InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 41 42 43 44 45 46 47 48 49 (of 90 pages)
Eeghe:She is sad because even if you no send, e still dey pain. She has accepted her fate. |
ItsCookie:K |
Kaisha na just vibes sha. She no get their time. If dem like am, dem like am, if not, she no send |
fitzmayowa:Na Prince matter. Prince reject Lucy, come talk say if na Nengi, e for accept Plus, Nengi follow for who no dey do kitchen work, na wetin make Lucy say she no get anything to offer. She no dey cook, she no dey clean, so, as far as Lucy dey concerned, she no get anything to offer |
aduntemi:She no humble at all, the babe na pretender. Babe wey yellow like that, wey even go do bumbum make guys dey follow her, humble, where? |
homesteady:At least Lucy come with the body wey God give her If this one been come Biggie house with the flat yansh wey God give her, she for dey parade up and down? |
Nengi "It's all my fault, I came to this house and showed them the humble person I am" Same Nengi "If I show these people who I am...." Abeg stay one place, you either dey humble or na another thing you be. |
Lazyyouth4u:LOL. That one na Top 5 material at best |
Beorn:E no get where women dey bond well and men go dey disarray. Even if men dey disarray, you no go ever know, because e no dey last, but you see women? Dem fit carry you for mind reach 10 years, unforgiving and never forgetting gender. |
ArchAnge1:Dem pass 15 for house, Ozo no go fit dey alone. E no even good make person dey alone for house, only thing be make e no get relationship, but friendships go good. |
ArchAnge1:Make she enter diary room dey talk about another person ni? You just dey take style decampaign Erica, dey do like BrightO for this thread. Be like Nengi matter don tire you |
She say she go take the immunity, but she no go tell house people. She say dem go dey alright for house, Indomie and garri dey, dem go survive Biggie ask if she get another thing to talk, she say she just wan dey the house, she no wan go house |
Anchor535:She don get herself back. Na home sickness been dey worry her |
Erica say she no wan go house because e no get wetin she dey do for house. She know say she fit dey dramatic, but she no wan go house Her only regret na when she been dey cry say she wan go house, she wan see her friends, because even if she see them now, dem no go wan see her now. So, she regret the cry wey she cry that time She say her favorite moments na the two parties, especially yesterday party. She say she been dey feel the outfit, she give shout out to T.Bally, she dey feel herself, dem take style drunk, but they were having fun |
Erica say if dem call her name for eviction, na security go carry her comot |
MizzD:Nah, I sabi the guy from here sha. |
MizzD:Erica mentioned her pot incident with Wathoni, but Laycon don zone out from the conversation by then, so, e fit be Nengi |
MizzD:As in. She and Dora were coming from two different places. Erica own be say she no know why babe wey she sabi six years, go come house dey treat her like stranger, Dora matter na Ozo. The verbal attack from Dora was unnecessary. I'm sha happy that Erica has now realised that Nengi no get any friend, Wathoni also realised it too, but that one dey fear to call name since. She just dey drop hints. Make she hold that information for her chest, continue her life. Everybody cannot like you, and some friends go do you strong thing. E hard, but we must move on. Today go bloody, this session no go even matter in 17 hours time, because I sure say another explosion for don happen. Ebuka don promise us a show, una good night. |
mystikal:LOL Delusions Nengi no go see any prize money, same way CeeC no see am. She is not an innocent party in the entire thing, so, all the agenda wey dem en agend, no fit elevate her to winner. Anyway, Ozo dey put head on top brezz, dey play with Dora. |
Broobembem:The fact that babes for that house no dey rush Ozo, don certify my belief say Nigerian girls no get sense. Na loud noisemakers like Kiddi wey no dey stay one place dem dey rush. Mumu babes |
Ozo don go beg Dora for forgiveness |
mcbliss2:okay |
homesteady:He no get problem with Nengi, so, he no get anything to say. E suppose turn off. |
Meanwhile, TolaniBaj dey here dey corner Wathoni last card |
mcbliss2:Dem been dey talk where e pain them too. They were talking about their personal interactions with Nengi and Wathoni, and na where e pain them be that. Dem no talk another person matter If na so you wan classify gossip, na him be say, that thing wey Laycon do with Tochi and BrightO today, na gossip too |
kosky:Wetin e for talk inside woman gist? |
Erica don talk her own version of the Wathoni pot gist. She say her mind been no even dey there, she dey defrost something, so, she no hear. Wathoni come snap at her say why she no answer her Wathoni version na say Erica ignore her. Pesin wey dey date ashawo, how her mind wan dey at rest? |
Rahkman:I swear, Dora hate Nengi. |
Erica say she no know why Nengi no like her, after saying she see the stunt wey she pull with that Truth or Dare. |
homesteady:Wathoni fit dey imagine aggression from Erica for obvious reasons. Once women dey give me gist and I hear something like, "I did not do anything oh, I just asked her to help me pass something and she flipped....", I dey take am with pinch of salt, because e fit be say dem no even approach the thing well Women no go ever tell you say dem no handle matter well, na always the other party dey unreasonable. |
I really regret say when this show start, I been think say na Eric go be the most entertaining Edo boy. See as BrightO dey make all the Edo wizards proud, while Eric don allow woman bottle an |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 41 42 43 44 45 46 47 48 49 (of 90 pages)
