OyinboPrincess's Posts
Nairaland Forum › OyinboPrincess's Profile › OyinboPrincess's Posts
@babyosisi - omo u don dey try for me this night ooo - see as u reply steady and na bere encouragement u wan fill my hand wiv oo - ose ooo ehen na - I know say God dey my back for everything na. Sure say anything fit happen na and I hope say one day sha, I fit give something to the 9ja entertainment business, wey I fit entertain people wey I treasure most - Nigerians. I knw say na so they don find Johnson na.... e b lyk say na the right place, right time b that ooo - but I nor dey chase dreams, I don catch am! So the time wey e come my side, double handed I go hold am so. Na so I understand wetin u talk na, ose ooo - na positivity u preach - wasere!! I hope say u too go carry go wey u wan go.. IJN. Ur spirit don high me this night @Emmysteve - looooooooool at yeye babes..... I knw say na mind I com apply learn am na, so even if na yeye babe, she still fit learn sha 'chop knuckle' back ooo |
@crownprince102 - chaiiii baba, see walka na... omo d man don cris b that ooo, e won put u for one v looooong thing jare - ehen, thank God for telephone creations ooo, wey e come give person mind create na. Ehen, follow the road wey I come give u for Peckham na, u go see the shop sha.... e small tho, but u go see many stick meat and Iyan don dey for mould already, packaged in transparent wraps for window self, u nor go miss am na. U knw say na, u nor b JJC, so abeg, no loose urself again for road oooo ![]() |
@babyosisi - my sista, na Nollywood nor go gree carry person from UK come act for 9ja na... I knw say e nor go happen ooo.. lol - but I HAIL U OOO for ur acknowledgement and support *chop knuckle* One love from London Sista 2 Lagos Sista (even tho I knw say u dey US) ![]() @quickly - ose for this ur comment ooo - my eye don clear well well na, no-one fit try mumu me na.... I don dey ontop jare wasere!! |
@sharpboysus - na my name b OyinboPrincess ooo nor b Oyinbooribcess - ur eye don nack abi LOOOL u don shayo abi wetin b lolak self?? |
@Idowuogbo - wetin b Hian self ![]() |
@Mordyb - abeg give me Mom's feedback o - make I come correct myself wey I don messup small I don laugh scata with ur comment re: ur female friends, wasere ooooo - u funi die ![]() |
@crownprince102 - chop knuckles ooo I don chop burger from time to time (sebi u nor dey see my cheeks abi!?!?!) lol but nor b everytime b that, occasionally. Ehen, for Peckham, I nor sabi the name jare but e dey for Peckham Rye, as una walk down pass Argos for ur right, keep heading down, under the train track wey get bridge above d road, e dey there for the right... na small shop oo but they sell am for there... the stick meat wey they sell sweet die self!!! Lewisham kee - omo many places dey there too, but wey they dey I nor fit explain ooo.... pele. U fit get Iyan na, even for all those small shops self - na Pounded Yam b that ooo.... only water u go take mix for house, e don ready b that ![]() |
@Herzumpther - ose ooo - I hail u ![]() |
@uzolexis - omo sista, no shock ooo - na me b this na ![]() You fit read d story wey The Net (9ja Online Magazine) come share on 7th Feb 2015 ![]() http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/ I knw say e go explain am small for those wey shock / disbelieve small ![]()
|
@Exjoker - nor b by force u go believe na.... but I nor fit lie ontop my own post. Next time I go shoot full video self!!! Make una subscribe to my YouTube channel, u go see am as I don upload na! ![]() @soldierdoller - no wahala, anywhere u wan post am, feel free na! ![]() @Amefrica - ose ose ose baba @crownprince102 - I knw say na confirmation mata remain oo - but the wey I don see b say, if e nor wan believe, no skin from my nose oo U fit buy Eba for Peckham, Camberwell, Brixton, Walworth, Sydenham, Lewisham... omo the list tire ooo, nor b new mata! I know say Oyinbo food make una mess well, even me, I nor fit chop am again ooo - I too dey like chop 9ja things na!!! As far as Guiness book... ROTFL baba Oyinbo's don dey cook these things sinceeeeeee ooo!! |
@Amefrica - wasere baba, omo if I fit (ehen na fit nor for) send am come I for send am na... pele ooo - e go spoil inside DHL ooo!! ![]() |
@mufutau55 - abegieeeee jare, nor b by force u go come gree na.... but nor b just one video wey I come get for YouTube oooo - make una check well... na me b this ooo.... na wa self. Omo baba God dey my back ooo!!! ![]() |
@crownprince102 - chaiiii - hw I go come arrange meetin wiv person wey I neva know, na wa oooo.... ![]() @heatmeup - I knw say if I don stay Abuja / Lagos for time like dis Oyinbo owner, my own Pidgin go flow die ![]() @soldierdollar - ose ooo lol - I don laugh scata wiv dis ur post ooo!! Applications flowin in.... NOT!! Omo see face wey don 'chop wowo lick plate' na LOL. Omo me self nor sabi hw Yankee Egusi go taste sha, u knw say I b Britico na u for carry the post enter any blog wey u get sha, as long as u go ensure my twitter / facebook / youtube links go visible well ooo... u for send me copy self ![]() |
@Edwardhead - wetin u dey talk na baba? |
@Lilboots - ose ooo baba - na small small I don dey learn am ooo fine small - LOOOL dis my face don 'chop wowo lick plate ooo' ![]() |
*R*O*T*F*L* ![]() Chaiiiii I don die b this with all the replys wey full here oooo - nor b small oooo!!! I wan reply all separately but u know say I nor fit na.... a few things wey I don pick up na, firstly #bluebloodforlife b me ooo, na Chelsea b that - pele I nor fit change ooo secondly, the Pidgin, na so e sweet me for my eye, so na so I come apply mind / mouth / ear learn am - I don borrow this ur swag b this oooAs far as the question reverting to Islam, pele no, na Christian I be ooo - I nor fit change am.... na my roots, my upbringing and na the level wey I come sabi b that. However, all under one sky we dey live na, so I nor dey get any kind feelings to any religion or culture, I accept ppl for their beliefs and backgrounds, na respect I get ooo!! Na, for the YAHOO boys out there, u knw say these my eyes clear well well oooo - ABEGGGGIIIEEEEEE nor try me ooo - I go rip u for arsepaper self!! U knw say this Oyinbo sabi wella, make u free me wiv these ur 419 stories ooooo - I nor gree hear am!! OnElOvE for all the comments - Baba GOD dey ooo |
@dokunbam - omo na me b this oooo - OSE I don receive ur congratulations baba - wasere ![]() @Chukky86 - sebi u nor dey use Palm Oil ontop ur own Egusi?? @mizkeleke - my sista - na so ooo - chop knuckles osseeeeee |
Omo - I think say I go thank individually for comments ooo, but na too many jare!! ![]() I salute u for these ur comments and time visiting my post... for those non-believers, na OYINBO I b ooo, u for go check my videos ontop YouTube, just search Oyinbo Princess.... for those wey wan follow me small, u know say my twitter and facebook page dey for my original post - oya na, make una follow sharp!! London 2 Lagos, ONELOVE - ose ose ose PS - nor b only Egusi I fit cook na.... anyone wey u like I go do am if I nor sabi already, I go learn quick sha - uploaded: fried rice ![]()
|
@loomer - na Oyinbo Princess I be ooo, check am for Google self ![]() u for follow me ontop twitter at facebook na |
@sallysalsa - na soooo ooo e b lyk say u for read my 'Egusi' thread for Food ooo |
@3cycle - ose ooo - e sweet die, nor b small ![]() @Mustack - ose baba ![]() |
@mxxpunkxx1 - abegieee send me message ontop my twitter na @OyinboPrincess I dey ok jare, u nko?? I don chop Egusi finish ![]() |
@mxxpunkxx1 - pay kee ?? ROTFL.... omo na free mata for any padi mi |
As I don dey try this Egusi - ehhh - e don sweet me well well ooo... I don kolo to taste am again, so na to learn the formula b the next thing ooo!! I nor fit relax, I wan chop am, the feelin too much self... so, I don carry my Oyinbo self go one local Afro-Caribbean shop, full my basket with all ingredients wey I wan use cook am. YouTube don help me sabi am na, so to cook am mysef b the next mata... If u go follow this Oyinbo wey to cook am eh, e go sweet u wella ![]() - Boil meat for one pot, add maggie cubes, thyme, paprika, small mixed seasoning, one chopped small onion for taste (you for use any meat wey u like sha, but me I dey use lamb & beef or chicken) - As u don dey boil meat, use the time to take one tin plumb tomatoes, one chopped onion & pepper (na the small red pepper oo - two I dey use, u fit put any amount wey sweet u - if na hot u like am add three/four) put all inside ur food processor - blend am well - The blended mixture u go now put for one small pot, no oil oo! Put am for high heat, make e cook well well... u go leave am for fire till the time e don reduce, don thick - As the mixture don dey boil, take ur melon seeds wey u wan use (1 cup) and blend am for food processor. U for use small water to blend ooo, so e go make a smooth paste, put am for one bowl, so u go add am to ur soup later - Check ur meat na, if e don soft (to the way u like am) take am off fire, leave am for the side, with the water... u go use small stock from this water to add to ur soup later. If e neva cook finish, reduce the heat small, keep checking until e don cook finish - Collect another pot, add small palm oil, make sure e don cover the bottom of the pan, roughly 1cm high. Put am for fire - The blended mixture wey dey another pot (tomatos, onion, pepper), check am - if e don reduce finish, turn off the heat/burner - Check ur palm oil na, if e don hot well well, start to dey smoke - ehen, e don ready b that. Add the blended mixture of tomatoes, onion & pepper - careful ooo - e go spit die - By this time I know say ur meat don cook, if u neva remove am from fire already, do so now - Take this time as u don fry ur mixture to wash the pots wey u don use finish ooo - u not wan finish cook with plenty washing to do na - Stir this ur frying mixture small ooo, make sure e nor go burn - As u don leave am to fry, cut Spinach into strips (the fresh one na the best one ooo) u for use scissors - e easy sha - Check ur mixture again ooo - if e don begin to dry small, add tiny stock from ur meat water, na dash u go dash am - Use ur nose to smell the frying mixture na.... if e don smell like e pepper don cook small, e don ready for the melon seeds b that.... Use one small spoon drop the grounded melon seeds into the pot, ontop the tomatoes, onion and pepper... keep dropping spoonfuls around ontop, spread am well covering everywhere - Let am fry small ontop the mixture for a few mins on high heat... after a few mins don pass, turn am well. These melon seeds dey stick, burn, well well, so now u wan turn am from the bottom regularly - As ur soup don thick small, add more stock water from ur meat - people like their Egusi with different thickness's, so find the one wey u like - Add two maggie cubes again to this ur soup - After roughly ten mins, e don cook b that add the meat to the Egusi and keep turning for another ten mins, this one go allow the flavours to enter ur meat small- Wen the ten mins don go, add the cut Spinach leaves and stir... after five more mins e don finish finally ![]() To serve, u for use Gari or Pounded Yam to eat am, some people even take Semo chop - na ur choice b that OMO THE THING SWEET DIE OOO - NOR B SAY ANYTHING... any help required, hunt me down ![]() https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4 You fit contact me here: Facebook - Oyinbo Princess Twitter - @OyinboPrincess
|
@Funjosh - I hope say I nor b computer oooo - loool, na for real... come follow me for twitter / facebook na if u nor too dey fear ![]() |
@Zaha - ose baba... lol... e never reach wow factor ooo ![]() Peeps - I don get new video ooo - na YouTube you go see am: https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4&feature=youtu.be |
@Kingstaplus - ose baba..... make una send me tweet self ![]() |
@Kingstaplus - baba u nor dey try b that ooo - na 2015 ooooo abeg download am na |
@Kingstaplus - baba u for follow me on twitter / facebook na.... u knw say I don melt, regardless of dodgin ![]() |
@Kingstaplus - abegie, u wan make this Oyinbo melt ontop ur words abi..... chaiiii lol |
@johnslick2 - baba nor b yahoo job ooo, na real mata baba.... u knw say na normal level I dey ooo abeg, make una follow my twitter or facebook, u for like my video ontop YouTube self jare.... chaiii u don make me laugh scata @yahoo boiz ![]() |
@loomer - I don accept am ooo |
'chop knuckle' back ooo
wasere!!


U fit buy Eba for Peckham, Camberwell, Brixton, Walworth, Sydenham, Lewisham... omo the list tire ooo, nor b new mata! I know say Oyinbo food make una mess well, even me, I nor fit chop am again ooo - I too dey like chop 9ja things na!!! As far as Guiness book... ROTFL baba Oyinbo's don dey cook these things sinceeeeeee ooo!!