?
|
Tatiana4u:No be small painment o Wlaahi, if you wan enjoy this thread, na to face only your fave matter. I no know why these people no go face their faves, later, dem go say Erica no be content. Any small news about Erica, dem go jump on top am. See obsession ![]() |
eleshin:Did Erica tell anybody something was going on between herself and Kidd? No be she dey deny Kidd for him front gan? This una selective reporting, always aimed at elevating the man and destroying the woman, dey always funny me. Please, bring any clip or news of Erica telling housemates say she and Kidd get serious relationship, because na two of them dey mumu themselves. |
jayjaycee0:I no like as we no come up this week, na wetin dey give all these people morale Last week wey Ozo fans even join hand to boost Nengi, we still beat am. We dey return next week to remind these people say no shaking. We dey where we dey |
ArchAnge1:Erica is a lady in the streets, but a freak in the bed. Highly recommended for long life and premium enjoyment ![]() |
ItsCookie:Allow people enjoy. Even you sef, i sure say you get some relationships wey end in tears. Wetin matter be say, you enjoy am when e last. No be say you go cry inside relationship, still cry outside am. |
If Kiddwaya die for Biggie house, na Erica kill am
|
ItsCookie:Is it your finish? Una just dey concerned for Erica pussy. He will finish with her, and she will enjoy it. Sex was made to be enjoyed. |
Dem suppose build statue for Ozo for Biggie house. A true Oracle |
crystalpapers:So, everybody wey attend command must sabi speak pidgin? You never see people wey no dey speak pidgin because e no dey sweet for their mouth? |
eleshin:Not lucky with the answers, else, they should be winning. That FIFA HQ question na daylight robbery and the question about Mike Tyson's last opponent no easy. |
I like as Tricky just dey laugh, dey call Ozo Oracle. "The Oracle said the answer is three. it's not me o, it's the Oracle." He go laugh small, "The oracle has done it again, he said the answer is Egypt" "Even before you finished, the Oracle already answered the question, Football" |
Switzerland don dey trend for Twitter because of this Betway and Biggie mumu |
Tricky just dey call Ozo oracle. No be small oracle. Biggie, suppose correct that nonsense wey dem talk say FIFA headquarters dey Germany. I no know which level of cluelessness dem dey operate on this year |
majamajic:Be like even Betway no sabi wetin dey sup. Germany, for where? |
Fayar:E no easy to carry show on top your back Dem go show some people for two hours, thread go silent, but once dem show Erica for two minutes, everywhere go just scatter, we go come dey discuss two minutes clip for the next three hours. |
Kiddrica ship causing headache everywhere See ogbonge analysis from people wey say dem no be content.
|
MamBi:Thank you for being sensible. I no know why people no fit reason like this |
Threebear:You spot a decline with at least three, not two. if next week, the votes increase again, you go come here come change mouth. You talk am like say she don dey up for four weeks, adn each week gets lower. Praise wey start for bottom, come increase small, he go still go down again, wetin you go call that one? LOL, we no change posiition two weeks in a row, na you sabi wetin decline be |
galaxyball:Na Kidd o, dey cook for her, dey feed her, dey wash and dry her hair, dey service her. No be slave sha, na things wey we dey do for love. |
Threebear:Her votes are declining weekly? From two voting weeks, abi how many times she don dey up, wey you dey bring this theory? LOL. |
Amya:
|
ERICAsHawk:My dear, our colors go mad Manipulation Blue Golddigger Gold Player Purple Pregnancy White Billionaire Black Jealousy Green Vanity Yellow Ashawo Red Fingering Pink Chokehold Grey You know say na foreign geng we be, so, na from Switzerland we dey import the Asoebi ![]() No dull yourself o, anybody wey no enter this ship now go miss, we no dey sell late tickets. |
stephleena:LOL, stop doing selective watching Erica wey say "We are Special Friends" no be your problem, but na Kidd talk dey pain you I know say you follow join for who wan make Kiddrica fail, because you wan laugh her, but know this now, Kidd say he will definitely continue a relationship with Erica after the house. He just confirmed to BrightO some minutes ago, so, carry all these your okoto yarns, go dump am for your fave WhatsApp group |
MamBi:He was telling Erica that Nengi fit dey form hard babe now, but say, if Ozo dey persistent, she go realize say na correcct guy and dem go eventually date He say dem don dey spend plenty time together, so, bonding dey. Erica been dey argue say even if guy dey persistent and physical attraction no dey, e fit no too work out. He come tell am say, Ozo na fine guy. She agree, say Ozo cute. The Wayas are wishing Ozone the best in their relationship. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 18 19 (of 90 pages)


