InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 49 50 51 52 53 54 55 56 57 (of 90 pages)
Erica dey always shake she don shake the can reach middle pf the ruler. this one no even understand the rules |
Thank God say dem stop that nonsense one minute. |
mizz2posh:Ain't nobody give a shiit about Eric ![]() that one don cast for these streets |
Dansuqi:Alex that was with Leo when Ceebi was having their issues. She been dey follow Leo the way wey Lilo dey follow Eric, she no get eye for any guy. Alex and Tobi no even happen until like Week 6, after Leo was evicted |
Bomboiy:LMAO ![]() |
Laycon dey do Kidd with Erica, wetin Kidd been dey do Ozo with Nengi. he know say e no sweet, but e dey sweet am to do the same thing with him guy |
DrakeBlend:help me ask am |
ToyinDipo:Say what? if you no get pictures or video to prove say Wathoni off paynt, as in, she pull am comot, na your dirty mind you dey use make assumptions. no come here dey post false information, e dey against Nairaland rules. the Truth or Dare question was: "Pick a guy and show him your panties" Wathoni pick Kiddi, take am go corner, show am paynt, she no even comot the shorts wey she dey wear, he just look inside to see the paynt. Except you dey talk another time, if na that one, she no off paynt, she no even off the shorts wey she dey wear. Na your kain guy go kiss babe, come go tell your friends say you give am six rounds of straffing. |
ToyinDipo:na your kain people dey put jara for gist, make e for sweet. she no off paynt, she show am paynt, no be the same thing |
Funny thing be say, Erica never still hear this Private Jet gist from Kiddi, he dey always tell the story when she no dey around |
Amya:only Prince Wathoni Dora Nengi Tolanibaj in his free time, he dey even give Lucy hope. Prince dey flirt steady with the girls. They said the guy is intelligent, he's used to getting girls, so, he no go ever shoot shot at anybody, he go just dey set trap, he dey always frown. Prince is it. |
Eeghe:Tolani even talk say he dey rotate up to 4 girls. I assume the 4 na she, Nengi, Dora and Wathoni. When I click say na Prince, na when Vee say he get "resting biiitch face", say she no know as dem dey manage the face, he dey always frown. Na Prince get that face. |
MzCherry:just read your mind for false info, if na here you dey watch am. some people go even add the one wey dem no talk, but dem think say dem hear. if you want correct info, go Twitter |
So Vee said Nengi talk say she like men wey get money, and she don look around, she never see man wey get money for the house, all they have is their 50 BB Coins. At least some things don dey make sense. |
Ka3na na correct babe, telling this stubborn Lucy hard truths and she still dey argue nonsense |
At least we don see who for win that chess game between Ozo and Nengi |
Hazardfan1:Come to think of it, how many people don see Nengi cook since show start? Na Erica some people wan crucify, meanwhile, even to butter bread, I never see her. Na only to dey open bumbum she sabi Na God save Ozo |
Vee say she dey like chop akara, but only with ketchup Neo come dey shout, "What?!!!!" He tell her make she wash her mouth, she don talk nonsense |
Kiddi dey ask Brighto when e cook food, because e never see am wash meat before. Brighto works in silence, these people no know |
Erica and Kiddi dey chop food from same plate, dem siddon next to Watho. Why dem dey always make the place awkward for Watho? Camera go come dey focus on her like say dem wan see her reaction |
davodyguy:Na Tricky |
Watho dey chop meat from Tochi plate Bonding |
ArchAnge1:Na her selling point be that |
See as dem dey rush Bright because e sabi cook, tomorrow person go talk say cooking no be skill Na skill, no be for everybody. |
GBOKASINCHA:Sleep She dey sleep **** Modified She don wake, I just spot her |
InSanety:Shebi I talk am See as dem don rush go famz BrightO because e comot poundo potato, even Erica dey call am her best friend on top food ![]() |
Kiddi been dey outside, wan follow Laycon gist, na so Dora come drag am enter house, next thing, dem show inside house, Erica dey siddon for kiddi lap, as he and Dora dey play Ayo. Ozo dey close to them, dey find who go play Ludo with am, Vee enter house, because Biggie say make dem enter house, she hail Neo, call am Morris Chestnut, Ozo have Ludo at am, she say she no sabi Ludo, but she sabi Ayo |
Acidosis:I dey give example, but your brain never mature to understand example. You know how many endorsements Erica don get and the amount wey go come after the show? You no know, your bias dey mess with your reasoning |
These ones dey gist multi-verse Na The Flash I use sabi this gist |
Acidosis:I don see your problem now. I nearly think say I dey talk to objective person. E go be. |
caprini1:No mind am. I get friend wey na order he and him wife dey order food most of the time, the woman dey work for CBN, making up to 400k a month, na that type of wife I dey find. No be say I go dey waste your productive time inside kitchen. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 49 50 51 52 53 54 55 56 57 (of 90 pages)

