Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,794 members, 7,851,676 topics. Date: Thursday, 06 June 2024 at 05:10 AM

Kendoschurrle's Posts

Nairaland Forum / Kendoschurrle's Profile / Kendoschurrle's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:28am On May 07, 2023
Immortal99:


Nobody forced them to pay when they were not sure of consistently being profitable.

no be the reason for the post be that. of course dem no force anybody but e get one guy wey I argue this thing with before say prop firms no send trader growth just dey pack money from dreamers

imagine.. dem dey make $11k for every single $1 dem pay out and this one never reach two years old o just imagine how much FTMO go don make

e good make people use that statistic see wetin dem wan enter inside as dem dey dream

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:43pm On May 06, 2023
Hmm

see why dem dey rush open prop firm everywhere grin

Ọmọ

fit be 0.5% for those wey collect pass first payout

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 2:50pm On May 05, 2023
pipfisher:


2% draw down limit is ridiculous. Trading should not be treated as slave trade.

2% na daily DD o. e no too bad. Person don post statistic here before wey show say people wey dem make steady money for prop firm no dey allow daily DD pass 2% sha
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:37am On Apr 30, 2023
Galleryeasy:


The ground is fair enough for everyone, the problem here is risk management, FTMO has swing account with leverage less than 35 if I'm correct. MFF and TFT allow you to keep your open positions through out the weekend.

I have 100k account I called swing account with MFF, I risk about 0.6% on the account, which can accommodate daily DD. I started trading the account Feb this year , taking at most 3-5 positions per month, currently the account is on 126k, not planning of withdrawing anytime soon till 3rd quarter of the year. You see , all you just need is adjustments.

Other accounts pay the bills .

this is nice o but no be serious risk?

these people fit pack up anytime o remember no regulation
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:54am On Apr 17, 2023
dottozil:
Pls am still having issues with my mt4 deleting the lines I drew on my charts, any help

na RAM dey cause this problem

check whether e go continue after you don free up enough space and thoroughly wipe the old MT4
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:22pm On Apr 04, 2023
smilinguy:
We are all tired of waiting.


imagine say una pay that opolo eye the 10k wey e want to show una this same Nostro grin grin

4 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:18pm On Apr 04, 2023
kendoschurrle:
predictive trading na lie

prediction wey 95% dey wrong lol

simple 260pips for gpbpjy wey don move only 220pips today smiley

i no dey try predict one direction

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:13pm On Apr 04, 2023
Donsheddy:


Trade closed manually...

R. R 1: 3.8 secured

We go again tomorrow

congrats

once that person quote am disagree i know say na sure trade grin grin grin grin grin

4 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:12pm On Apr 04, 2023
person wey never move SL to positive area before for hin life been wan become account manager grin grin

nothing wey we no go see for here

9 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 6:14am On Mar 30, 2023
EASYLIFE4US:


Your broker has some explaining to give😅

nothing to explain. na normal thing for spread to be very wide for that first one hour after market don open

jpy fit reach 35 pips spread sef.

open like four brokers down around that time and check you go see
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 7:23am On Mar 27, 2023
predictive trading na lie

prediction wey 95% dey wrong lol
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 3:25pm On Mar 24, 2023
Proudpolygamist:


. Come to think of it, I don't think propfirms need your evaluation fees for whatever reason when they claim to have billions of dollars that they intend to allow u trade with.
Who knew there would be something called a propfirm company one day before? So why would free evaluation challenge be something out of the world?

my brother e clear say you no understand how these people dey take make money

dem no dey give you any real account to trade all those numbers na glorified demo

dem know say 99% of people wey buy account go fail and plenty of those 99% go buy account many times

the big ones get more than 20000 people wey don buy at least one evaluation. if each one don spend like $100 average no be two milla be that already? lol

and if dem find good trader, dem go dey copy hin strategy for real account or thief the strategy completely na glorified ponzi these people dey run forget the grammar

i agree say e no matter if nostro na fake

na dreamers wey don calculate $500k wey dem go use buy new village I dey laugh grin grin grin
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 3:15pm On Mar 24, 2023
frostguy:
Today market is not bad

for day trader wey dey use tp

if not na frustration

so so stop and reverse for two weeks long long wick for daily chart everywhere shocked shocked

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 2:56pm On Mar 24, 2023
Proudpolygamist:


If that's the case, then how do they intend to keep the scam running? If it's a scam site, and they don't intend to fund traders then it's a foolish scam because it's not like I'll be giving them my trading strategy for them to profit from it LONG TERM.
If they won't fund traders, then traders won't be Hoodwinked with the said site and traders will leave, won't the nostro scammers also lose their prop firm accounts, considering that they can't copy and paste again?

my brother leave story ehn until they prove the allegations wrong i no advise anybody to trust them and put hope. nothing to lose but still

you no understand the gist if dem find ten good traders dem go copy their trades for different accounts until the trader don fail or give up

even if dem shuffle traders like that for just two months na serious free money

dem fit also reverse engineer interesting traders position abi how you think say dem dey steal strategies from copy sites?

at least the serious ones go dey pay you money as dem dey copy you or steal your strategy

anyway na still dem say dem say so OYO for everybody o
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:58pm On Mar 24, 2023
i hear say una Nostro na secret copy trading scam wey chinks knock up grin

dem dey use am run many prop firm accounts for other places. copying the trade of traders wey dem feel say get sense so as you dey pass for Nostro dem dey pass for FTMO and co

anyway na still good training

imagine wetin una resident greedy fake religious man wan collect 10k for grin grin grin

1 Like 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:11pm On Mar 18, 2023
na only lazy idoitots go pay am any kobo

if you sabi trade and you get 10k to waste on top that shameless old scammer with kids, you suppose get money to buy $5k account from myforexfunds or myfundedfx. if you trade well, dem go refund your entire fee and you go fit use your profit buy higher account

if you no fit do am and you go pay 10k to dubious old agbero, you don dash am money for nothing because you go still crash that account

e better make you use that money smoke igbo or eat suya

as expert scammer wey e be, e no go tell the mugus wey edey shop for how long one scaling period go be. e fit take three or four months for each scaling before you go reach that $500k, your children go don graduate from university or the company go don fold grin grin grin

e better make you buy small account use profits buy higher account you fit reach that $500k wey e dey dangle for una face within one year

11 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:06pm On Mar 18, 2023
charly20:


I think $30k - $34k are fair prices to be reached for before retracement. I also do not think $19k will be seen (at least not in March or April).

Since I'm bullish, i will not take even the clearest bearish signals.

Fundamentals and technicals are literally in alignment.

na you wey dey respond to frustrated mad man I blame

any single time wey e come back here begin form analyst and what not, e don dey find who to scam every single time

people wey don dey here since know how e dey go no season wey e no dey get this kain issue or somebody dragging him for crashing their account

make una ignore am everytime e begin dey form analyst or trying to force conversation no dey give legitimacy to a fraudulent liar

1 Like

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 10:19am On Mar 15, 2023
altteemy:
https://youtube.com/shorts/tvgY3tMh2cY?feature=share

Metatrader 4 and 5 are back on the Apple Store

boss check your dm abeg

been looking for you to create EA
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 11:47am On Mar 13, 2023
*edited*

I don help myself as usual
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:15am On Mar 11, 2023
forex traders 🤝naija pastors

dem go predict 100 things but only 5 go happen

will it stop them from predicting another 100? for where grin

if you like no follow the market dey predict wetin e go do as if you get secret map for ya parlor grin grin

5 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:57am On Mar 09, 2023
WAVESANDGOLD:



Organize a competition,

Set the risk parameters

the best trader gets to manage the account.



Samfelly lipsrsealed

dem go don freeze the account before the competition go end

e no suppose buy account if e no sabi trade

anybody wey e like make e choose, the account go crash no be curse

any trader wey dey good enough suppose fit afford 50 bucks buy their own account if e no fit, na still learner

so anybody wey go rush collect that account na hustling learner wey go still fumble

this current pipmarshall aka Bojbest wey take person username don write blog, sell course whoosai.. grin grin at least no be scammer sha but

e still dey struggle like all of us so e go use your account continue learning grin grin

13 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:25pm On Mar 07, 2023
jammer777:


grin grin grin grin grin grin
Baba werey, using set of fingers to explain support and resistance (Chai, forex wahala) after asking for your hawked yeye privileged info. I had to block you off and accept my loss.
No be curse alaye, na radarada go dey follow you till His 2nd coming.
No drop of shame in you, forex 419.
Meanwhile, send your aza make I bless you this morning.

grin grin grin grin grin

if people wey that man don deceive begin talk for here, day go dark and break

worst thing be say no single sign of change since over ten yrs

na still the same struggling with rubbish system and looking for who e wan sell am to

nobody go say e don benefit anything useful from him since wey e dey here

other people don come here change people life

other people like natruetalk, inforfirst and others wey dey help people get two heads

even the prop firm wey dey reign today na people like shevchen start the talk open our eyes for free many years ago

anybody wey still wan give meshach ukpoma money for anything in this 2023 e na him wan be mugu
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:19am On Mar 07, 2023
PIPSMARSHALL:



Pipcenturion have you lost yourself here? You wouldn't dare on forexfactory.


dem no born am well

if you see as e take humble for there dey call all the oyibo small boys wey e senior sir

na here e get mouth to brag and find who e go scam

3 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 5:43pm On Mar 06, 2023
Me77:
Hi everyone I bought mff account and got 12% discount using the march promo code TAKEOVER
Type TAKEOVER when you fill out your details and proceed to pay. The 12% discount is applicable on all challenge accounts.
You don't need to pay N5000 to anyone just to get a prop firm name.

you are blessed

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 2:48pm On Mar 06, 2023
OfficialP:
I guess na because it didn't happen here publicly

even with that one na still nonsense

every day people dey ask question for her dey receive answer free of charge

charging for that kain information na insult to everybody wey don help people here for free

make everybody begin charge for any answer wey dem get make we see who go remain for here

3 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 1:45pm On Mar 06, 2023
OfficialP:


those who DMed you last time, you asked them to pay #5000 before you can release the name to them. Is it the same prop firm?


BTW you can still drop the name, those interested in signing up will definitely DM you to get the discount code. or how you see am

the attitude for here no good at all

so pesin wan take advantage of other people and all the people wey receive that same message kip kwayet instead of talking here in public

no wahala make every thief begin dey find customer for here be that, if na so dem do for here since you know how many people wey for don lose serious money ni? okay o

finally anybody wey pay that 5k na compound bastaad

5 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:42pm On Mar 06, 2023
OfficialP:


those who DMed you last time, you asked them to pay #5000 before you can release the name to them. Is it the same prop firm?


BTW you can still drop the name, those interested in signing up will definitely DM you to get the discount code. or how you see am

just imagine nonsnese e no shock me at all na hin way

e don trade forex since naija gain independence but e still dey chase 5k from hustling people

empty soul wey pride, arrogance and fake religiosity go still kapia

5 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 10:53am On Mar 06, 2023
kozmicity:


What's the name of the firm?

you wan make e tell you so e no go fit make money with hin affiliate link ? grin grin grin

3 Likes 1 Share

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 12:14pm On Mar 04, 2023
smiley

6 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:17am On Mar 02, 2023
HumbleTrader:
For now, I'll try raising capital for my personal trading.

talk true.. you no fit trade the competition abi you don crash the account grin grin grin grin grin grin

5 Likes

Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 8:16am On Mar 02, 2023
Wonder why una wan kpai put for this UJ sell.. since last week whoosai undecided
Business / Re: Forex Trade Alerts: Season 23 by kendoschurrle(m): 9:16am On Feb 28, 2023
kendoschurrle:
abeg anybody fit do video tutorial for using FX blue trade copier?

to dey switch three platforms to close and open trades don tire me sad sad

i wonder how people dey fit trade many prop accounts

As nobody reply me i don do my own research but i no stingy die like some of una so i go share

socialtradertools and 4xsolutions dey sell automatic copier but na 60 dol every month... grin grin grin

so the alternative wey i find na to use this automatic stop loss and tp EA http://www.forexfactory.com/showthread.php?p=8253249#post8253249

setting sl and tp na hin dey take my time pass so with this EA don reduce the stress of managing my three accounts a lot maybe na because I dey leave all my trade to reach either tp or sl

when e reach when i go close for the day i close all trade wey still dey open in one touch with this script https://www.forexfactory.com/thread/post/7729467#post7729467

if you wan dey trade more than three accounts or if you no get lappy sorrry o

3 Likes 1 Share

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (of 8 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.