Pink22's Posts
Nairaland Forum › Pink22's Profile › Pink22's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 10 11 12 13 14 15 16 17 18 (of 22 pages)
True talk Alwaysbaby cjnone RUN and again i say RUN! |
Opelistic you have to get an ovulation prediction test ( opk) it is called predict. You can also chart ur basal body temperature ( bbt ) @Nictos Nictos the demon chase, the only woman wey demons dey fear i hail you. The kingdom of God suffered violence and the righteous take it by force. I like ur faith. Ur testimony shall be permanent IJN. You don order for maternity gowns so? Nothing does you sis. @Safe06 if u want develop bow legs na u sabi you too like knackson kai! Lol! |
Chei this children wetin i go do una. So una use that y/day rain take shake una oga bones abi, kai una don spoil. Our efforts will not be in vain IJN |
Opelistic nothing do u o, no go develop bow legs overnight o lol! Cjnone j dey hail o @Chi16 its true about the grapefruit and pineapple so many says it works for them . Abeg can any one post a pic of their honey,mustard, olive oil mixture? The mustard and honey just siddon for under oil dey up, i had to stir and stir so i can also scoop up some honey and mustard is that same for every one? |
Godiya always: In dz month of march, our eggs will march with DHs s.p.e.r.ms and we will march forward with our pregnancies by the grace of God in JSN. I can't shout o! It has been knacking knacking all d way for me and Dh cos afta now he will be away for another one month plus, so i must recover all d arrars. Bless u allGodibaby take am easy make person no go wounjor. So na because dh no dey all these while na im u hide face abi?body don dey sweet u now we hear ur voice. Abeg carry go my sista e no easy lol! @Cjnone am sure some one will bail you out as for me i no send hospital again i no want hear any yeye report ojare |
@Ifyemma Directions: Ferment about 100grams of mustard seed with 25cl original honey for 2days then on the second day mix the fermented mustard seed and honey with a bottle of 75cl extra virgin olive oil allow to soak for another 24 hours. Take 3spoonful of the mixture first thing in the morning and last thing at night for atleast 6months. It cures infertility |
@Ifyemma Directions: Ferment about 100grams of mustard seed with 25cl original honey for 2days then on the second day mix the fermented mustard seed and honey with a bottle of 75cl extra virgin olive oil allow to soak for another 24 hours. Take 3spoonful of the mixture first thing in the morning and last thing at night for atleast 6months. |
@Nictos congrats to you and ur sister is all i can say, keep praising Him for bfp |
VENUSS: @nictos. i was all tears by the time i finished reading ur post. pls do away with worries o . cos this has come to stay. relax and occupy urself and mind with beautiful and funny stuffs and also praising God.oh Venuss dearie tanx darlyn. Any where u are forgotten by men God will remember u for Good IJN |
Na wao this heat no be am o |
Das it, it came out small though
|
Sazyn walk into any Catholic church you'll get it. Howz every one, some one asked for a pic of the edible olive oil here's the one i bought. @Favored gal forget that Dr you understand ur body more than him, continue bding |
Kai this 75cl olive oil plenty sha o. Santagelo25 thanx so much that was uplifting. Hmmmm Twingirls, Twingirls, Twingirls , how many times did i call you, no wounjor that man o see the style wey u take siddon for table sef. You are a good student Safe06 will be proud of you o. Ameeeeeeeeeeeeeeeeeeeen for all ur prayers MamaT send me another message abeg |
MamaT i dey craze? Who am i to disobey you ever. Shun sir! @all my mustard and honey have been joined together in holy matrimony today lalalalalala ( singing) |
@Blessedmom ameeeeeeeeeeeeeeeeeeeen! Chei i don receive prayers for my head tire today. And i send all of them back to the senders IJN, the Lord will remember each and every one of us this yr by His special Grace . Girls if you have these measuring cups for syrup you can use them to get ur measurement for the honey and olive oil. 25cl is equal to 250ml, 75cl is equal to 750ml |
Opelistic Opelistical, ur name is added, that's why i reposted for double checking |
Chokl8y sooowy you here I'll tell ur mummy for that Dr. My dear that thing pain no get part two, no be ur anxiety at all, but no worries this na ur month IJN @Greenfruits thanks, just be specific tell God to take twins slap me lol!. He will remember u too dear |
joesQ: hello my darlin sis long time nd happy new month,God will definately remember us this month iv been a silent reader so im always around but nothing much happening hence nothing to write.to all d newbies u all welcome,pink22 thks for addin my name beloved1993 God is goin to bless u soon for all ur good deeds,pls my sis enlighten me abt this mustard seed,honey nd olive oil mixture.choi! joesq you no dey allow any concoction pass you. Oya carry Directions: Ferment about 100grams of mustard seed with 25cl original honey for 2days then on the second day mix the fermented mustard seed and honey with a bottle of 75cl extra virgin olive oil allow to soak for another 24 hours. Take 3spoonful of the mixture first thing in the morning and last thing at night for atleast 6months. Person wey give the insigt got her bfp by the 3rd or 4th month thereabout |
Ok here goes the list: Pink22 MamaTriplets Alwaystrue JoesQ Adedoyinsola Echala Skimpychick Godiyaalways profeseur omonikiba Ipio chi16 flakeey Ebony favored gal chidima wonyi beloved1993 Hawtmummie sen.tempest Enaeni kaynee Blessedmom Beetle shiloh tokerom swit2have bededlolo Gr8babe Uteh Golden777 Slimphemmie Redeemersave Globusacb Mrskemi09 Nguf Greenfruits Memyselfandi Loliporp heknowsmyname July16th Onyekaogu Accutategirl lanjum Aladunni kike100 zeezzy Marygold Rocksqueen RolaRayo Udoka Napa Santagelo25 lizzyslaw ladyGuinivere safe06 Muma Rainyday chok18y phewme12 twingirls nictos dreasinbc naffysa joyfullmum Maureen44 sorire Oct 20 cjnone2000@yaho waistbead Opelistic had to bring it to this page to make it easier for every one. You girls have been chatty lately b4 u know now na page 500 we go see. Baaaaaaaaaaaaaaad babes wey don spoil, una morning me i don my bedroom bulb to RED hehehehehhe wahala dey oh and happy new month. In this month of March we shall March into our bfps IJN |
MamaTriplets: @Safe, me too wan ask DH to fix red bulb for me ooo!!! Spoilt womanAmen MamaT my gals Hadassah and Jemimah are already cooking in here ooooooooo! Dats the olive oil u've got the real one |
MamaTriplets:even as no be me first answer God go still stone me with my twins. The one for cooking is in a big green bottle it goes for 1,800 or 2000, any good supermarket will have it. The GOYA extra virgin olive inside bottle na good one too. No buy the one inside plastic a beg na ororo even demons no dey fear that one |
safe06: [color=#990000][/color]@zeezyliscious,luv u mur*wink* kunfayakun,be patient and ask almighty Allah to order Ʊя̩̥̊ steps,He will surely do the best for us. Amin.Safe leaf Mata o i still be virgin. I was also thinking grinding the miracle seed will be beta. Original honey dey scarce o except u know person wey go supply you |
Wao Nictos that was inspiring, this yrs fasting ends today and av been asking God for the same miracle. He will show all of us mercy. @waistbead will add u shaperly @safe06 u spoil die lol! U know say heat dey u still dey expose apples for the bobo front. If na my dh u no go escape even if heat dey come down like rain. E no dey take eye see bobby. Welcome Echala and lizzyslaw . As for charting FF is the best o that's the one i use. I subscribed the VIP membership for one yr, now that i understand my cycle and everything about charting am just on the basic membership package . Mustard seed settled. Honey on the way, olive oil akamu case and I'll be set to start the therapy i cant wait. Hmm some things we take for granted, i dey always look mustard seed like something wey no dey important at all |
VENUSS: hi beautiful mamas, maybe u should add black seed (haabatu sauda) to ur mustard seed recipe black seed is according to prophet muhammed pbuh cures all ailgment except death. fortunately for me i have all these items at home including the black seed oil so am just going to mix all together.Venuss my sister u fit vex but just small. I go add u shaperly as u u said i always forget because u dey scarce pass Naira for here, no wahala i go add u now |
cjnone2000@yaho:ha Cj my sista no vex i dey look ur name korokoro like dis i think say i don already write am. A beg na only for catholic church person fit get the mustard seed? As MamaT sef talk say na for there she buy her own |
MamaT kai! Shaperly u don get all the concoction together u no dey slack. No mind the qty of the oil na the recipe happy drinking. Yes o Marygold don escape .where Udoka dey na? |
Ok here goes the list: Pink22 MamaTriplets Alwaystrue JoesQ Adedoyinsola Echala Skimpychick Godiyaalways profeseur omonikiba Ipio chi16 flakeey Ebony favored gal chidima wonyi beloved1993 Hawtmummie sen.tempest Enaeni kaynee Blessedmom Beetle shiloh tokerom swit2have bededlolo Gr8babe Uteh Golden777 Slimphemmie Redeemersave Globusacb Mrskemi09 Nguf Greenfruits Memyselfandi Loliporp heknowsmyname July16th Onyekaogu Accutategirl lanjum Aladunni kike100 zeezzy Marygold Rocksqueen RolaRayo Udoka Napa Santagelo25 lizzyslaw ladyGuinivere safe06 Muma Rainyday chok18y phewme12 twingirls nictos dreasinbc naffysa joyfullmum Maureen44 sorire Oct 20 cjnone2000@yaho a beg if i forget you just vex halla me |
Muma read back a few pages. MamaT shun sir! Am on it ur command is my wish. Will update the list soon as i finish compiling it |
MamaT no over laugh na this kind talk dey sweet you, you een? 100g mustard is equal to approx 6 tablespoons |
Ok exam mode deactivated! Am back, but una wicked o, una just dey scatter my head with laughter when i dey try to crack my brain for book, kai una too much sha. The worst olive oil na dat one for plastic bottle, wey dey even sleep like ororo no even go Der, even demons no dey fear dat one. Na that correct type wey MamaT dey take do flogging for night. Dr Alwaysbaby well done o for the ulcer lecture i think say na only knackson things dey switch you on. All newbies una welcome o , safe06 u spoil sha but how i wish i get your energy. One of my friends dey go on full time knackson from cd9 to cd 18 non stop, i dey always hail her. Take am easy no be the one wey you do finish begin waka like John Wayne . A beg where i go get mustard seed for abuja |
Kaynee: @ Adedoyinsola. You can get mustard seed from a herbal shop. I got mine from a herbal shop inside the market where Yoruba woman sell herbs. But I stay in Abj.i dey busy with exam but i still dey peep. Kaynee i dey abuja too which market you for see am. Hi all |
Hehehehe! Una no go kill me o. Marygold congrats girl. Welcome all to all the new mamas. I beg i get exam dats y una no too see me, will be back fully soon. Alwaysbaby you are the best God bless you dearie. MamaT i dey hail o everybody cheers |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 10 11 12 13 14 15 16 17 18 (of 22 pages)
. This month of March ℓ̊ G̶̲̥̅Ơ̴̴̴̴͡ 'Do Things'
. It has tayed wen ℓ̊ reach cloud nine cos of TTC. Wetin self
. Me wen sabi winey winey!!! This month ℓ̊ G̶̲̥̅Ơ̴̴̴̴͡ open WIDE and enjoy myself!!!
is the original in Glass or Platic Bottle. How much for 75CL. Ɣ☺ΰ know say as ₪a̶̲̥̅̊ oil tinz ℓ̊ nor want drink cholesterol full my body so ℓ̊ need the right tin. ℓ̊ don't mind a Picture self. Whoever reponds fast ♍åkє̲ JEHOVAH stone am with Twins sharp sharp, Amen.