Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,260 members, 7,818,886 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 07:20 AM

Hilarious Pigin Proverbs - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Hilarious Pigin Proverbs (1397 Views)

See Gobe: Chinese Man Speaks Pigin In A An Argument With A Nigerian Woman / Funny Sex Proverbs / If Pigin Gramer Was A Course In University (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Hilarious Pigin Proverbs by jeflexy(m): 12:22am On Apr 27, 2016
Hilarious Pidgin Proverbs:
1. Na for old age ashawo dey know the
value of pikin.
2. Na Woman wey never see problem dey
still hold breast before she run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear
pant
sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na
later e go
hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black
goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go
lay
boiled egg.
7. Small pikin wey dem carry for back no
know
say the journey far.
8. Person wey don faint before no be
stranger to death.
9. Person wey chop belle full, no know
wetin hungry man dey see.
10. No be as woman dey close eye enjoy
sex she dey enjoy labour pains.
11. Yansh no get teeth but e dey cut
shit.
12. IF GIRL TAKE HUSBAND DO
BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND
DO HUSBAND.
13. Cockroach wey jam fowl, jam bad
luck.
14. Na cricket tell him children say, No
matter
how ground strong, Them no go sleep
outside.
15. Pikin wey say him mama no fine they
use
style call him papa blind man.
16. No be eye wey dem take chop eba
dem dey
take dey share meat.
17. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
18. STUDENT WEY READ NA HIM
SERIOUS, BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW
BOOK.
19. Before you see monkey, monkey don
see you.
20. Thief wey jump fence enter house
where owner dey wait for am, no go jump
again.
21. Na wetin dey sweet for goat mouth,
Na im dey kill am.
22. If e be like say everybody dey craze"
na you dey craze.
23. Meat wey you dey forbid, no use your
teeth cut am.
24. My thing & our thing no be the same
oh.
25. Na happiness dey make prick stand.
26. Na as goat stand for market dem
dey price am.
27. Craze no hard to form, na the
trekking be
wahala.
28. Its a small world!! No mean say you
fit trek from Naija go London.
29. Akara and moin moin get the same
parent, na wetin dem pass through make
dem different.
YOU CAN ADD YOURS.....

4 Likes 3 Shares

Re: Hilarious Pigin Proverbs by halfricanadian(f): 2:42am On Apr 27, 2016
Opolo eye e no fit open eye.

Shit no fit get craze strong pass pupu.

To wee wee e better pass make person urinate.

a juju in time na a show for african magic
Re: Hilarious Pigin Proverbs by Nobody: 3:43am On Apr 27, 2016
Lol, nice one.
Re: Hilarious Pigin Proverbs by frozenSun(m): 4:28am On Apr 27, 2016
nice one

- DEM NO DEY TELL BLIND MAN WHEN WAR DON START

- PIKIN WEY SAY HE MAMA NOR GO SLEEP, HOW HIMSELF GO SLEEP?

- PIG ASK HIM MAMA WHY HER MOUTH TOO LONG, MAMA SAY NA WHEN HE GROW SHE GO ANSA AM

- NA ONE ONE GOAT DEY BORN, HOUSE DEY FULL

- ASHAWO WEY MARRY, NA HOLIDAY SHE DEY DO B DAT

- PUT ROPE FOR GOAT AND PUT GOAT FOR ROPE NA D SAME THING

- NA RESPECT WEY I RESPECT TO KEEP QUIET WEN U DEY TALK NO BE SAY UR MOUTH BIG PASS MY OWN

- PERSON WEY MARRY ASHAWO NO SUPPOSE DEY EXPECT HOLY DAUGHTER

- WHO NO GO, NO KNOW

- WE DON DRINK WATER REACH WHERE BE SAY WE DEY CHEW AM BEFORE WE SWALLOW

- NOR BE EVERYBODY WEY GREET U FOR MORNING WEY LIKE THAT YOUR MORNING, SOME PRAY MAKE U DIE FOR NIGHT.

- NO MATTER D SIZE OF ELEPHANT, E NOR FIT CAUSE EARTH QUAKE

- NA FLY WEY NOR DEY HEAR WORD DEY FOLLO DEAD BODY ENTA GRAVE

- OJORO NO DEY FOR PHOTO, AS YOU POSE NA SO YOU GO SHOW

- WEEKEND WEY GO SWEET NA FROM FRIDAY WE DEY TAKE KNOW AM

-
Re: Hilarious Pigin Proverbs by pussyeater(m): 4:54am On Apr 27, 2016
Wahala be like bicycle, E no hard to start.
Re: Hilarious Pigin Proverbs by mrtantalizers(m): 4:57am On Apr 27, 2016
Nice piece op.
Re: Hilarious Pigin Proverbs by IG264(m): 5:56am On Apr 27, 2016
Nor be how long them take lie down for woman,she go take born boy.
Re: Hilarious Pigin Proverbs by gaddafe(m): 9:19pm On Jun 22, 2023
Instead of bad thing to happen, make rain fall
Re: Hilarious Pigin Proverbs by Nolevel666: 9:36pm On Jun 22, 2023
This should be on the front page!

(1) (Reply)

Ladies Why Do You Waste So Much Time Dressing Up? / Must Read: 7 Ways To Get Your Ex To Fall In Love With You Again / Ladies,not Every Man You See In Church Is A Husband Material(see Why)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 50
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.