Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,600 members, 7,820,147 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 10:26 AM

How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal (4144 Views)

Please Help! She Don Make Me Fall In Love / She Don Put Me For Wahala / Not Yet Toasted Her But She Don Over Love Up. Please Advice (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)

How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by calid16: 9:11am On Jul 19, 2011
First and foremost, this girl wen i dey yarn about na my main bebe. We don dey together tay tay , since i de hustle to land jab . Things com better for me a few months back as i land jab wen de pay over a hundred k a month recently.
The bebe still de school for our home state but dey her final year sha. So recently she come spend weekend with me, we comot go different places see different things b4 she finally go back. Na last weekend na him she com phone talk say she don carry o, and she talk say for her family them train dem not to de remove belle o. I don gree say i go marry am but no be now i wan do am. The thing be say why she no carry belle all those days till now when man wan begin stand on him feet ? The thing de pain and vex me together i swear.
Abeg i no want all this akata with their pawpaw opinion that's why i use pidgin.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 9:19am On Jul 19, 2011
My Guy! You be correct person! At least you gree say na u do am, and secondly you like the girl and you go like marry am! Kudos! But i believe say that girl use ya head sha! Na as you get better jab she come carry, if na me e go pain me too.I no go lie, she no try at all! But e don happen be say e don happen! the only thing wey fit happen now be say you go marry am! No matter say na very bad time! But as correct guy wey you be i believe say you go still cool down sha! I no know wetin other people go yarn for here sha, but if na me, i go marry am take am like that, abi wetin you wan do again? smiley
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 9:30am On Jul 19, 2011
omon boy take am eazyyyy! Shooooh! abi  nor be u choko d choko? Wetin come dey make u provoke na? I understand say d chikala use level take arrange u put for her corner foreva but if na your sista, i swear say u go advice her to do d same tin! Afta all d prayers wey she don pray make u see light for ur life,Who nor like beta tin? Abi u get plans to disco d babe b4? Guy wetin don be don be oo! I troway salute for u sha because very soon u go become pap pikin!, accordin to p.skua- E NOR EASY eeeeeh
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by calid16: 10:58am On Jul 19, 2011
@sexkillz and boyloaf i thank una for una talk. But mak una understand say no b say i get plan to jilt my bebe. The thing be say i for lik enjoy dis salary small b4 i start to buy pampers and baby formula. I never even give mumsie or brothers anything sef before this thing happen.
I suffer small before i land this work, mak i wash the suffering comot small befor i enter another one na .
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by nawfia(m): 11:22am On Jul 19, 2011
@op, bros i dey feel u jor, man wey suffer suppose enjoy himsef small b4 him begin suffer say he dey save moni for pickin and family, chai, but i agree with boyloaf, pickin don dey involved and i knw say the chic fire enuff prayer for ur head b4 u land this jab, kuku plan how to dey spend ya salary cos e don b.u no fit run from this man, happy married life man.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by sistajay(f): 12:52pm On Jul 19, 2011
@ Poster. . . . . E don shele. . . . . . . .you gotta standby your woman, ready or not!!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by kpolli(m): 1:48pm On Jul 19, 2011
bros i no understand u. . . . u dey provoke say she carry belle when times r good. . . . do u want it when job no dey

but guy, u get job now, y u no buy protection. . . . well lets not cry over spilled milk, u don't necessarily need to marry her now but ehn. . . . u need to do something formal atleast
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Goldieluks: 1:56pm On Jul 19, 2011
Erm bros, grin
wetin consign akata english consign the tori wen dey fish head?

i read your story jeje,and i no understand wetin you mean,wen you say you no want problem,
but you agree to marry your chickito naw,abi na me no dey see well?
she don carry and she say she no go remove am,
you accept the belle and you agree say you go marry her,
so i no see any issue for there,especially since una love una sef.
marry her.Life na jeje,atleast you don get jab,make u take am step by step.E GO BETTER,GOOD LUCK!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 2:09pm On Jul 19, 2011
As u talk say dis na your main babe e be like say you dey play away match, no forget protection for that side if not na double wahala for deadi body. Ehn you come talk say e dey pinch you u for body as she get belle when dis kin tin happen you go look the bright side some people dey wey need pikin dem no get, some get money no dey even some sef the money wey dey no reach 100 plus in a month and wen u see the pikin belle go sweet you.  d babe sef dey feel like sharp babe i no blame am before you talk say na working class be your level i throway salute for am she gauge wella.

No vex ehn. chill even sef if you marry am u know say na person wey una don chop kwa kwa togeder so nothing spoil. I know say i don talk am b4 but if you dey play away match try stop am o because hmm my broda disease plenty for town. Condition mind now to begin know say you get family to service.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by 195(f): 2:45pm On Jul 19, 2011
I love this guy

for once this thread is bout Nigerian stuff and not bout these Akata foreigner's

Nice one brother- nothing do you
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by kasiem(m): 3:24pm On Jul 19, 2011
Shiaman, i dey feel ya style. Make i knack u leg 4 teeth, to get child nor dey easy as we dey see am so. D tin be say u go just arrange some send to ur mumsie, to show am say u don hammer job. After, u go take style com show am the babe, as ur wife to be, im go be as if u wan settle down, to run from babes. Soon, the babe go grad come get job, then im go be double income. Guy, u no get any reason to complain. Meeennn, go collect father's form for ur church. I throway my salute.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by omega25red(m): 4:23pm On Jul 19, 2011
poster

na your fault. If you know say you wan enjoy the money wey you dey make small you for wear rain coat na. so na your fault. Make you thank God say he give you pikin when you fit afford am
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by slimyem: 4:45pm On Jul 19, 2011
o boy,no vex ehn.u sef don talk say the babe na correct babe.she just do fast make she no go enter one-chance.
U go just try balance ur expenditure wella since u don enter already.
Happy married life in advance!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Talkyaown: 5:30pm On Jul 19, 2011
Bros, things never spoil, just begin save for the baby, hope say she dey her first trimester sha. When the baby don come safely finish, una go try find job for the madam. Papa Chike!!!!!!!!!!!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 7:00pm On Jul 19, 2011
Lol @ thread. Ol'boy I no dey like all this kain emergency marriage sake of say one akata carry belle. E no dey work at all because guyman no prepare for am.

If say I be you, I go tell the girl say no show, lai lai. Make she go comot am or make she do her worst. The babe sef na proper thief. She wan use belle rope you like maloo whey dem wan slaughter. Which kain koni-koni love be dat? My hand no dey oh. I don talk my own finish. Tell the babe to comot the thing sharp sharp, say you never ready. If she no gree, threaten am join sef. Na she be d first akata for Nigeria to carry belle? Make she do wetin her mates dey doo joor. . .yeye dey smell!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by kasiem(m): 8:08pm On Jul 19, 2011
This thread make sense die. I dey enjoy am
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by naso2(m): 8:33pm On Jul 19, 2011
correct guy. i feel u die.

But as others don talk , e don happen be say e don happen, as oyibo dey talk na to look for way forward.

Our people say "when man cut fufu from plate, the plan na to put am inside soup and then inside mouth, but if as him dey cut the fufu, the thing suddenly fall inside the soup, although the man go dey disappointed, but the only option na to collect the fufu wey fall inside soup and put am for mouth"

No let the thing too spoil your mind. me i just dey try arrange wife after over 10 years of work and i go tell you say, if to say one babe wey i really like play me dis kain wayo those days, i for dey very grateful now because pikin for don dey reach 10yrs.

Nothing spoil just kool your mind, the girl just apply caution before dis mini skirt girls come show u another road.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 8:48pm On Jul 19, 2011
calid16:


The bebe still de school for our home state but dey her final year sha. . Na last weekend na him she com phone talk say she don carry o, and she talk say for her family them train dem not to de remove belle o.
Tell her toba said shes insane. Her family never taught her not to go into premarital sex right? Her family never taught her not to do unprotected sex? She must be sick for bringing up such nasty excuses.


calid16:

The thing be say why she no carry belle all those days till now when man wan begin stand on him feet ? The thing de pain and vex me together i swear.
Abeg i no want all this akata with their pawpaw opinion that's why i use pidgin.


Back to u mr Footballer. U should come tells us to rejoice with u that u are a good goal scorer and an accurate sharp shooter. WTF? U wants to be sorry for u? Tufiapa. U should me sorry for ur self.

A good man must play his game well. a good man with future ambition would try not to engage in things that cab jeopardize his future. Now u aren't ready for marriage and responsibility, yet u ve gotten one all ready as a result of ur insensibility.

U should face the cross and carry it alone. A guy must be at least established enough first to himself solely, before thinking of feeding two or three.

See my advice and prayer is that by the grace of God, u must give birth to that child and when the time for naming comes, u must invite me cos i want to be there. Guy if u try to abort that pregnancy, u will smell pepper.

Now start preparing for marriage. Where is she from? Go to her family to collect the list of what to buy for the traditional marriage. Once u ve sorted that out, i will give u my phone number cos i will attend ur traditional wedding and church/mosque wedding.


For those that act like the OP, u better learn ur lesson now or never

I have said enogh. Im going to my house to eat dinner
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by calid16: 8:51pm On Jul 19, 2011
My pipo, make una understand say i no be rough guy, she sef no be rough babe. Na just say e go reach time for relationship wen una go de exclusively together. That na the reason why we stop use raincoat and sox, as in na us, us now.

Plenty of una think say i de selfish but honestly that no be the case. As new football season de start now, me wen like premier league die for like to de hang out with the bobos on saturday like this watch football till night before man go enter house. I for lik experience that kind life for like one or two years before i become i her prisoner grin

But now if we do this thing now, she go say she get exam or test and na be go de with pikin all day. What about money nko ? The mama fit com stay with us after she born or send person come from villa, that money wen boys for use trip guys no go de again. Na to just de plan plan, haba, e no too early ?
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 8:53pm On Jul 19, 2011
calid16:

My pipo, make una understand say i no be rough guy, she sef no be rough babe. Na just say e go reach time for relationship wen una go de exclusively together. That na the reason why we stop use raincoat and sox, as in na us, us now.

Plenty of una think say i de selfish but honestly that no be the case. As new football season de start now, me wen like premier league die for like to de hang out with the bobos on saturday like this watch football till night before man go enter house. I for lik experience that kind life for like one or two years before i become i her prisoner grin

But now if we do this thing now, she go say she get exam or test and na be go de with pikin all day. What about money nko ? The mama fit com stay with us after she born or send person come from villa, that money wen boys for use trip guys no go de again. Na to just de plan plan, haba, e no too early ?


If u talk again i go shoot u. Obey my advise and go prepare for wedding. call me if u need my help

toba:

Tell her toba said shes insane. Her family never taught her not to go into premarital sex right? Her family never taught her not to do unprotected sex? She must be sick for bringing up such nasty excuses.


Back to u mr Footballer. U should come tells us to rejoice with u that u are a good goal scorer and an accurate sharp shooter. WTF? U wants to be sorry for u? Tufiapa. U should me sorry for your self.

A good man must play his game well. a good man with future ambition would try not to engage in things that cab jeopardize his future. Now u aren't ready for marriage and responsibility, yet u ve gotten one all ready as a result of your insensibility.

U should face the cross and carry it alone. A guy must be at least established enough first to himself solely, before thinking of feeding two or three.

See my advice and prayer is that by the grace of God, u must give birth to that child and when the time for naming comes, u must invite me cos i want to be there. Guy if u try to abort that pregnancy, u will smell pepper.

Now start preparing for marriage. Where is she from? Go to her family to collect the list of what to buy for the traditional marriage. Once u ve sorted that out, i will give u my phone number cos i will attend your traditional wedding and church/mosque wedding.


For those that act like the OP, u better learn your lesson now or never

I have said enogh. Im going to my house to eat dinner



Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Phate07(m): 9:11pm On Jul 19, 2011
Guy, marry her. No biggie, you go survive. Make you try remove all these yeye negative thots. Marriage na one beta ogbonge stuff. Na real mata. Marry her, for real! She carry YOUR PICKIN for her belle!!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 9:25pm On Jul 19, 2011
Guy no mind everybody jare,marry the babe,as she dey with you when u no get money,na that kind babe i dey find,the one wey i know say go dey with me thru thick and thin(but i no expect thiick and thin period grin),omo cuz marriage for Nigerian now don turn another thing,to see good girl scarce especially prayerful one,no mind anybody pple dey make mistake,e fit be say this mistake now blessing in disguise just advise your babe to finish her school and start work cuz combine salary is ideal is this economical times.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 9:32pm On Jul 19, 2011
Hey! Toba AKA. Holier than thou! AKA Jesus Christ! AKA the man without Sin! Two things:

1. He begged to be addressed in Pidgin English! undecided

2, The poster is not happy about what has happened! He was only hoping it would have happened later!  Now he came online to share his predicament and get some consolation and some tips on how to forge ahead into a "forced fatherhood", and you are here giving a sermon and spilling BOLLOCKS! AKA na me go school pass! W.T.F!!! undecided Agreed he was wrong, but is that how you treat some one that sincerely cry to you for help?
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 10:13pm On Jul 19, 2011
@sexkillz, dnt mind toba or tobacco wateva! He is tryin to spoil d fun we r havin here wit his dum-a z z opinion, he only succeded in revealin how fake he is. Who asked u to use english language here? Na u speak am pass? I d i o t!
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Roland17(m): 11:25pm On Jul 19, 2011
This thread don trip me die, English don tire me speak, i salute all men and bebe's wen dey house oooo, calid16 i gbadun the fact say u still love your omio-mio despite wetin she do, make u no waste time, marry your osete, she sef follow u suffer na, make u no high again 4 vex, Oluwa wen burn the owu stove for ur life, go arrangie more for u and ur pikin wen dey come.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by lexicon(m): 12:25am On Jul 20, 2011
I like dis ogbonge tredi no be small. e be like say make i no commot hia again. dis na for u de original posta. . .now wey u don shine de congo sotee de congo get tumbi . . . u no get choose dan to mari d geshi. . . abi she never try reach ? notin dey for outside oooo. . . !
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by HighChief4(m): 2:45am On Jul 20, 2011
This thread na the real thing. My broda no be bad thing happen at all at all, as e be say you just dey start work, she fit born the pikin then when you don arrange wella una go come do the marriage. Abeg i no wan make you and that gal get any wahala at all, for am to stay with you when you dey waka everywhere dey find work na better person she be. No be every gal go fit do that one ooh. Abeg make you think am well
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by andy1(m): 3:03am On Jul 20, 2011
@op. Jezz go ahed and marry d babe. Since u dy sure say na u get d pikin, bt as nwa afo. I go advice u 2 shine ur eyes o. Cos girlz r nt 2 be trustd o. wink
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by Nobody: 3:07am On Jul 20, 2011
calid16:

First and foremost, this girl wen i dey yarn about na my main bebe. We don dey together tay tay , since i de hustle to land jab . Things com better for me a few months back as i land jab wen de pay over a hundred k a month recently.
The bebe still de school for our home state but dey her final year sha. So recently she come spend weekend with me, we comot go different places see different things b4 she finally go back. Na last weekend na him she com phone talk say she don carry o, and she talk say for her family them train dem not to de remove belle o. I don gree say i go marry am but no be now i wan do am. The thing be say why she no carry belle all those days till now when man wan begin stand on him feet ? The thing de pain and vex me together i swear.
Abeg i no want all this akata with their pawpaw opinion that's why i use pidgin.

HMMMMMMMMMMMMMMMMM. . . .
unfortunately for you this is one Jamo/Akata who can READ pidgin PERFECTLY!
Pawpaw opinion. mschew. [size=18pt]Rude sef.[/size]

anyway,

you made your bed.
lie in it.  tongue
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by JLekwa(f): 3:10am On Jul 20, 2011
cry iam to be trusted
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by calid16: 4:06am On Jul 20, 2011
I thank all una wey join head help me see reason for this thing. I gree say na fast one she play but that na because say she like sha not any other reason. This na my first time to sleep in 4 days, may be the 5 days break wen NLc give help make rest. I thank una sha.


HMMMMMMMMMMMMMMMMM. . . .
unfortunately for you this is one Jamo/Akata who can READ pidgin PERFECTLY!
Pawpaw opinion. mschew. Rude sef.

anyway,
you made your bed.
lie in it. 
aunty nor vex na, u kno say your people fit come here start dey yarn about human right, woman right , baby right and alimony right. grin i nor get the strength now. But shey you know say your husband dey find you ? Mr mercedes 200 minus 10, abi na baby benz be him name sef.
Re: How I For Take Do Now ? She Don Carry And She Swear Say No Removal by IykeD(m): 6:39am On Jul 20, 2011
OP, i dey feel u n your thread die, u be real guy. I sabi how u dey feel now and u for like dey on your own enjoy life small b4 u enter colony and if i be u i for feel same way but as em don happen and u sure say na u get am, take am as e be, after una don marry andf  madam don born the baby, just relax for a while, take care of am wella and make una still enjoy life small as if una still be bf n gf b4 una begin hammer for more babies, all the best mate, u be real guy!

(1) (2) (3) (4) (Reply)

Some Girls Are Terrible!!! / Is Love All About Sex?do Women Really Love It / Warri Big Boy Chief Ayiri Emami Bedazzles Wife With A Brand New Rolls Royce

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 74
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.