Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,162,737 members, 7,851,537 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 09:56 PM |
Nairaland Forum / Kendoschurrle's Profile / Kendoschurrle's Posts
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 9:25am On Mar 28, 2022 |
all the people wey dey claim contrarian go don hear am for JPY this last three weeks see as dem they blast up but people still dey enter sell by force. imagine say 80% of forexfactory people dey sell UJ 1 Like |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 8:16am On Feb 28, 2022 |
tonnieblaise: very true. if you draw enough random lines and boxes ontop any chart market go react on many of them 3 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 5:44pm On Feb 09, 2022 |
Riverrun: my dog chop my assignment |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 1:51pm On Feb 08, 2022 |
Elliotwaveforec: Qoyman: Elliotwaveforec:
|
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 11:50am On Feb 08, 2022 |
Richardio: brother talk true.. wetin be ya username wey we take know you? 2 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 11:48am On Feb 08, 2022 |
Elliotwaveforec: unfortunate fool, as na only daughters i get wetin we go now do am ? Better go carry block for site if you dey find prop account money. broke omo ale you no get kobo, you no wan still humble.. imbeside 5 Likes 1 Share |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 10:06am On Feb 08, 2022 |
Elliotwaveforec: if you dey join the contest for fun, you no go dey vex for disqualification like this. the one wey you win that year, you chop the money clean mouth o. if you win this one you for collect the money still. you're actually very shameless infact. poor, shameless and ungrateful 3 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 10:03am On Feb 08, 2022 |
infofirst: ignore this guy abeg. everyone can see what happened |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 9:20am On Feb 08, 2022 |
Feshizzy: forex frustration na ya mate?? the clown go still open new username join next contest. 6 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 7:00am On Feb 08, 2022 |
I for surprise if something like this no happen. no be nigerians again? once you do good thing for them small , na entitlement dey follow 4 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 4:55pm On Feb 04, 2022 |
Kaybee7000: lol you go wait tire nobody dey teach style for here o. maybe na before when i no know. jejely go forex factory if you still dey find style to copy. wetin you go get nah vague talk wey no go still point you anywhere because all man dey hoard system 3 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 6:05pm On Jan 30, 2022 |
samfelly:from the little wey I know, i know say every market day and week is different. market no fit give you the same amount every day o. E better to just follow system and see wetin e bring when week or month don end. but good luck. 3 Likes 1 Share |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 11:50am On Jan 30, 2022 |
TradingMaestro:my brother leave this story abegiii.. if person no fit trade responsibly with the tight rules the oga set imagine how irresponsible they will be when rule no dey.. 3 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 8:39am On Jan 30, 2022 |
so only 9 people out of 45 fit last ordinary one week for our competition with profit? oh boy! fear dey catch me o. all the ginger and oversabi knowledge wey we dey see for here still nothing come out if our oga increase time to one month maybe nobody go even win sef.. omo nawa o. this business hard die. 3 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 8:59pm On Jan 27, 2022 |
Kaesyrn: lol. you still dey doubt the power wey forex get over people. business wey go make you dey buy data dey trade demo and upload screenshot to collect accolade no be here we see person steal signal and screenshot for months use am take get telegram group to open new account and form jjc na small thing 3 Likes 1 Share |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 7:22pm On Jan 27, 2022 |
Kaesyrn: because na old member for here before |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 22 by kendoschurrle(m): 6:12am On Jan 26, 2022 |
Abambam: Na so e dey deceive hinself for over two years now. i never see this kind thing before. different people don tell am the same thing for here many times but him and people wey dey encourage the nonsense behavior go dey post fake deep shalaye.. even if na small pikin, that two years suppose dey useful to learn coding or graphic design 2 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 4:09pm On Dec 14, 2021 |
GreatestManEver:yes but even him changed to short term for ftmo. he used to hold gold trades for days before |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 1:10pm On Dec 14, 2021 |
intraday trading or swing trading which is better? i like swing trading but e be like say intraday dey reduce loss seriously. all the competition winners and prop firm people dey also trade short term too. hmm |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 9:36pm On Dec 08, 2021 |
i dey laugh all dis people wey dey expect direct answer on dis strategy question nobody go answer you. na roundabout answer you go get. funny enough na strategy wey dem never use achieve anything dem dey hide pass 4 Likes 1 Share |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 4:36pm On Dec 03, 2021 |
Keninn001: this advice is good but e fit still no work. in my small experience, two weeks or months no fit be the same for this biz. maybe na that week or month you wan do the challenge the system go get loss. and worst, even though the system go recover dem no wan hear. dem don disqualify you. na why I never comot money do the thing |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 12:10pm On Nov 25, 2021 |
rhynoemmie: Una go dey think say everything na bad belle no wahala. when he start dropping history like Gabsonfx I will personally join and praise him. That system no make sense. Wetin concern me sef? boom99:Why you never pay money collect account from them like others dey do? If you trust the system you suppose don borrow money do am. or even have live account wey you go don turn from $100 to even if na $500 since the past few months you don dey post screenshot. lol |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 9:05am On Nov 25, 2021 |
rhynoemmie: na very nonsense method o. real scalpers use powerful robots to enter many trades at once at reasonable risk. if you like go and copy rubbish from person wey still dey joke. using 1full lot to chase 3 pips on a tiny account will only work in demo. in live account, panic go scatter the account. one loss will wipe out one week of profit. 2 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 8:53am On Nov 17, 2021 |
FreshGuy2: una too dey quick fall for nonsense for this place. person steal dashboard from forexfactory modify am come dey sell you don dey lick am already. little research wey go save una money una no go do. you fit get different dashboard for here https://www.forexfactory.com/thread/532236-dashboard-trading |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 1:43pm On Aug 19, 2021 |
GabsonFX: i'm not sure sire. i believe if you're following the MM that comes with the system then you can't control any of them. stop loss has to go where its suppose to and you have to take profit when system says so |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 1:18pm On Aug 19, 2021 |
GabsonFX:so the lower drawdown system is better, Thank you. |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 12:57pm On Aug 19, 2021 |
GabsonFX: Hello boss. please I want to ask do you pay more attention to possible drawdown or to possible profit? For example, if a system can deliver 500%/year but can possibly lose 50% in drawdown and another one can possibly lose 20 or 30% in drawdown but make 200%/year.. which will you advise to trade with? |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 3:24pm On Jul 13, 2021 |
una too dey lie for here nobody dey accept say e crash account and e no get money or say e no sabi trade. everytime na personal or family problems |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 6:10pm On Jul 01, 2021 |
Aloysius10:storyy storyyy stoooryyy u never hear of trade explorer? bros trade ya demo jeje. |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 5:42pm On May 13, 2021 |
Tony142: SO you know say 99.99% are useless but instead of people wey don find the 0.01% wey good to teach others una dey run around with English. Make every new person suffer to go through the 5000 wey useless first abi? No wahala. Stop repeating that thing wey una dey use dodge person. psychology, risk management and strategy dey work together. none is more important than the other. back to my observation mode abeg |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 5:26pm On May 13, 2021 |
Eryyy92:Thank you jare at least you understand me. I no get money to buy any strategy so I still dey read and research with the free ones. E no easy at all but God dey 2 Likes |
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 21 by kendoschurrle(m): 4:53pm On May 13, 2021 |
Depressed111: Oga abeg make una no dey deceive newcomers. How you go dey tell person wey never get solid strategy about psychology? No be better strategy you go find first? Haba. If your psychology and money management na 100% you go still fail after some time if the strategy na nonsense. Forget story. |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 54 |