TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:44pm On Aug 02, 2020 |
Next time you want come Biggiehouse, if your name na Katrina, spell am well, no dey give us work. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:43pm On Aug 02, 2020 |
First housemate to be evicted is Ka3na |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:36pm On Aug 02, 2020 |
Dem go show una how dem vote once the two chosen housemates are evicted. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:25pm On Aug 02, 2020 |
Even Ebuka dey read all the tweets wey dey drag Nengi, and some people wan tell us for this thread say she innocent. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:22pm On Aug 02, 2020 |
Ka3na don go house.
Eric and Lilo fit dey safe
Na wetin make e no good to dey fight fight, when you first enter anywhere. Just dey observe like BrightO |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:08pm On Aug 02, 2020 |
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:02pm On Aug 02, 2020 |
nazablossom: Believe him at your own peril . He manufactured more lie to agenda the agend  I never talk anything about Erica and Nengi relationship outside house, and after that one, I will not mention their outside relationship again. I dey like believe say na wetin you show me for inside house I dey interested in, your outside life no concern me, but for context, I drop that post. I no need una to believe am, I just wan give context. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:58pm On Aug 02, 2020 |
SoiSoi13: Since you know so much do you have any proof? LOL |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:50pm On Aug 02, 2020 |
Sunnycliff: And biggie decides to pull up a fake Eviction stunt... Na to return my money be that oo Biggie no fit pull fake eviction stunt if people don vote |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:45pm On Aug 02, 2020 |
aroundnaija: So this is one is trying to tell us that she's pretending all these days abi  Yes. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:45pm On Aug 02, 2020 |
So, for this one mind, she no dey do, "I'm a fine girl, this and that"
She still dey contradict herself.
She say, "I came here and decided to be my free-spirited, humble self, be 100% me"
She still dey talk
"Maybe if I had come in, and shown them who I am...."
Na so pretenders dey forget themselves. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:41pm On Aug 02, 2020 |
Mariinee: Lmao, I think so too. Almost like it's Threebear, but he's not that vulgar. Fit be the same person, just that this vulgarity na the side wey he wan unleash, without spoiling the original reps for these streets |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:40pm On Aug 02, 2020 |
The same IsiAgu wey Tochi wear enter house, na wetin e dey wear today again for eviction show. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:39pm On Aug 02, 2020 |
Ozo say
"Many people can get famous under a second or a minute, we've had like two weeks so far, so, we all should be grateful"
This guy and Neo na the only people wey sound intelligent in their Diary Room sessions, just that Neo plenty talk dey outshine him intelligence. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:35pm On Aug 02, 2020 |
Mariinee: Lmao. Do you have a crush on him? E get who dey type like that guy for BBN thread last year, I no fit just recall the moniker, but the handwriting dey familiar. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:34pm On Aug 02, 2020 |
ItsCookie: Jehovah God!!!! 
The agenda must truly agend! No agenda here Na straight facts, but Nengi na your fav, so, as far as you dey concerned, she no fit do bad. The post no be for you. Like I said, na outside house dem go trash their matter, and na after the show I fit drop everything wey I don learn. For now, make we dey watch. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:20pm On Aug 02, 2020 |
Na Neo and Kiddi waste these people time |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:17pm On Aug 02, 2020 |
Lilo na dry babe from beginning to end.
She deserves to be evicted.
Even Eric dey try small inside Diary Room, but Lilo massively wasted an opportunity to sell herself to the audience, in a space she actually could.
A waste of space, good riddance. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:16pm On Aug 02, 2020 |
leaculpa: You are just being crafty & absolving nengi of any blame. isnt she the one flirting and stroking kidd, ozo, Prince at the same time. In fact she bounces between actively fiddling all 3 dicks within an hour. You're talking like she's this innocent girl all the guys are walking up to & toasting, thereby making the girls jealous.
This is not the case here & if it was, even I will defend her. Every nonsense action will be discussed & get a nonsense reaction. If you act whorish & never help around the house, u'll be called a lazy LovePeddler. Lucy is very right. Shes not jealous. I approve this post |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:13pm On Aug 02, 2020*. Modified: 6:30pm On Aug 02, 2020 |
Beze992: She has only made this disclosure once about herself and Nengi, and as far as I'm concerned she hasn't done anything wrong. I don't care if they tag her vindictive, its a game, Nengi has been tagged manipulative and an attention seeker by other house mates yet her fans keeps defending her even when they know that all these is true. Erica is not perfect, she will at times misbehave, and much as I know that her fans are reasonable people that call her out when this happens, let us also try to be less critical of her. We should defend more, she has never been malicious to any housemate. Yes she has her flaws, but, who doesn't? She and Nengi don sabi each other since, dem dey talk steady before the House. Sometimes, when Nengi dey Lagos, na Erica house she dey stay. Na Nengi suggest say make dem dey like Mercy and Diane inside house, when she learn say two of them dey enter house Be like as dem enter house, she come realise say Erica no fit be her Diane, so, she sly am for house. I understand where Erica pain from come, but I hope say she go dead the matter henceforth. Na for outside dem go trash the matter |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:07pm On Aug 02, 2020 |
homesteady: Almost one page is filled with "Laycon is smart" comments. Una no fit write wetin he talk? Half of them no even dey watch, dem just dey parrot wetin their team mates talk. The other half, even if na sneeze wey e sneeze, e still smart to them. Na so people dey see who dem like, na normal stuff. E sha no talk anything 'smart', e dey rigmaroll to avoid directly answering if he go tell housemates say he exchange their weekly shopping for veto power. He no smart, just sneaky. But he smart for their eye, so, make e be so. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:02pm On Aug 02, 2020 |
Prince don put hand for Lilo hair
Useful guy.
1 hour to live eviction, dem gats make that hair fast, or Lilo go find gele to tie as she dey comot from house |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:42pm On Aug 02, 2020 |
InSanety: Laycon is very intentional about not giving anybody highlights
He no dey ever drop anybody name inside his Diary Room sessions Even Oxlade no see shout out for the session "A friend of mine came to perform"  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:41pm On Aug 02, 2020 |
davodyguy: FYI, biggie enjoyed Laycon's chat. You'll know through the flow LOL E no get wetin una no dey talk. I gree |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:37pm On Aug 02, 2020 |
Biggie just dey trowey lamba inside gutter
No time for shalaye. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:36pm On Aug 02, 2020 |
Laycon just dey talk yawo
He has answered the question, he no just know, all this one na shalaye talk. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:35pm On Aug 02, 2020 |
Froshloaded: oxlade don blow small..
Away away away Na new song, e just blow this year Laycon own dey come, all na timing |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:35pm On Aug 02, 2020 |
aduntemi: Like! But it's just him, biggie, and the viewers. He should stop this coding of a thing abeg Very shady behavior |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:34pm On Aug 02, 2020 |
Froshloaded: So oxlade na even Laycon friend No be upcoming musicians all of them be? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:33pm On Aug 02, 2020 |
Akshow: Laycon na smart guy jooor. All the things we complain about the guy done code himself.
He's not gonna take those nonsense from praise again.
Distracted by Erica but he done come back to him sense. My guy is here for the mooolaaa! This one no mean anything. Na so e talk say e dey avoid her yesterday, na BrightO go tweak him brain small, all this him talk go disappear |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:31pm On Aug 02, 2020 |
Laycon is very intentional about not giving anybody highlights
He no dey ever drop anybody name inside his Diary Room sessions |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:29pm On Aug 02, 2020 |
Respect is earned.
If dem dey disrespect you, na because you present yourself for disrespect |