Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,346 members, 7,811,995 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 05:33 AM

Konji Don Cause Wahala Again? (video Inside) - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Konji Don Cause Wahala Again? (video Inside) (1536 Views)

Konji Don Hold Me O! / Here Is Why Your Sexual Urge (konji) Is So Strong And Uncontrollable (photos) / Does This Help Relationships Or Cause Wahala? (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Konji Don Cause Wahala Again? (video Inside) by mradjoy(m): 2:05am On Aug 09, 2015
Chai Konji! wetin you go cause ehn! SMHF Konji, u don try o, only u go make wife complain say my husband can not go more than one round, only you go make husband get wife for house n go still dey follow all those single pant chicks, only you go make some girls dey shout "I Love it BIG" because it fills up every where, Only you dis Konji again go make wife run comot for room, come sleep for sitting room saying you wan kill me "she na food ah ah?".

Ah ah konji ur own too much o, na you again Konji still cause one Lecturer for my Beloved Alma Mata, go land for kirikiri unexpectedly because konji don sweet am soteee e forget say one day, sinner man go die, e no go fit come back to dis world again. Oya make you dey konji all the iron for kirikiri na mtcheeew!

Konji I still hear say, na holl one man soteee, e go sleep with im daughter for lagos, chai abomination, na you again still holl one woman for zimbabwe abi na where sef? wey make say lailai she no go gree make anoda woman come reap where she no sow, so therefore she married her own son eekwe!

Konji, is it not the same you that made one crook woman and that crook guy connived and carry our oil money run go abroad? Yes na konji cause am, I know him very well, he's wicked! ok you no biliv me? oya see source na: http://newsrescue.com/diezanis-hustler-kola-aluko-super-yacht-naomi-campbell-billions-wealth-status/#axzz3iGjGrgJz

Konji, na you again still holl me one sunday morning wey I supposed dey church jeje, come bleep one girl sotee she fainted, my broda, na so dis stupid konji run leave me to sort out myself, chai konji almost send me go jail! Na ma girl friend she be dat time o, don't worry e dey consesual, grin grin but now I am born again.

Na dis same shameless konji holl dis people for dis video,
 
https://www.youtube.com/watch?v=6TMEpN-WXuY
(Konji Master) small time now dem go talk say na movie (Make Believe) she na true?
source:
https://www.youtube.com/watch?v=LxISo8dDKlc

Na so Konji dey do, e dey put some people for trouble no be smallu!

But konji you don try for me sha, you holl me soteee ma wife kon born twins! yes I am a married man now grin grin
Shooo, wetin time talk now, almost 2am, ah konji you don dey holl me again!

Konji Abeg leave me alone, I no wan born twins the second time, biko no put me for trouble! eeeeee. grin grin grin

#EnjoyUrSelf... Bye

(1) (Reply)

Ladies: Can You Use A Menstrual Pad Twice?? / See Two Guys Fighting Because Of A Woman / Meet A Gay Vatican Priest (photo)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.