InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 50 51 52 53 54 55 56 57 58 (of 90 pages)
Acidosis:You say she never boil egg, I dey tell you wetin she do wey pass to fry egg. Na until she cook banga, pound yam you go talk say she don do something? Some girls no like to dey cook, e no make them lazy. No be everybody go fit do everything and expecting all girls to dey good for kitchen, na ancient mindset. Na so men dey go bring wahala come house. I no wan know if woman dey good for kitchen, like Brighto, I sabi my way around kitchen, na who fit make money bring come house I dey interested in. |
Acidosis:Like I said, people wey no dey watch show dey always want drop hot takes. I don see Erica fry plantain, fry chicken, do toast bread, cook pasta, so, wetin you dey talk? She no like am, no mean say she no dey do am. BTW, just because woman no like to dey cook no make am lazy. |
ArchAnge1:It's creepy. I no dey reason that pervert side, but e dey creepy. Na one thing to dey rub head on platonic base, but when I sabi say guy dey do that thing for babe wey e like romantically, and the babe no know say na romantic like, e dey look creepy. |
nazablossom:Oya, whose fans go vote for Nengi? Just imagine possible Top 5, and who she go get outside them Bear in mind, CeeC and Tacha never played games with any guys in that house. So, I no know why una dey compare Nengi to them. |
I don clock say most people for this thread no dey watch the show, dem just want come argue and most of the argument na from people wey no dey watch, so, e dey senseless So many times, correct gist go dey happen for house, or person go make important point, nobody go post am, you go come here dey read mumu back and forth from people wey no dey watch, but wan argue pass. |
Ka3na dey tell Ozo say she dey proud of am fir making a decision to not be used. Even Ka3na lock the babe game for house. See congratulations in and out of the house. |
WhorErica:People wey been think say he get sense that time. And Northerners wey wan help am. Sir Dee no get correct fans. Some of them na even Tacha fans wey share votes for am. Sir Dee no get fans reach to help Tacha. |
These two useless ship people Liric dey kiss. Even their foolish kissing sound dey disgust me. The other one hand dey move under duvet. Biggie, I will rather watch Bright cooking. |
WhorErica:Sirdee been get fans? Nobody help Tacha for that house, na her fans move her, solid. |
Indepengent:Meaning Laycon will come second? |
Bright don cook him pot of ogbono finish, while those indomie and egg boys dey outside dey gist origin of humanity. Later now, dem go come dey beg am food |
nazablossom:She been no hear on time. |
Blackhawk01:Yes, March 13th, and March 5th Both Pisces. |
Geezeem:Honestly. I don't even think they will be able to have healthy relationships with anyone, until they really release the pain in their hearts |
Dansuqi:LOL Calm down my guy |
Wathoni say she should be booed up with Tricky Tochi ask am say why is she not She say because he's her friend, no be say she wan friend zone am. Tochi said, but you already friendzoned him. |
Wathoni say the coupling na either for the game or for highlights She dey always talk this thing. |
babiepraiz:No, I no school for Lagos |
Erica dey play with that Scorpio talk, but she correct die |
Eeghe:I don see say her mumu no get cure. |
Dansuqi:Too many people are ahead of her. Tacha and Mercy were Top 2 from the stage, and it never changed. Nengi don lose too many people already, she no go fit return from that, the people wey even hype Mercy last year, most no dey with her again. |
Tochi say some people don mark some people, so, step back. Wathoni counter am with "But you know there are some guys that like up to three different girls" Tochi agree, say, but, e go get who the guys like pass of the three girls. Wathoni dey argue am. Tochi dey try help this mumu, but she no wan help herself. E no good to dey obsessed with anybody. |
Anyway, Tochi dey tell her say even if she talk say she no dey concerned with getting boo'd up, e know say she dey think things. He come dey advise her, say make she no dey intimidated by anybody, or feel pressured to join the Boo'd up gang, make she just dey try socialize with housemates. He say if she like person, make she no tell the person, make she show the person, because she be girl, she no suppose tell guys say she like am, she suppose show am. If the person reciprocate, good, if not, make she bone am. Eeghe, your guy dey talk sense. |
Tochi disagree with Wathoni say the booed up thing happen fast He say people wey dey booed up, na because dem find each other early and anybody wey no get boo, na because dem no show up early. For middle of their gist, Nengi show, to distract Watho bonding moment, but she don go. This babe should allow Watho meet man now, wetin be all this close-marking? |
Anytime camera dey Wathoni face, she dey talk "Booed up" |
Eeghe:Ne better fan you be. I no dey vote plenty, I give up to 5 different housemates online votes, Tochi get like 80 from the 200 wey I share, I dey take style hope make e no dey bottom, because e get some people wey I wan see for that bottom. You try well well, hope your votes go elevate am comot from danger zone |
Eeghe:She told him she didn't want relationships in the house, so, the guy gree say make dem go with the flow. Na Erica put hold on the exclusivity thing. |
doziefrank07:What of TolaniBaj, Praise and Wathoni? For now, na only Tochi, Kaisha, and Bright I dey 90% sure of. The rest, na give or take |
MJBOLT:She no fit misbehave where Ka3na dey. Ka3na na Bosslady, Nengi no want competition, she want mugu. |
Lilo no fit go house this week, she fit no even see bottom 4, because bottom 4 candidates plenty. |
Froshloaded:Dem get money? |
Eeghe:No, you hear am well |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 50 51 52 53 54 55 56 57 58 (of 90 pages)




