InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 14 15 16 17 18 19 20 21 22 (of 90 pages)
Kidd dey try explain to Erica as she take dey lead Laycon on. She been dey talk say she no dey lead Laycon on. Kidd come tell am say, she no dey conscious of am. He say, because she dey very nice, e easy for guys to misconstrue her niceness for liking them. He come cite as she dey dance with Laycon for party on Saturdays, say e dey sexual She talk say, na so she dey dance with Ozo, Prince and even Neo, especially Neo. Kidd agree, but say, for her, e fit be normal dancing, but if you dance like that with guy wey like you, he no go read am the same way, wey dem Ozo go read am. Kidd come express concern say Laycon dey uncomfortable for the house, and he no wan make he dey uncomfortable. Erica say na she cause am, Kidd say na two of them cause am. She say na because they are always all over each other in the house. Say Kidd dey always flirt with am, dey kiss her neck and say nasty things to her. He come ask her say nasty things like what? Na so Big Brother remember say NBC fit query them, dem go break. |
Akshow:You see where the views are? E no show like that for my own, my own, na only the likes I see. Na as e appear, I screenshot am I posted a video with Erica getting 145k views. Shebi you don see am for the screenshots wey I post, except you no look am well So, where your comments of 3k+ in the last one week? ![]() |
Froshloaded:You wan make NBC query them? Better go visit your pornhub in peace |
Akshow:I did not cover anything I am asking how you take see the views E be like you no sabi how IG be, because on IG, the views show just under the video, before caption sef. First off, that is a Reel, not even a proper video, you clearly no know the difference. Post a screenshot of the 200k views if e legit, no dey lie through your teeth for nothing. When you go for judgment, na this kain mumu thing dem go list for you as lies. Unprovoked and unnecessary lie wey no even fit favor you. Post screenshot, Awa Lies. |
100naira:Long may it continue |
100naira:She never know. She dey look this Prince as average, make nazablossom catch am first
|
Akshow:This video? How you take check the views? It is even a Reel. Screenshot the 200k in the views Erica got 145k+ for dancing and cleaning. Look at our engagements. We fit get reach over 3,000 comments in one post. Please, screenshot two posts where una get up to 3,000 comments in the last one week You think your one hit wonder videos follow join for engagements? Erica get active followers for her IG, no even go there
|
If Wathoni never talk "Boo'd up" and "I want to break tables" in a day, she no go fit sleep. I no fit wait for Sunday, make she come dey go |
mariahAngel:Na the people wey dey judge pass, dey do pass. I sabi your type. |
carammel:Na Ultimate Light Skin Couple be Production Pets this year. Una go enjoy them. |
ERICAsHawk:LOL Na so dem dey lie for their CV too, no take am serious. |
mariahAngel:Sister Mariah, I no say make you no talk o. As you dey use the same hand wey you use type this thing, position prick wey you go put for the mouth wey you dey use talk, continue. I no hold you. |
ERICAsHawk:Very unnecessry something and disrespectful too. If say dem fit, that her rubbish talk, don reach to strip her of some of her winnings. People wey no dey watch show, go use that her rant now, to dey yab the watchers. |
ERICAsHawk:broad perspective ke? Anybody wey dey cast Erica on top sex, no dey look from any broad perspective, no mind them. All of them na hypocrites and Pharisees. Dem want make people dey look them as modest adn decent outside, meanwhile, dem no dey emulate wetin dem dey preach, in their private lives. Just ignore them, or use am laugh, as dem dey do for Twitter. |
If some obsessed fans learnt to leave ex-housemates alone and understand that show don finish, adn once show don finish, shop don close, make everybody go face the work wey dem dey do before, that Mercy rant for no happen. E no get who fit convince me say, that rant no dey personal. E sure me say some fans wey get her number, don dey call her to back some current housemates, na wetin make she change am for those people. Sadly, na so she insult all the BBN watchers, plus even the organizers sef. Make una dey leave these people after show. No dey find their opinion any small thing. Their support or otherwise, no go determine who go win the new season. |
I hope una dey hear as people dey sing, Prince adn Erica with one correct duet like that. Simi and Ladipoe, come outside!
|
meobizy:Na Prince suggest say make dem do the campaign to reflect constitution, because Naija constitution no recognise male rape. i been no agree, but I no dey house. Na the people wey dey house decide to center am on female experience |
I like this last scene, the best so far |
zicoraads:LOL I been want post this picture since o, na so I forget E make sense die Anyway, the Wayas dey dance now, make I enjoy. |
zicoraads:Premium couple with Premium Content. E no dey accessible to just anybody. Enjoy, my guy ![]() |
If only dem fit use intelligent conversation win tasks ![]() Biggie, I no like as Neo never win correct money, abeg bring Dance Challenge, pair am with Erica, make dem win that one too ![]() |
Dannyxy:LOL Erica is doing well, ooin.
|
zicoraads:zico leave that babe, she dey more interested in Erica losing, than her fav winning. Jealousy no dey affect the person wey you dey jealous, na the person wey dey jealous e dey affect pass. Na so her chest go dey pain her, anytime wey Erica win. As for me, I don decide to face my Erica in peace, come sprinkle Kidd with small love too, because he dey give my baby joy. I no wan dey waste my vex again. |
Just last week, Praise been talk say if you dey Erica team, you no fit lose. Today, Praise sef don tap from the anointing. |
LOL Tell you fave to go and collect magic fingers o. see as Fingerica just dey live her best life for Biggie house. Eating good, chopping international standard kiss, collecting finger, collecting massage, getting some good choking from Kidd's magic fingers, and still winning everything, while bossing around your faves. Na Erica dem do this Biggie house for. Enjoyment officer. Child of Grace ![]() Go and beg your fave o, na Kidd fingers be the koko. |
stephleena:LOL E pain you, abi? Erica will keep wining, and na so e go dey pepper you for body. 6 weeks remain o, you better start being happy for others, make good things reach you and your fave too. BTW, with her combined winnings so far, Erica don turn millionaire o. Is God not wonderful? |
Amya:Make we thank our Special Friend o You know say when correct guy dey give you foot rubs and feed you garnished noodles, you go just dey relaxed. |
dominique:Kidd and Dora don do the second round and dem fail am. na Erica and Praise dey win. Dem get 40 points |
Vee no dey ever calm down, na she dey spoil Laycon game |
MamBi:No. he just dey play the second round now |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 14 15 16 17 18 19 20 21 22 (of 90 pages)


