Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,490 members, 7,819,778 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 11:05 PM

Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin (496 Views)

Atiku: What I Will Do Differently To Put Nigeria’s Economy On Right Path / Buhari Govt To Leave N77 Trn Debt For Incoming Administration - DMO / Chinese Loan: Selfish Lawmakers Have Put Nigeria In Jeopardy – Amaechi (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin by Splashme: 12:43pm On Sep 05, 2018
Nigeria President Muhammadu Buhari collect loan of $328 million from China to take improve di West African kontri telecommunication and IT infrastructure, to add join di $73 billion debt wey di kontri dey owe before.

Dis dey come as President Buhari dey China for six-day visit wia im go also follow join di economic meeting as di current oga of Economic Community of West African States (ECOWAS) to tok money mata wey go benefit im kontri and di region.

For statement wey di Nigerian presidency release last week, dem describe say di loan na between Galaxy Backbone of Nigeria and Huawei Technologies of China to take "develop information and communications technology" according to di plan wey Buhari administration don put down.

Abuja-based Debt Management Office (DMO) record show say debt na $73.2 billion as at June 2018. And with dis new China loan, e go increase reach $73.5 billion wey be like N23 trillion.

For March 2018, director general of DMO Patience Oniha tell tori pipo say di goment dey work on plan to reduce domestic debt and say "... borrow borrow wey we dey do suppose begin reduce in di medium term."

But Nigerian pipo no suppose worri say di kontri debt wey dey increase fit make di kontri go back to recession, according to Finance Minister Kemi Adeosun. According to her, Nigerians wey say borrow borrow don enta anoda level.

"Di borrow borrow na to take fund capital expenditure to grow di economy... wetin di government dey borrow for dey important", tok Adeosun earlier dis year. "Nigerians suppose dey concerned if to say di goment dey borrow money to take pay salary, take travels, do training and oda tins wey fit waste money."

According to di DMO, for March 2016, Nigeria debt na N13.8 trillion


https://www.bbc.com/pidgin/tori-45393956?SThisFB

Re: Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin by Nobody: 12:48pm On Sep 05, 2018
angry

The lifeless one na the chairman for borrow borrow. Him go share to his brothers and fellow criminals, 50 eggs wey the nation's fowl lay ,come go meet another farmer make him borrow am 50 eggs make him see whether dem go hatch to chicks.

Na real lifeless olodo
Re: Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin by Redxy(m): 12:49pm On Sep 05, 2018
And we havent seen the effect of the money in the country!
Things are getting harder daily
No wonder NIGERIA seems to be among the most poorest country
and we claim we've a good president! Nigerians, its up to us to think aright nxt yr in the upcoming elections and do the needful.
Re: Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin by Nbote(m): 12:50pm On Sep 05, 2018
Hehehe.... I lyk d way dem talk... Borrow borrow make me rich
Re: Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin by wordcat(m): 1:03pm On Sep 05, 2018
Wetin concern me?

By now, every Nigerian suppose don get one P,,
Either Passport or PVC

1 Like

Re: Buhari Borrow Borrow Don Put Nigeria Debt For N23 Trillion - BBC Pidgin by Splashme: 11:32pm On Sep 13, 2018
wordcat:
Wetin concern me?

By now, every Nigerian suppose don get one P,,
Either Passport or PVC

Abi oo

(1) (Reply)

Kemi Adeosun's Note As She Resigns [A MUST READ] / War! NDDC MD Nsima Ekere Fights Udoedeghe Over APC Guber Ticket / Analysis On Osun Gubernatorial Election 2018.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.