Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,814 members, 7,851,735 topics. Date: Thursday, 06 June 2024 at 06:50 AM

Kendoschurrle's Posts

Nairaland Forum / Kendoschurrle's Profile / Kendoschurrle's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:50pm On Jul 13, 2023
infofirst:


Die keh.. They will adapt asap. What are you talking about... The industry standard is no time limit. Unestablished or upcoming firm will struggle. Be careful before you join any prop firm that just launch after today o

this same guy abi hin brother been dey the naija MFF discord room just last month dey boast say MFF no go ever do unlimited time... say those firms wey don do am go fail soon grin grin grin grin grin

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:54pm On Jul 12, 2023
infofirst:
Which stage are you in prop firm journey?
Phase1: Struggling to get a challenge account
Phase 2 : Got a challenge account
Phase 3: Trying to pass a challenge account
Phase 4: Funded but not yet pay out
Phase 5 : Funded and blew the funded acct
Phase 6: Funded and withdraw
Phase 7: Funded, withdraw and blew the funded account
Phase 8: Funded, withdraw, and withdraw and scale up
Phase 9: Acquiring multiple challenge accounts and funded and withdrawals.
Phase 10: Loading personal accounts with profits from prop firm.

Phase 9 smiley
I never see reason to move to phase 10 unless props begin fail. Make I dey save first

FTMO wan join no limit after dem don form no shaking tire grin grin grin grin

i don keep their money down and I dey wait MFF too

4 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:25am On Jul 12, 2023
PraiseGod4u:



There is no high probability setup for a systematic trader.
Because before taking a trade, all your checklist should be met.
We are the ones gambling while calling it trading

gbam

unless na vibes and inshallah you dey use trade, nothing like high probability

every trade get the same probability

wetin dey funny me be say people dey hammer on emotions as one of the problems wey traders dey get still dem dey make room for emotions with this high probability talk grin grin

like i don talk before, if dem no fit code your trading system (that is if e no get clear rules wey you dey follow every day), you never start grin grin

4 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:48am On Jul 09, 2023
XAUTrader4L2:



Baba I am not healthy enough to be a scalper or day trader

buy no swap or swing account

options plenty but if you no want no lele
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:02am On Jul 09, 2023
zedegit:


Does anyone ever know enough? Even as you think you know, they may be formulating new rules which you may not be aware of until you equally breach it.

Thanks for your input though.We learn together.

NB: I am not preaching anything. I am simply expressing my observation.

na why you suppose use firm wey get reputation to protect. dem no fit make up rules wey no dey before to avoid paying you because that 10k wey dem no pay fit make dem lose millions if people no trust them again

and even if that kain thing happen for firm wey don already pay you first payout, you no lose anything

these firms na stepping stone use dem build strong personal account, and save up serious money for your life, and then anything wey happen after no concern you

and from wetin we dey see, prop firm industry no dey go anywhere

some go fold but the industry go still dey bubble for a long time

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 10:58am On Jul 09, 2023
XAUTrader4L2:
People really enjoying with prop firms, making some of us feel left out smiley

Unless say you get six figure usd personal account you suppose find way join

na easy way to make more with small and also build personal account
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:56am On Jul 09, 2023
zedegit:


Meanwhile that of mffx has something to do with the trailing 6% [/b]which they say they calculate from the highest ever amount you made.

Someone took $5000 close to $5500 then lost 4% (Daily DD)which is $220. They took the account from him. He not only lost his account but also lost his generated profits of about $200.

[b]Another they accused him of using EA to trade, seized his account and denied him profits.


I can go on and on but what do I know? I suggest you join their discord community and follow complaints and their response. You will learn one or two.


you don't know enough to dey preach this thing brother grin grin

the person wey choose 6% trailing account na the idiot because dem explain the rules clear for their page

why e no choose standard evaluation like normal people wey get sense grin grin

for EA, MFFX no dey stop EA usage unless na arbitrage or HFT

prop firm rules dey feel limiting sometimes but you no fit ignore the HUGE opportunity wey dem dey give people

just find way adjust

me for example i go prefer 10% daily DD and 20% lifetime DD but since I no fit get am with any of the reputable ones wetin I do? reduce my risk by 50% simple

anybody wey no fit trade with MFFX no fit trade with others e no matter who you wan call

1 Like 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:36am On Jul 09, 2023
Emmizay12:


lol na only people wey dey blow prop firm accounts dey scream scam,


but the rate at which propfirms are everywhere these days, with different conditions, me I'm waiting for the propfirms that will do a 1 step 5% profit target only, with the same trading conditions and prices of a MFFX 2 step account

Is this prop firms the future of Forex trading or is this just a bubble about to pop?

e no go pop per say because na wetin brokers dey enjoy since except say dem dey swallow the whole profit alone

TFT wan celebrate reaching 100 milla in payout soon

imagine how much brokers like FXPro wey don dey for 15 years plus go don swallow clean mouth

but make una dey careful with firms wey una dey choose because if the firm dey depend on only lost challenge money, e go fail

the best firms we go last na those wey know how to make money from profitable traders too

those nigerian firms like consummate and co, i no go even near them at all because na clear ponzi dem dey run grin grin all these A book and B book no concern them o
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:28am On Jul 09, 2023
if you no wan get wahala with TFT news ish, choose their Standard Swing acccount. leverage go reduce to 1:30 but e still dey okay if you no be gambler wey wan hammer immediately

na wetin I choose because I hate restrictions. no be say I dey trade news but my open position fit use news as fuel make person no come tell me nonsense

na why i no fit use FTMO and MFF i go beat their time limit but market ya werey gan I no wan lose my challenge money if month no good

for me the top three na:
MFFX
TFT
FundedNext

I dey monitor Fundedengineer. dem no get any stupid limits and no confusion for account type. before year go end, I go add them and then relax cool cool

3 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 3:58pm On Jun 30, 2023
klinksd:


...My Oga, if you want to be vawulent, come out plain, the weekend is already here...which of the two traders is it?.... grin

...🏃🏽🏃🏽🏃🏽🏃🏽🏃🏽🏃🏽🏃🏽🏃🏽🏃🏽

hian

i no dey talk to anybody in particular o just sharing serious something wey I don discover tey tey
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:21am On Jun 30, 2023
market dey trend like only few days every month but intraday traders go wan dey trade everyday dey expect miracle

you go just dey one spot because you go give back profit from those few good days for the many many bad days

this june, na only like five days market move well well for one side

other days na zig zag

unless you be scalper wey dey find 10 pips, you go dey deceive yourself if you wan trade everyday

5 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:06pm On Jun 28, 2023
peteregwu:


I think https://the5ers.com/ prop firm are offering no time limit too.

thank you. rules too plenty and 100k highest account small
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:29pm On Jun 28, 2023
OfficialP:


TFT. I think they will start it next month

thanks
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:17pm On Jun 28, 2023
i wonder why mff and FtMo no wan do no time limit

i don get mffx and fundednext as na dem look genuine pass for the no limit people

i dey find two more make i balance.. any idea?

No 8cap abeg so all those bespoke and maven no concern me

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 3:50pm On Jun 27, 2023
as you dey take advice

better dey listen to people wey get prop account and wey don collect at least one kpakam grin grin grin

e get why grin grin

my people say person wey dey use mouth drive moto no dey ever get accident grin grin

if you like dey follow the mouth of people wey still dey dream na you sabi

no risk too little make your journey no tough pass as e suppose be

no risk too much make you for continue dey progress reach where you wan go

na you get strategy na you know wetin go happen before you lose 8%

my mentor tell me say "that number of pips loss for your worst drawdown, multiply it by 5 and set your risk with that in mind"

i arrest my cases grin

7 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:47pm On Jun 27, 2023
OfficialP:
Here's the thought coming to my mind.

if you have 10000 prop account for. example, 5percent of it is 500 usd.

That's the actual capital you have to trade with. Trade the account with the mindset that your capital is 500, not 10000

good idea but also remember say the target na based on the total amount. you go need wait almost one year to pass phase one and two (unless say you dey pack 1000 pips every week grin)

how many people get that patience?

the prop firm wey you dey trade with fit don pack up before you pass too grin grin

if to say person fit trust these platforms completely ehen

the idea above make sense pass. trade that 8% ignore the big amount

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:01pm On Jun 26, 2023
Nwadaka:
I loaded mad on GU buy , anticipating to pass my 100k phase 2 to challenge today, just 2%. Good luck 🤞

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:56am On Jun 26, 2023
Donsheddy:


Na wetin my fragile heart fit carry oh 🥲

my brother do your thing

na so you go last long

many prop traders wey don collect payouts for up to year dey risk very small

many of them dey use 4-8 weeks pass phase one and two for big big accounts then settle down they collect 3-5% every two weeks after them don pass

calculate 3-5% of 300k account and you go see grin

other people go do gidigbo with heavy risk collect first payout but them go lose the account by the next payout come start afresh

if you no fit comot eyes for trade wey you open, you don risk too much be that and that fear go still wonjure you las las grin grin

10 Likes 2 Shares

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 4:52pm On Jun 23, 2023
saintelvnn:


Even if I save 100$ I would still trade with 0.10lot size, just one position, $100/1000lots=0.10lots, same tin for me man cheesy
There is no difference at all, na only when I won invest I go use small lots and keep am there but now you see ehnn if no trade I no eat grin grin

Yeah 20% on mad volatility that's why I'm still working on getting sniper entries to guide my SL bro

lol
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:29am On Jun 23, 2023
klinksd:


Risk Management is central and basic for any trader that wants to be profitable in the long term. That is clearly not in dispute here.

Just so we are clear, if your strategy hits SL 10 times at a row, you would not bother to tweak it...? cool

you dey miss the point brother

strategy wey hit 10 straight SL fit still win the next three grow the account by 10%

if you don backtest strategy for 5-10 years and e dey always come out in very good green when year don end, just focus on risk management and relax

problem be say many people no even get strategy wey dem backtest that long so once the loss period come, dem go panic begin add silly filter

the ones wey even try backtest go still wan hammer overnight

na why people dey fail prop firm wey be no-time limit multiple times grin

2 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:22am On Jun 23, 2023
OfficialP:
Risk management is the key.

All this sophisticated technical analysis is not worth it, trade will win and lose, it doesn't matter how you analyzed the market.

Knowing this will stop one from changing systems and strategies and be at peace

welcome grin

coin toss strategy wey get like 1:3 RR go get the same result with all these snake in the monkey shadow strategy

people wey no fit subdue their greed and impatience go think say na further maths strategy go save them grin grin

e be like goalkeeper for football. whether you buy am 500 milla e go still concede goal wey the one wey dem buy 5k go concede

2 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:53pm On Jun 22, 2023
infofirst:


My Tp Got slippage by like 32.7pips some 17mins ago and hit. Bonus for me. I think the side one is makes one feel otherwise

my own hit extra 20.4 pips for another broker but on the dot for prop firm grin
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:04pm On Jun 22, 2023
prop firm brokers with their wayo dey always make me laugh for news grin grin grin

take profit no dey ever get slippage even if price pass TP by 20 pips due to spike grin grin

but if na SL grin grin grin

anyway, we go dey use long spoon dey chop with this devil still cool cool

4 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 2:11pm On Jun 16, 2023
EmmanuelVi:

Aah! Bro, there are a lot of things to do to stack the odds in your favour, some of these goes back to the very building blocks of Technical Analysis itself;


abeg sometimes learn to shut up and observe

all these yati yati wey you dey talk i no know who you dey do am for

the guy don dey post calls here since with good R:R.. how many you don post?

make we hear word abeg

na so una go pack theory for head like naija teachers but nothing come out undecided undecided

5 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:44am On Jun 16, 2023
VeeVeeMyLuv:
for some pairs like gold he is very correct.

But for some other pairs haba, the signals are as clear as crystal

yes e dey correct

that gold especially i no know why person wan dey trade am alone

i no fit grin
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:32am On Jun 16, 2023
Fxwarrior:
There are good months and bad months.

Best is to sit out this month.

Unstable market is not worth trading for your capital sake.

na why i no fit trade one pair be this

instead make i dey trade one lot on only one pair

i go do 0.1 for 10 pairs

no how wey all of them go dey misbehave throughout the month

2 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 4:24pm On Jun 15, 2023
omo anybody wey miss today go cry o grin grin grin

see long candles everywhereeeee

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:55am On Jun 15, 2023
realone12:
omo! all this on wether the price Will go up or down? we are in dip shit

grin grin

na wetin dey always make me laugh be that

both strategy wey simple and the one wey be like further maths go still make and lose money

why you go choose that further maths one?

anyway like one of my guys go say "if dem not fit code your strategy you never ready.."

all these subjective strategies wey Mr. A go dey see tortoise shoulder and another one go dey see change of character.. lipsrsealed lipsrsealed lipsrsealed

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 4:00pm On Jun 13, 2023
Emmizay12:


but is MFFX spread okay for scalping on the 5mins timeframe?


yes for standard account

the swap free account spread take style large o unless you wan dey trade only EU

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:59pm On Jun 13, 2023
EASYLIFE4US:
Thinkmarkets broker that tft is using now is a very bad broker, they stop hunt too much and even push your stop loss beyond where you placed it. I'm considering dropping tft because of this b-book broker's nefarious actions

na the same thing everywhere brother

check mffx discord and everybody dey complain for eightcap and thinkmarket

imagine 50 pips slippage on top small cpi news grin grin grin

if you put stop loss, dem must collect am once news reach whether you like am or not grin grin

somehow normal broker no dey get this type of big slippage for broad daylight like this grin

i guess dem gats make back their money by failing as many people

dem want make everybody become scalper or close their position before news when e be say na that news fit move market go your direction lol

anyway, if you dey chop with devil, hol long spoon grin

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:28pm On Jun 03, 2023
rainlover:
Where's meshpips? Baba has been silent lately

na normal with that one. heat don too much e don disappear

e go come back next season grin

na so e be since 2012

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 71
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.