InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 53 54 55 56 57 58 59 60 61 (of 90 pages)
Ozo dey use him foot dey play with Erica, Kiddwaya don go spoil the play |
E no good to dey collect relationship advice from guy wey like you romantically. E go just dey whine you, make you sef dey doubt your feelings for the person That thing wey I talk say, Erica no put Laycon inside bottle, I know wetin I see. Na Laycon put Erica inside bottle, she just no know. |
BrightO dey tell Laycon say "if you like her, let her know" We no hear who the 'her' be, before dem call them for general meeting. |
This game with plenty rules Make these people no spoil Ozo abeg, the last game mess with the guy mind no be small |
Praise and Tricky, dey drop the terms and conditions for their planned game tomorrow. |
WhorErica:Na Twitter narrative you prefer, wey go favor your babe, because na her type full there. |
These ones dey plan another Truth or Dare. Hope say dem dey bring creative dares now, no be all those their kiss this, smooch that. If dem no dey lick body, suck woman nipples, or give me correct strip tease, make dem use tomorrow night hold vigil ahead of eviction night. Some people go need prayers to survive am. |
bennyblings:Odogwu no dey talk wetin you talk, but na internet we dey, we be anything wey we say we be |
Psychedelia:Same way the guy fans on Twitter no wan insult the girl, na all of them dey tip toe around each other as Kiddi and Erica dey tiptoe around each other All these things wey dem dey tell other people, dem never tell each other. I hate nonsense. Talk something with your chest or shut up. |
bennyblings:Twisted narrative. She never said her spec was only riches, all these boys for this thread sef. Hustle, make women wey like rich men, no dey provoke you. Na who no get money dey always dey offended when women say dem go like get rich man. |
Sunnycliff:E be like you never follow girls gist before. E get some things wey I go read for this thread, I go imagine say na one small 14-year old boy write am. Many girls dey paranoid say guys wey show interest in them, na because of sex, especially guys like Kidd wey dey follow any girl wey smile at am, to play. Cheap slut no send wetin you wan use them do, especially if you don promise them enjoyment and good life, like Kidd don promise Erica. Dem cheap, e no hard to impress them. Make una no dey post some kain things, like small children. |
Na Erica paranoia go mess her up finally, I don see am. She get serious abandonment issues Pesin wey go just siddon dey reason "he's flirty, he will follow somebody, he will do this and that...." And I understand, na because e dey flirt true true, but when you don think everything, come reduce am to 'mental connection', na rubbish be that. The babe too dey emotional, na wetin make she no fit play game. He dey follow her gist, dem dey flow very well, which other dirty mental connection she dey find? Talk your truth or shut up. |
Anybody wey think say Laycon na mumu, no sabi anything. Anybody wey think say Erica dey bottle Laycon, I just dey laugh am. |
I no dey even think Saturday party, I dey think Sunday eviction These foolish people think say na couple's retreat dem come do |
Bestcreamreview:You no wrong. And the fact say e never click for him mind, mean say, just because you sabi flirt with women, no mean say you sabi how women dey think. Wathoni matter no shake am, na Nengi own. One of the "two hottest women in the house" Two of them sef get poor communication skills. E no tell her wetin dey him mind, she no tell am wetin dey her mind. Just dey yarn dust to other people. |
2O22:I hear am But I no wan talk am, because I no wan post about the girl again. Make I hold my opinion. I know wetin guys mean, when dem call babe 'mature' |
Tricky don mention their Boo of the booless tag. Dora come add, "We are the ones that are everybody's bestie" Wetin dey worry this one? She think say na brezz carry anybody come Biggie house? This bestie issue dey pain her sef. Be like she and Erica go dey go counselling together. |
Ka3na dey clear Praise. Say, she like am, but make she no assume say she wan use am do anything pass fvck. E no dey old enough for her to marry. |
Acidosis:na Ozo seek advice, Biggie no fit give you wetin you no ask for. Laycon never reason say e get problem yet |
Tolani say "it could possibly end in tears for you, but if you like him, I don't see what is stopping you" This one na hard babe. Fear of tears no fit stop her. Go-getter. I no know wetin make Erica just dey laugh like mumu, dey talk yawo. Dey use laugh hide the pain she dey feel, dey try scope Wathoni opinion of Kiddi. Fear fear.
|
Getnewinfo:She go go house on Sunday. E go soon end |
Kidd does not like girls who assume he wants to sleep with them....Baba, but wetin you wan do again? Between me and you, wetin you get for mind? Na only BrightO dey trustworthy for that house, e do 8 years, e no gbensh, him intentions pure. |
nazablossom:Thank you ![]() |
Acidosis:Plenty of them na bottom 4 candidates. Na wetin make I say dem fit evict 6 of them. |
nazablossom:I dey watch film ![]() |
Praise no sabi talk. |
gameboy727:Prince will look good with anybody, he's Mr. Nigeria ![]() |
I wish dem fit evict 6 people on Sunday, make I see road |
This Kiddi and Erica na annoying people. Watho suppose slap their hand. |
I no know say Praise na Biggie PA |
See as Wathoni smile big when Tricky show |
WetSmoke:Honestly, the advert dey brilliant. Hope dem pay the people wey come up with am plenty money |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 53 54 55 56 57 58 59 60 61 (of 90 pages)
