TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:41pm On Aug 03, 2020 |
If say some people for this thread go Big Brother Nigeria, na kill dem for kill some housemates, because the kain bile wey dem dey vomit for here ehn? I just dey imagine vein dey pop from their heads as dem dey type  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:30pm On Aug 03, 2020 |
E hard to dey vex for Ozo.
Loveable guy, e get small problem, but who no get their shortcomings?
His heart is always in the right place, even if his actions are sometimes poorly thought out.
Las las, make all of us remember say e get wetin we don do before, wey if camera dey there when we dey do am, and we rewatch ourselves, we go just dey insult ourselves.
Na because we never donate ourselves as lab rats, na wetin make we think say we be scientists. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:24pm On Aug 03, 2020 |
Anytime wey I see Neo with Vee, I go just remember Ka3na talk |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:53pm On Aug 03, 2020*. Modified: 9:25pm On Aug 03, 2020 |
Ozo, when you comot from that house, we go supply you correct yellow babes with better bakassi. We must cast out this spirit of Tony Umez from you We go finish your destiny with yellow babes with yansh! What nonsense!  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:47pm On Aug 03, 2020 |
Wetin Neo say he dey do for here? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:43pm On Aug 03, 2020 |
carammel: At this rate, Frodd Nwanem is a wiser man than Ozo 
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:41pm On Aug 03, 2020 |
Dora, thank you for telling him this. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:38pm On Aug 03, 2020 |
Which yawo this yeye Neo dey yarn so? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:28pm On Aug 03, 2020 |
adaramola12: Make una watch, e day go meet nengi that guy na OZOWUR  Be like you sabi the guy |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:26pm On Aug 03, 2020 |
Brezz 1:0 Bumbum |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:23pm On Aug 03, 2020 |
LOL
This thing go sweet |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:22pm On Aug 03, 2020 |
Dora no expect Ozo to choose her |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:21pm On Aug 03, 2020 |
NENGIsmells: but ozo go hear am o. because dora go commot and na nengi go remain , nengi go show am. but we trolls batalion 125 dey him back. Dora na sure Top 10 material. She no go comot anytime soon, e dey okay |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:20pm On Aug 03, 2020 |
He and Nengi dey hold hands.
LOL |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:17pm On Aug 03, 2020 |
Wey that yeye Neo?
Make e come collect him L. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:15pm On Aug 03, 2020 |
InSanety: Na today we go know if Ozo don break him bondage, or dem still tie am inside calabash Yes!!!! Dora for the win. He don untie himself small |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:07pm On Aug 03, 2020 |
Na today we go know if Ozo don break him bondage, or dem still tie am inside calabash |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:05pm On Aug 03, 2020 |
Why Biggie go dey give 20 minutes for HoH to choose deputy?
When It was Veto power, no be on the spot something?
Dem for call am immediately |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:56pm On Aug 03, 2020 |
InSanety: Ozo go win HoH next week and break this demonic chain.
I believe him government die. One prediction down. On Thursday night, the second one go enter. If say dem dey play bet with this thing, I for collect small money from Betway hand. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:07pm On Aug 03, 2020 |
Ozo!!!!
Their Daddy!!!
The people's man wins it astoundingly!!!!!
Everybody go home |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:15pm On Aug 03, 2020 |
superlicious: must Nengi be the main gal.walahi if I was there,I no go gree.I must be the main character. No be she be the main character. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:14pm On Aug 03, 2020 |
I love the rehearsal already.
Make e just make sense finally. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:48pm On Aug 03, 2020 |
Greizman: Please what time is the head of house game? 6:00 PM |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:47pm On Aug 03, 2020 |
geezprince: they are both my guys so I go dey follow you sef celebrate the milestones and I go dey vote them together....but that finale like this Na Lakeside get me. Laycon straight!!!!! I understand. Na normal stuff |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:33pm On Aug 03, 2020 |
geezprince: Till the finale then..... Till then. For now, I go dey celebrate her milestones as una dey celebrate una guy own. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:32pm On Aug 03, 2020 |
Kidd dey learn work where Neo dey  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:29pm On Aug 03, 2020 |
geezprince: The backlash no dey affect fan base. People don already make up their minds on who to stan as money and emotions don dey involved. I just dey clear you say no be by trends, retweets and likes. Na by engagements Be like una no understand how engagements dey influence voting. Make I no tell una again, una go understand later. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:23pm On Aug 03, 2020 |
Be like Neo don forget say Vee dey that house.
His love for Nengi is so overwhelming, Tochi can relate. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:22pm On Aug 03, 2020 |
geezprince: I understand what you are trying to say but....foreigners too dey comment and like posts o. And dem no dey fit vote via sms. No be by social media hype. Organic stans plenty for Laycon like sand. Foreigners dey send money to vote, no reason am. No be my first rodeo be this, I know how dem dey send money to vote, and when you consider say abroad money get value pass Naira. LOL. Guy, e no get wetin una wan tell me today, backlash dey, but the massive love don overshadow the backlash. I never even read NL people tears  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:03pm On Aug 03, 2020 |
Samueltemi337: What's my business with Instagram followers
she can have a million for all I care
season three cee-c had the highest followers she nor still win
season four Tasha had the highest followers she nor still win
So chop the followers while my guy can chop the 85 million
BTW your girl have only 16k followers on Twitter and my guy get 64k We still dey cruise We're catching up. Make she just dey trend, we go catch up. She has more engagements than your guy still, on any platform. We're cruising. All publicity is good publicity, make we enjoy ourselves today  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:09pm On Aug 03, 2020 |
Samueltemi337: This one just they deceive himself LOL All na cruise My babe dey follow your guy for IG, end of this week, she go pass am. He reach 200k followers almost one week before her, as at last night, na 10k he use pass her, now, we don cut am to 6k. Cruise  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:43pm On Aug 03, 2020 |
ChristoBam: Lol so followers translate to support. Most dey follow to troll in case them go lock account from non followers. Others wan see their favorite porn star.. And Don jazzy dey hype everyone for that house no whine yourself. He's not supporting anyone. Engagements translate to support, not followers. Nengi get pass 211k followers, yet, all her comment section she no dey get reach 2k comments, na soso 700, 329, 546 comments full her page. Dem no dey insult her, na love love full Erica page. We stand gidigba, make una continue dey help her trend, make people dey sabi her, dey vote for her. Anybody wey talk too much, go show us their Virginity Report Card for this thread today ;F See as my babe dey glow today, dey happy. God bless Kiddi for helping her with konji, may weaklo never catch his fingers  |