Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,103 members, 7,818,294 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 12:09 PM

Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) (2022 Views)

Buhari’s Statement On Aisha Is A Wake Up Call For Women – Senator Olujimi / DASUKI GATE: Speak Up, Nigerians Tell Jonathan / News Breaking Nnamdi Kanu Issued Death Threat Against Gov Obiano (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by shamecurls(m): 3:39pm On Mar 03, 2015
Country people!!!! Country people!!!! Country people!!!!! How many times we call una?? How many E be like say una jus dey look oh....We don beg una,no dull yourself..no dull yourself..

Person wey wan write exam, no go sleep before exam,person wey go church for miracle,go siddon ontop prayer mat dey seek Baba God face, person wey dey ask Imam for prayer,go disturb Allah until hin prayer dey answered.

Ok, make we go dere..we wan go dere so dat when we go dey talk later,una go listen well well and know the enemies...those people wey devil wan use scatter the plan God don make for us,our children and their children children.

When we talk say dem wan shift elections, many people come hia dey shout say na lie. Dem no shift am? Dem no shift am?? Elections wey suppose hold for February 14,Sambo Dasuki threaten Jega,INEC eventually move election. Jonah,come go yarn say hin no sabi anything. How he go sabi??

Ok,after Nigeria spent $billions on PVC and Card reader,after 75 percent of Nigerians don collect PVC, we tell una say PDP no go allow Nigerians vote with PVC. Na Edwin Clark come call press conference with some morally bankrupt yesterday's men begin insult Jega. Now Edwin Clark is Jonah godfather. Clark say Jega give PVC to Northerners say PDP no wan PVC or card. All that film Clark pull,we don talk am for hia..we talk am say dem PDP no wan PVC..Because with PVC rigging no go dey.

Make we kontinu?? Oginni? Na for our future we wan talk..because some yeye old men wey don enjoy Nigeria when dem young wan scatter am for us the youths.

We come leak information say Mohammed Adoke,the most useless Attorney General,ever for Naija,come go for night swear affidavit say FG no wan PVC? if nobi for God and man dem wan push this yeye lawsuit go front of one compromised Judge who go ban PVC. But God pass them..God pass dem...

Now,remember say Edwin Clark don talk say hin go make hin boy Jonah fire Jega because Jega no wan play PDP ball. NOW JEGA IS GOING ANY MOMENT FROM NOW. Clark told the whole world he was going to get Jega fired. We hear say Jega don pack hin load go.jega is not a civil servant,he is a political appointee just like a Senator. JEGA HAS BEEN FIRED!!!!!!!!

Jonah no care at all.As he push Sanusi away,after Emir leak story of $20B, na so Ebele don sack Jega. We talk am here..yes na we talk am here first.....Jega don go...because dem wan rig and Jega no wan allow them..na wa...SO,TO STAY IN POWER AT ALL COSTS TO RIG ELECTION DEM FIRE JEGA!!!!

Now,the plan is to bring in a New INEC Chairman,who don collect $Billions put for Dubai and Singapore bank from PDP. This new Chairman will talk say PVC no go work and dat the card reader useless, so na to go use Electronic Voters Register wey PDP don format before...Na wah...na the film wey go happen from today be dat.

We don tell una..we don yarn am for hia..we don shout am oh...no talk say you no hear oh...
Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by midolian(m): 3:45pm On Mar 03, 2015
You mean JEGA is fired?

Dis one na beer parlour gist o..
Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by 9jatriot(m): 4:07pm On Mar 03, 2015
This rumor is getting too much APC should go to court and get a court injunction preventing anyone from interfering with the independence of INEC. They should be more proactive than this reactive noise making approach they are using GEJ does not care about the nation so a level of force within the law has to be used against him for him to behave.

For example, you can imagine if those house of rep members did not climb the fence that day what the outcome would have been. APC should stop this gentle man approach, we are dealing with a maniac for Christ's sake.

1 Like

Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by ZKOSOSO(m): 4:12pm On Mar 03, 2015
Mayday! Mayday!! One Lunie don escape from home o!!

OP na suspect!!
Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by kaycexx(m): 4:26pm On Mar 03, 2015
I don talk am say, make gen Buhari, be the Efcc chairman since e one fight corruption, based on ex general wey e be make e still help fight insurgency.

And for oga Jona make e become the minister so e go fit work for e department and help build the economy well make anoda person become the president.

FFK wey sabi talk anyhow make e be minister of information as na e talent to they talk or newscaster e go good.

Abeg make amaechi join nollywood leave politice.

Naija for good small
Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by tinkinjow: 4:29pm On Mar 03, 2015
Okay, are you done
Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by Nobody: 4:57pm On Mar 03, 2015
so many sahara reporters ...
Re: Breaking News!!!! Breaking News!!!! Breaking News!!! (wake Up Nigerians) by tit(f): 5:05pm On Mar 03, 2015
if i see jiga ehenn
i go dose am one dirty slap
idiot
pians

(1) (Reply)

2015 POLL: How Jega Ignored Me For A Meeting - Oritsejafor / Orubebe Is On Point / Plagiarism : "I Belong To Nobody " A Case Against President Buhari.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.