₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,767 members, 8,432,518 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 08:06 PM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 45 46 47 48 49 50 51 52 53 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:22pm On Aug 01, 2020
Dem dey ask Nengi where she wan go

She say Miami, Greece (Kiddi ask Mykonos?) She answer say na that place wey everywhere white (Santorini), she mention Ibiza too


If day she knack travelbeta boss, shebi she for don go all these places
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:19pm On Aug 01, 2020
Kiddi don dey control him other side chick

Dey tell her say she get luck e no catch her for Abuja (be like e late, Abuja guys don dey run am steady)
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:16pm On Aug 01, 2020
Eeghe:
I do not really understand this
Do you mean that he has a low self esteem or that he thinks too highly of himself?
Me I think it’s the former?
I mean the former
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:07pm On Aug 01, 2020
Dannyxy:
Gist of Laycon-bright-tochi August meeting in the lounge.

So laycon, bright and tochi were in that garden discussing house matters, and how relationships are happening fast in the house.

Tochi implied that some guys are everywhere, trying to block other guys from getting girls, SBD laycon replied that "the girl has to be interested, for the guy to continue"

They continued, that the guys more than girls are in terms of spec and only few guys are getting the girls, that girls like to go after guys that other girls are interested in(Kidd) and center of attraction. Then bright chipped in that "laycon" could be the center of attraction one day , that things change, laycon replied saying "if he becomes center of attraction, he would knack heads"..

Still on their boys gist, laycon told them , thst everybody knows he likes Erica, but he can't be stressing him for "ATTENTION", that's eh he has been distant, that he good Erica he liked her, and she said "awnnn", it was awkward when they where In the kitchen and Kidd came to hug her from behind, he had to leave.


He re-stated that HE can't be dragging for attention, and said "people don dey forget say na game bring them come here"...

Tochi replied him that "Erica is an Igbo girl, he should comot eye", and called him a volvo , implied Erica would not ride, then instigator Bright told him to shoot his shot and flirt with Erica, hug her, hold hands and other stuffs...


Lol... grin
This part funny me, because Tochi na Igbo boy and the only reason he dey kiss Kiddi ass na because Kiddi hold bar.

E go dey hail am " bossman, bossman" when e see am, only to come outside, dey complain about Kiddi to other guys like say Kiddi dey oppress am.


Na Kiddi fault say he dey control the babes wey Tochi like? Na Erica fault?

The guy way no straight. You suppose dey wary of those friends.


Finally, no be all the 20 housemates Kiddi fit host after the show, e get some people wey e go screen out.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:02pm On Aug 01, 2020
aduntemi:
He should also be more open in DR sessions. Let us know where his head is at, so his fans can open prayer on his head.
His diary sessions dey leave space

Like, na there wey people fit really connect with your person, without Kayode changing angle. He gats utilize am well


Today conversation show say him head still dey ground, e good. Maybe he no too sabi dey talk straight to camera, as opposed to talking to people
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:56pm On Aug 01, 2020
If you tell babe say you like am, and she answer you with "Awwwnnn"

My guy, forget, you no dey comot from that friend zone, in fact, dem dey look you like puppy wey dem go dey pet if you too make trouble, then discharge you when oga show.

Laycon na strong guy

Pesin tell me "Awwnnn", I fit use like one week recover from the trauma. I go just dey waka like zombie, dey wonder who I offend
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:52pm On Aug 01, 2020
This was such a healthy, sound, necessary conversation from the three Booless Bros


Be like Laycon head still correct, I hope say e no go listen to that instigator, BrightO
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:47pm On Aug 01, 2020
codedguy1:
See am dey tell laycon to hold erica for waist for 20mins grin person wey no see paynt for 8 years.

I don laff taya grin
grin grin grin grin

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:46pm On Aug 01, 2020
The gist continue


He say when he comot, as Kidd go, she call am back to ask why he go, he answer her say na because knife no dey, she ask am say "Are you sure that's why?" E no too answer, she come say, "Is this going to be a problem?"


Bright say next time, make he try him luck, go hug an from back, if she remove him hand, na code be that, if not, she go fit dey comfortable.


Bright don begin to dey ginger people
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:43pm On Aug 01, 2020
Dem don put Laycon on the spot, dey ask am say why he no tell Erica say he like her


He say he don tell her say he like her


Tochi ask wetin she answer

Laycon say:


She didn't say anything o, she laugh one kain laugh, come say "Aawwwnn"


He dey talk as Kidd come from back dey hold Erica last night when he dey her side for kitchen.


He say e make am feel awkward, but he no dey feel sad or pained or angry.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:40pm On Aug 01, 2020
nazablossom:
Tochi and always using Nengi as an example grin
He get colour problem

For him eyes, na yellow babes be the most sought after girl, and na so society dey tell us.

I no too blame am
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:39pm On Aug 01, 2020
MamBi:
embarassed embarassed embarassed embarassed embarassed embarassed

Her reverse psychology dey always fail with Kidd undecided
The entire exchange is always so pathetic.

She constantly brings up this same vibe, despite the guy telling her in multiple ways say the vibe don die.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:37pm On Aug 01, 2020
Bright say guys dey more than girls for the house, based on, no be all the girls be spec, compared to guys
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:36pm On Aug 01, 2020
Tochi say girls dey always like guys wey other girls like

Laycon say na normal thing, once person put value on you, your value go increase

Laycon say e hope say people no go lose sight of eetin bring them come house
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:34pm On Aug 01, 2020
These one's dey talk say Praise fit no get action for house, because e cast himself as e talk say e dey engaged


See these ones, Praise wey don cure konji finish grin grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:33pm On Aug 01, 2020
E be like Tochi no dey see wetin girls dey see for him body


Eeghe your guy no think say na spec he be o
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:32pm On Aug 01, 2020
Na only Laycon dey talk better for this group
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:31pm On Aug 01, 2020
Bright dey brag say if e want put head for somewhere, e go put, give them fire for fire.



Laycon say as e dey like this, if anything happen, e happen, if e no happen, e no happen, e dey him dey
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:30pm On Aug 01, 2020
Laycon don tell them say he feel say na only hooking up everybody dey dey talk of for the house


Tochi say "Everybody dey hook up, why you no go hook up?"



Laycon say the house na cruise


Tochi say oppression dey the house, some people go just dey oppress you with girl wey you wan follow
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:27pm On Aug 01, 2020
Froshloaded:
Make kiddy clear this girl, say e no get anything to do with her, so she go fit find her levels..
Na discharge e dey try discharge her so, but she get coconut head, she no dey hear word
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:25pm On Aug 01, 2020
E no get age wey women go dey, wey sharp guy no go fit control them.


See as Wathoni balance, 29-year old woman, make 27-year old Kiddi dey shoot her "LLLLL"

She go sabi sidechick work well

She dey tell Kiddi say she dey 2 years older than him, like say e go change as e don run her street
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:22pm On Aug 01, 2020
nazablossom:
Where's my problem child abeg huh

InSanety how far grin
She scarce this morning o.

Na once I see her with one fine blonde wig, I never see her since then
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:20pm On Aug 01, 2020
Kidd dey discharge Wathoni

She still dey talk vibe, meanwhile the guy dey tell her say e get guys wey dey interested in her.

He come dey tell her, "We have a vibe, but it doesn't have to be a sexual vibe. Like, I have a vibe with Kaisha"


Wathoni, collect your Discharge Certificate dey go, at least you kiss hot boy grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:18pm On Aug 01, 2020
Wathoni

"That day you kissed Erica, he (BrightO) asked me are you okay?"

Kiddi

"You're a big girl, why won't you be okay?"
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:16pm On Aug 01, 2020
Kiddwaya

"I know people see me and think I'm flirtstious, but I'm a flirtatious guy, I'm not a player"


Na only Tochi don lie pass Kiddi for this house


Which kain unprovoked lies this guy dey drop?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:14pm On Aug 01, 2020
Amillionn:
I can’t believe what Kidd just said; (while him and tochi are talking about tochi shooting his shot tonight with Tolani, Tochi tells Kidd that he overheard Tolani telling Brighto that she likes two guys one of which he suspects is Prince and then Kidd says, it could be Prince, tochi, trikytee or laycon.

Now I understand why he didn’t mention Neo or Eric Cos they are engaged or even himself and I know he didn’t mention Brighto Cos it was Brighto Tolani was talking to when she mentioned the name of the person she likes but why didn’t Kidd mention Ozo as an option?

I can’t comprehend. I’m truly confused on how this guy sees Ozo Cos Ozo is actually lying down right there so it’s not like oh! he skipped his mind or did I miss something in the convo?
*I don laugh scatter leg* grin


E dey see Ozo as Jew boy, he no fit control babe like TolaniBaj
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:10pm On Aug 01, 2020
homesteady:
Oh Kidd... See how he just controlled Wathoni.

In Tochi's mind, let me be like this guy oh.
Goals

Na wetin make e dey always go talk to am, make e tap from the greatness
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:07pm On Aug 01, 2020
fitzmayowa:
No its Wathoni, Tochi was tip toeing around her earlier today...
It's not Wathoni, it's TolaniBaj
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:07pm On Aug 01, 2020
ItsCookie:
All I am saying is that Erica worked very hard to gather her own fanbase, big or small. Her charming smiles roped a lot of people in. Her smiles, not Laycon's, not any other HM, hers!

I don't like glory hunters.
So you sabi reason like this


God bless you

How Laycon get fans for Erica? I no dey like mumu talk. Erica get heavy fanbase and no be Laycon bring them.

Erica fans have never claimed to give Laycon fans, but these Laycon fans keep assuming they have been giving Erica fans. How? Will they abandon Laycon to vote Erica?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:04pm On Aug 01, 2020
Tochi dey collect tips on how to woo babe from him oga kiddi


Be like na TolaniBaj he wan toast, but he express fear say e be like na Prince she dey feel


Kiddi Kiddi, Toasting Counsellor
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:29pm On Aug 01, 2020
I still no believe say Ka3na go dey bottom 4

Lands and diamonds suppose come through for her. The babe hold bar

If she dey that bottom, my fear be say these housemates go actually evict her, and that is one less action mama. Next week, Lucy go go house

Wetin go remain? Nonsense.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:18pm On Aug 01, 2020
igasiboy98:
If this news that ka3na is in bottom 4 is true. She fit go house o
She and Praise fit go house if na two people

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 45 46 47 48 49 50 51 52 53 (of 90 pages)