Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,160,424 members, 7,843,303 topics. Date: Tuesday, 28 May 2024 at 10:13 PM

BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before (891 Views)

Kashim Shettima And Muhammadu Buhari At Governor Zulum's Son's Wedding (Photos) / Jonathan Visits Buhari — 3 Days After Railway Complex Was Named After Him / President Buhari's 3 Beautiful Daughters Rock Matching Outfits (photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by IronHammer: 8:06pm On Dec 06, 2018
BBC News Pidgin
menu
'Jubril Aminu and Muhammadu Buhari': Three presidents wey don use 'clone' before
03 December 2018

Muhammadu Buhari
"Jubril Aminu no be my clone," according to President Muhammadu Buhari "because l dey alive."

Dis na im reply to long time claim say dem be two, no be one Buhari, real and fake, alive and dead.

'Make una no give Atiku Abubakar American Visa' - Protesters to US Embassy
'Jubril Aminu' tori say na fake Buhari dey rule Nigeria no get evidence
Di rumour wey first begin dey spread for social media tey tey don full evri wia sotay some pipo begin dey wonder like wonderers weda small fire dey inside dis smoke.

One reason why some pipo dey ready to believe dis kain rumour be say, tori of how pipo dey replace odas dey ground even if na for feem e dey happun pass.

But for real life some presidents wey get harsh regime don get bodi double and di reason no be sickness or marriage but di serious business of security.

Late Iraq president Saddam Hussein and im bodi double
Di late Iraqi dictator Saddam Hussein employ plenti bodi doubles wen im dey rule di Middle East kontri wit iron hand according to U.S. Military officials.

According to one expert, di way Iraqis dey know weda na di real or fake Saddam na if im bodyguard dey serious or dey play.

Tori of di way Hussein dey use body double steady, popular sotey wen dem capture am for 2003, Defense Secretary Donald H. Rumsfeld open up for press conference to Americans wey no sure weda na di real pesin dem capture.

Joseph Stalin for Russia
Joseph Stalin wey rule di former Union of Soviet Soviet Republics from 1922 to 1953 na one ogbologobo for propaganda a.k.a fake news.

So no be surprise say im get bodi doubles. One possible double na Felix Dadev and wit di blessing of current Russia President Vladimir Putin, im open up unto im secret for 2008 wen im don reach di age of 88.

Dadev tok say im biggest assignment na wen im travel go di Yalta conference for Crimea for 1945.

Na for di Yalta conference di main winners of second world war - America, Britain and Russia - decide how dem go arrange Germany and di rest of Europe afta di war. Dadev na di pesin pipo see pass, but di real Stalin remain coded.

North Korea Kim Jong il
Former North Korea leader Kim Jong il na pesin wey dey sick wella before im die for 2011.

Mr. Kim bin get stroke for August 2008 but by 2009 im don make 122 visits complete wit media escorts to factories, farms, military bases and oda to prove say im dey alive, well and in charge.

Dis na sign by pipo say im dey use bodi double.


https://www.bbc.com/pidgin/amp/tori-46429263?SThisFB=&__twitter_impression=true

1 Like

Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by LibertyRep: 8:40pm On Dec 06, 2018
Rumor full ground too say Hillary Clinton too get body double.

Me I belief say Buhari himself dey enjoy as the rumor dey spread so tay e don reach obodo oyinbo land. If not why hin no just wan follow him country people talk.
Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by Nobody: 8:47pm On Dec 06, 2018
Lol grin grin
Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by IbrahimDamola: 9:00pm On Dec 06, 2018
Jibril el-sudani na clone abeg.

3 Likes 1 Share

Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by IronHammer: 12:56pm On Dec 07, 2018
There's need to set aside party affiliation and regional politics to engage the situation at hand with critical thinking and objective questions.

We can't wish away a reality on altar of sectional politicism. In fact, it would be foolish of Nigerians not to unravel the real identity of their president no matter its cost.

Body double is real
Circumstances prompting the accusation are real
Evidences provided so far by the accuser are glaring

To unravel the identity of the man in Aso Rock is a task all must undertake.

Lalasticala

1 Like

Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by WATCHOVER(m): 1:08pm On Dec 07, 2018
IronHammer:
There's need to set aside party affiliation and regional politics to engage the situation at hand with critical thinking and objective questions.

We can't wish away a reality on altar of sectional politicism. In fact, it would be foolish of Nigerians not to unravel the real identity of their president no matter its cost.

Body double is real
Circumstances prompting the accusation are real
Evidences provided so far by the accuser are glaring

To unravel the identity of the man in Aso Rock is a task all must undertake.

Lalasticala
May God bless you

1 Like

Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by mcbreeze: 1:30pm On Dec 07, 2018
IronHammer:
There's need to set aside party affiliation and regional politics to engage the situation at hand with critical thinking and objective questions.

We can't wish away a reality on altar of sectional politicism. In fact, it would be foolish of Nigerians not to unravel the real identity of their president no matter its cost.

Body double is real
Circumstances prompting the accusation are real
Evidences provided so far by the accuser are glaring

To unravel the identity of the man in Aso Rock is a task all must undertake.

Lalasticala


If people from other side won't call us haters

2 Likes

Re: BBCnews Pidgin: Jubril Aminu And Muhammadu Buhari, 3 Wey Don Use Double Before by IronHammer: 1:44pm On Dec 07, 2018
mcbreeze:



If people from other side won't call us haters

Because we're not one people and will never be

There's no single trust among nations forced together by Lugard to exist as one, this alone will hold this country down till eternity.
There can never be a reasonable development insofar we remain one
Things can only get worst
Those hoping for better Nigeria are daydreaming

Some are opposed to a body double occupation of Aso Rock simply because it was alleged by an Igbo man even when are much aware of its existence

1 Like

(1) (Reply)

Why Army invaded Daily Trust offices / Reports: Pdp To Withdraw From February 23rd Presidential Election / 2019 Nigerian Elections : Predictions

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 25
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.