Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,243 members, 7,957,585 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 03:16 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (41787 Views)
Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by seagulsntrawler: 2:08pm On Dec 07, 2014 |
Monkey sabi jump from tree to tree but na the one wey near pass he fit take try am. Pikin wey carry bald head come dis life, na headache go worry am die. 1 Like 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Firefire(m): 2:09pm On Dec 07, 2014 |
daxon001: If na you for small pikin wetin u go do? |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by viczing(m): 2:09pm On Dec 07, 2014 |
1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AdeniyiA(m): 2:09pm On Dec 07, 2014 |
no matter wetin you dey smoke, you no fit high like the most high 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by ifoundmyperfect: 2:10pm On Dec 07, 2014 |
ahnie: You dey take style find twouble... Person wey leave hot oil for fire go sleep, make he prepare to come back come quench fire b4 the fire go quench am.... 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:11pm On Dec 07, 2014 |
pat077: And none dey wey go ever fit big pass pikin head or long pass pikin body! 3 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Aare2050(m): 2:13pm On Dec 07, 2014 |
Na person they pay person money, Man piking head wey big, na to dey manage am like dat. Person pikin no go wicked wicked we chase am give lion chop 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Ofeakwu(m): 2:13pm On Dec 07, 2014 |
They no D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣̥ tell pikin make ìm stand up for seat, if im mama no ¢αℓℓ am, im papa go ¢αℓℓ am 2 Likes
|
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by viczing(m): 2:13pm On Dec 07, 2014 |
No matter any truth wey lie mohammed talk lie must dey inside am shikena 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by chidiezeh(m): 2:14pm On Dec 07, 2014 |
E don Tey wey yansh day for back 3 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by okeyokeyjah(m): 2:15pm On Dec 07, 2014 |
Dreambeat: |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by ahnie: 2:15pm On Dec 07, 2014 |
fowl wey go new place...must carry one leg up. ifoundmyperfect: 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by oba2flex(m): 2:18pm On Dec 07, 2014 |
Oldman wey snatch small pikin cap wear for head, na him say make pikin play wit him head. Coakroach like to dance but fowl no dey give am chance at all Na small small pen!s take dey grow Na from clap dem dey enter dance Sun no fit dry clothes carry go Dem no dey cut left hand commot for body sake of say e dey useless Na from beginning dem dey know dog wey go fit hunt If u say nothing dey happen,put fire for ur neighbour house na 4 Likes 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by August17(m): 2:19pm On Dec 07, 2014 |
Issue dat Issuet Issue wen dem say make papa and mama no hear, na papa and mama dey settle am... He who fights and run away,na fear dey catch amMM 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Dreambeat: 2:20pm On Dec 07, 2014 |
Man know man na him dey kill man,man know man na him dey help man(two edged sword). 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by daxon001(m): 2:20pm On Dec 07, 2014 |
Firefire:I go cry bring down d house.cos i go kno say no b my malee bak b dat.i hear say na since small(3 days old) i don sharp. |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:23pm On Dec 07, 2014 |
PapiWata:me I sabi soil pidgin well well.I go pidgin school in my country we dey Brazil near Philippines. Back to the topic THE PERSON EYES WEY GO OPEN GO SEE PROBLEM (Oju eni mala ari iyonu) IF YOU BLOW PICKIN EYE HE GO SEE VISION (Back from loju ariran) IF YOU OPEN EYE WELL WELL ,HE GO SEE NOSE) (boju back fara bale arimu) 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Dreambeat: 2:23pm On Dec 07, 2014 |
The thing wey old man sidon see,small pikin go climb palm tree,e no go see am. 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:25pm On Dec 07, 2014 |
PapiWata:me I sabi spik pidgin well well.I go pidgin school in my country we dey Brazil near Philippines. Back to the topic THE PERSON EYES WEY GO OPEN GO SEE PROBLEM (Oju eni mala ari iyonu) IF YOU BLOW PICKIN EYE HE GO SEE VISION (Ba fe OMO loju ariran) IF YOU OPEN EYE WELL WELL ,HE GO SEE NOSE) (boju ba fara bale arimu) |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by simplychic(f): 2:28pm On Dec 07, 2014 |
If cunny man die na cunny man go bury am 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by simplychic(f): 2:32pm On Dec 07, 2014 |
Nobody dey tell small pikin make he no get leprosy, so far he dey ok to live inside jungle 3 Likes 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by iykemoney90(m): 2:32pm On Dec 07, 2014 |
u no fit use prick ginger olosho person wey dey close to person na him dey hear (perceive) him mouth odour 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Chatlaury(f): 2:34pm On Dec 07, 2014 |
Monkey smart,monkey smart,but e nor fit smart for desert. I get am before nor bi property. Nor bi the way dem dey drink water naim dem take dey drink pepper 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AUSVINS(m): 2:36pm On Dec 07, 2014 |
Man wey carry goat go market get bia bia the goat too get bia bia na when market close dem go know who carry who go market. 4 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by LeoSanchez(m): 2:38pm On Dec 07, 2014 |
if you ask me na who i go ask.. 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AUSVINS(m): 2:40pm On Dec 07, 2014 |
Na nyash mess but na head dem dey beat 5 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Ohrydo: 2:45pm On Dec 07, 2014 |
Pweke! Oooo boi, una dey vex o |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by IamOpemipo(m): 2:46pm On Dec 07, 2014 |
No be perrson wey car bash go pik plate number Dead dey bury dead..we no dey knw who"s next A man wey open. Eye tear shaki for soup is a fearless man 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Wec: 2:48pm On Dec 07, 2014 |
Who dey cry dey see who bele-ful go hungry 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Kelklein(m): 2:48pm On Dec 07, 2014 |
[size=18pt] Wetin small pikin dey see for under bed when hin stand up...elder no fit see am if hin lie down flat [/size] 1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Jygga: 2:48pm On Dec 07, 2014 |
If u chop winch, na person put am for your mouth. 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Wec: 2:49pm On Dec 07, 2014 |
Anybody wen dey waka 4 ur head go waka lust 1 Like |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)
Kano Monarch, Dahiru Abba, Shot Dead / Photos From Ikwerre Bicycle Carnival, Rivers State / Olowo Of Owo, Folagbade Olateru-olagbegi Has Died
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 35 |