Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,424 members, 7,830,123 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 04:35 PM

Kendoschurrle's Posts

Nairaland Forum / Kendoschurrle's Profile / Kendoschurrle's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 6:07pm On Oct 19, 2023
.
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:53am On Sep 29, 2023
infofirst na better man sha because nothing wan make me do wetin e don do for this place wey people wey get integrity no reach five

person come here insult all of una begin dey try gaslight una by whitewashing liar and scammer wey everybody know for yearrrsss

e rush post screenshot of money many of una begin "congrats boss" everywhere. Una no get common sense? *spits*

if people wey been dey this thread wey dey manage millions of dollars come back ask una to naked enter market for giveaway una go do am sef take video grin

funny thing be say people wey get proper money no dey feel pressure to show anybody. e get reason why many of them no dey here again sef. na riff raff wey don trade more than ten years but e no get even $50k personal account go dey tension una.

i no surprise sha. as I talk the other time, na Nigeria we dey.

make una dey mumu dey go na una lose. grin

make una continue dey serve weekend entertainment grin

4 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:40am On Sep 29, 2023
i been talk say I go dey look this room like zoo as nothing concern me here again but Feshizzy posts wey I see today don make me login.

Bro you no do well for this angle wey you dey take

nothing like impostor na the same old cargo wey small pikin dey Worry. GABSONFX2 na Pibsbasketting and other name wey e don us. even that time wey e dey form mature, these signs been dey there. no dey give am chance to deny this behaviour for future. even hin fellow criminal don confirm say na him. so abeg stop am.

the madness wey e dey show now na pepper of wetin we do am when e start dey defend meshpips the criminal grin

as I talk that time, na heavy attention seeker wey jealous dieeeee. if e no dey get attention, e dey be am like death. na why e dey struggle since to show una say e get small money. and broke nyashlicking fools plenty for here so e go everly get support.

e no even try surprise people small, e jus dey struggle to find way to get the mumus to dey call am boss boss upandan and to "punish" those wey no dey hin side.

the rep wey infofirst get for here dey pain am and hin gang die. if infofirst leave this place, you go see say e go disappear again.

so abeg no dey talk say na impostor. na lie. na the same animal.

11 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:18am On Sep 01, 2023
there is no court anything.. dem don rug pull

their owners believe say the prop market don peak

i dey sense am from their language since

company wey dey make the kain money wey dem dey make go don do legal research tey tey cover their nyash if dem get long term focus

these ones dey collect money till last minute conveniently announce the thing for end of August. na why dem freeze price raise that time lol. Otilor.

e go benefit others like FTMO and TFT sha

i believe say prop industry no need more than five big names if e go last

maybe na this thing go push am finally

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:35am On Aug 31, 2023
kozmicity:


Nobody asked for it. We just finished this type of issue yesterday and you want to start it again. Behave yourself.

Who are you??

na lie o
leave am make e market hin "intellectual" property make money from hin "brain work" according to una oga wey mumu grin

3 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:52am On Aug 30, 2023
Kaybee7000:




Boss pls let it slide na beg I dey beg pls and @realoney guy abeg let us move on pls

i don move on

the amount wey i lose to am i don recover am x 1000 since then e also teach me make i no dey listen to any forex guru so i take am as tutorial money

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:51am On Aug 30, 2023
lol

una dey make me laugh for this place but na so e be for nigeria too

person go join boko haram k'l and r''ape people finish. when dem catch am, e go beg, government go forgive am give am uniform

person rig election, hin followers k'll and wound people, as e seize power finish, people talk say make we move on pray for am to succeed

this criminal and hin oga don con una again.. see that apology as e take choose hin words carefully lol grin grin
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:13am On Aug 30, 2023
realone12:
kendoschurrle you don speak the truth everyone has been avoiding..

🤣🤣 our former oga is not really interested in saving meshpips ... he is just mad about our boss infofirst influence on the current FTA members.

tell me how we no go follow infofirst.
it's practically impossible not to love infofirst..

I notice our former oga always take the opposite of all infofirst opinion..

even when Elliottwaveforec fought infofirst, as usual, our former oga jump in Elliottwaveforec's defend..

we can now see the pattern clearly 🤣🤣🤣

my man ! you don see am nah

dem think say people no get eyes abi wetin?

the guy na attention seeker.. so when e see people getting attention naturally body dey pepper am die

e fit do anything for attention. when e dey answer pipsbasketting na so e dey deactivate dey come back too because clout na drug for am very shameless person

e no send meshpips. just like meshpips no send the people wey e dey fight inforfirst to mentor the other day all of them na ulterior motive

but God punish dem for this one because them dey try attack the one person wey hin hand clean die for this place grin grin grin

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:08am On Aug 30, 2023
infofirst:


Maybe we are going to 100pages. Let me let you know that one of the aim of those people is to see FTA exist no more or unattractive and only if we gave in since, you will not possibly be here today asking questions. The battle is more than what you think.

@jameselias I stand with you

dont mind these fools wey no know how talk take start
everybody wan form contrarian as dem dey do for twitter
if nobody fight this guy and people like am this thread for don close sinceeee

from 2012 till 2023 different people get issue with one person... more than ten yrs

check every FTA thread, people drag am. every fking year.. but one idiot (and hin bunch of senseless minions) suddenly wake up today think say e wan whitewash am grin grin

dozens of people don fight am try stop am from doing hin nonsense

some of them like naijababe, honerico1 and co even try coddle am but as snake wey e be, e still bite them

many of them dozens of people wey fight this guy don move on tey tey forget nairaland many don become big traders, others don build careers. still this man wey don almost clock 50 dey here dey do nonsense and hin fellow gray hair agbaya dey use am try score points due to jealousy..

omo.. what a waste of old age grin grin grin grin

7 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:01am On Aug 30, 2023
GabsonFX2:


Meanwhile, I'm not vouching for meshpips.

Meshpips will become a better person and that's my goal....time will tell.

you see say this fool wey jealousy wan wound no get any single sense .. grin grin

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:08am On Aug 30, 2023
Feshizzy:


Going by this your new found logic,
Then Saxy4c is a saint,
And you owe him an apology as well.

So until meshpips becomes a large scale criminal like saxy before we can call him out?

point of correction o Saxy4c no collect money from anybody sell strategy e no even collect account trade for anybody. he only use somebody account claim rep. finish. still that old fool Gabsonfx attacked him like a mad dog dragged him everywhere when e found out. if you see as e dey announce the "discovery" in episodes like say na one big scam the guy do.. e don reach the turn of a proper thief e wan change mouth.

anyway i know wetin happen
e no like as infofirst don become the pillar of this place.. as usual, that kain thing dey pepper am for body
na why e no talk anything about meshpips nonsense wey don happen even this year until inforfirst quarrel with meshpips
so this nonsense wey e dey do na to paint infofirst bad or make inforfirst vex leave the thread nothing else

unfortunately for am, e don destroy whatever remain of hin nonsense reputation wey e build on faking and too many arselickers wey think say e get money to give them
make una ignore am abeg when e don crash hin trading account, e go deactivate as usual claim offshore worker or say e don tire for the thread grin grin

we know them wink

7 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:44pm On Aug 29, 2023
anyway me I have done my part

anybody wey search that fool name for google go land for nairaland and e go see wetin go make am avoid am

if una like make una dey deceive unaself with obfuscation

na why every serious trader wey been dey here don ignore all of una

una well done ehn
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:38pm On Aug 29, 2023
seeteazain:


If someone scams you, you either seek justice (refund) and where that fails, you can involve the police. And if you agree to let go, then you do that completely while avoiding the same process that led to you being scammed. So others way no send the money again don move on but you no gree collect refund and you no gree let go. If na so we dey take address issues for this country, you think say people way for remain go reach 1,000.

e clear say you no get sense but make i reply you one last time. you dey talk nonsense for matter wey you no know anything about. you know how long person drag this case? you know all the promise wey e make and break? abeg shut up

dragging the lying scum meshpips aka meschach ukpoma and people like am na to make sure say others no fall inside their trap if you no fit understand that, fk off
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:26pm On Aug 29, 2023
as for the fool above wey dey seek attention na so e dey always side any dubious character wey enter this thread even the one wey enter three days ago, e go defend am

make una dey fool dey go grin grin grin
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:24pm On Aug 29, 2023
seeteazain:
From the little I have gathered since gabsonfx volunteered to refund is that most of those calling mesh a scammer are doing so because he either mocked them for failing accounts or because they follow the bandwagon effect.

When the movement for calling mesh a scammer began in less than an hour, people rushed out but now provide evidence and get refund, stories about mockery, potential scamming and his intention to market his product/service.

In as little time I observed things here, his methodology might not suit the majority of people here, but if you can't proof he has scammed you, then you have no right to call him scammer.

meshpips collect money sell nonsense strategy wey e lie about the backtest. e crash my account. he is a scammer. he did the same for others wey no send the money again and some no even dey this thread again. if you wan use that one decide say na gang up against him, na you sabi. e also show say most of una dishonest slowpoke

the person claiming say e wan refund people na loudmouth.. e no get shishi to pay anybody we know. so make una rest.

if you like carry money give am you go hear am.

2 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:14pm On Aug 29, 2023
JasonNOTStatham:
I get fixed match, I get 100% correct scores... Game finish, correct scores don cut.

It is not my fault, I am not a scammer, na the players and referee cause am.
I can manage your betting account, I have sure update and signal, see screenshot proof. DM! DM! scammers keep off.

AH! omoh account don blow! Sorry guys, no refund on my SURE games... I did not scam you, it was VAR!
VAR cancel two goals. We go again next week, I have another GUARANTEED strategy, see pic proof. shocked

Guys join my premium crypto and Forex sure trading signal group, $100 every hour. "We" manage accounts and gives 200% accurate signals, a no scam zone. Scammers don't DM me, serious minded people only.

Ah! sorry guys, today signal was bad due to news. We go again tomorrow... For those that their accounts got blown, I am sorry. There would be a free signal this week.

Wahala no surplus? grin

exactly my brother
make every thief begin hustle be that .. no more chasing people wey wan sell anything grin grin

it's a pity sha say people dey struggle to keep the thread sane and alive since this old fool dey struggle to trade. e don get account to show off now him and and his gang of criminalism supporters wan come destroy the place for nothing

goodluck to una o grin

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:08pm On Aug 29, 2023
kendoschurrle:
i see say una no learn anything from wetin me and this thief do here this year or maybe una just wan keep thread busy grin

e don chop plenty of us for here before but shame no go allow some talk because true true e no use gun rob anybody cheesy

but e go use lie and misrepresentation make you pay am for strategy wey be nonsense or make you give am account wey e go crash guaranteed evidence choke everywhere if you wan search

see wetin i talk about this guy before.. people wey det argue about language and meaning of scammer know wetin dem dey do

person wey dey always lie about hin strategy and hin trading skills, use the same lies to collect money to sell that same nonsense strategy or blow people account na scammer. if e no tell these lies person go give am money for anything? if una like make una use oxford dictionary tire. iidotts

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 4:57pm On Aug 29, 2023
GabsonFX2:
So he is no more a scammer, now a potential scammer or scammer to be.......

Meshpips depends only on FX to survive, if he strived to obtain knowledge and information, and decides to sell it on any platform including FTA, or decides to publish a book on it in order to sell and realize some profits....does that make him a scammer or a potential scammer?



this old fool follow pursue people wey come here try sell strategy or signal but today now nothing wrong with am because hin friend dey involved grin grin grin

ah nigeria cheesy cheesy

6 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:47pm On Aug 29, 2023
charly20:



Mehn, some kind matters tire me to read. Comot other season fuckups from the kain meshpips, I don outline wetin en don do this year alone and baba Gabson still wan vouch for the man.

How you wan condemn the activities wey you accept say na fuckup from the kain meshpips come still dey call am good man?

So from wetin Gabsonfx2 dey talk, meshpips na better person and we are just crucifying him for no reason

With the kain history meshpips get, wetin make am better person?

Part of being a forex trader is being able to speak facts without kissing ass.

No be every "underdog" dem dey side with. The underdog fit just still bite you for nyash.

e no believe that nonsense wey e dey talk. no mind am. if not why e no buy 300K account for am since? why e no help meshpips pay chicken change wey those people use drag am for here? why e no help am when e go village as per billionaire wey e dey claim?

na attention seeker. people wey dey do contrarian for contrarian sake.

even when e drag saxy4c here "expose" am, na because the guy don dey get too many fans, so tey nobody send am and e pepper am for body grin grin e begin find way to bring that one down unfortunately that one hand no pure too. but e no do quarter of wetin the meshpips wey e dey call good man don do!! na make you dey see the kain person wey e be.

omo make we leave matter for mathias abeg

e even pain me say I give am attention wey e dey find

never again !

10 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:33pm On Aug 29, 2023
if you be newcomer for here

the only "boss" wey you suppose dey listen to na infofirst finish! e get years of positive reputation. e never cheat anybody. e dey even do like messiah sometimes grin grin e no go ask you for money if e really wan teach you anything and e get evidence say e be really good trader!

every other person wey dey claim jagaban for here, you fit sabi trade pass them o and many of them no get reputation na low quality men

ehen,, i don do my vawulence finish

see una next time cool cool

13 Likes 2 Shares

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:29pm On Aug 29, 2023
charly20:
Never a dull moment for this place, abeg grin grin grin

Meshpips no be better person. Nothing anybody fit tell me.

my brother everybody know the truth including the gaslighting man

these are people wey we been dey look up to sometime ago (i been follow dey call that Gabson man sir that time lipsrsealed lipsrsealed) but e no too tey for me to see say all of them na wassshhhh grin grin

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:57pm On Aug 29, 2023
GabsonFX2:
Answer my question or remain silent and unfortunate for life.

Has Meshpips scammed you before?

If yes, prove it, and you get refunded in 30mins
.

Else, sh*t d fck up for life.

keep ya miserly pennies bastard. I no need am any more grin grin grin he ate the money but where is he now? grin
you feel say i be the children wey dey lick your foot to seek one thing or the other..you think say I need giveaway or ya fake paper money thunder faya you my man grin

me miserable? grin grin you no look well grin grin

come collect my account stop me from typing make I see animal.. na idiotts like you dey make this playground sweet

if you like pretend like say you no know wetin the guy do

you wey be the same person wey "uncover" saxy4c that year e don reach your lying scum friend time you dey fake ignorance meanwhile saxy no collect account with lies or even collect money from anybody to teach anything o idiottt

make una continue grin grin

na disingenuous animals like this man and the beggars wey dey worship them dey spoil this country.. una go see truth una no go talk am for silly selfish interest

omo make una continue dey suck unaself off for there o not my business anymore self

7 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:25pm On Aug 29, 2023
GabsonFX2:
Meshpips was just over confident, and as a man with family who would be more money focused - he pushed himself beyond measures while trading. This led to his predicament last year which I would not have to divulge further. And since I recently came back here and saw all those saga, I called his line to understand the situation and had some empathy. Life throws shade, it's OK.

I blame him for trading for people or asking people money to trade, cos it mostly does not end well.

Meshpips, ask those who have called you names here and have shamed you with allegations that you are a scammer or that you have scammed them, to come forward. Let me refund them.

Again, Meshpips has scammed you, prove it and I will refund you now. OR keep quiet forever.

you are a big idiott but I no surprise. na community of fakers flock together.
which money you wan use pay them? stop your empty boasting oga we know ya story grin grin
keep supporting evil attention seeking old man with a child like you

as if you no know say meshpips no put gun for anybody head collect money
if you dey serious, talk about those wey e collect money from teach nonsense or those wey e collect money to give small information wey e collect free or those wey e crash their account in the name of trading for them!

oponu radarada!

anyway we don talk the matter tire those wey get sense to see wetin dey happen go ignore una undecided undecided
still MESHPIPS MESCHACH UKPOMA PIPCENTURION na fake-ass lying, manipulative nincompoop. Those of us wey e don deceive chop don do enough to make sure say others no become suya for am.

anybody wey allow make dem deceive am na hin sabi. we go too laugh grin grin

5 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 10:28am On Aug 29, 2023
infofirst:


We must counter him. So unsuspecting fellow will not fall victim.
He has done enough damage already. Is it not interesting that some still fall for his traps.

Gabsonfx aka pipsbaketting na attention seeker tey tey

e go everly wan take opposite side with hin fake maturity make e for dey different

if nobody dey mention hin name body dey bite am

na why e dey always deactivate account up and down think say people go beg am

when the attention don hungry am tire, e go create new account come here talk one or two nonsense

anybody wey call meshpip hin guy for public with evidence wey reach more than ten years na either idioot wey no get sense to avoid criminal,
person wey attention dey hungry or a fellow criminal mind

make nobody answer am for hin fake sympathy for meshpips drag all of themmmmm presss their neckssssssss grin grin grin grin

16 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:32am On Aug 11, 2023
forex hard no be your village people dey do you grin

if you wan give up, give up

i no dey motivate anybody cheesy

7 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:16am On Aug 11, 2023
i see say una no learn anything from wetin me and this thief do here this year or maybe una just wan keep thread busy grin

MESHPIPS na frustrated theif and scammer na so e be since 12 years ago till today

i see info and others wey dey try even listen to hin nonsense and na laugh i jus dey laugh

if you think say e really care about the people wey lose account den you be small pikin grin grin

e dey find way justify say e wan collect money pass phase 1 and 2

anybody wey give Meshpips aka Pipcenturion aka Meschach Ukpoma money for anything na big mugu grin

e don chop plenty of us for here before but shame no go allow some talk because true true e no use gun rob anybody cheesy

but e go use lie and misrepresentation make you pay am for strategy wey be nonsense or make you give am account wey e go crash guaranteed evidence choke everywhere if you wan search

ask yourself wetin e wan teach you wey e no fit make withdrawal for ordinary 5k account, e no fit grow hin own personal account too

person wey plenty people don paint black brush..you think say all those people dey lie?

body go tell you no worry grin

my own be say make una no dey follow am argue when e don try that hin poor gaslighting attempt

una suppose don dey see through hin nonsense by now

the best thing for people like the mugu na to talk wetin you wan talk ignore hin response because e go wan divert attention from the main thing

when e don crash account e go run come back here begin dey find mugu na so e be since 2012 grin grin cheesy

11 Likes 2 Shares

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 6:59am On Aug 11, 2023
altteemy:
Holla @kendoschurrle, thanks for the E***e connect. 👍

no wahala bro
thank God say you deliver
otherwise na me for pay grin grin
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 10:35am On Jul 17, 2023
see that thing wey I talk

Many people no dey take giveaway accounts seriously

imagine only 500 bucks payout after dem don giveaway like ten milla

nawa

na also warning for people wey think say this thing easy grin grin

you go dey see the money dey dream but collect am nah whoosai grin grin grin

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 6:18pm On Jul 13, 2023
BrightFuture48:

Lol is moving there gradually. All these giveaways is prelude to that.

I was thinking one time that with all these giveaways, what would be become of these coys but sincere not many people are passing those challenge giveaways especially due to time constraints. Even veteran hedge fund managers dare not achieve that target in a month.

i doubt if challenge go become free o unless dem go reduce payout from 80-90% to like 40% or less.. even that one sef. hmmm

people no dey value giveaway accounts dem go use am gamble dey try to hammer because dem no pay for am
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:18pm On Jul 13, 2023
PraiseGod4u:


He wasn't the first though.
He just used giveaways to publicise it.
Mentfx and bespoke did it before mattl

Oh ok but e be like say others no trust themselves because na MFFX loud pass
if not for them i for no hear about no time limit and na so for many people
even that ment funding na the first time wey I dey hear am be this and as I just check their page i sharply close am grin no wonder dem no popular
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:01pm On Jul 13, 2023
infofirst:


He dey play ni.
Those American guys took a big risk too. It works @MattLCEO

na why i dey believe the guy die. e nor easy to change entire industry kudos to him

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 93
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.