₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,767 members, 8,432,518 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 08:06 PM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 46 47 48 49 50 51 52 53 54 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:10pm On Aug 01, 2020
Eeghe:
He declared her as “the girl he would like to date in the house” and chases her well in his own way
He also flirts with others but at least I do not see him courting them like he does Erica
You are definitely watching the show
Exactly.

See now, he don come corner the babe as she dey iron. Dey do like all those guys wey go dey hover when e see say some guys dey look him babe, that kain, "Make una see me o, I dey here".

Monitoring spirit
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:06pm On Aug 01, 2020
GalPissetzky:
its not fully certain o. dont be surprised to see laycon shoot his shot on nengi or erica and they bounce am and all him agero fans go decamp o. i still feel na girl go win am
If Laycon cast for those babes hand, e fit deal him campaign a fatal blow.

Na make e just dey avoid them, before dem turn him Delilah, he kuku get dada like Samson already
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:03pm On Aug 01, 2020
MamBi:
Break table break table undecided

And when Tochi asked her how she would break table, she says sitting on Kidd’s bed or even just talking to him will shake the table ... angry angry

I just wanted to enter the tv and shake her a little bit... She is just playing herself out of the game by fixating so much on someone who thinks she is easy..

If she really wants to break that table, she needs to get her lazy arse off the bed and do something... undecided

I don’t like people that talk and have no action....
I still dey wait her since Thursday wey she say she go sleep for the guy bed.


If she wan break table, make she go after all the guys wey Nengi don put for bottle.

Her problem be say she don cast for house finish, na cries of a wounded cricket
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:58pm On Aug 01, 2020
Borussia1:
I meant Kidd not laycon sorry. But you don carry talk go another place.

She told Kidd that she wouldn't find him attractive if she was blind, meaning that she's attracted to him physically as she no blind. She also made Kidd promise not to initiate sex with her cos she doesn't trust herself if he does.

Now the physical attraction is already there on both sides, Erica is the one asking for mental connection. And even if Kidd refuses to commit to her, she still won't leave him
She is not asking for mental connection.

She has established that there is no mental connection, she is not telling him, "Oga, mentally connect with me, abeg, I take God beg you"

She and Ozo were having mental connection on Thursday afternoon, Kiddi go lie down for corner dey observe them, later that night, he corner the girl dey tell am him family gost. Na him dey always ask "What do you want me to do?"


Your guy is actively chasing her, he is doing the most with the girl, so, he is definitely the one that wants more.

Na sex she wan sex with am at best, she no talk say she wan marry am.


BTW, You have no right to be possessive over babe wey no be your own. I no dey see am dey monitor him other babes like when Nengi dey gist with Tricky Tee, but some days ago, he go dey complain to Tochi say Erica dey always dey with Laycon. You don ever see Erica tell TolaniBaj say she no like as he dey always dey with Nengi?


My own talk for here be say, no weave the gist like say Erica dey chase man wey no dey look her way. The man dey chase her too. Actively
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:45pm On Aug 01, 2020
So, wetin una dey try tell me be say Kaisha escape Bottom 4


See God!


Her crase continues
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:37pm On Aug 01, 2020
Borussia1:
So what did she mean when she said she wouldn't fall for laycon if she was blind if she wasn't referencing his looks?

Kidd is very possessive, it doesn't mean he fancy her. He does the same whenever Ozor is trying to talk to Nengi
She said she wouldn't fall for Kiddi if she was blind, not Laycon.

Yes, because Kiddi get trash behavior and blindness mean say you go judge person by their character, without your judgment being affected by looks.

Nobody wants to be with anybody wey dem no dey share good mental connection with, because one day, the physical go fade, but the mental no go fade.

Kiddi still dey insist say he wants more than sex, but the babe no gree. So, if we are basing our judgment on their words and actions, na Kiddi dey find commitment, the babe don settle her mind say nothing like that go happen.


E dey funny me when guys dey always think say all girls just wan trap guys.

See Ka3na wey tell Praise say na gbensh she dey find, so, make e no think say she go catch feelings. We hail am say she be Bosslady, but Erica dey talk the same thing, una wan force commitment inside her mouth.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:19pm On Aug 01, 2020
Lay on and Wathoni det reflect outside.


Wathoni invite am to reflect on bed with am, dem don go lie down for the garden bed
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:18pm On Aug 01, 2020
Borussia1:
She's been yapping since the day they danced together at that party. Go back and watch
I said it was yesterday she established to him that she only wants him physically. She had not told him that before yesterday, she had only been telling him he is flirty

Yesterday, was the first time she told him firmly, that this is how it is going to be between us. If she still complains afterwards I will take you seriousky.


The funny thing be say, she no dey monitor am, when he dey follow Nengi for yansh, she no dey interrupt am when e dey jump on top babes bed, when she dey with am, she go even dey invite TolaniBaj make dem hug the guy, na she reach out to grab Nengi yansh yesterday. She dey flow with him flirts


But small rub wey Ozo rub Erica for back two nights ago, Kiddi don appear, she call Laycon for kitchen, Kiddi go appear, she follow Praise gist, Kiddi go appear, she follow Neo dance, Kiddi go appear, she follow Ozo dance, Kiddi go appear

Na Kiddi been dey find exclusivity, want pressure the babe into relationship with kiss and all him guys wey dey hail am. Na she tell am say she no wan date anybody for house, she never for one day, claim Kiddi as her guy.

Na your guy dey mark territory aggressively, so, if anybody is a clingy person and trying to force commitment, na Kiddi wey no go gree the babe flirt in peace. He no carry wife come Biggie house, make e no dey cockblock dem Laycon and Ozo like say e get property
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:08pm On Aug 01, 2020
Borussia1:
Since she already said she's attracted to him physically, and also knows his a fvckboy, she should stick with the physicality and stop yapping about mental connection, she knows what she want and she's getting it on a steady.

Asking him for commitment every single time put a question mark in her intention.
Na just yesterday night she establish all these things.

She never yap about am today. But watching
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:56am On Aug 01, 2020
Akorkor:
Laycon is trending again
That one na paid trend.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:53am On Aug 01, 2020
Borussia1:
And that's normal to you. It's barely a week since they had anything physical and she's looking for mental connection.

She s trying to blackmail Kidd into commitment, and she's being very careful about it so as not to totally push him away into the willing hands of her competitors.

If she was really serious about the mental connection she wouldn't have had any physical.

She doesn't mind having physical connection but she's raving about mental? Lol, your head thinks and your body reacts, Erica is just pretending, and she's never letting Kidd go no matter what even if dude flirts with several ladies till the final day.
How many guys dey wonder about mental connection before dem nack?

You think say e no get babes wey go tell you, "I like you for your body, but nothing else about you interests me"? Una dey like talk like say men and women no be human beings the same. If say na man talk wetin Erica talk, una for call am player, some people go even call am scum, say na her body e dey find. But woman talk the same thing, you say she dey try pull commitment from am.

Erica dey right, if say she blind, she no for like Kiddi, because his attitude is very repulsive. Na wetin make she tell am say, she like am for now, but eventually, she go lose interest.

Na normal thing, no come here dey talk like say you never like person die before, based on their physical, date them sef, only to notice say una no dey move on the same wavelength mentally. At least 70% of people fit get this story. Some people dey even marry based on physical connection.

She don tell am say, when she dey bored with am, she go move on, so, no worry, your guy no hets commit, she no ask am for exclusivity, because even she sef tell am say she no wan date for that house.

Make dem dey flex each other, na normal stuff in real life. Even virgin sabi those kain parole.



As MamBi take talk am, na so the thing be
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:46am On Aug 01, 2020
Wetin Aristotle dey reason this morning?

He just dey alone, dey pace, dey think.

Be like e don dey review some life decisions
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:45am On Aug 01, 2020
This Nengi wig make sense this morning
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:39am On Aug 01, 2020
Dezenazil:
I actually liked him but his attitude threw me off. He is isnt a loyal friend plus he touches people(girls) inappropriately.
He isn't a friend at all.

You don ever see am enter diary room claim anybody?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:11am On Aug 01, 2020
Vee don dey advise this babe again, Eric go hear am later
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:00am On Aug 01, 2020
Valto:
shocked shocked seriously cheesy
Yep
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:58am On Aug 01, 2020
GalPissetzky:
ka3na and praize are single., and she like bossy guys. see ka3na and praize migght end up marrying but praize is not the type of guy i expect a queen like ka3na to spend jher life with. may she come marry me please . she is free to sample as many dicks as possible
Praise is engaged.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:55am On Aug 01, 2020
Valto:
lolz u can lie oo grin
No be lie.

I no recall the lap dance, but he kiss Ka3na and he handle Dora breast
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:53am On Aug 01, 2020
If Tochi and Wathoni hook up, shey we go fit call them Totoni? grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:37am On Aug 01, 2020
GalPissetzky:
she dey try to throw cece stunt, e go fail am
No, no be her game be that

CeeC game for even better for her, CeeC was a woman scorned, plenty women relate to that story, nobody scorn Nengi, na she dey do suwe for people head
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:30am On Aug 01, 2020
nazablossom:
Okay. I'm reading that page now grin

But she didn't tied Prince down na

Prince should hit ignore button like Ozo did, Abi Dem tie him destiny with Nengi grin
She no tie am down, but as she dey do them, their fans no go like her.

You see as Ozo fans dey do prayer mountain on top her head.

If she continue dey use people to boost her ego, without regard for their feelings, the small fanbase wey those people get, go dey work against her at their exit.

She no fit build alliances like that, she no dey like Tacha and CeeC on that note.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:21am On Aug 01, 2020
nazablossom:
She's not my babe.

Wetin happen? I slept very early.
I have over 70pages to read now shocked
She pull Prince in, whine the guy, rease am, tell am make he shoot him shot t her (same way she did Ozo), as the guy shoot am, she withdraw.

The way he come dey beg her, dey try twist the thing back to him favor, while she continued rebuffing him, just make the guy look like much

She no dey stay one side
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:16am On Aug 01, 2020
galaxyball:
You usually have a lot more to say, wetin happen? grin
No be everybody I go waste plenty words on.

Some people no deserve pass my 'K'
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:15am On Aug 01, 2020
Eeghe:
I shaa know her heart will play her on this, and probably very soon...once KiddW bones for her, she will start craving for attention ...so I will be here to still love her thru all the patches (rough and smooth)
P.S. I don’t blame KiddW on this at all. He is who he is, and you either deal with it or bounce.
Na tomorrow the match go continue.

But na once a week she dey do the cry, so, e fit wait till next Thursday.

I look forward to it.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:14am On Aug 01, 2020
scondy:
get this straight...she doesn't ve to straff kidd to loose respect....a guy is chiking u in a small space and is still shooting shots everywhere....if she really respects herself as she keeps claiming ....u wont see her smooching and kissing....all that shalaye na to justify her continued kisses....all na pretense....

I dont even have a problem if she wants to have a thing with him....but she should drop all those bullshit story ....let's just ship kiddricca in peace ....

I personally like kid's free spirited nature ....trying to tame him is not to be decided by her....na d guy go love up come tame on him own .....if like what u see and wanna take the risk....do so...if u cant ...stay away ....but entangling and reading epistle to anyone willing to listen is nonsense....

hm's call them a ship...she ll retort ...no o...next min..u r kissing and smiling foolishly...mtchew ....
K grin grin grin grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:05am On Aug 01, 2020
Hazardfan1:
Omo, she try,I was madly impressed.

No be crime to fall in love sha, but she still dey use her head. She shouldn't get desperate, if the guy wants to have Nengi, she should leave dem to mess each other up.

If she go fuccck for National TV, she don ruin her career.
She handle today matter well, it was impressive.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:04am On Aug 01, 2020
ArchAnge1:
I didnt know that

If she said that then I'm wrong
She tell Praise say na fvck she dey find from am, yesterday night.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:03am On Aug 01, 2020
Anybody wey hear Erica talk, go know say she talk am like say na just cruise she wan cruise with Kiddi.

E dey pain some people say she no straff this night, say she no give them the highlights wey dem need to scatter her game, so, dem go weave story, make assumptions and wait for another day to laugh.

Kiddi fit knack another day

But for today match, na ERICA 1:0 KIDDI....una good night grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:51am On Aug 01, 2020
ArchAnge1:
he uses his looks and money

Kidd isnt slick like he thinks he is

Bad guys dont have anything, yet they handle babes finer than erica

Nengi will mess kidd up, if erica that me I know nengi is smarter than can see through him, nengi will finish him

Nengi was fuckingg with prince 10 questions ahead

10 questions, she knew all his answers and had questions waiting in front

Check this conversation

Nengi - I want a man that makes me chase him

Prince - I now know what to do


Nengi - you picked me 2nd today

Prince - were you hurt that I didn't pick you first?


Nengi - I dont care, I didnt pick you first when I was hoh, would have picked you first but wathoni picked b4 me

See how those first 2 conversations contradict themselves, then she baits him with the last one after making him needy while saying that she wants him to not be clingy



I fear that girl like mad, she is very intelligent, very very, she is playing not just the housemates but we that are watching
See, you don sabi where Nengi dey go, so, her element of surprise don off.

Nobody see this ela wey Erica give Kiddi

and if Erica fit see wetin Kiddi dey do, na im be say, she fit see wetin Nengi dey do. E make sense why she been dey press the babe yansh earlier on, when she been siddon with Kiddi.

Kiddi don cast for that house.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:47am On Aug 01, 2020
Tonnyray:
Omo I wonder how I missed that clearing. Me way don say my final goodbye to Erica. I must drink my reserved bottle of Baileys to this tonight.
Dem dey call her Stargirl for Twitter, you know say na her kain babes all those sexually liberated feminists dey like.

The ones wey go dey tell men say na fvck dem wan fvck, and if dem fvck finish, dem go move.

You know say, the guy tell am say he wan come sleep for her bed, na so she tell am, "Nah, let's not get ahead of ourselves."
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:44am On Aug 01, 2020
Psychedelia:
LOL. Jonzing. Keep lying to yourselves, okay?
You seem to forget this is just the second week.
As the days go by and the isolation blurs her sense of judgement, Kiddwaya is gonna bust those cakes.
It is inevitable.
I give it 2 weeks.
If e bust am, na because she gree am, and that one sef no bad.


Anyhow anyhow, all na for your entertainment.

Enjoy
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:42am On Aug 01, 2020
ArchAnge1:
he thought she was high, kidd is irritating, I noticed how he started pressing her anyhow when she was acting high

Erica knows that he wants sex that's why she doesnt sleep on the same bed with him
He think say he don master the game.

He no know say Boss level never reach.

Make e just dey follow mature Nengi, maybe e go hammer for that side

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 46 47 48 49 50 51 52 53 54 (of 90 pages)