Openbusiness4's Posts
Nairaland Forum › Openbusiness4's Profile › Openbusiness4's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 33 pages)
Lightangel65:Carry go, nutin do una, u have my blessings! God didn't make mistake when he created man before d woman. Am happy d next generation of boys will take back d world from d asslicking simps of men that have brought manhood so low in this world to the point that some females now see us as EQUALS. That's how low masculinity has fallen in this damn world. Am happy d next generation of men are not weakling simps but woke guys that will change d system back to the normal order of nature. Daz why am raising my sons d right way, dey can never b simps. Am raising dem to be the zero alphas of aplha males. Let d simps continue doing ladies first and licking their shoes, but suffer their fellow men. D time of simps in govt power in dis world will soon be over, alpha males will rule the world once again and d world will be back to normal d way it should be. |
This upcoming generation of boys go brutal ohhh. See dem for dis thread, am juz laffing here. I pity all the young girls in their time. D seed of bad parenting by all dis indomie and feminism mothers will be ripe soon. Na women go suffer am. Thank God I don't have a daughter ![]() |
oblozzolawrence:she can always deny d profile and say a scammer used her pix. May una no dey do half detective work. Dem no dey catch thief hold for hand, cuz thief wey u catch an hold for wrist fit escape. U catch a thief by d balls an hold it tight , no escape again. So d point is, if u really wanna finish d job, juz chat d girl up on IM, tell her say, "I'm a mature mind and will like to be intimate with u". Na d magic language be dat. If na hoelosho runs girls, she go open gate for u straight to enta, cuz dat statement na dia password. From der u handle d rest and hold her by d balls, she no fit escape again , otherwise dah ur screenshot na wash, she go deny heaven and earth say na scammer dey use him pix. Hoelosho babe na him u dey take play laidis? Dos girls dat r deep into it, dem dey sharp pass razor blade. Daz y their mumu boyfriends or fiancee or husbands don't know about it, right under their own roof, d girl go dey control runs outside dey accept contract while lying down on his chest and d mumu wee be saying baby i love u and be promising heaven an earth, while d girl is fixing d next appointment it is extremely dangerous to be a mumu man in this generation ![]() |
friday2011:LMAO, even if they read it one million times, they won't do anything about it, in short dem fit block d guy comment on their page for it. They don't like this kind of intelligence. Those aboki carts pushers have incredible passion and are extremely passionate about collecting refuse. They are super efficient at their work. And they know if they allow them to continue, dey will send Lawma business back to village, like Lawma send Cleaner Nigeria back to village Those guys are prompt. U can bet on it that between so so time, they will show, so u can plan and arrange ur thrash on ground for dem to pick up. U can even make a permanent arrangement and tell him to come at pick ur dirt and pay, u can negotiate their fees based on d amount of thrash ur disposing. Unlike govt Lawma dat is fixed and non negotiable. At d end of d day, dos guys are cheaper and even if higher, d diff is not much, but dey are super effective, always available. And they help out sometimes, deh will pack d thrash by demselves, just show dem d thrash, dey will go there an pack it themselves and u pay. But dos useless Lawma trucks will be doing drive by on d street as if they are doin drive by political rally. Na pipu go dey chase dem to throw garbage inside, in d process, s9me garbage will pour on d road and litter d street. Dirty will scatter everywhere. Cuz d trucks are big and dey don't always c parking space to park wen dey come around, and dey can't always park in d middle of d road cuz dey block traffic and pipu driving cars wee para for dem for blocking d flow of traffic. So many times, na drive by pick up dem dey do. So their system is fundamentally flawed. But Aboki pipu are 1000 times more efficient to pack out the thrash. so most pipu prefer dat. Lawma dey vex cum dey use govt power arrest aboki cuz aboki dry chop d moni dey wan chop. Dem no wan go village ![]() |
obonujoker:Kikikiki, yes oooohhhhh, na cuz of d revenue drop dem dey arrest dem. Those Lawma trucks are so useless ehn. Dey will b coming once a week or once in several weeks, and dey wee cum at stupid hours as if pipu don't go to work, as if pipu dee dey inside house 24/7. Dat tin still cuz fight for my side wen d landlord say him wan collect Lawma bill, say dey don cum meet am say every house for street muz pay Lawma bill monthly, say we tenants go share d moni. Na so we para for am say on top wetin, say na aboki everybody dey pay dispose thrash, nobody gat time to b watching street like a spy dey try ur luck weda one useless truck go show. D landlord cum talk say na d law wey dem give am, say we use truck we no use we must pay for d service. Na d mata we still dey settle . God bless aboki truck joh, na dem be d original clean up Lawma trucks are just too inefficient |
free2ryhme:oga, d bolded na lie joh. D reason dey are arresting dem is cuz dey r the main competition to d waste collection business. Govt wanna force everybody to b using Lawma truck to dispose waste. Dey bring bill that pipu shul pay monthly an nobody shul use aboki cart pusher again. But d problem is aboki pipu dey cum every morning to pick up thrash, so dey are more reliable. Lawma trucks come like once a week, some areas sef even longer dan dat. Before Lawma truck or their agents trucks go cum, dirty don full everywer for street. Pipu will turn d front of ur shop, car or house etc to dustbin. anywer dey c chance dey pour it, especially at night. Cuz Lawma no dey cum around steady. But aboki pipu always cum daily. 7am dey don dey work, pay as u go service. So most neighborhood (except wealthy areas), prefer aboki cart than waiting for one useless truck that will come around wen pipu have gone to work and ur thrash wee b piling up like a mountain. As long as aboki still working, nobody wanna patronize Lawma trucks, their patronage will be low and they can't make d money dey want to make. Daz why dey are using political power to kill their main competition. Many aboki are enlightened now, dey don't drop waste by d canal like before, dey drop it by Lawma thrash collection depot in d area or drop it in abandoned bushy places. Most waste u see inside d canal no be aboki truck pusher, na pipu wey dey d surrounding area dey drop der waste there, an this is common in areas where aboki cart pushers are scarce or don't operate, areas under Lawma trucks. Cuz as d trash don pile up and d trucks no dey cum steady, pipu juz go an dump it in neutral location like canal, cuz when dey drop it in front of pipu shops or house or cars or street, dem dey swear for dem, an for some areas if dem catch u doin it, walai u go do sanitization dah day ehn, u go enta gutter, sweep road u go tire ![]() |
OP na seasonal film u wan release? This wan wey u write the movie title na "Lord of the Simps" . Real men know the 2 easy things to do to put her brain back on factory reset anytime it malfunctions. |
