Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,585 members, 7,958,812 topics. Date: Thursday, 26 September 2024 at 02:28 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (41797 Views)
Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Wec: 2:50pm On Dec 07, 2014 |
Dem say.. meat wen u no fit swallow no test am! 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:52pm On Dec 07, 2014 |
E dey hard for persin wey dey pray for talkless of persin wey dem swear for. Theif wey dey theif dog, them tell am say make he catch goat come, he say he dey fear say the goat go bite am. Coniman die coniman burry am. I tell you say fire burn white man you dey ask of he bear bear. Team Benin 6 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:52pm On Dec 07, 2014 |
No matter how river cold,fish no go wear sweater. Yes life sweet,dat no mean say boys no go drink alomo bitter. 6 Likes 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Flexy2vybes(m): 2:53pm On Dec 07, 2014 |
Persn wer hold ground no dy fall D way wer pikin play wit hm mama breast hin no fit try wit him papa blorkos Pikin wer carri hm papa 4 up na blorkos dy break hm eye No be say gal toto swt nahim u wan Bleep d gal die LIFE GOES ON 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:53pm On Dec 07, 2014 |
Area hot, area hot e no fit boil yam No be today yansh start dey get center pathing. 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PROCTOR: 2:55pm On Dec 07, 2014 |
I will chop the life of my head....i don't know the back of tomorrow 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by elari(m): 2:55pm On Dec 07, 2014 |
I wonder y the use of prick as a proverb, plenty pass 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nikapetrelli(f): 2:58pm On Dec 07, 2014 |
Dis thread no be here o,lwtmb.Naija i hail una Pidgin,especially Warri pple 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by oba2flex(m): 3:01pm On Dec 07, 2014 |
Any babe wey no get bwest na her papa she take chest resemble 3 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AAlozie(m): 3:01pm On Dec 07, 2014 |
If person bite me for head and hin no fear d hair wey dey for my head, when I bite am for n.yansh, I no go fear hin shít 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by HopeAlive14(m): 3:03pm On Dec 07, 2014 |
HopeAlive14: Here na some additions: 12. Na the leaves wey dey near hole dem dey cut take cover the hole o. 13. Wife no dey complain say im husband too dey touch her body o (shebi oga don pay every?) 14. Na the little “water” wey dey husband body im from dey give im wife o. 15. Water no dey vex for soap o.. soap no dey vex for water o. Oga and madam, brother and sister abeg make una settle o. 16. If you wake up for morning and fowl begin pursue you, better run for your life o.. you no know whether im grow teeth over night o. 17. Who say you, your family and Nigeria no go better im go be like bottom of pot wey dey on top of fire o. God bless Nigeria! 3 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Microbyte: 3:03pm On Dec 07, 2014 |
1. Prost1tute no de ashame to enter bed with a man...no be today! 2. T0t0 no get plenty water, but ede reach Pr1ck take bath. 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Feranmicharles(m): 3:04pm On Dec 07, 2014 |
HopeAlive14: The pidgin way dey numb 6 dey ghost mode abi cos na only wetin be pidgin 4 dah numb 6 |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PassingShot(m): 3:05pm On Dec 07, 2014 |
kokoA: LWTMB oooo But, e go land e go land na im butterfly take dey enter bush. 1 Like 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Feranmicharles(m): 3:06pm On Dec 07, 2014 |
publicenemy: Even if she was raped |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 3:12pm On Dec 07, 2014 |
Soup wey sweet na money kill am 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Uffakowoicho(m): 3:13pm On Dec 07, 2014 |
person wey naked no dey put hand for pocket o person wey u know for night u no go take torch dey check am for afternoon o person wey i fit beat i no dey pray make God help me again mouth wey chop plenty pepper no get love for yaghch o 4 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by johnbuck81(m): 3:13pm On Dec 07, 2014 |
ikebe(ukwu) no dey tire d owner. 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by onoxyx: 3:13pm On Dec 07, 2014 |
make I help una with these few...... ..... i get am before no be achievement dog when no get tail, na God dey help am drive flies who no go no know na small pikin wen no know him mama boy friend dey call am uncle na matter how heavy rain fall, na ground he go enter na wen u use motor jam mad man, u go know say him get owner dem no dey learn left hand for old age na for clap dem dey enter dance na small shit na him dey spoil nyansh half bread is better than full chin chin, provision store is better than kiosk na Wetin man chop na e be him o na another man head be stone when dey dey break coconut okpolo eye no be tear eye na who know man dey kill man 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Bj5all(m): 3:16pm On Dec 07, 2014 |
Na run wey no b run na woman dey hold breast dey run, when better run come, she no go know when wrapper go fall. If them dey advice pikin wey get mama, who no get go dey listen Na wetin person get he dey use do shakara, na make pig put he brokos for back Na when small pikin ask for sometin and he no reach he hand, na e go say wetin I b wan use am do Na as small pikin hand long reach na so he go take am catch winged termite. Person no dey steal for market carry hand go back. 3 Likes 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 3:16pm On Dec 07, 2014 |
osasyankee: I frankly do not know why this happens. I mean you do get control of the thing by walking and thinking and squeezing your PC muscles to hold it back. But the moment you behold the sight of a toilet at times even as you try to unlock the door...it will be as if you just cant control it anymore. . Then you suddenly break into a race to quickly unfasten your belt and unzip your trousers. And you had better hurry otherwise........! I try hard to just act normal and I try not to think that I am close to the toilet. Just act and pretend as if when I get inside, I will sleep first and do other things before going to the bathroom. 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AUSVINS(m): 3:19pm On Dec 07, 2014 |
Slave no dey tell him master make them list properties wey dem get. Water wey u no fit drink no use am wash face Hunger wey get hope no dey kill person . No matter how needle small fowl no fit swallow am 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Horllamideh(m): 3:24pm On Dec 07, 2014 |
Pesin wey no dey cry easily must start shedding tears from im house if he wan attend funeral....."Ati okeere ni oloju jinjin ti n mu ekun sun" 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by DCONE1(m): 3:31pm On Dec 07, 2014 |
publicenemy:hahaha guy your crase nor get measurement. |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Sacramento4real(m): 3:32pm On Dec 07, 2014 |
1.Wen Garri see wetin hot,e change e name to Eba. 2.Dem nor dey nor use prick test cutlass medicine. 3.Na wen small pikin never know im mama boyfriend im dey call am broda.wen im now,na badt guy im dey call am 4.Nor be by power penis take dey stand up o.Na patience. 5.Temper hot,temper hot,e nor fit boil Yam. 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by chaloner(m): 3:34pm On Dec 07, 2014 |
1. When thief thief thief thief thing, e don red be that. Wahala dey o. 2. Year wey get January dey get December o. 3. No matter how snake long reach, e no fit wrap imself around palm tree from bottom to the top. 4. If needle fall inside river, dem no go fit see am pick again o. 5. Na fly wey no get Special Adviser dey follow dead body enter grave (no wonder we have so many Special Advisers in Government) 6. Do to other people wetin you want other people to do to you. 7. No matter how okro plant grow reach, e no dey tall pass who plant am. When time to harvest am reach, the owner go bend am down. 8. If woman deny man food, na man go still chop am. 9. Person wey no chop beans no dey poo beans o. 10. Dem say love is blind. If blind person lead another blind person, both of them go fall inside pit. 11. Na people wey dey use Mace fight for assembly Mace go tear head, no be me wey siddon jeje for my house. 12. D water wey Buhari don take eye cry for naiJa go fit make ocean for Katsina. 13. If army slap you, you go know say police na your friend 14. pikin no fit compare prick with him papa. 15. you no need spoon to chop slap no matter how chicken fly e must still come down 16. Na only person when get patience well-well, go fiti cook stone sotay e go done reach to chop. 17. Where there is a will, you go meet relative plenty. 18. Out of all lizard when lie-down ontop roof for sun, na only the one when belle dey worry am, go fiti know hinself. 19. The run when buffalo run after wey hunter shoot am wound, na to save him own life TOGETHER with hunter life, make am dey run. 20. No how wey hungry fiti wire bush rat, wey he go forget himself put leg near the place when only one ripe banga dey for ground, because na trap be dat. 21. Na the ting when bush rat take eye see for night, come make am by-force dey wakka SOFTLY for afternoon. 22. Man pikin when take eye see die, begin dey run like antelope, nogo remember the leg when dey pain am before. 23. No how wey tortoise wakka go far, na for inside hin house he go sleep that night. 24. Monkey no fine, but him mama love am. 25. Over-sabi person when carry him dog go sell, come take the money buy baboon for market, go regret hinself and cry say "had I known", when time reach. 26. Na as goat take stand for market na ehm dem dey price am. 27. Pikin wey no play today must play tomorrow 28. If we pound yam inside Bill Gate's jet and cook delicious soup on top Bill Clinton's head, a clueless President will still remain clueless!!! 29. bosom wey stand gidigba today must fall tomorrow 30. Rake from today till tomorrow you no fit use teeth grind bottle 31. Small girl wey no wan sidon for one place, na one prick go advice am one day. 32. Pikin wey say him mama no go sleep, him ma no go sleep 33. Person wey say my water no go boil, him own no go hot. 34. Na person wey don chop beleful dey ask for big meat 35. rolling stone na person push Am.. 36. he who fights and run away, na fear dey catch am. 37. you no fit use big prick threaten ashawo 38. na co-operation naim make rice full for inside POT. 39. Person wey madman don bite before if I'm see mechanic he go take off 40. -no mata how u wash yansh,e go still smell. 41. -Sunday wey go sweet,na Friday we go know. 42. No matter hw u shake am reach... D last drop of ur piss belong to ya boxers... 43. Dey say Monkey fast Monkey fast, na becus tree near each orther 44. Oldman wey snatch small pikin cap wear for head, na him say make pikin play wit him head. 45. Coakroach like to dance but fowl no dey give am chance at all 46. Na small small pen!s take dey grow 47. Dem no dey cut left hand commot for body sake of say e dey useless 48. If u say nothing dey happen,put fire for ur neighbour house na 49. E dey hard for persin wey dey pray for talkless of persin ey dem swear for. 50. No matter how river cold,fish no go wear sweater. |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Gistdutch: 3:34pm On Dec 07, 2014 |
Naa where man dey work hin dey chop that naa y dey call am workchop. Naa today, no be today yansh begin dey back e don tay 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AUSVINS(m): 3:34pm On Dec 07, 2014 |
Dem dey beg baber make him barb mad man hair,Dem for beg the mad man if him go free to barb him hair first. 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Goodnuel: 3:38pm On Dec 07, 2014 |
Bj5all:Na this one wan kiiii me laugh |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by publicenemy(m): 3:39pm On Dec 07, 2014 |
DCONE1: Lol. |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Sacramento4real(m): 3:40pm On Dec 07, 2014 |
Wen small pikin don get small money,e go tell e papa say make everybody cook he own soup. 3 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by orobs93(m): 3:40pm On Dec 07, 2014 |
When hand don too Tey for pocket head and eye go go meet am oh. 1 Like |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)
Photos From Ikwerre Bicycle Carnival, Rivers State / Olowo Of Owo, Folagbade Olateru-olagbegi Has Died / Bride Price: Man Slams African Parents, Says "I'm Not Paying"
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52 |