Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,084 members, 7,821,737 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 05:28 PM

AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read (1059 Views)

When Amebo People Come For Your Wedding / Pastor Chris Oyakilome And Wife Anita Wedding Photo And More *amebo* / Her Fiance Is Gay. Should I Do Amebo? (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by richardjemedafe1(m): 8:49pm On Dec 08, 2014
AMEBOR YARNS (Strictly 9ja Pidgin)

E get one fine babe for we yard, her name na Julie but we dey call her "Julie Pepper"....sake of say, she dey carry crested voke take tidy people fuckup like say tomorrow nor dey.

As una dey read this informate now ehnn.....The kain pattern wey Julie take dey tidy Dumebi fuckup for we yard ehnn, nor be here. All Chidumebi face don add weight and em teeth don run comot for em mouth finish. Naso plenty plenty hot star dey comot for dem em eyes....Julie Pepper, carry Chidumebi take show man Godey, con trowey am yaka for man Devo face, as e dey hot!

Hmmmm Nairalanders, we yard people nor gree seperate dem, nahin i kneel down dey beg Julie Pepper say abeg make she pechill unto the marra. She say if i sabi wetin he do her ehnn, i go follow her treat em Bleep up. I say ehen, abeg wetin Chidumebi do oh? . . . .Naralanders, una fit believe am say, trouble dey sleep, yanga go wake am?

Chidumebi get liver, fap Julie BB pin. Nobody even sabi where he from fap her pin, he con dey send her message say:;

**Chidumebi:;Hi <3
**Julie:;~no reply~
**Chidumebi:;How are you sexy? :*
*Julie:;~no reply~
**Chidumebi:;How your side nah? sad
**Julie:;~no reply~
**Chidumebi:;Babe i jollof you oh. <3 wink
**Julie:;~no reply~

Nairalanders, una nogo belive say she no gree reply all em pings oh,..............so today, naso Chidumebi ping her say ;

**Chidumebi:;38654235980652687 :*

""""as he send her the ping, naso she sharperly reply am""""

**Julie;; smiley :* which network be this? <3
**Chidumebi:;Cartoon network :p

Nairalanders, as i hear am, nahin i look em face, con see s ay em mouth don swell up like Índia pomo.....naso me sef vex, sharperly nod Chidumebi hot slap....i swear, the guy nah serious contender for mumu merit award. . .una see the kain parade wey he wan take kpai himsef? Well sha, nah the tachere level wey Chidumebi take buy Julie Pepper trouble. Abeg make i still dey beg her make she free am abi make i leave her make she tidy em marra as e dey hot? Make una cast quick, i dey H abeg, make i go smoke garri if una say make i leave Julie Pepper make she tidy em fuckup wella as e dey hot.

#Richard
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by iceberylin(m): 9:44pm On Dec 08, 2014
Is this a joke undecided
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by Nobody: 9:50pm On Dec 08, 2014
Ar u tryin to b funny?
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by LEvuls(m): 12:00am On Dec 09, 2014
My guy u try, e no easy to write for pigin engrish even some of us no sabi speak am well as e supos be.

#thumbsup
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by LEvuls(m): 12:00am On Dec 09, 2014
My guy u try, e no easy to write for pigin engrish even some of us no sabi speak am well as e supos be.

#thumbsup
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by richardjemedafe1(m): 5:52am On Dec 09, 2014
iceberylin:
Is this a joke undecided
My guy this 1 nobi joke oh..na true life tory whe happen 4 my yard som hour ago
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by richardjemedafe1(m): 5:54am On Dec 09, 2014
LEvuls:
My guy u try, e no easy to write for pigin engrish even some of us no sabi speak am well as e supos be.

#thumbsup
tenx bro....here 4 m******s when I day na pidgin be our official language
Re: AMEBO Yanrs(strictly 9ja Pigin) Must Read by richardjemedafe1(m): 5:56am On Dec 09, 2014
badoolee:
Ar u tryin to b funny?
Abeg who fit break/translate this girl language for me??

(1) (Reply)

8 Categories Of Boyfriends Ladies Should Know / Three Options / When And Who....guys Only

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.