Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,166,109 members, 7,863,873 topics. Date: Tuesday, 18 June 2024 at 08:14 AM

Rovert's Posts

Nairaland Forum / Rovert's Profile / Rovert's Posts

(1) (2) (of 2 pages)

TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:11am On Oct 05, 2010
Pipo, 1st of all, me tink say make we try for the big 1-0 obodo. Dat go be pure sherubawon 'n gbege mumu pipo.

Me too I see wetin Igwe do for nite O! Me 'n my iyawo agree come agree say de boi hold imsef well sha. 2 many tings for fit spoil yestady if e no behave. Im papa still dey dere; Sheila's yeye dey dere (ah 9ja peeps neva dey deal with all the kin tings); e fit be say if e touch wonkin e no go fit hol bodi again and finali e go be lik say e dey act cause of nomi. I tell my madam say e for just touch im hand to let am no say e good but we neva dey de kin situation im dey 9my iyawo remind me say me too no do beta b4 we waka go aisle.

Abeg una go vote sha, at least we get drama to watch. I hope say e no go propose sha, eish!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 2:29pm On Oct 04, 2010
Abeg na wetin dey shele? Ah dey work so I no dey watch, make una help man pikin jare!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 11:50am On Oct 04, 2010
beeswax:

@rovert sheila initially nominated munya but she changed it to mwisho since ha can save himself as hoh. The tally still remains k1=4 and munya=3

Mi bad! I no read de last line. E good sha na Munya & K1 dey up after nomi, but Mwisho better put Uti up with Munya if e go get chance to kick out 1 of the 2 ogbologbos!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 11:39am On Oct 04, 2010
trae_z:

guys like Sage Yacob said it's all about money. BB makes more money with only 1 housemate gone and 6 staying to the final. Big Brother is a Pi.mp!

Omo, I tire for all dis una cry say Biggie dey rig de show! Na una money dem take plan de show abi make dem no make profit? Abeg make una lef Biggie to scheme away, as long as I enjoy mysef (if Uti win na bonus), dis game is definitely DEF!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 11:34am On Oct 04, 2010
tatiana009:

Nominations;

Uti: K1 Munya
Tart:K1 Munya
Sheila: K1 Mwisho
Mwisho: K1 Munya
Munya: Uti Mwisho
K1: Uti Sheila

K1: 4
Munya: 3

Dis info no correct O! Uti, Sheila, Mwisho & Tatiana nominated Munya & K1. So both had 4 votes each.

The guys are all strategizing cause they think only the males are serious competition. Mwisho didn't go to BBA to make friends (eish, except also to get engaged!) but money! If I were him, I'd put my game cap on and switch K1 with Uti, therefore putting Uti up with Munya.

To be fair sha, I think Biggie will put all housemates up for eviction and then evict 2. But I fear for Lerato sha, cause in order of public votes so far, Uti & Munya will be okay. Sheila & K1 will squeak through also but Mwisho, Lerato & Tatiana will have to fight it out for the last spot.

What I want though is a straight Munya vs Uti fight but then that will make the final boring!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 7:11pm On Sep 27, 2010
quote author=melanie74 link=topic=467188.msg6831766#msg6831766 date=1285610178]
Abeg based on our bobo fan page, we don decide to do obama pikin as naija but iya bakassi and rato for orishirishi
[quote][/quote]

Me I dey think say e beta make we put 1 person wey be Igwe paddy back for de huze lik some pips don talk. Igwe fit craz if nobodi be im paddy dere O! We know say mumu, ruralboi and now bushman no gree im own so dey fit set am up. Make we no forget say im palle don delete so pressure dey im head O! Abeg, we fir make am Obama sis & Gman?[
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 6:39pm On Sep 27, 2010
My pipo, wetin dey hapin? Make we ur koni no come pass us O! Na 26 minutes remain for the Monday show to start, so we MUST agree now. GM & Obama sis for me, all kurukere wey we get to focus on this 2 pipo and de obodos wey Igwe carry. Even sef time to take bushman iyawo obodo don reach; make we teach mumu dem lesson. We need to sherubawon (make dem fear) noW!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 9:32pm On Sep 26, 2010
montelik:

My people no be say i wan discourage una, but d truth is bitter. mumu don do him home work since before him enter that house. From d one wey be say he dey nominate far away countries and never nominate from sadc, to d one wey him come dey befriend cricket. D boy wey know say him get mad fan base for sadc (una see Meryl's aunty dey check him out wink)and he don tour all these countries before he come enter d house. Even when bba revoultion hms dey campaign madly for Jen, dem still no fit dent am. Oh boy d truth is bitter, mumu is very powerful in sadc and all the hms from his region no just be am at all, dem no fit compete with am.

My people loyalty is what brought us this far. From 3 votes with Meryl, 5 votes with Sheila to Uti now commanding a consistent 8 vote majority. See what disloyalty and opportunism has done to bushman mogoro. Only 1 vote, even d east africans abandoned him because of him and his country peoples behavior. It is d alliance we built through loyalty that has brought mumu down from 12 - 14 votes to now 6 - 7 votes. If we start trying to be too scheming like mufc we will start losing votes d way they did as well. Do you think Moz would have supported Uti this round if we hadn't saved Jen from an embarrassing 15-0 drubbing. Before we start to dey over-calculate just look at Mwisho who went from 9 votes to 1 vote in just a few weeks because he started being too smart for himself. Food for thought.

NA FOR WHERE BUSHMAN GET 9 VOTES? I HEAR WETIN U TALK; 9JA GO GIVE AM TO OBAM SIS BUT ALL ODA KURUKERE VOTE MAKE PUT FOR IKEBE & GUITARMAN
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 9:28pm On Sep 26, 2010
preshizeee:

SO WE NO GO SHARE VOTES

SO WHO GO TELL DEM FOR TWITTER & FB SAY NA WETIN NAIRALAND TALK? ABEG WE NEFA AGREE WETIN WE WANT - GUITARMAN & IKEBE FOR SURE. WE FIT THROWAY SOME FOR OBAM SIS
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:33pm On Sep 26, 2010
Whateva happens, make we lock down the 8 wey we get now. Leave TZ for bushman; Bots for follow Mumu so make we put guitar man to shake im obodo. Make we give Igwe the best chance abeg!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:25pm On Sep 26, 2010
preshizeee:



Best thing na 2 send d bombo raggae man & d won dem burst im mouth na both of dem sure pass , as e dey we don loose TZ Vote

Me I tink say na bombo & ekebe mama naim be d surest bet. Dem no lef dem pips O!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:13pm On Sep 26, 2010
Kx:

can someone pls give us the details of the country votes per nominated housemates?

Last week you voted to save Kaone, Meryl, Mwiso or Uti. This graph shows that Meryl had zero popularity votes, while Mwisho had one, Kaone has six and Uti had eight.

Uti was the most popular Housemate with eight countries voting to save him, while Meryl had no countries voting to save her.

Therefore, because she received no country votes, Meryl has been evicted.

Uti

The countries that voted to save Uti were: Angola, Ethiopia, Ghana, Kenya, Mozambique, Nigeria, Uganda and the Rest of Africa.

Kaone

The countries that voted to save Kaone were: Botswana, Malawi, Namibia, South Africa, Zambia and Zimbabwe.

Mwisho
The country that voted to save Mwisho was: Tanzania
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:05pm On Sep 26, 2010
Abeg, Nairalanders wey be 9ja pips, make we no scatter our votes. Na true say Code get im country; so make we throw Pastor Paloma back into de house so mumu go lose at least 2 votes. Make una no forget say K1 pips go vote for am, so na 3 votes e go lose come get only 3.
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 7:33pm On Sep 26, 2010
Make we make up our mind quick for de pipo wey go go back O! Make SA & Paloma go back, dem go spoil show for Mumu.
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 7:22pm On Sep 26, 2010
Pipo I hail una! Igwe don make am again this week. The obodos wey e get last time remain kamkpe. Abeg make una leave de Sheila gal for barn, e go spoil shows for bros. I tink say make we put pipo wey go take vote from Munya like Tatiana and maybe Jen back. I for say Meryl but im obodo no like am. I hail again my pipo!
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:12pm On Sep 20, 2010
I don start vote O! Abeg make una do am for all d 4 ways, plus d 3 ways for oda obodos.
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 8:05pm On Sep 20, 2010
De Zim pipo don dey copy us so make we broke am pass b4. No dey talk hw u go do de deed just do am.
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by rovert: 7:45pm On Sep 20, 2010
Na yeye dey worri d boi. We know say e go swap imsef, e fit try lef imsef! We for show uma pepper if e do am. Abeg work don start O! We go leave TZ for dem, take SA, dem no fit do anytin about am. Na 8 we get de last time, na 8 we need now, to shake all dem haters!
TV/Movies / Re: New Film On Fela: Ejiofor Takes Lead Role, As D’banj Fails by rovert: 12:58pm On Jun 14, 2010
I like Chiwetel's acting; I think he is one of the very best actors of Nigerian progeny. It really would have been a disservice to Fela for D'banj to play the role. Since Chiwetel grew up in London, am sure he picked up some Yoruba. So good on him for the part!
Satellite TV Technology / Re: Official Thread Of Free To Air Satellite Tv (part 4) by rovert: 4:27pm On Jun 09, 2010
George D congratulations! May you have opportunities to prosper open up more for you this new year of your life. May God reward you with more knowledge from the fount from which you have shared copiously. Enjoy your day!
kiss kiss kiss kiss kiss wink wink grin grin cheesy cheesy cheesy
TV/Movies / Re: Big Brother Africa 4 (The Official Thread) by rovert: 1:27pm On Nov 05, 2009
Endemol & Multichoice have very smart people! The 3 Nigerians selected for BBR just tickles me:
Kevin: a wanna be rapper who thinks he has swagga; Geraldine: a 'virgin' lawyer who does not know the things that happen inside a court room and covers her protruding teeth every minute, and Nkenna: a very uncouth person recruited to diss Nigeria so much we're now the laughing stock of Africa.

Have reduced my watching to the barest cause am just plain bored with the housemates antics and conversation!

By the way, Nkenna should voluntarily leave come Sunday!
Satellite TV Technology / Re: Official Thread of Free-to- Air Satellite TV [part 3] by rovert: 6:13pm On Sep 17, 2009
I'v been watching MyTV for nearly 1 hours now. Is it now free!
Satellite TV Technology / Re: Official Thread of Free-to- Air Satellite TV [part 3] by rovert: 2:27pm On Aug 12, 2009
Folks, like most of you kept saying to new joiners, I've been reading the threads to get a hang on FTA. Well done to you guys who have pooled such a wealth of info.

I use a Strong 4653X with a 60cm dish and would like to for Astra2B sometime. I have pay TVs but why pay when you can get it free, abi?

(1) (2) (of 2 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 41
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.