Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,522 members, 7,812,632 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 04:30 PM

"Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan (43253 Views)

Tosin Saraki's Wedding: Obasanjo, Patience Jonathan, Otedola, Dino Melaye Attend / Photo Of Babangida With Obasanjo & Abdulsalami Abubakar / Obasanjo & Patience Jonathan Hug At The Burial Of Umahi's Mother (Photos) (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

"Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by simongonner: 9:54am On Apr 09, 2016
"Why I Danced Hold-Tight With Obasanjo" - Patience Jonathan
Hello, this is Jebose. Can I help you?Eh, Jebose, na who you dey yarn Amerikana for. You nor sabi my namba again. Oloshi. Hehehe. My mommy. The mommy of all mommies.

Gerraautt. Who be your mommy. Your mama dey for una Onicha Ugbo grave. I beg nor mommy me.

Mommyyyy… you mellow this morning o. Hope nothing dey pa?.How far mommy. This one wey you call me so for early mor mor
Sharraap. You nor happy I call you?. I hia say you rite buku say Waiting for my hosbans to die. Na which womans dey wait for im hosbans to peme?. Na wa for you and dat buku. You go sell so?
Haba madam. How you take don hia nah… I be wan ask make you waka come be Chief Launcher na! But you jus comot word for my mouth
Dat your smelly smelly maut. You dey aks me who tells me. You forget say I be fes lady. I dey hia eferythins about my friends

Eyyaaahh!!! So I be your friend. You come leave me go waka dey dance with baba Iyabo. Na wa o, madam. You fall my hand sha. Friends don’t let friends dance with retired Presidents na.

Jebose if I slap you?. Idiot. I say you be nonsense pikins. Scaliwag like you. Make me I dance with you?. Church rat of Onicha Ugbo. Hmmm. It is not your folt o. I swear. Na me carry my Etisalat begin call your yeye China made Nokia flipu fone. Alakoba

Madam the tin wey pain me be say you come dey hold baba iyabo tight sef for dance floor. I beg where Oga Jonathan dey wey you dey tap agbalagba current?
Oloriburuku omo ale. If i hole am nkor. Na only me waka come nah. Jebose, wetin konsan you if i dance hole tait with Daddi Iyabo. I say wetin konsan you. You nor be my hosbans. Or you be my boi frens?.Mscheeww.. which kain korent you say I tabu… baba nor get korent o.
Eh. Madam cool down nah. Make I talk my own. Body just dey pain me. How old man go dey gbadun you like dat and I dey hia dey dream and provoke.
Jelosi don kee Jebose. I go report you to Alhaja. Daleru. You wan scatter my hause. I beg wetin you get. Wai I go dance with you?. You wey be Common reporter. You nor get agbara reach baba OBJ. You nor be former presidence of Naija two timeses. One wey be soja boy and the other be civilian presidence wey we waka enter democrasi. You nor get money. You nor sabi plenty peoples. You nor get korneshion… Common buy recharge card for your yeye Glo line, you nor get money for recharge. Your fine gel pikin still dey drink SMA made in Alaba. Make you hia nau. Baba Iyabo na im get Naija. Na only him fit tell EFCC make dem free me and my hosbans Jonathan. Baba Iyabo be power and privilege. You na jus gbeborun. So anyhow baba want, I go dash am. If your bodi dey pain you, go aks your papa PMB make im give you APC melesine. See as una dabaru Nigeria since your papa come with jibiti shange. I beg Jebose, levu don shange. Free me. Let me be. Daddi Iyabo be my latest bes frens. If you like you can go and die. I nor send you.

Hia… mommy so na so you go take do me. Remember sha, no condition is permanent o. I fit be President tomorrow
Hehehehehehe…makeuna see Jebose O… Egba mi O. You, be President tomorrow?. Make you sidon dia dey wait for tomorrow nah. Your own kondishion na pamanence becos since I sabi you, you never shange: You still dey live for that your foolish face me, I face you room and parlor for Mushin, dey que for 4a.m in the morin to go shit and baff becos na only one toilet and baffroom dey for the face me I face you hause. And you don live for the same hause since I sabi you. So your own kondishion dey pamanence…

Madam, God dey O. All this dance you are sharing, Dia is Allah O
Which Allah? Omashe o. So Alhaja don konvashion you to Muslim?. Eyyaahh. Your own don finish. No wonder I see dat foto wey you be like Almajiri for Kano. No wonder you dey follow PMB. You see unaself?. Pesin nor see pentro. Nigerians dey sofa. Your broda, Kachikwu wey dem put in charge of our oyel say im nor be majishan… Nigerians nor get eletriciti to charge fone. Pentro nor dey to enjoi life ni ile wa. God don ponish una wey comot my hosban. Una don see shange nah. Very soon una go begin see credit. I beg I wan call Daddi Iyabo make I see where the nest parry dey so I go dance with am. Jebose, comot for my fone, I beg. Gerraaauutt. CLICK.

Azuka Jebose



http://saharareporters.com/2016/04/08/why-i-danced-hold-tight-obasanjo-patience-jonathan

2 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by mackhunter77: 10:55am On Apr 09, 2016
*yawn*

13 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by psyqs(m): 11:46am On Apr 09, 2016
angry warris dis?

22 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by Nobody: 11:58am On Apr 09, 2016
Although i cant make sense of all written above
*
All i know is Baba and fat women.

35 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by omusiliyu(m): 12:12pm On Apr 09, 2016
When OP is high on Oshogbo weed

39 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by PRINCENWAEZE(m): 12:13pm On Apr 09, 2016
grin. The reason is because na only him waka come grin


And jonathan belike mama peace

11 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by nom44311: 12:13pm On Apr 09, 2016
Crap!

2 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by Nobody: 12:13pm On Apr 09, 2016
Honestly speaking.......I couldn't comprehend......pidqin from A to Z.......a whole uniport graduate........pidqin lanquaqe n' literature must be her course in uniport......uniport don suffer grin grin grin




BTW.....Have yhu collected ur 4.5qb from mtn??

4 Likes 4 Shares

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by badmrkt(m): 12:13pm On Apr 09, 2016
''lubishhh"
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by Adefave1(m): 12:13pm On Apr 09, 2016
someone should pls explain dis

angry
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by gqboyy(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
sombarry explain ds pls

4 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by 9jvirgin(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
Nonsense! Senseless!

4 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by DaVinChiSam(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
Please
How do I unread this nonsensse?

24 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by eke96: 12:14pm On Apr 09, 2016
Dry!!!

3 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by shamecurls(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
#Simple

She was hornyy

1 Like

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by buskie13(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
.foolish mods on duty……

7 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by Soreza(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
What is this nonsense

5 Likes 1 Share

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by segebase(m): 12:14pm On Apr 09, 2016
bullshit
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by Wendyslim(f): 12:14pm On Apr 09, 2016
Which one come be my own now? undecided
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by OCTAVO: 12:15pm On Apr 09, 2016
Oh
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by Nobody: 12:15pm On Apr 09, 2016
Lol
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by nzgal: 12:15pm On Apr 09, 2016
This conversation sef
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by mbaboy(m): 12:16pm On Apr 09, 2016
Rubbish,who uploaded this trash

8 Likes 1 Share

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by annexes: 12:16pm On Apr 09, 2016
very dry...

4 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by odinese(m): 12:16pm On Apr 09, 2016
G
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by wristbangle: 12:16pm On Apr 09, 2016
undecidedundecided

Thrash!

3 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by eleko1: 12:16pm On Apr 09, 2016
.
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by dewaskillz: 12:16pm On Apr 09, 2016
OBJ always cuddling to dem mamas.
Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by toluxa1(m): 12:17pm On Apr 09, 2016
I don't understand what this senseless and unproductive topic is doing in the front page. It makes no meaning. Who would spend valuable time reading that thrash up there. Please take it off NOW.

16 Likes

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by olutosfem(f): 12:17pm On Apr 09, 2016

1 Like

Re: "Why I Danced Hold-tight With Obasanjo" - Patience Jonathan by EagleScribes: 12:17pm On Apr 09, 2016
Hmmmm. This life ehn

(1) (2) (Reply)

Why FG Exempted Dangote, BUA From Border Closure Policy / Wike Vs Awara: "We Will Conduct Supplimentary Election In Rivers State" - INEC / Open Advice To South West Governors On Housing

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 48
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.