₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,786 members, 8,432,589 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 11:30 PM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 52 53 54 55 56 57 58 59 60 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:29am On Jul 31, 2020
kowema:
Guys, if you need underground gist, then you better goan vote Bright.O.

His conversationa reveals a lot of things we don't see.
Imagine Tolani likes Prince and we didn't notice.
Bright had always known Lucy liked Prince so he intentionally shoke their that table the day he asked Lucy to kiss Prince. Erica also likes Eric. All from Bright. Drama will soon burst in d house
Watch show, una no go watch, you go come dey collect information from Bright.

Erica does not like Eric, na Bright dey create fantasy for him head, same way he create Laycon love.


Erica already clear Eric say she dey look am like her younger brother, because she use two years pass am, she clear am before dem even enter house, but BrightO dey see imaginary love.


Bottom 4 fit reset him brain on Sunday.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety:
BrightO don dey download gist for Tolani this night.

Tolani say Ozo dey bored with Nengi

Bright say he dey chase Erica.

From there, Bright open him folder to bring out the Laycon and Erica gist, make e supply Tolani as Laycon give am.


No be everybody you suppose share some information with, before you know it, gist go spread for house and casting go happen.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:58am On Jul 31, 2020
Brethren, it is 3:00 AM Nigerian time, and Wathoni no dey Kiddi bed.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:44am On Jul 31, 2020
homesteady:
grin grin grin
One get daddy and abandonment issues

The other one get mummy and daddy issues.

Erica say she grow up without her popsy and her mama no like am

Kiddi say him parents no give am love and attention.

Wetin these two people dey use each other do?



Potentially unhealthy relationship. No wonder dem go dey do flirting competition the whole day, swear say dem no like each other again, only to end up gisting for hours by this time.

Prayers and therapists, na wetin dem need. Not love and relationship.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:37am On Jul 31, 2020
Erica and Kiddwaya don't need each other.

They need prayers and therapists.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:30am On Jul 31, 2020
After all this gist, Erica go go meet Laycon dey tell am about mental connection, "if I was blind, I won't be attracted to Kiddi"
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:28am On Jul 31, 2020
Kidd and Erica na the same thing.

Two of them like attention of the guys and the girls.

Two of them recognise Ozo and Nengi as competition

Two of them work towards denying their competition of the top guy and girl in the house (why Kiddi dey cockblock Ozo when e dey with Nengi/Erica, why Erica dey vex when Kiddi talk with Nengi)

Two of them don't mind, if the people they think as 'small fish', hang around this top guy and girl (why Kiddi no dey cockblock Prince or Tochi when dem dey talk with Nengi, and why Erica no dey vex if Kiddi play with Wathoni or TolaniBaj)

Two of them get big ego, so dem dey always try outdo each other in flirting with others, to annoy each other.


When Two Pisces meet, na wetin dey happen be this.

Words of wisdom from my weed joint.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:19am On Jul 31, 2020
geezprince:
Biko, please tell me the bad things he said.
No be me go tell you.

You go see am.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:15am On Jul 31, 2020
geezprince:
Erica has some toxic supporters,damn! the way dem don drag Laycon today onto say he catch feelings.
As if they have been waiting for the n!$$@ to bleep up.
Omo! I see drags I fear.
Na small thing wey dey necessary, dem no need anything big.

Laycon talk some bad things about the babe this night, dem dey use am hold am, no be just the like. Come add say for Diary Room, the babe go dey sing him praises, yet, he go enter tell Biggie say e no get who be him friend, e no sabi anybody.


E go bloody this season. I can't wait grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:00am On Jul 31, 2020
Agenda everywhere

Ebuka for don draft question, trowey, draft again like ten times this night alone.


And Saturday never reach

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:57am On Jul 31, 2020
This one last card na bumbum, everytime, the bottom of her bottom go just dey dance.


Na she dey objectify herself.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:29am On Jul 31, 2020
I remember when I dey Secondary School, e get one girl for my class wey get smiling face, like, she dey always smile and giggle.

One day, one female teacher ask her question, na so the girl begin dey smile. The woman confuse, come ask wetin make her dey smile. We tell her say na so the girl face be.

The woman say, "So, you're always smiling? Hmm, it's not good for a woman to smile too much, because men will take you for granted"


Na Erica crime be that. She too smile, na wetin make people dey manufacture relationship for her, dey look her like who anybody fit toast. When you go dey open teeth for everybody, why dem no go table your matter?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:16am On Jul 31, 2020
Dansuqi:
Yes but we need to agree on a common ground.theres no ambiguity here.two girls politely rebuffed two guys.one got angry and started avoiding her while the other simply accepted her decision and related with her well.which is more mature?
Maturity has nothing to do with the situation.

Na only mumu dey hang around babe wey reject am. Like sharp guys dey talk, if one ATM no dey dispense, na to move go the next one. Make he hang around her, for wetin? Make she dey feel herself on top him head? A whole premium guy, at his age, should just be hanging around woman wey no gree stay one place, na jazz?

Ozo no owe anybody friendliness for that house, but he owe himself good mental health, make nobody come dey stress am because she yellow and she do yansh.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:09am On Jul 31, 2020
ArchAnge1:
he is hurt, said that ozo and prince are hovering grin
The guy don drop some hot takes this night.


He said Erica dey vex say the guys no dey fall for her, and the one wey she want dey misbehave.

The same guy dey remind Bright say "shey you know she's an actress..." As per, she dey play am.


Na this guy wey Erica go siddon dey tell all her hopes and dreams, e go dey fill her head with nonsense Aristotle lines, make she get 'mental connection'

Na only Ozo and Erica never agend on top anybody head for that house.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:02am On Jul 31, 2020
ArchAnge1:
erica never liked eric

Maybe na the gist, eric use take grab lilo quick


Guys they do am, use fine girl dey get local girl

For loli mind she is the chosen one, no wonder she dey carry that foolish Eric up and down like throphy cheesy
Erica tell Eric say she dey look am as younger brother, so, she no fit date am.

I no know where this like from come.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:00am On Jul 31, 2020
ArchAnge1:
ozo just gisted with her and laycon is wailing
Lol, e don look those guys see say dem fit offer 'mental connection' plus looks, e gats monitor the progression of events
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:54am On Jul 31, 2020
Wait, Laycon talk say Ozo and Prince dey try slide in with Erica
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:52am On Jul 31, 2020
Ozo fans just dey catch cruise today, una fav never give una heartache.

Lucky guys
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:48am On Jul 31, 2020
MamBi:
Seems like Laycon is too smart to get roped in.. Seems like BrightO’s ministry na to dey scatter tables..

From this his gist, Erica apparently liked Eric but as Lilo collofi am, she switched to Kidd who is not serious..

All these love permutations Na wah shocked shocked
The entire talk don dey boring.

Since Bright begin dey instigate, all the Pastor jokes don reduce sha grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:45am On Jul 31, 2020
Time to test Laycon's intelligence.


If he gree BrightO enter him mind, e don cast be that
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:44am On Jul 31, 2020
MamBi:
Tochi, well done...

I am liking this guy more and more...

As Kidd came to lie down beside Nengi (probably to infuriate Erica), Tochi carry pillow go lie down for Nengi’s stomach...

Me: YES. Make all of us die there.... grin grin
Shebi I tell you say Tochi like Nengi well, e just no wan move on am, because e dey reason say him oga fit like am too and e no fit offend the Oga

But then, e been get small hope say Erica don come hook Kiddi, only for things to be looking gloomy today. Na wetin make this evening, when na only he and Kiddi dey table, he come dey grill am on Erica matter, make e know if coast clear.

As Kiddi no wan stand one place, Tochi fit just move, and damn the consequences. He fit make money tomorrow, but babe wey yellow like Nengi scarce grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:40am On Jul 31, 2020
Bright dey convince Laycon say he wan date Erica.

No be say true true Laycon wan date her

Na the same way he convince Wathoni to toast Kiddi


Thank God e dey bottom this week. Yeye instigator.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:38am On Jul 31, 2020
spinna:
Kidd telling Erica hes considering opting out of the truth or dare cos pple feel hes a bad boy.

The truth or dare game is good for the booless and bad for the shippers.

Wathoni don dey involve herself and kidd..gosh so thirsty
Wathoni no do anything, na the guy jump on top her bed, before Prince come save am.

Kiddi wan dey play with Wathoni as e dey play with her before, e no like as she no dey give am face again. He wan get all the girls attention.


Na wetin make he go acquire Erica when e see say Ozo dey rub her. This afternoon, when she and Ozo dey gist for parlour, e lie down for lounge dey fake sleep, because e wan monitor them.


When na Ozo and Nengi, e wan cockblock Ozo too. The guy like female attention, he no too different from Nengi and Erica.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:32am On Jul 31, 2020
Kaisha dey sleep for odd places walahi
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:29am On Jul 31, 2020
MamBi:
They even de-oracled him.. They said they will change oracle...
Ha!

Mere humans, de-oracle an oracle?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:27am On Jul 31, 2020
Jake420:
I'm tired of seeing Erica and Kidd together abeg
Two confused mumu people.

See Ozo trying to rescue her from the guy.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:25am On Jul 31, 2020
Luckygurl:
Where's Eric without his Lilo?
Same place Vee dey without Neo.

Dem dey represent their spouse for the meeting.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:21am On Jul 31, 2020
Acidosis:
Game of lonely classless low-lives. Funny how the game planners are the least 4 housemates.
Jesu! grin grin


Na game for the unwanted housemates
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:20am On Jul 31, 2020
See Ozo dey smile like mumu, as Erica dey rub him foot grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:20am On Jul 31, 2020
MamBi:
Why is Praise subbing people who have coupled up? E dey pain am?
The booless dey find kiss, dem gets use TorD take get am.

People like TrickyTee fit no still see anything


Meeting without Oracle, na yeye meeting

*modified*

Oracle dey room
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:17am On Jul 31, 2020
dominique:
Is that Lilo clinging to Prince or are my eyes paining me?

One game with plenty rules and regulations, Praise wetin sef, you too talk
Na Lilo o, your eye clear

No mind them, plenty rules, like say dem go give us hot hot.

If person no collect strike tomorrow on top that Truth or Dare, I go go drag Praise by him dada, comot from that house
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:16am On Jul 31, 2020
ArchAnge1:
Kidd wan use style drag erica from ozo side, just watch grin
No mind the guy

When e dey cockblock Ozo with Nengi, e dey sweet am, now wey Ozo dey play with Erica, he wan dey chook head.

Make dem go call Nengi for am.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 52 53 54 55 56 57 58 59 60 (of 90 pages)